Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,194,844 members, 7,956,170 topics. Date: Monday, 23 September 2024 at 06:44 AM |
Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / What Do You Like About Pidgin English? (5284 Views)
Nigeria Pidgin Proverbs & Their Meanings / What Are The Things You Like About Other Ethnic Groups And Tribes? / Nigerian Pidgin English And Their Meanings (2) (3) (4)
What Do You Like About Pidgin English? by bolex(m): 3:18pm On May 02, 2006 |
1st I go like to thank all the admins Wey dey put ma threads for front page , E dey make me feel welcomed es in boku boku to all of una Next , make I use this opportunity thank all ma fans (If I get any ) Wey dey reply ma posts The first oga God , ,,,,, I hail you o Say i dey get LOVE wherever I carry ma leg go Oya, make una talk in pidgin o Na wetin una like gan gan about the language Me, I like pidgin because I am so used to it I just love the way it sounds It sometimes shows seriousness Oya, isale EKO and waffi boiz et gals Make una show una talent o |
Re: What Do You Like About Pidgin English? by bluenubian(f): 3:25pm On May 02, 2006 |
me, as omo mushin, i go tell u why i like speak pidgin, when person speak pidgin, e dey make person feel like say dem dey sing, abeg the grammar to sweet jare, |
Re: What Do You Like About Pidgin English? by Roscodaddy(m): 3:26pm On May 02, 2006 |
Bolex,you too much for this matte wey u carry come ground so,some people no dey even wan yarn this language ,dem too form abeg carri go ,no bodi holy pass |
Re: What Do You Like About Pidgin English? by bolex(m): 3:28pm On May 02, 2006 |
ROSCODADDY: nothing dey happen ma brothers and sisters |
Re: What Do You Like About Pidgin English? by Rhodalyn(f): 3:29pm On May 02, 2006 |
hey!! bolex, U no they talk say i know pidgin past U lol |
Re: What Do You Like About Pidgin English? by lauryn(f): 3:29pm On May 02, 2006 |
too bad i cant speak it well, but i luv it still |
Re: What Do You Like About Pidgin English? by bolex(m): 3:31pm On May 02, 2006 |
Rhodalyn: sh*t if someone told me in 10 years you can speak pidgin I will bet ma life on it how surprising you seemd oyinbo to me na good thing o |
Re: What Do You Like About Pidgin English? by bluenubian(f): 3:31pm On May 02, 2006 |
catch da vibe, get the feeling ( always wanted to say that) |
Re: What Do You Like About Pidgin English? by Rhodalyn(f): 3:31pm On May 02, 2006 |
i cant speak it too but i just say anything, really |
Re: What Do You Like About Pidgin English? by bolex(m): 3:33pm On May 02, 2006 |
Rhodalyn: I thought as much |
Re: What Do You Like About Pidgin English? by bluenubian(f): 3:33pm On May 02, 2006 |
ok nna, i don tire for nairaland, remain small make i peme, abeg make i carry my nyash go sleep, una too too much for ur pikin. i go catch una after later |
Re: What Do You Like About Pidgin English? by Rhodalyn(f): 3:34pm On May 02, 2006 |
bolex:wetin go make U do that bolex helpppp im short for pidgin lol how embarrassing! |
Re: What Do You Like About Pidgin English? by Rhodalyn(f): 3:35pm On May 02, 2006 |
bolex:so U think sey i no sabi pidgin language ebi so |
Re: What Do You Like About Pidgin English? by Outkast(f): 4:04pm On May 02, 2006 |
rho una dey speak pidgin for ghana? me i just like the language sha, when my cousins for benin dey talk am, d thing just dey sweet me bele, |
Re: What Do You Like About Pidgin English? by Rhodalyn(f): 4:13pm On May 02, 2006 |
l.o.l Outkast i no think sey U sabi pidgin language i fi think sey it only be blee |
Re: What Do You Like About Pidgin English? by Outkast(f): 4:16pm On May 02, 2006 |
my dear i sabi am well well oh! even though popsy no dey like when i dey talk am, sha me i no send. |
Re: What Do You Like About Pidgin English? by diddy4(m): 4:29pm On May 02, 2006 |
