Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,162,751 members, 7,851,576 topics. Date: Wednesday, 05 June 2024 at 11:18 PM

Super Eagles Match With Zambia No Go Hold On Saturday – Angry Akwa Ibom Youths - Sports - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Sports / Super Eagles Match With Zambia No Go Hold On Saturday – Angry Akwa Ibom Youths (669 Views)

Photos From The Super Eagles Match Against The Crocodiles Of Lesotho / Photos From Super Eagles Match Against Tunisia / AFCON 2019: Photos From Super Eagles Match Against Guinea (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Super Eagles Match With Zambia No Go Hold On Saturday – Angry Akwa Ibom Youths by NewsinPidgin(f): 10:55am On Oct 06, 2017
Up to 200 youths for two communities don threaten to stop d Super Eagles match against Zambia on Saturday.

Youths for d two communities, Obio Etoi and Obio Ofot, where d Godswill Akpabio International Stadium, Uyo dey, don swear to scatter everything for d World Cup qualifying match wey Nigeria and Zambia go play dis weekend.

Dey want make d Akwa Ibom state government fulfill dia promises to dem if dey want make d match go on in peace.

Youths from d communities wey reach about 200 with plenty placards yan say even as dem get dat kind fine beautiful stadium for dia side, say plenty members of d communities still dey unemployed, many of dem go get wetin to do while d state government no gree construct roads inside dia communities as dem bin agree before dem build d stadium.

Sunday Peters, wey be d youth leader of Obio Etoi village, wey lead d protesters, yan say since 2011 when Julius Berger start work for d stadium, d villagers no get anything to show for am.

Him talk say;

“D company bin block all diversion ways to d community with dia heavy equipment and machines, and at some point we bin sell our land to maintain d road. Na why we dey cry to d state government and we go continue to cry until dem do”.

As him take put am, because of dis tin wey Julius Berger do, d communities around d stadium don become flooded as most water ways don dey blocked by dia equipment. Eteidung Ezekiel Inyang Ekott, wey be d village head of d Obio Etoi, kon talk say d youths’ action no be to disturb d Super Eagles’ match wey dey come d communities, but to attract government attention to dia promises to d communities.

Him talk say dey bin don send plenty letters already from him palace to d state government to remind dem of wetin dem dey face for dia communities but dey don ignore dem.

Ephraim Inyang, wey be d state Commissioner of Works, wey come d protest venue with Charles Udo, wey be d Information Commissioner, talk say dem bin don mark d road for construction. Him still talk say dem go soon start work for dia in a week time.


#confamtori

Source: http://newsinpidgin.ng/super-eagles-match-with-zambia-no-go-hold-on-saturday-angry-akwa-ibom-youths/

Re: Super Eagles Match With Zambia No Go Hold On Saturday – Angry Akwa Ibom Youths by AdultMaleNegro(m): 11:04am On Oct 06, 2017
Dem dey craze
Re: Super Eagles Match With Zambia No Go Hold On Saturday – Angry Akwa Ibom Youths by mazimee(m): 11:18am On Oct 06, 2017
If slap sense for their lazy head ehn...

(1) (Reply)

De Bruyne Better Than Ronaldo, Neymar - Pep Guardiola. How True Is This? / Breaking: Barcelona Sign Phillipe Coutinho €160m From Liverpool / Premier League Preview And Predictions (game-week 32)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 9
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.