Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,162,478 members, 7,850,659 topics. Date: Wednesday, 05 June 2024 at 06:52 AM

Match Preview :- United V Southampton. - Sports - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Sports / Match Preview :- United V Southampton. (403 Views)

Chelsea V Southampton FA CUP / Leicester V Southampton 1:0 FT / Arsenal V Southampton: News You Need (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Match Preview :- United V Southampton. by Lahgman: 8:35pm On Aug 18, 2016
EPL 4 PIDGIN.
By Lawal Hafis (Lahgman).

MATCH PREVIEW : UNITED V SOUTHAMPTON.

SMALL TORI
E don reach 94 days wey Premier League Football don shele 4 Old Trafford. Baba Special go ginger hin boys as dey go get confidence on top the 3-1 Koboko wey deh samah Bournemouth for Vitality Stadium. Red devil go dey hope say make dem samah Saints koboko for the first tym for Old trafford since Jan. 2013.

WILL PAUL POGBA SHOW?
Dis wan na big mata , na only Baba special fit answer dah question say the world record signing go show. For anoda tori, Jesse Lingard, the pikin wey score jolly goal for Community Shield don return as e don standa gidigba from the yeye knock wey e carri for Community shield. Chris Smalling go full ground bambam after the suspension wey hin carry over from last season.
For Southampton angle, Ryan Bertrand fit show after wey e don recover from hin knee injury. Redmond, Hojbjerg and Pied their new signin fit show.

WATIN THE PLAYERS DEY YAN?
"Southampton na beta team, wey finish for 6th last season, say dey go wan finish for beta position this season. Na our first match for old trafford and e go sweet our fans make we give them koboko". --Juan Mata.

" We sabi say United don standa pass last season own, but dat one no mata. We go put beta power and show dem fire". ---Dusan Tadic.

WATIN SHELE LAST SEASON?
For January, Saints(shey na wolli) nak united 1-0 for Old trafford, the goal wey Charlie Adam nak with hin head. United too no dey dull as dey nak dem 3-2 for St. Mary's wey Martial tear dem net two times.

WHO BE THE BETA PLAYER WEY GO SHOW?
1. Zlatan Ibrahimovic (Baba Ibro) :-he don tear net two times for Leicester city and Bouremouth match.

2. Eric Bailly :- This one don sweet the belle of united fans and baba special. He don collect beta player award for two matches wey he don show.

3. Nathan Redmond :- The former Norwich pikin no get tym to sleep wey don start to dey tear net.

4. Jose Fonte and Cedric Soares :- wey win Euro 2016 with dem Portugal.
WHEN THE MATCH GO SHELE?
The match go shele for Friday night for 8pm.

TALK YOUR OWN!!!!
My own nah say united go samah dem koboko but e no go plenti pass 2-0.

(1) (Reply)

Match Preview : Arsenal V Basel / Are You Tired Of Losing Your Bet Always? Check Here For Win / African Cup Of Nations 2017 Draw

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 37
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.