Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,152 members, 7,818,474 topics. Date: Sunday, 05 May 2024 at 04:48 PM

This Kain Life - Nairaland / General - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / This Kain Life (243 Views)

(2) (3) (4)

(1) (Reply)

This Kain Life by lalaponcus(m): 12:35pm On Jun 17, 2017
THIS KAIN LIFE.

Jesu.
Na you I come see o.
I don mess up big time bros.

That apple of sin eh,
I don chop am again o.
That coke of lust eh,
I don drink am again.
That origin of sex eh,
I don shark am again o.

Na so so fail I dey fail.
Like that bros wey be Paul for bible,
Na bad I dey do instead of good.

Like pikin wey im sandal pack shit,
Na so the fly of death dey follow me.
Dey hover over my life as if I be Egyptian first born under Pharaoh.

Like omo boy wey go give girl belle,
Na so the spirit of stagnation dey draw me back.
Dey hold my trouser strong as if say I thief im moni.

Bros J epp mi.
As e be say my efforts be like man wey dey fetch water put for inside basket.

Baba God give me power.
As e be say my power don fail for battle like engine wey knock for highway.

Na that joy of salvation I need now.
As e be say the joy of this life dey bring sorrow along like auntie wey dey always carry friends along when broda wan take am out on a date.

Na your peace I need now.
That kain peace wey Jesus get dat year o.
The one wey make my oga dey fire sleep down when the sea just dey tumble and rumble.

Peace wey surpass human understanding be the name.
Wey dey make fanta fill my belle even if my mate dey pop champagne.
Wey dey make me dey more nourished than my mates even if na garri I dey chop and dem dey eat pounded yam and egusi.

That kain peace.
That kain joy.
Abeg give to me bros J
#NaBashorun

Okontas.com

(1) (Reply)

How To Spot Buy Or Sell Side Analyst From Nigeria / Young Community Leaders Initiative / Reps Summon Minister, AFN, CBN Over ‘missing’ $150,000

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 14
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.