Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,536 members, 7,819,919 topics. Date: Tuesday, 07 May 2024 at 06:42 AM

Malaysian Government Out On Yahoo Yahoo Boys - Travel - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Travel / Malaysian Government Out On Yahoo Yahoo Boys (6299 Views)

A Nigerian Died Because A Racist Malaysian Hospital Refused Him Treatment(Video) / Malaysian Social Visit Visa / Malaysian Cities: Photo Gallery Of An Emerging Market Economy (2) (3) (4)

(1) (2) (Reply) (Go Down)

Malaysian Government Out On Yahoo Yahoo Boys by OlaBamitu: 1:02pm On Nov 24, 2011
oboy yahoo-yahoo boys done put guy men for wahala. 3 days ago we get tori sey one darky hammer too much egunje from em yankee mugu. dem yarn d mugu sey dem get pay here and need to make the transfer to her, so unto lovina lovina, d babe come pay too much egunje of 500,000 yankee wey be almost 75 mila naija pay. trust our naija guys, instead of this guy to waka enter naija direct, em go gather guys from everywhere dey celebrate for restaurant becus em own share na 50 mila naija. (and the funny tin be sey, dis guys no go ever gree give you 50 naira, rada dem go spend 100,000 naira for drink for you and ashawo)
Na kasala don burst. the guys come tell the mugu sey after she don pay dat moni, sey malaysia eke hold am, omo na em the yankee mugu come go report to her govment, na em govment call US embassy for here to go reles their citizen and investigate the matter. only for dem to fin out sey no wite man, no money, sey na darky handwork.

dem catch the persin wey get d account wey dem take recive the egunje, d persin come yarn, na Malaysian govment reliz officers full everywhere dey go condo by condo and house by house dey burst houses, you get kpali or you no get, na enter you dey enter. dem even come dey catch guys wey get ugu for house and see guys dey chat life mugu and dere wite man face wey dem dey use, seize computers, printers, ugu, and more.

oboy no darky dey sleep for house na for malaysia. yesterday eke pursue us tire with bike and chains of handcuff, na inside forest i sleep, come back na come baf. as i dey end dis report na i dey go out again ready for outside run again.

shud dis be done to we that innocent, after all, they,ve gotten the culprit.

Omo na broken pidgin we go speak here, becus na yahoo yahoo mata be dis, make we no promote am for the foreign community to know much
Re: Malaysian Government Out On Yahoo Yahoo Boys by OlaBamitu: 1:04pm On Nov 24, 2011
MOD abeg dis na serious matter to let guys know about d tori before dem go gbap dem

abeg front page

guys Pidgin please

thanks for response
Re: Malaysian Government Out On Yahoo Yahoo Boys by OAM4J: 2:47pm On Nov 24, 2011
na wa o. So you be yahoo yahoo?
Re: Malaysian Government Out On Yahoo Yahoo Boys by justwise(m): 3:49pm On Nov 24, 2011
Ola Bamitu:

MOD abeg dis na serious matter to let guys know about d tori before dem go gbap dem

abeg front page

guys Pidgin please

thanks for response

make una enjoy the run-around with Malaysian cops, na so life dey now.
Re: Malaysian Government Out On Yahoo Yahoo Boys by Nobody: 4:06pm On Nov 24, 2011
i laff in pidgin grin
Re: Malaysian Government Out On Yahoo Yahoo Boys by ijeburemo: 4:37pm On Nov 24, 2011
Na wah oh kasala don burst be that but me nor even like that malay and i wonder why 90% of naija boiz for that area be yahoo-yahoo
Cos wen kasala burst person way nor chop inside go pay and dit time na almighty yankee dem go job, D matter go hard oh
Re: Malaysian Government Out On Yahoo Yahoo Boys by OlaBamitu: 5:19pm On Nov 24, 2011
c ha darky dey gather for chinese restaurant until dem close, maybe 2am, den come see race wit eke

na unoda pesin chop dis parol wey efrybodi dey sufa now
Re: Malaysian Government Out On Yahoo Yahoo Boys by ibrak200: 9:59pm On Nov 24, 2011
embarassed
Re: Malaysian Government Out On Yahoo Yahoo Boys by lovejo(m): 10:36pm On Nov 24, 2011
Na you sabi wetin you do for your condo or area, i dey Malaysia for 3 yrs and no intimidation or harassment from any eke, i dey hear your rumour but don't generalise it cos i still go out today and i have never seen any of my friends callng me if i'm in any trouble cos they are not also in trouble. Not all 9ja here dey do yahoo for here, so majorly those that got arrested are without visa, and 1 day over stay is now rm3000 (150,000) so they are really making money from getting illegal immigrant now.
Watch out fr season 2.
Re: Malaysian Government Out On Yahoo Yahoo Boys by justwise(m): 10:39pm On Nov 24, 2011
lovejo:

Na you sabi wetin you do for your condo or area, i dey Malaysia for 3 yrs and no intimidation or harassment from any eke, i dey hear your rumour but don't generalise it cos i still go out today and i have never seen any of my friends callng me if i'm in any trouble cos they are not also in trouble. Not all 9ja here dey do yahoo for here, so majorly those that got arrested are without visa, and 1 day over stay is now rm3000 (150,000) so they are really making money from getting illegal immigrant now.
Watch out fr season 2.

illegal immigrants pays that much for over staying?
Re: Malaysian Government Out On Yahoo Yahoo Boys by lovejo(m): 10:47pm On Nov 24, 2011
Yes that is the new law.
B4 if you over stay for 100 years, it is rm 1800 (90,000 naira) but this new law only few have been aware and a friend of mine just fell victim of it.
Re: Malaysian Government Out On Yahoo Yahoo Boys by justwise(m): 11:07pm On Nov 24, 2011
lovejo:

Yes that is the new law.
B4 if you over stay for 100 years, it is rm 1800 (90,000 naira) but this new law only few have been aware and a friend of mine just fell victim of it.

That is harsh, what will happen if one does not pay?
Re: Malaysian Government Out On Yahoo Yahoo Boys by lovejo(m): 11:15pm On Nov 24, 2011
6 month jail before deportation, and if no one is able to raise get you the ticket the person will be there until he has the ticket, only if you are arrested illegally, if the person go there himself, it can be sorted out without prison sentence, but he must be ready to pay and leave the country, Human Right Abuse is only problem here, which is common in most asian countries.
Re: Malaysian Government Out On Yahoo Yahoo Boys by justwise(m): 11:34pm On Nov 24, 2011
lovejo:

6 month jail before deportation, and if no one is able to raise get you the ticket the person will be there until he has the ticket, only if you are arrested illegally, if the person go there himself, it can be sorted out without prison sentence, but he must be ready to pay and leave the country, Human Right Abuse is only problem here, which is common in most asian countries.

Hmmmm . . .that sound scaring, i feel sorry for pple who knowingly over stayed their visa then.
Re: Malaysian Government Out On Yahoo Yahoo Boys by koghuma: 12:47am On Nov 25, 2011
@justwise whats ur yahoo IM id
Re: Malaysian Government Out On Yahoo Yahoo Boys by justwise(m): 1:57am On Nov 25, 2011
koghuma:

@justwise whats your yahoo IM id

i use Hotmail.
Re: Malaysian Government Out On Yahoo Yahoo Boys by HighChief4(m): 2:09am On Nov 25, 2011
lovejo:

Yes that is the new law.
B4 if you over stay for 100 years, it is rm 1800 (90,000 naira) but this new law only few have been aware and a friend of mine just fell victim of it.

Omo that one harsh oh, why the person go pay for ticket for em deportation and still go jail, wetin UN come dey do?
Re: Malaysian Government Out On Yahoo Yahoo Boys by koghuma: 2:10am On Nov 25, 2011
I have hotmail too, paste you Hot mail. IM
Re: Malaysian Government Out On Yahoo Yahoo Boys by Tegese: 2:24am On Nov 25, 2011
Ola Bamitu:

oboy yahoo-yahoo boys done put guy men for wahala. 3 days ago we get tori sey one darky hammer too much egunje from em yankee mugu. dem yarn d mugu sey dem get pay here and need to make the transfer to her, so unto lovina lovina, d babe come pay too much egunje of 500,000 yankee wey be almost 75 mila naija pay. trust our naija guys, instead of this guy to waka enter naija direct, em go gather guys from everywhere dey celebrate for restaurant becus em own share na 50 mila naija. (and the funny tin be sey, dis guys no go ever gree give you 50 naira, rada dem go spend 100,000 naira for drink for you and ashawo)
Na kasala don burst. the guys come tell the mugu sey after she don pay dat moni, sey malaysia eke hold am, omo na em the yankee mugu come go report to her govment, na em govment call US embassy for here to go reles their citizen and investigate the matter. only for dem to fin out sey no wite man, no money, sey na darky handwork.

dem catch the persin wey get d account wey dem take recive the egunje, d persin come yarn, na Malaysian govment reliz officers full everywhere dey go condo by condo and house by house dey burst houses, you get kpali or you no get, na enter you dey enter. dem even come dey catch guys wey get ugu for house and see guys dey chat life mugu and dere wite man face wey dem dey use, seize computers, printers, ugu, and more.

oboy no darky dey sleep for house na for malaysia. yesterday eke pursue us tire with bike and chains of handcuff, na inside forest i sleep, come back na come baf. as i dey end dis report na i dey go out again ready for outside run again.

shud dis be done to we that innocent, after all, they,ve gotten the culprit.

