Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,166,326 members, 7,864,568 topics. Date: Tuesday, 18 June 2024 at 08:44 PM

Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi - Literature (16) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi (318266 Views)

Life Of A Rugged Guy +21 / Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi / I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (13) (14) (15) (16) (17) (18) (19) ... (51) (Reply) (Go Down)

Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(m): 10:26am On Aug 01, 2018
fabianiweka:
5 star hotel no be name ooo
Tell us the name of the hotel
Up date fast before I go lost temperature give up


gbosaa! for u my man

i been dey expect am,but the gbeduness of the whole tori nor just gree dem see mistakesgrin

i go halla the name next time

fabian and suit classic hotelgringringrin
i nor go schoolsmileywell

1 Like

Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Holywizard: 10:38am On Aug 01, 2018
Ride on bro
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Horlaslim(m): 11:10am On Aug 01, 2018
YoungZubi update this tori fast abeg
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Ohidata: 12:38pm On Aug 01, 2018
Youndzubi, you do well. Abeg do update nah. See as I hold my phone dey wait update
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by muzzybest713: 1:49pm On Aug 01, 2018
Youngzubi you have made a fool of me, see as a grown up man like me just dey laugh mumu laugh for shop since morning, Nna ur head dey there more ink to ur pen
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(m): 3:13pm On Aug 01, 2018
episode...............20


nothing good comes easy
----------------------------------
terms and condition dey always apply
----------------------------------------




i later reach house that evening,as i shuk head enter compound the first peson i jam nah sentino,omo the guy carry one babe like dat,nobi maya,this one yellow like roasted plantain,that kin yellow wey breaching cream dey give,upon say nah evening her fake colour still stand out like gorilla



spana!"my guy long time no see........sentino yan as him leave the fake coloured girl come meet me for wia i stand



senty baba!,see as u just dey fresh,ah ah!,bros tell me watin u dey chop nah..........i yan as we shake hand



ah! my guy i been dey think say i don fade finish o!,bros i don loose my job,asin as i dey so eh!,i nor just won trouble my life again,nah to begin enjoy the one wey i don hustle get,at least i get 4 boutiques wey dey supply me income so i still dey pop!...........sentino yan



ehyyaaa! no worry my guy,see eh! e get one better job wey i go connect u join,as i dey reason u so eh!,i nor go stay for this house pass this week,asin level don change like APC,i don dey hama die!........i yan sentino



shey nah G level?........sentino ask



no! nobi yahoo matter o!,this one nah sure link,..........i yan



oya yan me full gist nah,as i dey so,i no fit wait to turn lagos big boy,all my mate dem,we all graduate at thesame time,guy last time i sight three of them,nah my boy dem dey call me,even bouncers dey follow dem for back sef,infact nah becos say i begin change am for dem inside bank when one of dem come deposited cash nahim we manage sack me,as my sure guy for school back then,i been dey greet Am as my personal person nahim the goat come dey bushit me,him just ignore me,omo e pain me reach bone o!,as i begin para for am nahim manager vex come carry sack letter dash me......."sentino yan



ha! how come u nor dey vex asin u sound happy upon say dem sack u...........i yan onto say sentino just dey smile as him dey talk




vex for watin? bros i won blow,bank work nor fit waya me the kin money i been dey expect.....sentino yan



ok nah,no just worry i get the solution,so wia una dey go,i mean u and this ya fine babe.....i yan


ah! nah outing o!,dem two sef but one still dey dress inside,i won carry dem go shayo for bar before dem go come cool my day for house"wink".....sentino yan



ehn! dat means say i go follow una,since dem two at least u go hand over the one wey dey inside to me nah........i yan




anything for my man,but the problem be say,their price too cost o!........sentino yan



price ke!'" if their generation nah for sale i go buy dem village people join.........i yan




hahaha!!!!!,u too funny o!,but nah 25k per night so two of.dem nah 50k........sentino yan



u dey mad!!!!........i yan



ah! nor vex bros shebi i tell u,their price high..........sentino yan



ooooo!! why this guy come dey insult me like this nah,see senty........i yan



yes bros....sentino yan




i go pay dem 200k each,no i go pay the one wey i go carry 250,but we go dey drain dem till we tire i yan as the one wey been stand with sentino begin waka come meet me