i get am for pidgin, i get am for english, i come get am for french, anyone wey come my way, i speak dey go, no yawa, no nkwobi, pidgin na the second official language wey we get for naija. who no kno go know later. wetin people dey yarn sey dey no fit speak am well, pidgin no get past tense and present tense just speak the thing they carry go person no dey look your face, na the only language wey u fit spark and make mistake, people go still clap for you for spoking correctly. abi nobi so? |
Re: What Do You Like About Pidgin English? by Outkast(f): 4:30pm On May 02, 2006 |
na so o! my bros, na so |
Re: What Do You Like About Pidgin English? by Christino(m): 4:34pm On May 02, 2006 |
Omo, e be like say na here una dey run things, infact na here be koboland, leave naira for dem aje wey dey form. Na we we dey here, and i dey sign in, life. As you see my name sef, me man i be born, bred and unbuttered lagosian from the roots of Agege. God dey with us now dat na why we just dey kampe and to all dem ajes wey dey beef us, no be say we poor o, we no just dey show ourself. Wetin dey pan, notin dey, yan me tori no yan me rubbish. E go be. |
Re: What Do You Like About Pidgin English? by my2cents(m): 6:37pm On May 02, 2006 |
- I like the fact sey I fit dey talk to fellow naija among oyibo and dem no sabi wetin I dey talk about - I also like the fact sey when I dey naija, I fit blend in. Most pple dey even swear say I neva leave lagos sef |
Re: What Do You Like About Pidgin English? by tinky(f): 7:12pm On May 02, 2006 |
Omo e no good as we come jabo dem akatas. Dem go jus dey wonder say na wetin be dis rubbish wey dis people dey yarn. But d tin be say dem never soji say na our 2nd language be dis. I dey gbadun d tin wen dem wafi dey speak am. Pesin wey wan form say im no fit speak am, make im commot 4 naija. As i be like dis na half of my life i spend for ikoyi, but i no fit dey form island chic say because i don live 4 ikoyi 4 many years b4 make i come dey form, lailai 4 why? Naija chic 4 life. No lele. |
Re: What Do You Like About Pidgin English? by Christino(m): 7:31pm On May 02, 2006 |
Re: What Do You Like About Pidgin English? by lauryn(f): 9:05pm On May 02, 2006 |
@ diddy4dt lmao |
Re: What Do You Like About Pidgin English? by hotangel2(f): 9:41pm On May 02, 2006 |
My mummy and daddy taught me not to speak pidgin english. it shows that you are an "omota" if you speak it. I dont like to interact with people that speak pidgin. I mean, when i see them, im like, WHy do you have to talk like that? Can u not use good phonetics? Speak good english. I always pray for anyone who speaks pidgin, and i want to use this opportunity to say. Wetin dey shele my people/ infact ehn this thread na the baba of all the other thread wey i been don dey see for hia. The reason wey me like to dey talk to pidgin be say, e sweet well well, dat is to say, pidgin na better language, when i dey speak am, my belle go just dey do me sweet sweet. Like say i dey on top of this world. Neways sha, wetin make bolex start this topic sef? Well sha, oo, person wey no fit pidgin don lost teee teee. Abeg find urself oo! |
Re: What Do You Like About Pidgin English? by bolex(m): 9:43pm On May 02, 2006 |
hot-angel: obedient child i can see you obeying your mum & dad well you dis omo ita lol **sikes now |
Re: What Do You Like About Pidgin English? by diddy4(m): 2:08am On May 03, 2006 |
hot-angel: you, this girl. you are one funny character. |
Re: What Do You Like About Pidgin English? by hotangel2(f): 2:18am On May 03, 2006 |
diddy4dt: Ohh u think so? |
Re: What Do You Like About Pidgin English? by freddie1(m): 7:48pm On May 03, 2006 |
Pidgin english makes it easier for you to express somethings aptly! Make una no vex say na grammatical i dey take hala una o! |
Re: What Do You Like About Pidgin English? by zionchic(f): 9:04pm On May 03, 2006 |
