Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,154,381 members, 7,822,788 topics. Date: Thursday, 09 May 2024 at 04:55 PM

My Karmo Experience (water Nearly Pass My Garri) - Literature - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / My Karmo Experience (water Nearly Pass My Garri) (440 Views)

How I Nearly Witnessed A Jungle Justice / R.I.P "Little Saint" Dedicated To The 7 Year Old Alleged Garri Thief Killed. / How To Pass A Failed Test- A Short Comedy Story (2) (3) (4)

(1) (Reply)

My Karmo Experience (water Nearly Pass My Garri) by countsparrow: 2:57pm On Apr 11, 2015
This thing na true life tory o, as I don learn my lesson, I talk say make I share am with una...


Na so I dey feel cool one sunny day o, I don chop belle full na him I dey find bekun bekun...

I carry my yansh wear Karmo dey Bounce, as if dat one no do, I carry bus go one area for my side, i wan go see one fine chikito... As I dey waka for road, na so I see one truck wey soldiers dey use transport demselves pass me, if u see d soldiers as dem strong face, u go think say dem just dey come from Bornu state...

Next thing na red light I see for d back of dem car, na dat time my head tell me say... WATER DON PASS MY GARRI...
As d soji boy wey I be, na so I pick race, see as d soldiers jump down dey chase me... As I dey run, I dey cry inside, as I dey cry inside, I dey see my grandpapa and grandmama face wey don die since 1913... As I take recognize dem face, na only God sabi cos dem neva born me and dem neva dey take pics dat time...

Na so I dey pick race for road dey dodge passersby, d soldiers dem sef no relent, d thing be like temple run, na so I see one IBO man boutique, and I just run enter am commot my short kia kia... As d IBO man bin wan raise alarm, na so I start dey speak in tongues, cos as at dat moment, English don commot my brain...

Na wer God save me o, d soldiers no see me, na so dem go one company go dey accuse dem say one person run enter d place, dos pple talk say nobody enter.... 30 minutes later, I don dey forced to buy jeans from d IBO man for 2,500 naira, to make matters worse, d jeans na for Onitsha dem do am, na so dem draw Shakira put for front, but as my life important pass shakara dat moment, I no mind.

40 minutes after I commot d boutique d soldiers still dey find me, d thing pain dem as I take escape, but God wey get my life use, spare me... Na so I waka reach house dat dat they think wat would have been to say dem catch me o...

1 Like

(1) (Reply)

The Man That Never Cries. Part3 / Albert Aderemi Adedoyin Painting Contest 2nd Edition / How We Were Converted

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 11
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.