Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,162,740 members, 7,851,544 topics. Date: Wednesday, 05 June 2024 at 10:12 PM |
Nairaland Forum / Entertainment / Celebrities / Suspicion : Part 1 (376 Views)
Suspicion Of Beef Between The Psquare Brothers Arises / Nigerians Blast Ahmed Musa Arrest By UK Police On Suspicion Of Beating His Wife / Davido Arrested On Suspicion Of Being A Suspected Fraudster (2) (3) (4)
(1) (Reply)
Suspicion : Part 1 by Nobody: 3:21pm On Jan 08, 2016 |
When Felicia see the packet of Durex for her husband, Uchenna suit pocket, she cum slowly sidon for chair. She been dey fold all her husband rough clothes for wardrobe when she carry the jacket. Feeling say something touch her hand, she cum decide to search all the pockets till she see the condom packet. That morning, her husband don already dey road dey go Abuja for presentation representing their branch office for annual meeting. The jacket na wetin e wear go work last Thursday. Felicia cum pick her phone after she don reason many things wondering why her husband go continue to dey dey unfaithful to her. As she carry phone, nai be her hussy number wey she call. The next thing wey she talk be say "When you don reach Abuja, let me know" The tone of her voice nai make Uchenna know say something is not right. E cum call her ask wetin happen wey make her dey sound so harsh and disrespectful. She say nothing. Unu know say when man love e wife, e dey take time study her. And when man know e wife, e dey know when she is hurting and when she is happy. E cum call her again say make she talk wetin happen. When e don pressure her nai she say "The girl wey you nor wan leave so, make you come collect the remaining condom wey you use take sleep with her so that you nor go buy new one. Useless unfaithful man. Your mates dey think how to love their family, your own na to dey throway your sperm for gutter. What did I do to deserve your unfaithfulness? Am I not true to you..." Na so Uchenna just open mouth in surprise. E nor fit talk anything as she continue to dey curse am for phone. Uchenna was lost in thought. Na only Felicia cut the call as she dey cry not knowing what more to say. Women! Women!! Many of dem nor really know how to handle man wey dey cheat on dem. Even though your man dey carry about, that nor mean say you get the right to talk to am anyhow. And mind you, e get when to tell man some kain things. When Uchenna reach Abuja, he was so disturbed that e nor fit do e presentation for the board meeting. Na so e embarass himself befor the board members. Dem cum tell am to go and prepare more say dem nor expect say the manager for e branch go send a staff wey nor know what it means to give presentation for board meeting to come represent. My pipo, that pepper eye nai e take come house the following day cos news don spread reach e coworkers say he was booed from the stage when e dey fumble . As he push the door open, throway e briefcase for chair, nai e waka enter room. Na so e use one hand grab Felicia wan slap her befor. E cum drop e hand, push her for the bed "What is wrong with you? Why you dey always think foolishly? Becos of your suspicion and foolish talk, you don make me lost my reputation befor my managers and directors for my company. Next time you try this foolish thing, I will make sure you leave my house." Na there nai Felicia for toss the packet of Durex condom give am. "Wetin be this? Useless and shameless man wey nor go put e prick for one place." In that moment nai Uchenna cool down. E pick the condom packet. This time, e was more furious "So, this was the reason you ruined my presentation? Becos of this thing that you saw? This is preposterous!" Meanwhile, the previous week, for office nai one of dem for celebrate e birthday small for office. And after the close of work that evening. Dem cut cake, toast with some good wines. Eat chicken fron Sizzlers. The coworker cum invite dem to Frank hotel for the birthday bash that night. Na packet of Durex nai e share as invitation card. Uchenna just come home straight while the others use their own as gate pass to the venue of the party where dey party till the break of dawn. Those wey tire, lodge till morning for the hotel. When Uchenna tell e wife about the condon finish, na so her blood cum cold. She try to beg Uchenna that night but Uchenna just dey vex for e presentation wey the issue make am loss. When e go work the following week, e surprise to get a demotion letter from the head quarters all becos of e failure to represent e branch office well for the annual board presentation. When e come house, e just dey look e wife dey vex. E drop the letter for table nai e go e bar wey dey sitting room. Na there e for open the bottle of Hennessy begin drink. Befor e drink half of the bottle , e nor know. E wife nai cum take the bottle go keep when e finally doze off. Now, Uchenna is fast asleep. If na you be the wife, wetin you go do when dey break to help the situation becos you don know wetin happen to your husband all becos of your susspicion? And if na you be Uchenna, what will you do now? My pipo, mostly women, nor dey take your man waka waka issue take dey disturb the peace in your home. No matter wetin you go do, na only the grace of God dey make man faithful. So, nor kill yourself cos you fit end up losing your home. And as a man, try to be yourself at all times. If your woman dey suspect you for wetin you nor do, try understand say she is a human. And every good lover is always jealous. Try and forgive then move on. Anger na very poisonous thing wey be say, e dey even destroy the container wey dem keep am. If you are angry becos your partner offend you, you may end up hurting yourself if you fail to forgive at the right time. It is our prayer say we go marry till night. And we nor go let any issue of unforgiveness or suspicion take away our joy from us. Amen. Now to my question, who do you blame for the demotion of Uchenna? *Uchenna. *His wife, Felicia. *The Condom. *The coworker wey use condon take do Invitation Card. *The Will Of God. Oya make unu talk and learn. And remember, when you are suspecting your partner or feel convince say e do you something, wait make e come. Then talk am one on one with am. Don't call. Nor send message. May God give us the grace to learn the good things of life. Amen. |
(1) (Reply)
Shizzi Drags Tunde Ednut And Masterkraft To Court For Theft - See Proof / Cobhams Asuquo Flaunts Urbane & Dapper Look In New Photos / Actress Stella Damascus Flaunts Curly Natural Hair!
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 30 |