What Do You Like About Pidgin English?

A Member? Please Login  
type your username and password to login
Date: July 26, 2008, 08:48 PM
223902 members and 127246 Topics
Latest Member: sugared
Nairaland [Nigerian Forum] Home Help Search Who is currently online? Login Register
Nairaland Forum  |  General Discussion  |  Culture  |  What Do You Like About Pidgin English?
Pages: (1) (2) Go Down Send this topic Notify of replies
Author Topic: What Do You Like About Pidgin English?  (Read 1251 views)
bolex (m)
What Do You Like About Pidgin English?
« on: May 02, 2006, 03:18 PM »

1st

I go like to thank all the admins

Wey dey put ma threads for front page ,

E dey make me feel welcomed

Kiss Kiss Kiss Kiss Kiss :-*es in boku boku to all of una

Next , make I use this opportunity thank all ma fans   Grin (If I get any )

Wey dey reply ma posts

The first oga God , ,,,,, I hail you o

Say i dey get LOVE wherever I carry ma leg go

Oya, make una talk in pidgin o

Na wetin una like gan gan about the language

Me, I like pidgin because I am so used to it

I just love the way it sounds

It sometimes shows seriousness

Oya, isale EKO and waffi boiz et gals

Make una show una talent o

Kiss
bluenubian (f)
Re: What Do You Like About Pidgin English?
« #1 on: May 02, 2006, 03:25 PM »

me, as omo mushin, i go tell u why i like speak pidgin, when person speak pidgin, e dey make person feel like say them dey sing, abeg the grammar to sweet jare,
Roscodaddy (m)
Re: What Do You Like About Pidgin English?
« #2 on: May 02, 2006, 03:26 PM »

Bolex,you too much for this matte wey u carry come ground so,some people no dey even wan yarn this language ,them too form abeg carri go ,no bodi holy pass
bolex (m)
Re: What Do You Like About Pidgin English?
« #3 on: May 02, 2006, 03:28 PM »

Quote from: ROSCODADDY on May 02, 2006, 03:26 PM
Bolex,you too much for this matte wey u carry come ground so,some people no dey even wan yarn this language ,them too form abeg carri go ,no bodi holy pass

nothing dey happen ma brothers and sisters  Grin
Rhodalyn (f)
Re: What Do You Like About Pidgin English?
« #4 on: May 02, 2006, 03:29 PM »

hey!! bolex, You no they talk say i know pidgin past You??? lol  Cheesy Cheesy Cheesy Cheesy Cheesy Cheesy Cheesy Cheesy
lauryn (f)
Re: What Do You Like About Pidgin English?
« #5 on: May 02, 2006, 03:29 PM »

too bad i can't speak it well, but i love it still
bolex (m)
Re: What Do You Like About Pidgin English?
« #6 on: May 02, 2006, 03:31 PM »

Quote from: Rhodalyn on May 02, 2006, 03:29 PM
hey!! bolex, You no they talk say i know pidgin past You??? lol Cheesy Cheesy Cheesy Cheesy Cheesy Cheesy Cheesy Cheesy

sh*t

if someone told me in 10 years you can speak pidgin

I will bet ma life on it

 Shocked Shocked Shocked Shocked

how surprising

you seemd oyinbo to me

na good thing o

bluenubian (f)
Re: What Do You Like About Pidgin English?
« #7 on: May 02, 2006, 03:31 PM »

catch da vibe, get the feeling ( always wanted to say that)
Rhodalyn (f)
Re: What Do You Like About Pidgin English?
« #8 on: May 02, 2006, 03:31 PM »

i can't speak it too but i just say anything, really Cheesy Cheesy Cheesy Cheesy Cheesy
bolex (m)
Re: What Do You Like About Pidgin English?
« #9 on: May 02, 2006, 03:33 PM »

Quote from: Rhodalyn on May 02, 2006, 03:31 PM
i can't speak it too but i just say anything, really Cheesy Cheesy Cheesy Cheesy Cheesy