Omo na broken pidgin we go speak here, becus na yahoo yahoo mata be dis, make we no promote am for the foreign community to know much     
you sef you sure say you dey innocent?
Re: Malaysian Government Out On Yahoo Yahoo Boys by OAM4J: 4:06am On Nov 25, 2011
Tegese:

you sef you sure say you dey innocent?

Innocent ke?
Re: Malaysian Government Out On Yahoo Yahoo Boys by OlaBamitu: 7:39am On Nov 25, 2011
Broda dis bush we enta PASTOR folo us dey run enta am

I am sure very innocent. but its not all about being inocent or not. just seeing computer in your room (Just 1) every dey folo enta
Re: Malaysian Government Out On Yahoo Yahoo Boys by lovejo(m): 7:51am On Nov 25, 2011
Bro.
Is your laptop clean and do you have valid visa.
Re: Malaysian Government Out On Yahoo Yahoo Boys by OlaBamitu: 9:20am On Nov 25, 2011
yes
Re: Malaysian Government Out On Yahoo Yahoo Boys by justwise(m): 9:22am On Nov 25, 2011
lovejo:

Bro.
Is your laptop clean and do you have valid visa.

I guess if your lappy got some dodgy stuff even if its deleted then. . . you have alot to be afraid of.
Re: Malaysian Government Out On Yahoo Yahoo Boys by OlaBamitu: 9:58am On Nov 25, 2011
thats true
Re: Malaysian Government Out On Yahoo Yahoo Boys by DAY12(m): 11:28am On Nov 25, 2011
lylylylylyly, i dey laugh in malay!!!! grin

* run enter bush*
Re: Malaysian Government Out On Yahoo Yahoo Boys by 27naira(m): 1:32pm On Nov 25, 2011
Can someone correct the title of this post.

It should rather read "Malaysian Government out on Scammers " or maybe "Malaysian Government out on Ola Bamitu and Co."

e no get anything worth discussing on this issue, rather e dey make me dey shame the more.
Re: Malaysian Government Out On Yahoo Yahoo Boys by lovejo(m): 3:25pm On Nov 25, 2011
poster you are guilt has charged, grin grin grin grin grin

Learn to live where there are few blacks, or where the population of 9ja are not outrageous, i definitely know you are living in KEPONG, i read news everyday and this happens in Kepong.

Think of your safety and future before choosing to stay where you can be arrested base on concentration of black, no human right lawyer or public lawyer to fight for any innocent Nigeria.
They do not hate us because of scam, but because of our lack of ethics and no egards for simple law, common sense is not common among most 9ja here, i know what i'm saying. When Malaysian ranks the list of country with scam or doing dirty deals, Nigeria is not in the 1st ten, but Nigeria are the one living with high exotic lives, 9ja are the ones given the police man money without committing any crime, so now they have seen us as cash cow.


In anything you do, apply wisdom it helps a lot.
Re: Malaysian Government Out On Yahoo Yahoo Boys by wanaj0: 10:09am On Nov 27, 2011
Nigerians are loud and that is the major problem. And we believe that money is the ultimate.

Learnt most Nigerians are rushing to the embassy to claim that there passport is missing so that they can collect emergency travel certificate to travel home before things will get out of hand. Chuks for the embassy seems to be in the know of what is going on.

Anyway, yet to see any unusual movement for Mont Kiara.
Re: Malaysian Government Out On Yahoo Yahoo Boys by Nobody: 1:27pm On Nov 27, 2011
this story is fake which bush you dey sleep? and OP do you have right to enter bush legally in malay? as for me i did not see bush when i traveled to malay everywhere was full of skyscrapers and tall condos which bush?  where cctv no go pick you
Re: Malaysian Government Out On Yahoo Yahoo Boys by dustydee: 5:39pm On Nov 27, 2011
comeback home na?
Re: Malaysian Government Out On Yahoo Yahoo Boys by opiacino: 6:19pm On Nov 27, 2011
hahahaha, im white, yet I understood every word!
These yahoo guys deserve every bad ting they get!

(1) (2) (Reply)

Jaws: Divers Spots World's Largest White Shark 2.5tons In Hawaii(Pics) / Invalid / Change Of Name On Passport

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 52
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.