Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,775 members, 7,817,190 topics. Date: Saturday, 04 May 2024 at 08:02 AM

How To Become Popular - Career - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Career / How To Become Popular (332 Views)

How To Become Popular With Your Work/services (2) (3) (4)

(1) (Reply)

How To Become Popular by NewsinPidgin(f): 12:53pm On Aug 25, 2017
Dese days, most people feel say if you no popular, if people never know you, you never make am... Dem don carry dese thing for dia head sotey you go see as people dey do stupid tins just so dia name go comot for everywhere.

As I check my Oyibo spelling-book wey dem dey call Dictionary, I find out say to dey popular mean to dey common where plenty people dey and to dey generally accepted which mean say people go love you as you dey.

E dey pain me when I know say plenty people don confuse popularity with stupidity. Dem go dey do stupid tins unto say dem want make people know dem.

E get one tin like dat wey I don dey hear again, wey dem dey call "FACEBOOK CELEBRITY". Abeg una know wetin e mean? Cos dis kind tin don weak me.

Person go just wake up for morning, enter Facebook, write better 'nonsense' come post. All dese one na unto say you want likes abi which one?

Ehn ehn, dear slay queens and slay kings, make una try to dey wear cloth for picture... Stop to dey show us your hungry body.

And again, popularity wey no dey bring money na wash. Everybody go know you finish but to chop 1 square meal a day na wahala... Who your popularity EPP?

If you wan dey popular d right way, if na Popularity dey hungry you... You just want make people know you, follow dese steps:
1. DEY RELEVANT
2. GET SENSE
3. DO GOOD ALWAYS
4. LOVE PEOPLE
5. GET UR OWN LIFE OUTSIDE SOCIAL MEDIA

N.B = No be everybody go blow... Some people na underground people. Na dem be d kingmakers.

Shey now, Neymar dey collect better money from the club wey sign am, You don ever reason how much d owner of d club go get to fit give Neymar dat kind money?

If you be Oga, shey na out of d plenty money wey you get na imm you go pay your staff abi?
I just pour out dis wan from my mind make we for learn how to do tins well.


#confamtori

Source: http://newsinpidgin.ng/how-to-become-popular/

(1) (Reply)

Abia Local Government Council Workers Are Living In Bondage / Join The Intelligence Group (recruiting) / MASTERING JOB INTERVIEW SKILLS

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 15
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.