Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,195,281 members, 7,957,721 topics. Date: Tuesday, 24 September 2024 at 06:22 PM

My Owu Diary - Literature - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / My Owu Diary (585 Views)

Women Of Owu And Morountodun (2) (3) (4)

(1) (Reply)

My Owu Diary by lasniicy: 6:39pm On Nov 28, 2015
Na wen Owu holl you, na den you go realize say June and July no b d same.

Na wen Owu catch you, na den plenty crazy ideas go dey enter ur head (both the right and the wrong ones) like magnetic waves wey from no wia dey come.



During dat 2013 ASUU strike, mehn both hunger and owu just dey serious dey wire me.

"Ah just dey pray may 'em call off the strike, may ah know weda ah go still dey collect little choppings from my people" you know as tinz dey be na, abi you no know"

E dis get my guy wey me and am dey stay for d same hood, ehn name na Bethizzy, ehn b student like me sha, ehn dey too form "spanish" *too dey hang hand*. Ah no know weda na owu dey force words comot from dis my guy mouth, cos d kian tin wey ehn dey talk, ah no believe say person like am go dey talk am.
"Dis my guy come come dey reason me say may we write application go submit for some hotels wey dey for "NEW HEAVEN" "IN ENUGU", say 'em dey look for workers (mehn ah dey ready to do any work so far say money go come out after every every) ehn say na the next day na ehm we go go dia. Buh ma bro ah no holl shi shi for pocket "even 5naira wey tire, ah no get".

Dis D'day come, ah don cool down write my application finish, come package am for de remaining envelop wey dey my popsy drawer, wey momsy use send IV's for people for last bazaar.

Person go ask me wia my People dey all dis yle. "Mehn forget those people cos dem ma too Owu dey nack 'em small, Momsy and popsy na "state workers" and you know as state govt work dey be. Govt dey owe my popsy and momzy 'em parastatal, **Momsy don book Mass for Jehova to change their mind so tey ehm no get T,fair money again.


So back to the matter'
Me and dis my guy "Bethizzy" trek from Abakpa to New Heaven, 'Person wey dey stay for Enugu go understand wetin ah dey talk' if na dis year that thing happen, ah for say ah dey trek for PMB. Shi shi stupid people like us no holl.

May ah chop abeg

1 Like

(1) (Reply)

The National Cake (my First Play In Pidgin) / Wishful Thinking! / The Secret Angel's 7

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 9
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.