I thought as much  Grin
bluenubian (f)
Re: What Do You Like About Pidgin English?
« #10 on: May 02, 2006, 03:33 PM »

ok nna, i don tire for nairaland, remain small make i peme, abeg make i carry my nyash go sleep, una too too much for your pikin. i go catch una after later    Grin
Rhodalyn (f)
Re: What Do You Like About Pidgin English?
« #11 on: May 02, 2006, 03:34 PM »

Quote from: bolex on May 02, 2006, 03:31 PM
sh*t

if someone told me in 10 years you can speak pidgin

I will bet ma life on it

 Shocked Shocked Shocked Shocked

how surprising

you seemd oyinbo to me

na good thing o

wetin go make You do that bolex Grin helpppp im short for pidgin lol Cheesy Cheesy Cheesy Cheesy how embarrassing! Embarrassed Cheesy Cheesy
Rhodalyn (f)
Re: What Do You Like About Pidgin English?
« #12 on: May 02, 2006, 03:35 PM »

Quote from: bolex on May 02, 2006, 03:33 PM
I thought as much Grin
so You think sey i no sabi pidgin language ebi so??? Angry Cheesy Cheesy Cheesy Cheesy
Outkast (f)
Re: What Do You Like About Pidgin English?
« #13 on: May 02, 2006, 04:04 PM »

rho una dey speak pidgin for ghana?
me i just like the language sha, when my cousins for benin dey talk am, d thing just dey sweet me bele,
Rhodalyn (f)
Re: What Do You Like About Pidgin English?
« #14 on: May 02, 2006, 04:13 PM »

l.o.l Outkast Cheesy Cheesy Cheesy Cheesy i no think sey You sabi pidgin language Cheesy Cheesy Cheesy Cheesy i fi think sey it only be blee
Outkast (f)
Re: What Do You Like About Pidgin English?
« #15 on: May 02, 2006, 04:16 PM »

my dear i sabi am well well oh!
even though popsy no dey like when i dey talk am, sha me i no send.
diddy4 (m)
Re: What Do You Like About Pidgin English?
« #16 on: May 02, 2006, 04:29 PM »

i get am for pidgin, i get am for english, i come get am for french, anyone wey come my way, i speak dey go, no yawa, no nkwobi, pidgin na the second official language wey we get for naija. who no kno go know later. wetin people dey yarn sey dey no fit speak am well, pidgin no get past tense and present tense just speak the thing they carry go person no dey look your face, na the only language wey u fit spark and make mistake, people go still clap for you for spoking correctly. abi nobi so?  Cheesy Cheesy Cheesy
Outkast (f)
Re: What Do You Like About Pidgin English?
« #17 on: May 02, 2006, 04:30 PM »

na so o! my bros, na so
Christino (m)
Re: What Do You Like About Pidgin English?
« #18 on: May 02, 2006, 04:34 PM »

Omo, e be like say na here una dey run things, infact na here be koboland, leave naira for them aje wey dey form. Na we we dey here, and i dey sign in, life. As you see my name sef, me man i be born, bred and unbuttered lagosian from the roots of Agege.
God dey with us now that na why we just dey kampe and to all them ajes wey dey beef us, no be say we poor o, we no just dey show ourself.
Wetin dey pan, notin dey, yan me tori no yan me rubbish. E go be.
my2cents (m)
Re: What Do You Like About Pidgin English?
« #19 on: May 02, 2006, 06:37 PM »

- I like the fact sey I fit dey talk to fellow naija among oyibo and them no sabi wetin I dey talk about

- I also like the fact sey when I dey naija, I fit blend in.  Most people dey even swear say I never leave lagos sef  Grin
tinky (f)
Re: What Do You Like About Pidgin English?
« #20 on: May 02, 2006, 07:12 PM »

Omo e no good as we come jabo them akatas. Dem go jus dey wonder say na wetin be this rubbish wey this people dey yarn. But d tin be say them never soji say na our 2nd language be this. I dey gbadun d tin when them wafi dey speak am. Pesin wey wan form say im no fit speak am, make im commot 4 naija. As i be like this na half of my life i spend for ikoyi, but i no fit dey form island chic say because i don live 4 ikoyi 4 many years before make i come dey form, lailai 4 why? Naija chic 4 life. No lele.
Christino (m)
Re: What Do You Like About Pidgin English?
« #21 on: May 02, 2006, 07:31 PM »

