Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,702 members, 7,809,667 topics. Date: Friday, 26 April 2024 at 12:47 PM

Oya Use This-10 Ultimate Signs To Identify Ghetto Wey Dey Form. - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / Oya Use This-10 Ultimate Signs To Identify Ghetto Wey Dey Form. (899 Views)

Abeg Dat Oil Wey Dey Inside Condom / Oya Memes Don Land As E Dy Hot / Oya Let The Meme Begin... (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Oya Use This-10 Ultimate Signs To Identify Ghetto Wey Dey Form. by sylvesterxyz(f): 11:32am On Oct 10, 2017
No be say to come from ghetto na bad thing even me, I fit testify say na Ghetto I come from.

First of all, E get something wey people for your side go do, your number 6 go tell you say na ghetto dey come from ni.

For those of e na wey they form say e na no knw where ghetto dey for this country (Nigeria). Me I go humbly tell you say “you can LIE for for Africa oo”.

Here now, now I go show you 10 sign wey you go use identify person wey come from ghetto. Me wey write this post, I be half Ghetto, half America.

My papa impregnate my mama for United State. But na ghetto hospital for inside Ajegunle them born me. Na wetin make me be Half Ghetto and half America.

1.Shouting UP NEPA.

Chaii! This one sometimes they make me vex like say tomorrow no they.

In case you never experience am ,go ghetto any time wey NEPA(PHCN)bring Light. Na so everybody go they shout “UP NEPA” like say Nigeria done win World Cup. E come be like say na tradition for ghetto be that o.

2.Courage and Brave. Omo na confirm courage na him ghetto people get.If you get any of your friend wey no they fear to waka(walk) late in the night make you say na ghetto person be that.

Ghetto people no dey even fear police joor but if na army come they go just Humble pass humble smith self.

3.Best Food is Beans and Bread. Awooo!

Apart from say ghetto people love “AGEGE bread” with all their heart. Because of the secret ingredient wey they make the bread belle full person. Majority of ghetto people best food na Bread and beans especially “Agony Beans”.so next time use this, identify them too.

4.Trek 4 Africa. No be say to enter car and bike na him be war oo but ghetto people just like to trek. Them fit dey go C.M.S from Orile. They go tell you say na just 45 minute walk exercise be that one.

5.Okrika na Original.

Only a ghetto sombori go tell you say na “Mumu dey go they go boutique”. One of the major signs to identify ghetto person na with the Okrika cloth wey him wear for body. And the truth come be say na ladies they buy as am pass.

6.Football as best sport. How you go expect a person from ghetto make him best sport na swimming, where him see swimming pool abi how you expect am to say him best sport na Hockey. Say him even know wetin be Hockey self. Na him normal street soccer him know na.

7. Eat while walking. One of the way to sharperly spot somebody, from ghetto na say he/she dey like to eat something as them they waka for road. Whether na puff-puff, Oofio or groundnut they go dey eat am for road.

8.Prefer Pidgin Language. Make I write this sign for English.

It not as if a ghetto person does not know to speak good English but it is because speaking English sounds too officially or too serious to the speaker himself.

Therefore ,if you have that friend that will always prefer pidgin Language to English it a sign that he/she is from ghetto.

9.Prefer Second hand (London used) product.

The same love wey ghetto people get for Okrika product na him they share give London used product. They believe say London used product they strong pass new one and because him they cheaper. If your friend like Second hand product well-well just know say na one of ghetto sign be that.

10.Drop dirty anyhow. 75% of ghetto people go chop something finish come throw away the pack for ground. No be say they no know where dust bin/recycle bin dey but na how most people they run things for ghetto.

Hence , if you notice 5-10 of this sign for any of your friend habit just know say na Confirm ghetto be that person.
s.

source : https://3naija.com/10-ultimate-signs-you-are-from-ghetto/
Re: Oya Use This-10 Ultimate Signs To Identify Ghetto Wey Dey Form. by vivie01(f): 1:11pm On Oct 10, 2017
cheesy cheesy cheesy @OP, this is a nice write-up! Heard ghetto guys are down-to-earth and rugged beings.

1 Like

(1) (Reply)

Is Poverty A Curse? / BRODA SHAGI 'shomo Age Mi Ni' Do You Know My Age / Single Ladies Are We 2geda?

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 15
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.