Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,239 members, 7,818,814 topics. Date: Monday, 06 May 2024 at 05:30 AM

The Wicked House Wife (A Very Very Touching Story In Pidgin English) - Nairaland / General - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / The Wicked House Wife (A Very Very Touching Story In Pidgin English) (4537 Views)

"I Need A Wife": A Keke Man's Advert In Asaba, Delta State (Photo) / Shocking News: Wicked House Maid Uses URINE To Prepare Meal For Her Boss' Family / Pidgin English "chyking" Lines You've Used Or Heard (strictly Pidgin) (2) (3) (4)

(1) (Reply)

The Wicked House Wife (A Very Very Touching Story In Pidgin English) by Iceking1(m): 11:04am On Oct 18, 2014
Once upon a time.
Time time.
Mr Oghenedoro marry two wives: Ejiro
and Ovigwe.
Ejiro born 3 girls why Ovigwe born one
boy and one girl.
The boy pikin nai be the papa favorite
son. Na so e love the boy with all e life
becos say na boy.
When the boy so complete 5 years, nai
the papa say e wan mark the pikin
birthday for am.
Na so e cum give the pikin mama, Ovigwe
money make she go buy all the things
wey dem really need for the occasion.
He himself cum reserve one bottle of eva
wine say nai e go use take say prayer for
e son befor the party go really start.
On that faithful day, the two wives don
ready everything for the party.
All the other 4 children dey there, the
papa, the two wives and the papa
brother wey dey stay Effurun wey e
come a day befor the day. That one na
native doctor work e dey do for Effurun.
Around 10 that Sunday, as dem reach
house from church, the papa cum call e
son enter room, nai e carry the eva wine
bottle e cum use am pray to God
Almighty.
Say make God protect e son.
Make e live to become who God want
make e be.
As e pray finish, e cum pour some wine
for the glass cup, give Nathaniel. Befor e
say make e pour e own, Nathaniel don
drink the wine.
For e mind befor, as e pour give e pikin, e
go pour for himself. Dem two go cum
toast befor dem drink am.
But e surprise when e see say e pikin dey
drink am.
At once nai the son say
"Papa, this drink dey bitter"
The papa cum laugh as e dey wan drop
the bottle of eva wine for top of e table
top fridge.
Na there e for say
"How eva wine go bitter"
But befor e know what, the glass cup don
fall from the son hand break for the tiles.
Na once nai the papa cry out
"Ose IJulie biko jere o"
Papa Julie I beg run come o
Na so e brother wey be babalawo rush
enter the room.
As e see Nathaniel for e papa hand, foam
dey comot from e mouth, e cum rush the
pikin take.
"Wetin happen"
But Mr Oghenedoro nor fit answer.
He Open Nathaniel mouth.
Na die the pikin dey so. Nai be e bag wey
e rush go collect for e brother room start
to do some kain incantation.
E rap rap rap nai be one thing wey be like
small calabash wey red pieces dey e
mouth wey e shook inside Nathaniel
mouth. Na so Nathaniel cum vomit some
black black things wey be like rubber nail.
He vomit till e cum dey very weak.
Mr Oghenedoro brother cum say make e
turn for am. As e dey give am the one
wey e don turn for himself befor, na so
the glass of eva wine start to boil like
water for e hand.
E cum dey laff as e dey look am.
Na there the Mr Oghenedoro for
understand say na poison dem poison
the eva wine.
That means, dem wan kill the son befor.
The brother come dey ask am wetin e
wan do now?
He say e must know who poison the
drink.
E cum hide go buy another bottle of eva
wine come the house nai e call all he
household enter parlour.
When all of dem sidon finish. He cum give
all of dem one one glass cup.
Na so e cum carry the new eva wine wey
e buy so, meanwhile e don open am for
room befor e carry am enter parlour, e
cum dey share am among everybody.
As e share am finish, e cum say make
every body dey drink e own one after
the other.
Na so e eye dey their body as dem dey
drink.
Na when e reach mama Nathaniel turn to
drink nai drama start.
Na so her hand begin shake.
The drink come dey throway.
Her husband cum shout for her to drink
am.
Na there she for confess say na she
poison the drink.
Say she wan kill Nathaniel make the
husband for suspect her mate drive her
comot from the house.
As she confess finish, everybody blood
just cold.
Na so birthday take close.
And Mr Oghenedoro cum send mama
Nathaniel packing.
If who hide something follow you dey
find am, how you go take see am?
Na God!
On this note, I say anybody wey dig pit
for us, na only e wan go push eself fall
put.
Amen.
E get some battles wey we nor go fit fight
for this life.
Na God dey fight dem for us.
Many women don loose their marriage
becos of matter wey nor concern dem.
Becos of wetin dem nor do.
And wetin dem nor know concern.
But becos of say dem get one problem,
pipo go just assume and conclude say na
dem do some kain things wey their hand
and leg nor know about.
If man babe dey, dem go say na the man
wife kill am.
And many pipo don still die too just becos
of say somebody wan wicked another
person.
If you want make dem drive your mate,
why you go kill someone else?
Why you nor kukuma kill that mate make
matter end?
This life em, wetin we nor dey see many
and big pass wetin we dey see o.
Na God we dey beg make e continue to
fight for us.
Anybody wey wan use our head take do
stone na e head nai another person go
take do catapult.

1 Like

Re: The Wicked House Wife (A Very Very Touching Story In Pidgin English) by Tenim47(m): 11:28am On Oct 18, 2014
Dat1 no b new tin

(1) (Reply)

A Big Thank You To NAIRALAND / People Are Awesome: Amazing Feat Of Human Endurance. / Do You Need A Business Website Or Mobile Application Development?

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 22
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.