Jenny wia u think say u dey go!!.....the olosho wey dey inside shout as she jump outside


i go burst ya brain die she yan to me as she near me........sentino babe


dem never born u well Jenny,u don craze abi,watin make u leave sentino wey una two dey before,nah my own man nahim u won come swap,see i dey inside dey hear everything so go meet sentino and leave this bros for me becos na me he suppose be with........the olosho wey been dey dress inside shout on her fellow olosho friend as she begin drag her back



chisos ! i shout for my head as i sight the olosho,Chai her own bleaching nahim worst,come see colour riot,e be like say nah expired breaching cream she use



like play like play,dem begin fight,trust all this aje-pkako ashawo,almost say nah nylon dem wear nah dia clothes dey first tear into puzzle


gidi gidi gidi!! dem upgrade their madness as dem begin tear their bra,by then all the tenant don dey rush outside


waaa!! their pant reach ground as dem begin wrestle,abuse just dey fly comot for dia mouth like testimony,as one of dem bend down to grab the other for leg nahim she tear nyash open omo come see as her yansh take black like pot e come be like say nepa take like for dat side as everybody wey dey inside we compound shout iyee paa!!! blackout le leyi o!!!
cream nor reach dia!!!!!



trust naija youths instead make dem go separate dem nah their phone camera dey do work as some dey snap while some dey video



the fight tey!! till our landlord waka com out nahim tenants pocket their phone as dem begin run go separate dem




later later,dem go borrow rapper from neighbors nahim dem tie go back to their joint wia they from come


i look around from wia i stand,omo sentino nor dey around at all,nah when i sight maya her babe for gate i know say my guy eye sharp gan!,



spana!......peson call me

i turn as i sight oga landlord, he use him hand signal me to come


goodevening oga landlord......i greet as i near him

how are u.....oga landlord yan


fine sir o!,how body.......i yan


body dey under clothes,ehen! spana howfar about our discussion........oga landlord yan


oh! i don forget o!,but i get her number here,the thing be say i nor fit give out the number but i go use my phone call am then u go follow am talk......i yan



ok thats alright.....oga landlord yan


em! oga landlord....i yan

yess.......he yan

e get watin i won follow u talk o,.......i yan

ehn! oya make we enter house.....he yan as i follow am,we begin waka enter him house wen i hear gate sound,i turn as i sight spata with him lady friend


spana!......spata yan

i nor even ahswear him,i just troy my house key for am then waka enter oga landlord parlour



so watin u won discuss with me......oga landlord yan as we settle for one big couch



em! sir i been dey fin better duplex wey i go buy,so i won know if u get any one abi i should use my agent........i yan


house?,duplex?.........oga landlord yan



yes house duplex even complex,why u come dey surprise abi i too small to buy house?......i yan



no! o! thats not the case young man,u are full grown up man thats true,but why the sudden need to purchase a house?......oga landlord yan,the thing vex me die!! as i stand up

goodnight sir!.......i yan as i waka comot

spana come!!!,dont misunderstand me o!.........he yan but i don enter compound sef


i waka near my door,but e don lock from inside so i begin nock,omo i nock tire! as i begin wonder if spata still dey alive




u go wait small abeg!!!.......i hear spata voice shout from inside


spata u dey craze??

for wia i nor even hear pkakam again,nah just woman sound i dey hear small,so i kukuma go find better chair sidon for frontage nahim my phone begin ring


hello ma!........i yan


spana!,bravo! what a good start,now that u av proved strong and reliable,i would need u to get more four able bodied guys,once its done give me a call......big mama yan for phone


ehn!,ok nah,hwfar about ya percentage.........i yan


for a start just keep all the money,u will be needing even more so as to get your guys gingered,make sure u get well trusted guys people u sabi well well,so take ur time and get dem,u and spata should work hand in hand.........she yan



ok no le'le mama after u na u o!!....i yan


good bye...........she yan and cut the phone




hmmm! something dey smell o!,e dey sound like gang o!,no le'le sha!,after all nothing good comes easy,man gat to hustle,man gat to hama!!




