Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,154,194 members, 7,822,026 topics. Date: Thursday, 09 May 2024 at 02:21 AM

Chai !!! Nigeria Debt Don Hit N12 Trillion Naira - Celebrities - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Celebrities / Chai !!! Nigeria Debt Don Hit N12 Trillion Naira (467 Views)

Danku Strips Unclad Over Messy Controversial Debt And Prostitution Scandal / Yvonne Chai Saung-Wang And Oge Okoye Feature In Nollywood Film / Rumours Debt Recovery Team Car Acquired By 2face's Rumours Nightclub (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Chai !!! Nigeria Debt Don Hit N12 Trillion Naira by AKPOSbaba: 10:28am On May 12, 2015
Di money wey Nigeria dey owe thru borrow borrow,even kakulator no fit kakulate am again.
Di kakulator wey my oga try to use for office to konvat di N12.062 trillion to dollar,
explode for hin hand and katch fire!
If u be pesin wey dey follow Naija mata welwell,u go know say for di 1990s,our debt no plenti at all.
Wich way democracy?
Dis 12 trillion naira,na money wey Naija dey owe as at
march 31,2015 and i know say e go don rise welwell by now.
We stil dey wait for di latest data from the Debt Management Office (DMO)
for di month of April and dis month to know how much he don enta.
My queshon now be say,
Wetin dem borrow all dis money take dey do?
Our refineries no dey work.
even student no dey gree carry excursion go our refineries again bicos notin dey appun for dia.
No good roads,potholes,potholes full evriwia, school fees dey inkriz evriday,
our doctors dey strike anyhow,Agege bread sef don cost.
Kpomo wey plenti pipo take dey see front even tho say e no dey give anytin for bodi,don cost die.
Na yahoo-yahoo most of our graduates dey do afta school bicos no work.
Di ones wey gofment manage give job,dia salaries dey smell bicos e no reach pinch.
NEPA dey one side dey crase dia own.
No need to talk about fuel skasiti bicos,to look for needle wey fall for inside river,
dey easy to see, dan to see fuel buy for filling station nowadays.
Na wa o govment.
Wich way Naija?

Re: Chai !!! Nigeria Debt Don Hit N12 Trillion Naira by Orunto: 11:04am On May 12, 2015
Naira is finished. Bokoharam wanted it so and have succeeded in rendering our NASS, CBN and the MOF all incapacitated. Whoever brought bokoharam to Nigeria, will perish and rot in hell IJN!!!!

(1) (Reply)

Movie Star, Bimbo Thomas Opens Liquor Store / Taylor Swift Wins Big At The Billboard Music Awards 2015: See Full Winners List / Select Ur Best

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 15
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.