i see say una dey flex on dis site, actually dat was a solid line hot-angel, u took all the vibes from my mouth. well bros and sis mii like pidgen b'cos na the only tin wey dey make mii jell wit pesin 4rm naija and he dey amaze my pallies whey bin dey dis side, pidgin na da tin but as hot- angel talk like joke like joke why parents dey wahala dem pickin dem se make dem no talk dis language na forming abi wetin? |
Re: What Do You Like About Pidgin English? by dominobaby(f): 9:22pm On May 03, 2006 |
Ma piple, i hail una o. Bolex, baba God go butter ya bread 4 ds tin wey u start 4 here. Person wey no fit tok pidgin no jus try at al. Pidgin english na d way 2 yarn wetin u wan yarn witout yawa. D lang. dey sweet me so tey, if i wan send txt or drop message on paper 4 ma siblings or pallys, na pidgin i dey use! I too like am. |
Re: What Do You Like About Pidgin English? by bolex(m): 11:31am On May 04, 2006 |
pidgin should be in the dictionary damn , me love it i cant stop thinking of how to speak it na the thing be dat o nuttin dey happen no kain but , seriously .,,,, i always used to think it's some omo ita language until i cd not get it off ma mouth ma whole children must speak it ma generation sef if possible e no easy o |
Re: What Do You Like About Pidgin English? by lovelyS(m): 1:07pm On May 04, 2006 |
Well done ma burothers and sisiters make una pardon me for my lateness.i be don come bfor now but ma Boss dey delay me for office.but now i don come.And i go like make i tell una the Origin or make i call am History of pidgin English. THE HISTORY OF PIDGEN ENGLISH In 1817,Wen head still dey for knee,Dat time Wey Oyibo Dem (Biritsh oyibos) first com nigeria (na Lagos dem follow enter nigeria dem no sey if them folow east enter peren dem no go return 2 der country in peace because dem Igbo go finish them in two days)(no be mi talk am o,na histiri oooo).So as Dem enta Lagos dem go strait to Oba of Lagos, Oba ***Hmmm (i no remember in Name) na in dem com dey talk in English sey "GOOD EVENING SIR"He no answer,there leader com begin dey introdus ihnsef sey"MY NAME IS SAMUEL HUGHES AND ME AND MY PEOPLE ARE HERE TO MAKE YOUR COUNTRY A BETTER PLACE FOR EVERYONE AND IT WILL BE GOOD FOR YOU IF YOU AND YOUR PEOPLE CAN CORPORATE WITH US''(Our king no gree respond).And he(Dem leader) begin dey ask question again say "WHAT ARE YOUR ACHIEVEMENTS SINCE YOU HAVE BEEN ON THE THRONE ?" and "SINCE WHEN HAVE YOU BEEN ON THE THRONE ?"no response from De King or any of him people, to Dem suprise,Dem no hear sey King talku na in Dem com conclud sey Our king no hear All De grammer dem dey blow. As Dem Oyinbos don kno sey our king or any of De vilagers no hear all De bigie-bigie grammer wey dem dey talk Na hin dem com conclud sey na from language dem go take stat de divelopment.Ne hin Den com do miting among Demself sey dem go send one person from lagos go Biritain make e go len good-good English,so dat He go dey interpret De Big-big grammer to De king and him people.But make una com see wetin hapen o.As Dem prisent De idea give The King of Lagos(Dem take hand and dey even use drawing to tell am)Dat dey wan send one or two of hin people go dere country to len English so dat he go dey interpret to dem na hi King.At first De king no gree,he even vess sey dem go fite dose oyinbos and even declear War agaist them.But make U trust Oyinbo people,na hin Dem cary some of De youth and som men wey Dem kno say dem fit cause trouble put inside cell.Na Him the King com surrender say hin done gree and he even good sef make them choose any poeple them like among the poeple of the communty. THE END I beg my people na here part 1 of the torey go End make Una no Vess. And Anibodi way want make i continue, Talk Am Make I yea U !!! I LOVE U ALL !!! i no kno' how dem dey talk dat one for pidgen Englis(h) |
Thousands Of Topless Swaziland's Virgins Dance For King To Celebrate Womanhood / Does A Person Die When A Star Falls From The Sky? / Marrying Any Black Woman Is A Big Responsibilty!
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 53 |