Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,837 members, 7,810,219 topics. Date: Saturday, 27 April 2024 at 12:29 AM

Me Sef No Well - Literature - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Me Sef No Well (568 Views)

All This Slay Queens Sef, I Wonder If You Read Your Bible? (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Me Sef No Well by pcaliphate(m): 2:54pm On May 20, 2016
" I no wan talk too much but I gat to say something". Hello Everyone. Here is a joint comic piece titled "Me Sef No Well".

Rasheed, I dey always code if cold cold me,
No be James Bond forming, na just to make GP bold.
To con dey use blanket tie wrapper, when lecture dey hold for class,
Omo na stranger to the route to first class.
Anytime body wan hot, na Expectations be the self-medication.
Only a glance at the Labour market, dey make my stressed feeble legs stand attention.
Oh Boy  - Me Sef No Well.

Heloquent, eight o'clock lecture wey motor no dey, your guy dey enter booth.
Na adventure I dey call am, until the day engine oil reason my white trouser suit.
Five times venue changing, how person no good get headache?
Sometimes e dey be like say oven dey inside my head wey dey bake the ache.
Na just the agidi on my side, malaria na regular catcher of me.
If ill wan con draw the agidi, self-medication na reminder of wetyn I dream to be.
So no be only You - Me Sef No Well.

Rasheed, you go don hear say I faint two weeks ago?
Me no no say stress dey do ajo for my body, e just dey accumulate dey go.
Me wey be regular student for school, and my punctuality na first born of early.
With no time to cook, na junks be the waiter wey dey serve my belly.
Exam period wey book dey full my front, my body dey always frown.
But me dey always bone the signal, not knowing e go bring faint wey go fall me down.
So no be only You - Me Sef No Well.

Heloquent, as you faint everybody for class surprise.
That night, I shaparly reason the two night missed sleep wey don soak for my eyes.
With the books wey dey to read, and project to type, wetyn man go do.
The way my body dey do me sef, doubt full my clue.
No vex say I no con check on you, no be my wish not go out
Na the ache for head, weak for body, cattarh for nose, and cough for mouth.
So no be only You - Me Sef No Well.

Rasheed, we started from the bottom, now we are here.
Thank GOD for the Grace, Strength and Care.
The long run race in its final lap is almost over.
The learnt lessons in this fall walls, will make us bolder.
The endurance will make our parents proud, and success giving us a high five.
As we graduate to another phase in life.
Bro - It Is Well.

Helloquent, I Thank GOD for keeping us alive to witness this final lap.
As signing out, dinner and convocation party, await us all.
Induction as professional historians coming soon, a plus to our CV.
With the clock ticking in its usual tick,
I can't wait to say Straight Outta Unilorin,
Throwing my cap in the air, feeling fulfilled.
Bro - It Is Well.

#TeamFinalist. #ClassOf2016.


GOD Bless Us All #Peace.




By Olowo Tosin John (Heloquent) and Olorunishola Rasheed (Genrash)....

(1) (Reply)

Happy Birthday To Flow1759 / Mysterious / Yio Ti Buru To (it Would Be Terrible)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 13
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.