 Shocked
lauryn (f)
Re: What Do You Like About Pidgin English?
« #22 on: May 02, 2006, 09:05 PM »

@ didy4dt
lmao
hot-angel (f)
Re: What Do You Like About Pidgin English?
« #23 on: May 02, 2006, 09:41 PM »

My mummy and daddy taught me not to speak pidgin english.

it shows that you are an "omota" if you speak it. I don't like to interact with people that speak pidgin. I mean, when i see them, im like,  WHy do you have to talk like that? Can u not use good phonetics? Speak good english.

I always pray for anyone who speaks pidgin, and i want to use this opportunity to say.

Wetin dey shele my people/ infact ehn this thread na the baba of all the other thread wey i been don dey see for hia. The reason wey me like to dey talk to pidgin be say, e sweet well well, that is to say, pidgin na better language, when i dey speak am, my belle go just dey do me sweet sweet. Like say i dey on top of this world.

Neways sha, wetin make bolex start this topic sef? Well sha,  oo, person wey no fit pidgin don lost teee teee. Abeg find yourself oo!
bolex (m)
Re: What Do You Like About Pidgin English?
« #24 on: May 02, 2006, 09:43 PM »

Quote from: hot-angel on May 02, 2006, 09:41 PM

obedient child

i can see you obeying your mum & dad well

you this omo ita

lol

 Cool

**sikes now  Wink
diddy4 (m)
Re: What Do You Like About Pidgin English?
« #25 on: May 03, 2006, 02:08 AM »

Quote from: hot-angel on May 02, 2006, 09:41 PM
My mummy and daddy taught me not to speak pidgin english.

it shows that you are an "omota" if you speak it. I don't like to interact with people that speak pidgin. I mean, when i see them, im like, WHy do you have to talk like that? Can u not use good phonetics? Speak good english.

I always pray for anyone who speaks pidgin, and i want to use this opportunity to say.

Wetin dey shele my people/ infact ehn this thread na the baba of all the other thread wey i been don dey see for hia. The reason wey me like to dey talk to pidgin be say, e sweet well well, that is to say, pidgin na better language, when i dey speak am, my belle go just dey do me sweet sweet. Like say i dey on top of this world.

Neways sha, wetin make bolex start this topic sef? Well sha, oo, person wey no fit pidgin don lost teee teee. Abeg find yourself oo!

you, this girl. you are one funny character.  Grin Grin Grin
hot-angel (f)
Re: What Do You Like About Pidgin English?
« #26 on: May 03, 2006, 02:18 AM »

Quote from: didy4dt on May 03, 2006, 02:08 AM

you, this girl. you are one funny character.  Grin Grin Grin

Ohh u think so?
freddie! (m)
Re: What Do You Like About Pidgin English?
« #27 on: May 03, 2006, 07:48 PM »

Pidgin english makes it easier for you to express somethings aptly! Make una no vex say na grammatical i dey take hala una o! Grin
zionchic (f)
Re: What Do You Like About Pidgin English?
« #28 on: May 03, 2006, 09:04 PM »

i see say una dey flex on this site, actually that was a solid line hot-angel, u took all the vibes from my mouth. well bros and sis mii like pidgen b'because na the only tin wey dey make mii jell wit pesin from naija and he dey amaze my pallies whey bin dey this side, pidgin na da tin but as hot- angel talk like joke like joke why parents dey wahala them pickin them se make them no talk this language na forming abi wetin?
dominobaby (f)
Re: What Do You Like About Pidgin English?
« #29 on: May 03, 2006, 09:22 PM »

