Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,265 members, 7,818,903 topics. Date: Monday, 06 May 2024 at 07:43 AM

I Just Called Aso Rock: - Sports - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Sports / I Just Called Aso Rock: (545 Views)

Telephone Conversation Between Aso Rock And Stephen Keshi! / Telephone Conversation Between Aso Rock And Stephen Keshi. / Telephone Conversation Between Stephen Keshi And Aso Rock (2) (3) (4)

(1) (Reply)

I Just Called Aso Rock: by paj(m): 8:05pm On Jul 05, 2010
, ring,
, "Thank you for calling Aso Rock, for english, press 1, pidgin, 2, Abiriba, 3, (*2*), correect, , to yan directly with Oga Presido,chook 1, im VP, 2, vice VP, 3, (*1*), correeect. , omo abeg wait, is coming, ",
Bros J: "Hello, " :
Pa J :"Hey bros, how far na?"
Bros J:"Na who be dis?"
Pa J:"na Pa J, from DC, I been send U my youtube las' mont, " cool
Bros J: "Yes yes, aah, Goaaalaaaaaaaso, insai d neeet O, wi ganna, ", shocked
Pa J:"but Bros na how U go take my song greet me when U wan fall my hand with FIFA now?" angry
Bros:"but ol'boy as I don hear reports from Cybereagles sey when Arsenal begin lose U sef flipflop comot from dia back join Chelsea so I been tink sey U go turn Ghanaian after I ban Nigeria, " cool
Pa J:"TUFIAKWA!!U don see pesin use Kenkey chop Ewedu before??, U don see the toilet for the Ghanaian Embassy?Abeg if na play make U stop am O! angry but make I ask U, U mean am?"
Bros J:"why not?" cool
Pa J:"But Bros, dat na like setting the house on fire to get rid of rats, oyibo dey call am oferkill!"
Bros J:"But if previous occupants don feed the rats Otapiapia and dem no die,how man for do?See, for our village if U put smoke inside rat hole U go see am do high jump comot one time!!"
Pa J:"ah ha!!so na to just use Ogboju for dem, correeect!!"
Bros J:"Well, more like a calculated warning with the intention of, "
Pa J"Ah, ha!!.Bros J, I feel U!Good idea!After Obama,na U biko!I duff hat!!! I see where U dey carry go with this one, and I wan make U know sey I gat ya back paparapa, I full ground well well for U, in fact, if U wan form new Komitee and just like the Supa Eegus go need fresh legs,U go need fresh faces, U know, Honest Nigerians wey dey selfless and not just dey look after dia own sef, U know?Plenty peeps fit back me up wiff wetin I dey talk on dis idea, just ask dem, dem go tell U sey as I see am na so I call am, no wuruwuru, no magomago, no cunnycunny, if U like sey U fit do background check on me and ask my previous employers and current famli members, dem go tell U sey "That Pa J, na correct guy!"I be clean pesin, and I dey get along wiff everybody, and no dey ask for too much back, now, na where I fit fax my resume make U look am?, ?Hello?, helloBros J, hello, "
, *phone computer voice*, "If U'd like to make a call, please hang up, and dial again, "
Pa J:" undecided "

(1) (Reply)

Strange! : Octopus Predicts All German Matches Correctly / Falconets Receive Scholarships From First Lady / Fifa Boss Sepp Blatter Apologises For Gay Comments

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 13
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.