Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,195,634 members, 7,958,893 topics. Date: Thursday, 26 September 2024 at 06:49 AM

Oga Elijah *full Pidgin Story* - Literature - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Oga Elijah *full Pidgin Story* (881 Views)

"Nwa Aba Na City" (a Pidgin Story) / AS E DEY Happen(a Pidgin Story) / Naruto Chapter 593 (pidgin English) (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Oga Elijah *full Pidgin Story* by Hydronium(m): 7:08am On Nov 16, 2014
“Kingi, as e be so ehn, go chop, make you gbedu wella, because all the rain wey no fall for the past three years, na today you go hear am. That rain go tear ground today.” Oga Elijah talk finish, comot for Ahab front. As he dey waka go, He begin dey reason say him sef suppose go chop, but as e be so, him don already talk word wey pass am, him gats go pray make the talk nor pafuka for ground.
He waka reach the top of Mount Carmel, he fall yakata for ground con begin dey pray. He pray sote, he reach one point, he con stand up, call him bodi, Shobolo. “Shobolo, go look the water.”
Shobolo scratch him head as him dey waka go. He begin dey think. Na which kain errand be this, water don turn television? As Oga don say make other people go chop, Oga nor know say we go chop abi?
He reach water, e no see anything. Oga still dey pray when he come back. “Oga, no show o.”
Oga continue dey pray. Small time, he stand, “Oya go check again. E suppose don show now.”
Shobolo go check, come back, “Oga, I say e never show o.”
“Make you still go dey check, seven times sef. Sha make sure say you see something.”
Oga comot go pray again. Shobolo scratch him head. Him be wan grumble but he sabi say Oga go know, so he quiet. How person go just dey waka all this waka on top empty stomach, and nor be say the place near sef. Wetin Oga want make he see for the water? Money dey on top? Na wa o.
E reach the seven time, Na him Shobolo see something for the top of the water. He happy. He begin dey run, dey wave him hands from far, dey shout. “Oga, e don show o, e don show o.”
Oga Elijah stand, “Wetin you see?”
Shobolo begin look. He know say, e fit be say Oga wan catch am whether him dey lie. “Oga, I swear, I nor know wetin e be, as I stand dey look, sun dey beat me, hunger dey wire me, na im I see small something on top the water. E be like cloud, e small sha, e nor big pass my hand. Maybe na hunger no gree make signal clear.”
Oga Elijah quiet. He con begin dey tie him cloth for him body like Rambo. Shobolo begin confuse. “Oga, wetin you dey do so?”
“E concern you? Go tell Kingi say, make him start him jalopy, dey run go house now, say rain go soon tear ground o. Run go tell am now now!”
Before Shobolo know, sky don black, e be like say heaven wan fall. As he tell King finish, na him the rain start. He wan run go back go meet Oga, na him he see Oga Elijah dey tear go for front like Okada. He never see anybody wey dey run like that before. But why Oga dey leave am go naa?
As the rain don start, he reason make he find where he go hide, na him he remember the canteen where Kingi just chop finish. Choi!
Rain flog him head comot before he reach. Na empty plate remain. Ah, na which kain life be this?
Re: Oga Elijah *full Pidgin Story* by Hydronium(m): 7:11am On Nov 16, 2014
Please leave comments o

(1) (Reply)

The Curse Of Contentment / My Experience With The Kidnappers / Nobel Laureate, Wole Soyinka Gives The 2nd Eminent Lecture Series Of UNIBEN

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 13
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.