Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,154,918 members, 7,824,859 topics. Date: Saturday, 11 May 2024 at 07:28 PM

Wetin U Go Do? (a Funny Story) - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / Wetin U Go Do? (a Funny Story) (435 Views)

Come In And Smile B4 U Go To Bed / When Your Secretary Is Very Sexy – Funny Story / U Go Laugh Tire (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Wetin U Go Do? (a Funny Story) by kingot(m): 12:21pm On Jul 14, 2023
*Goes to get some clothes in boutique*
Me: Oga how much be this green polo?
Guy:15k boss
Me: No be all the polos I dey talk about, na just this one. This green one wey I dey touch.
Guy: *smiles*...Yes boss, na 15k. Everything don cost for 9ja now
Me: Omo!! so money wey I hold for two polo and one Jean, na price of one polo
Guy: Ahh, e cheap sef na
Me: and I like the polo ooo
Guy: You fit buy am, then gather more money come another day con buy other ones.
Me: Hmmm... omo if I buy this polo, na only once I go wear am for this life. On the day of rapture.
Guy: *laughs out loud*.. This man, you too funny.
Me: I dey tell you o..Dem no born me well to buy 15k polo con use am dey come Alaba everyday.
Guy: *laughs*
Me: Put am for nylon for me abeg
Guy: Boss boss...jeans nko?
Me: You wan dash me that one?
Guy: *laughs out loud*.. Take sir
Me: You don see 15k na, you don dey call me sir.
Guy: *still laughing*...no be like that oo, boss
Me: Oya na, we go see later....*collects the polo and goes home*
{Later that night}
Babe: Baby m, since I came to see you today, you've been dull somehow. How are you na? was work hectic today?
Me: *smiles and kisses her*... I'm fine my love..don't mind me jare, I'm okay
Babe: *kisses me on the chest and rests her head there*... My king
{The next morning}
Me: *wakes up*...Baby??
Babe: *comes out of the kitchen, wearing the green polo*... Heeyyy sleepy head, you're awake. I just finished frying plantain for us, should I bring your own here?
*
*
*
If nah you wetin u go do?
Re: Wetin U Go Do? (a Funny Story) by brain54(m): 1:21pm On Jul 14, 2023
Na to chop plantain na…

Come chop the real food join. Early morning chopping make brain die.

Abi What else?
Re: Wetin U Go Do? (a Funny Story) by kingot(m): 2:11pm On Jul 14, 2023
brain54:
Na to chop plantain na…
Come chop the real food join. Early morning chopping make brain die.
Abi What else?
untop my 15k polo? Oga we die there o

1 Like

(1) (Reply)

What Would Happen? / If You Receive This Alert / Bushkiddo Guy No Money

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 10
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.