Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,155,543 members, 7,827,029 topics. Date: Tuesday, 14 May 2024 at 05:00 AM

Usain Bolt Is A Bad Neighbour - Sean Paul's Wife - Celebrities - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Celebrities / Usain Bolt Is A Bad Neighbour - Sean Paul's Wife (4094 Views)

Usain Bolt Is Spotted Up In The Club . . . As Girls Twek All Over Him!! (pics) / Lady ‘in Bed’ With Usain Bolt ‘is Widow Of Notorious Brazilian Drug Lord’ / Ice Prince Hangs Out With Sean Paul In Rwanda(photos) (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Usain Bolt Is A Bad Neighbour - Sean Paul's Wife by AKPOSbaba: 1:58pm On Jun 03, 2015
U fit dey your own,u no go know say some kain of yor doings wey u take as normal,
dey abnormal to oda pipu.
Dis na exactly wetin dey appun bitwin di fastest man,
di man wey sabi tia race pass for di world,Usain Bolt and grammy award winning reggae miuzishan,Sean Paul wife,
wey her name na Jodi Jinx.

Jodi Jinx don accuse Usain Bolt of noise polution for dia area for Jamaica.
She also yarn for facebook say Usain Bolt na neighbor from hellfire
bicos he dey disturb di area wit too much noise.
She say,di loud noise from cars,motorcycles
and di loud miuzik from Usain Bolt house fit make pesin run mad.
She also yarn say apart from di bike noise,
na so so party and so so shout Usain Bolt sabi and she no fit wait to park comot for di area.
She say she no get one singo respect for Bolt again bicos na evriwia he dey carry him bad karata go.
She even yarn say, although pipo love di bobo welwell sha,but na bad example to di world.
Jodi Jinx say two times now for dia area,
Usain Bolt don shoot gun gbosa! gbosa! and di gunshot sef fit deaf pesin ears.

Some pipo nor go too blame di 100 and 200 mita record holder, Usain Bolt for di loud miuzik bicos, apart from di race,di oda work wey dem know am for,na DJ work.
Usain Bolt and Jodi Jinx husband,Sean Paul neva yarn anytin for di mata but plenti of Bolt fans including reggae,dancehall miuzishan,Popcaan,won kill her wit curse for twita and facebook .

READ MORE FOR HIA....http://ogakpatakpata..com/2015/06/usain-bolt-na-bad-neighbour-from-hell.html

Re: Usain Bolt Is A Bad Neighbour - Sean Paul's Wife by Nobody: 2:05pm On Jun 03, 2015
WAZOBIA fm

1 Like

Re: Usain Bolt Is A Bad Neighbour - Sean Paul's Wife by Trinxie(f): 2:14pm On Jun 03, 2015
hehehe grin ...dis Jodi lady needs to mistakenly come to Nigeria. Everything is noise. Here we shout to do anything LEAVE ME ALONE!!! GET OUT!!!...we even shout STOP MAKING NOISE!!! in a way that it would be louder than the noise itself.
You can't blame us tho...Nigerians don't understand bedroom voice, na workshop voice we get. Biko leave Uncle Usain alone

4 Likes

Re: Usain Bolt Is A Bad Neighbour - Sean Paul's Wife by importexpert(m): 2:19pm On Jun 03, 2015
Sister report to d appropriate authority.
Re: Usain Bolt Is A Bad Neighbour - Sean Paul's Wife by VickJames(m): 2:20pm On Jun 03, 2015
Pidgin journalism! Good
Re: Usain Bolt Is A Bad Neighbour - Sean Paul's Wife by bamog(m): 2:23pm On Jun 03, 2015
Can diz lady live in oshodi or iwo road in ibadan!!! Wia noise nah our daily meal!!!!
Re: Usain Bolt Is A Bad Neighbour - Sean Paul's Wife by CertifiedFreak(m): 3:09pm On Jun 03, 2015
Dude, lady ain't telling the whole story.
Re: Usain Bolt Is A Bad Neighbour - Sean Paul's Wife by atilla(m): 6:14pm On Jun 03, 2015
E be like akpororo and usain bolt resemble well or the origin wey I shak yday still dey inside my blood

1 Like

Re: Usain Bolt Is A Bad Neighbour - Sean Paul's Wife by Chanchit: 6:41pm On Jun 03, 2015
If this lady live for my block. For one day, she fit collapse when Nepa take light and generators start coming on with different ringing tones.
Re: Usain Bolt Is A Bad Neighbour - Sean Paul's Wife by KingsJohnson(m): 7:34pm On Jun 03, 2015
Fellow nairalanders, pls help me wit dis
www.nairaland.com/234801/new-business-idea-no-fund#34271793
Re: Usain Bolt Is A Bad Neighbour - Sean Paul's Wife by jotey(m): 7:58pm On Jun 03, 2015
atilla:
E be like akpororo and usain bolt resemble well or the origin wey I shak yday still dey inside my blood
I notice am sef
Re: Usain Bolt Is A Bad Neighbour - Sean Paul's Wife by kelechiMarie(f): 8:32pm On Jun 03, 2015
I hate noisy neighbours!but then Nigerian noisy neighbours are something else. I used to have one that'd play wizkid's album with loudspeakers throughout the day. Thank God he moved out!
Re: Usain Bolt Is A Bad Neighbour - Sean Paul's Wife by AKPOSbaba: 10:01pm On Jun 03, 2015
Dj Bolt
Di Noisy Neighbour-Jodi Jinx
grin grin

(1) (Reply)

What Is Burna Boy Doing With Corazon Kwamboka? The Kenya Big B00ty Lady / Davido Arrived Nigeria To Inspect His Completed 30billion Mansion In Lekki(PV) / 5 Years Old Girl, Breaks Internet With Her Lovely Photos As She Joins Instagram

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 14
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.