Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,852 members, 7,810,280 topics. Date: Saturday, 27 April 2024 at 04:51 AM

Emi La O Ni Yo Si? (why Won't We Be Glad?) - Literature - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Emi La O Ni Yo Si? (why Won't We Be Glad?) (573 Views)

Emi(legend Of The Human God): Reboot / Emi(spirit): Lineage Of Gods / Emi(spirit): Legend Of The Human God (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Emi La O Ni Yo Si? (why Won't We Be Glad?) by lalaponcus(m): 1:33pm On Jul 09, 2017
EMI LA O NI YO SI? (WHY WON'T WE BE GLAD?)

Emi la o ni yo si.
Emi la o ni yo si
Bi a ti fe ko ri
Be na lo ri
Emi la o ni yo si.

Beeni o.

Everyday we pray pray pray.
For every camp ground we pray pray pray.
Hold wall and pole to pray say our night go turn to joyous day
Say make Baba God turn around every dismay
Make He put fire for destiny helpers nyash make them begin come without any delay.
Make we sef get moni to marry better wife and born correct ajebutter pikin to display
Unto say people don too dey talk for period wey don tey
Say we no go see anything hold for hand even when our hair don turn grey.

Well,
Hallelujah Hurray

God don honor everything wey Him word say.
Dey give us Yanfun yafun blessings make we begin spray.
Turn us to predatory bushmeat wey begin chase the demonic hunters like prey.
Come twist our debtors hands so tey dem begin repay.
Unto say na Jesus be that name wey every knee must obey.
Him turn our dirty clothes around come give us shine shine cloth wey dey make us slay.

Nor mind them o Auntie.
Nor pay attention to those nay-sayers Uncle.

You just continue to trust in baba God.
Nor siddon dey look as people dey collect their own favour o.

Mmba.
Call on that same Jesus make Him no pass you by.
Because na im be the only gentle saviour wey dey hear person humble cry.
Because Him be dat perfect friend wey dey help to carry all our sins and griefs.
Because Him be the Area Fada wey everybody must loyal to.
Because na only a dey discharge angels to guard you even if you dey ghetto.
Because na only Him be Dike, strongest man wey no fit lose any battle.
#BASHORUN

Okontas.com

Happy Sunday to everyone

(1) (Reply)

"Why The Cat Is After The Rat" A Story By Ebiowei Goddey / Help With Writing / The Unseen Love

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 10
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.