Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,157,900 members, 7,834,990 topics. Date: Tuesday, 21 May 2024 at 12:02 AM

The Nigerian Insecurity Is Not Secure - Culture - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / The Nigerian Insecurity Is Not Secure (308 Views)

See The Nigerian Tribe Where Women Don’t Wear Clothes For The Fear Of Death [PIC / Emir Of Gwandu, Muhammadu Bashar: Homosexuality, Lesbianism, Cause Of Insecurity / BROKIN; The Nigerian Pidgin History And Origin. (2) (3) (4)

(1) (Reply)

The Nigerian Insecurity Is Not Secure by Pricelessfina(f): 4:18pm On Feb 06, 2020
Mazi; abeg I need wan small explanation

Egbon; which explanation again?

Abeg; helep me understand why CAN dey do protest for the Nigerian insecurity, how that wan suppose help the country? Abeg helep me understand

Me; sef, I no understand this question wey you dey ask me. Na Nigerian insecurity be your problem or na the protest be your problem?

Mazi; I no get any problem; I just wan understand wetin concern bird with tooth brush. CAN in my opinion has no business doing protest, protests for the Nigerian insecurity or anything at all is strictly for activists

Who talk that wan Egbon? This thing wey you talk now now, dey the constitution?

No, e no dey constitution but my own be say… see CAN na religious organization and dem no get any business with politics

So the thing wey you wan tell me now be say the Nigerian insecurity wey we dey experience now, na only politicians dey experience am, religious people no dey experience am?

Mazi, you no understand the thing wey I dey talk

Abeg helep me understand am abeg. Because you no fit talk that thing wey you dey talk. Anybody fit protest and yes, CAN na religious organization and if dem don see say dem wan add protesting to the prayers wey dem dey pray against this Nigerian insecurity wey we dey see so. Who you be to talk say e no good?

As you explain am so, you don make me understand because I just dey think say the only work of a religious organization na to dey pray but I been no know say dem fit organize protest

Read more; https://everyevery.ng/pidgin-news-24-the-nigerian-insecurity/

(1) (Reply)

This Is A True Reality Of Our Dear Country (nigeria) / Got Some Great Project Idea Needing Funding? / Nigerian Timekeepers Are In With The Alternative Culture - Nigerian Timekeepers

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 7
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.