Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,156,264 members, 7,829,530 topics. Date: Thursday, 16 May 2024 at 08:33 AM

This Life Na Endurance - Religion - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Religion / This Life Na Endurance (610 Views)

‘Na My Matter Go Kill You’ – Church Banner Spotted In Benin, Edo State. Photo / The Endurance Of The Saints - Paul Ellis / "Oh God, Na Like This We God Dey?" Church Poster (2) (3) (4)

(1) (Reply)

This Life Na Endurance by nzgal: 4:11pm On Feb 14, 2016
My people, I no hapi dis sunday cry cry

The kain tin we we dey use eye see, ear hear nowadays, no be small tin. Na soso yeye news we dey hear. If you check frontpage, na mostly bad news. Sometimes the tin sef go affect us personally as we fit loss person we close to us, or loss property or loss job or money.

This weekend, I loss one of my big bros for accident. The tin pain me too much becos im dey help people too much. Im las boy nay 5yrs, now papa don go. embarassed undecided undecidedI kon dey think say all the struggle for this life na wetin sef? Everyday of our life be like say na fight to survive.

Bible say the enemy dem wey we dey fight na 1)Satan, 2)im wicked people for this world, and 3)the sin wey dey our mind and body. E don tey wey some of us don dey fight this fight. Although Baba God don help us win many of our fight. But weThe kain tin we we dey use eye see, ear hear nowadays, no be small tin. Na soso bad bad news we dey hear. Sometimes the tin sef go affect us personally as we fit loss person we close to us, or loss property or loss job or money. Everyday of our life be like say na fight to survive. Bible say the enemy dem wey we dey fight na 1)Satan, 2)im wicked world, and 3)the sin wey dey our body. E don tey wey some of us don dey fight this fight. Although Baba God don help us win many of our fight. But we never win finish. Some of us don fight unto death, some fight tire kon give up, but some still dey fight with endurance oh.

Jesus don already talk sey for this last days, plenty problem wey pass us go dey, and people go suffer well well. But e still talk sey if we endure the problem, we go win. (Read Luke 21:19.) Wetin endurance mean?

WETIN ENDURANCE MEAN?
For inside Bible, endurance no be only to just manage bear problem wey pass us. We still suppose get better mind and still dey happy even if the problem pass us. [/i]Endurance go help us get strong mind to do good things, e go help us get strong faith and we go dey patient. Bible say if we get endurance, our hope go dey strong and we no go stop to serve God when problem dey. Even when problem big well well we no go shake and we no go fall, if we get endurance. The book still talk sey, when we dey endure, we no go dey think of wetin we don suffer but we go continue to put eye for future say e go better.

WETIN GO HELP YOU ENDURE

Beg God mek e give you power. Jehovah God na the Baba God wey dey help us endure. (Romans 15:5) Na only im really sabi us well. So e know wetin go really help us endure. Bible talk sey: ‘E dey give people wey dey fear am wetin dem want; e dey hear as dem dey beg am mek e help dem, and e go help dem.’ (Psalm 145:19)
God don promise us sey e go help us endure, if we beg am mek e help us. (Read 1 Corinthians 10:13.) Sometimes e fit comot the problem. But many times, e go give us power mek we fit dey patient and dey happy, as we dey endure. (Colossians 1: 11) And e no go let us get problem wey pass our power, sotey we come do wetin im no like.

Mek wetin you dey learn from Bible mek your faith strong. Why e good to learn wetin dey Bible? For example: [i]Person wey want climb mountain wey high well well, suppose take one day chop three or four days food. [/i]Na so e be with Christian. We need to study Bible well well so that we go fit bear any wahala and mek we fit reach where we dey go. Mek sure sey you get time to dey study bible. Na all this things go mek our faith strong.—John 6:27.

Remember sey na God side you dey. Problem dey mek us suffer. But no be only that one. Problem go still mek us show which person side we dey. How we dey behave when we get problem, go show whether God na really our King. Why we talk like that? Satan na God enemy. E no like as God be King. Na im mek am talk sey people dey serve God because of wetin dem dey gain from am. Satan talk this kind thing to spoil God name. Satan talk sey: ‘Na everything wey person get e go give to take save im life.’ Satan come talk about Job, sey: ‘But to change things for am, take your hand touch am for im body and im bone, and you go see sey e go curse you for your front.’ (Job 2:4, 5) Satan never change since e talk this thing oh! For where! E go happy to see sey we don stop to serve God, so make we stay God side oh.

Put your mind for wetin you go gain. [i]Think am for your mind sey, you dey travel with motor for night. As you dey drive dey go, the motor come off for where bush dey. You start am, e no start and mechanic no dey for where the motor for spoil. But you get friend wey be mechanic for the next village and you know sey, if you try push the motor reach there, the mechanic go repair am
. Life fit be like that sometimes. Things fit no easy for you sometimes and you fit think sey the problem don pass your power. E fit be sey even Jesus think like that. When dem wan kill am dat time, the disgrace wey dem disgrace am no be small and body pain am well well. But bible talk sey e put mind for ‘the better things wey go happen for front.’ (Hebrews 12:2, 3) Jesus know sey the problem go end one day and sey the good thing wey God go give am for heaven no go end. Today, things fit no easy for you and e fit be like sey the problem don pass your power. But no forget sey, the problem go end one day.

Love dey mek us endure. (Read 1 Corinthians 13:4, 7) How? Na Jesus talk say make we love God and love our neighbour. The love wey we get for God go mek us bear any problem wey e allow. (Luke 22:41, 42) The love wey we get for our neighbours go help us fit bear anything wey dem do us, even if e pain us. (1 Peter 4:cool Husband and wife wey love theirself well well dey get problem sometimes. But the love wey we get for the person wey we marry go help us bear any problem wey dey the marriage and the marriage go even come strong pass as e dey before.—1 Corinthians 7:28.

Mek we no endure for only small time but mek we endure go reach the end. Think am sey one boat dey sink. Any passenger wey dey the boat wey no want die, must swim go reach land. But anybody wey no get power to swim, go drink water till e die. Na so e go still be for person wey stop to swim before e reach where land dey. Our oga Christ do use blood and body take do ransom for us. Make we no let anything make us tire. The fight for this life strong and we fit tire, but make we no give up. Mek we get the kind mind wey apostle Paul get, when e talk sey: ‘We no go stop.’ We go endure, we go win. (2 Corinthians 4:1, 16)

As my people say "God dey"

(1) (Reply)

Shocking; Isis Says Jesus Is Coming Soon..... / The Pure In Heart / See What A Catholic Priest Was Caught Doing In Lagos. Wow!!!

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 20
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.