Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,156,508 members, 7,830,520 topics. Date: Friday, 17 May 2024 at 01:11 AM

Van Gaal Gats Go!!! - Sports - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Sports / Van Gaal Gats Go!!! (559 Views)

Arsenal And Manchester United Fans React To Shock Louis Van Gaal Announcement / Victor Valdes Mocks Van Gaal After Spurs Thrashing. / Mourinho Signs Pre-contract Agreement To Replace Van Gaal At Manchester United (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Van Gaal Gats Go!!! by forandy(m): 8:46am On Jan 12, 2016
...nothing dey work for united cry

Today Manchester United no be de same United me and you bin sabi five years ago, unto say everything don change. The United we sabi dey play ball wey dey sweet for belle and dem be king of comebacks. You no fit win United of last five years home and away na, e no dey possible, when we reason your matter, e go be for you. But Louis Van Gaal don yarn say that one na United of the past, e say make we face reality because we (the fans) still dey live for the past. Na true?

Under David Moyes, United performance no make sense unto say we bin no dey win better matches and we come go finish 7th when season finish. But we no play boring game sha, we play attacking football wey dey sweet belle, e just be say our midfield bin no strong like that and the way Moyes dey talk for press conference like say water dey em muth or em dey fear anybody, come make the fans and board feel say em no fit control the club.

After wetin Louis Van Gaal do for World Cup, United fans think say em go do beta thing for United, we even think say baba go come win us trophy. When baba come, e talk say make we judge am after 3 months, after three months baba still dey struggle but we feel say na just problems wey new coaches dey go through and we go dey alright soon. Season finish o, Van Gaal carry us enter Champions League, na that one e take console us after we go trophyless for the second time.

Van Gaal sign players take join Mata and Fellaini wey Moyes buy. Van Gaal buy Herrera, Marcos Rojo, Di Maria, Falcao, Darmian, Schweinsteiger, Schneiderlin, Valdez, Roberto, Memphis, Blind and Martial. Some of the players either no work for Louis Van Gaal or dem still dey struggle with am. Di Maria, Falcao and Valdez no dey the club because nothing come out for them under Van Gaal. Di maria say e no like Van Gaal style of play, Falcao own na loan dem loan am but e no play anything for Unted, e just dey fall for ground like person wey drink shekpe; e score four goals before em leave the club. Valdez own na because e say e no go play U21 again that’s why Van Gaal drop am.

The rest of the players follow Van Gaal enter second season, em buy some enter this season sha. Van Gaal don spend up to E300M for United but we still dey struggle. October we bin dey top of table on time like that before we come dey go down like people wey dey find oil. We come enter one yeye run like that wey we no win any game for the 7 games wey we play and people think say dem go sack Van Gaal to stop all this disgrace e dey take give the team and the fans but nothing come out, the board still dey give am time.

United play nonsense against Sheffield United on Saturday 9th of January and we see say nothing don change for the style of play wey Van Gaal dey use. We just dey pass ball everywhere and we for draw that match if no be last minute penalty wey Memphis and Rooney use send us to the next round.

The truth be say, If we no sack Van Gaal now, we no go finish top four and e go problem to our next coach because we go dey expect higher things from am. We don see say Van Gaal no fit Change em style of play no matter wetin we talk, so the only wey for United to start to play better game na to sack am. People talk say we need to buy players before the team go dey perform well, but abi we don see wetin Van Gaal dey do with the players e buy? My point be say any player wey we buy go still play nonsense under Louis Van Gaal because e no go fit blend with em style of play.

Mourinho dey available and Guardiola go dey available by the ending of the season. We fit sack Van Gaal now then employ Mourinho to handle the team or Sack Van Gaal now then employ Giggs to handle the team till season end before we employ Guardiola because I no sure say we go even finish top four or even win any trophy under Van Gaal this season.

#MUIP

1 Like

Re: Van Gaal Gats Go!!! by Nobody: 9:11am On Jan 12, 2016
Long epistle but i support the highlight, he gat go
Re: Van Gaal Gats Go!!! by forandy(m): 9:51am On Jan 12, 2016
Oma307:
Long epistle but i support the highlight, he gat go
Walahi angry undecided
Re: Van Gaal Gats Go!!! by Okotoko1(m): 2:33pm On Jan 12, 2016
When is he going abeg?
Re: Van Gaal Gats Go!!! by forandy(m): 7:50pm On Jan 12, 2016
Okotoko1:
When is he going abeg?

Lol...as soon as the Glazers borrow a working brain to enable them see his yeye philosophy isn't working angry grin

(1) (Reply)

Real Madrid Top World Richest Football Clubs List / January Football Transfer Window: 10 Best Signings / 7 Surprising Soccer Transfers That Never Happened but almost did

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 18
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.