Ma piple, i hail una o. Bolex, baba God go butter ya bread 4 ds tin wey u start 4 here. Person wey no fit tok pidgin no jus try at al. Pidgin english na d way 2 yarn wetin u wan yarn witout yawa. D lang. dey sweet me so tey, if i wan send txt or drop message on paper 4 ma siblings or pallys, na pidgin i dey use! I too like am.
bolex (m)
Re: What Do You Like About Pidgin English?
« #30 on: May 04, 2006, 11:31 AM »

pidgin should be in the dictionary

damn ,  me love it

i can't stop thinking of how to speak it

Grin

na the thing be that o

nuttin dey happen

no kain

but , seriously .,,,, i always used to think it's some omo ita language

until i cd not get it off ma mouth

ma whole children must speak it

ma generation sef if possible

e no easy o

Cool
lovely_S (m)
Re: What Do You Like About Pidgin English?
« #31 on: May 04, 2006, 01:07 PM »

Well done ma burothers and sisiters make una pardon me for my lateness.i be don come bfor now but ma Boss dey delay me for office.but now i don come.And i go like make i tell una the Origin or make i call am History of pidgin English.
                                    THE HISTORY OF PIDGEN ENGLISH
In 1817,Wen head still dey for knee,Dat time Wey Oyibo Dem (Biritsh oyibos) first com nigeria (na Lagos them follow enter nigeria them no sey if them folow east enter peren them no go return 2 der country in peace because them YIBO go finish them in two days)(no be mi talk am o,na histiri oooo).So as Dem enta Lagos them go strait to Oba of Lagos, Oba ***Hmmm (i no remember in Name) na in them com dey talk in English sey  "GOOD EVENING SIR"He no answer,there leader com begin dey introdus ihnsef sey"MY NAME IS SAMUEL HUGHES AND ME AND MY PEOPLE ARE HERE TO MAKE YOUR COUNTRY A BETTER PLACE FOR EVERYONE AND IT WILL BE GOOD FOR YOU IF YOU AND YOUR PEOPLE CAN CORPORATE WITH US''(Our king no gree respond).And he(Dem leader) begin dey ask question again say  "WHAT ARE YOUR ACHIEVEMENTS SINCE YOU HAVE BEEN ON THE THRONE ?" and  "SINCE WHEN HAVE YOU BEEN ON THE THRONE ?"no response from De King or any of him people,  to Dem suprise,Dem no hear sey King talku na in Dem com conclud sey Our king no hear All De grammer them dey blow.

As Dem Oyinbos don kno sey our king or any of De vilagers no hear all De bigie-bigie grammer wey them dey talk Na hin them com conclud sey na from language them go take stat de divelopment.Ne hin Den com do miting among Demself sey them go send one person from  lagos go Biritain make e go len good-good English,so that He go dey interpret De Big-big grammer to De king and him people.But make una com see wetin hapen o.As Dem prisent De idea give The King of Lagos(Dem take hand and dey even use drawing to tell am)Dat dey wan send one or two of hin people go dere country to len English so that he go dey interpret to them na hi King.At first De king no gree,he even vess sey them go fite dose oyinbos and even declear War agaist them.But make You trust Oyinbo people,na hin Dem cary some of De youth and som men wey Dem kno say them fit cause trouble put inside cell.Na Him the King com surrender say hin done gree and he even good sef make them choose any poeple them like among the poeple of the communty.

THE END

I beg my people na here part 1 of the torey go End make Una no Vess.

And Anibodi way want make i continue, Talk Am Make I yea You !!!

I LOVE You ALL !!! i no kno' how them dey talk that one for pidgen Englis(h)
 
  Time To Abolish Dowry  They Want No Gifts At Their Wedding!  Funny/Silly Superstitious Beliefs You've Heard/Believe!  Page 2
Pages: (1) (2) Go Up Send Topic to Friend by E-mail Reply 
Google
 
Web www.nairaland.com
Sections: TV/Movies (2) Music/Radio (2) Celebrities Jobs (2) Career Romance Books Politics Sports Fashion Travel
Health Schooling Religion General(2) Business Webmaster Programming Computers Phones Cars & Trucks

Links: Page1 Page2 Page3 Page4 Page5 Page6 Page7 Page8 Page9 Page10

Nairaland is owned by Oluwaseun Osewa
Nairaland Forum | Powered by SMF 1.0.12.
© 2001-2005, Lewis Media. All Rights Reserved.