Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,733 members, 7,809,818 topics. Date: Friday, 26 April 2024 at 03:26 PM

Double Dipping - Culture - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / Double Dipping (662 Views)

Africa's Population To Double To 2.4 Billion By 2050 - Telegraph / Africa, Why The Double Standard? / Double post (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Double Dipping by easystudy101: 8:19am On Dec 11, 2014
Wetin I wan talk about for dis post fit surprise some people. De tin too been surprise me de first time wey I experience am. For yankee, I notice say people no like to eat from de same plate with anoda person. Dem dey call am double dipping!!

Me and one babe been dey on a dinner date one day. So as we dey eat, she come tell me say she no like de meat wey dey her plate. Well...., I stretch my hand with my fork to collect de meat from her plate. Den I come notice dis frown for her face. She say I no suppose do like dat.

For my mind I come begin wonder wetin dey wrong with wetin I just do. She say ee dey rude and no be clean habit. Na so I shake my head with smile for my face! Ee no go happen again be wetin I tell her. But dis na babe wey me and her don "run tins" wella. Which one clean pass, de kissing or say I put my fork for her plate?

Anyway sha..., I come later find out say na normal tin for yankee. Nobody dey like share food from de same plate with anoda person, especially if you need to use spoon/fork to eat de food. To dem na easy way to spread germs. And na im make disposable plates na de common tin here. People no dey use regular plate and culteries for party dis days. Every tin must be plastic or paper wey you fit troway.

Hygiene dey important. People need to protect dem sef from disease. But I still no understand how disease go take spread when you and anoda person dey eat from de same plate. Afterall, each person dey eat from different corner of de plate.

Dis one come remind me of all dos people wey I don share food with. From when person be pikin, wey five or more children dey eat from de same plate, to when guys dey drag food from one plate for hostel for secondary skool. Sometimes guys dey even share spoon. When ya friend chop one spoon, you collect am from im hand, wipe de face and den use am..., lol. Secondary skool life na wa!

Or dos days wey bobos dey do eating competion from one big pot. Everybody dey struggle to chop pass de odas from de pot of rice and beans wey ya next door neighbor cook. Even sef, de person wey cook de food fit no chop anytin..., lol.

Na im be say person for dey get mouth disease or tuberculosis every week. But we tank God dat one no happen. But I respect de people culture and reason to protect dem sef from disease through DOUBLE DIPPING. But if you look am from anoda angle sha, you go see say oda behavior serious pass dis one. Most people dey put dia mouth for places wey no safe at all at all. All dos PLEASURE POINTS wey people dey suck like ripe mango and nobody dey complain about am.

I no wan yan too much before de topic branch go anoda side, lol. But Stil me I no get problem with sharing food from de same plate with person wey I know. And I hope say you too no get problem with am..., or abi you get?
Re: Double Dipping by tpiah2: 10:25pm On Dec 11, 2014
Double dipping is what they call some types of fraud in the US.

So, what are you trying to say or imply?

Oro okunkun inu elede longbe.

(1) (Reply)

... / Effects Of Porous Borders On A Society's Culture / Honda Accord 1999 Baby Boy For Sale N520k

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 12
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.