how far my guy,so u still dey plan to hama!,when i don dey count millions..........spata yan as him wear only boxers come join me for wia ahsidon



i look am as i unlock my phone the open my message alert show am




whaaaaat!!!!! spana!
nah wia u from jam this kin currency,ah spana my boss i hail thee o!.........spata yan as him continue dey look my phone


howfar guys sentino yan as him join us





to be continued

5 Likes

Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by IAmXcessiz(m): 4:15pm On Aug 01, 2018
How far oga DPO.... He don run comot for house??
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Speakout03: 4:23pm On Aug 01, 2018
Spata never see notin, well done
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by WILLIAMSKECH: 4:32pm On Aug 01, 2018
Confirm tori, abeg update. ⓑⓤⓣ ⓘ ⓢⓔⓔ ⓢⓞⓜⓔⓣⓗⓘⓝⓖ ⓑⓐⓓ ⓘⓢ ⓐⓑⓞⓤⓣ ⓣⓞ ⓗⓐⓟⓟⓔⓝ.
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Nobody: 5:09pm On Aug 01, 2018
This man, I'm still loyal to ur government. Youngzubi u b Baba!!!
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by wizsolzy(m): 7:34pm On Aug 01, 2018
Wahala boss dis ur ogbonge tori na block. Laugh won kill me for were I dey smoke my pkoli. My niggas come dey say pkoli done make me crase..
In kiss daniels voice ..baba.... cheesy grin
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(m): 9:11pm On Aug 01, 2018
muzzybest713:
Youngzubi you have made a fool of me, see as a grown up man like me just dey laugh mumu laugh for shop since morning, Nna ur head dey there more ink to ur pen




thank u brotherly,nah for u to laugh and be happy make me write the story so baff am!!!grin
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(m): 9:13pm On Aug 01, 2018
WILLIAMSKECH:
Confirm tori, abeg update. ⓑⓤⓣ ⓘ ⓢⓔⓔ ⓢⓞⓜⓔⓣⓗⓘⓝⓖ ⓑⓐⓓ ⓘⓢ ⓐⓑⓞⓤⓣ ⓣⓞ ⓗⓐⓟⓟⓔⓝ.

thanks our over seer grin
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(m): 9:15pm On Aug 01, 2018
007Nonny:
This man, I'm still loyal to ur government. Youngzubi u b Baba!!!


i sight u manly tem! tem! no le'le!
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(m): 9:18pm On Aug 01, 2018
wizsolzy:
Wahala boss dis ur ogbonge tori na block. Laugh won kill me for were I dey smoke my pkoli. My niggas come dey say pkoli done make me crase..
In kiss daniels voice ..baba.... cheesy grin



aaaaaaaaaaaaaaaaaahhhhhhhhh!!!!! and i been reason am say i nor go puff!!! jombo today eh!,see as this ya comment make me begin rap papersmiley nbanu make i sechara! only one bo!!
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by blazebaba(m): 9:35pm On Aug 01, 2018
By
Youngzubi:



olodogrin nah me and u dey carry zero over 13 for maths dat time but i been reason am say u for don sabi small by now

500+200=800 smiley

bros e be like say na ya phone type by him sefgrin

you for just call me for phone nao angry
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by zeezeegal(m): 10:00pm On Aug 01, 2018
Present
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by ngenec: 11:10pm On Aug 01, 2018
This story is very very intriguing
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(m): 3:47am On Aug 02, 2018
blazebaba:
By
you for just call me for phone nao angry

no vex as ya number no dey go nahim make ah halla u here my man
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by fabianiweka: 4:27am On Aug 02, 2018
The olosho yash black like nepa carry light
The yash na city
Oya kwantinue
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by wizsolzy(m): 7:40am On Aug 02, 2018
Youngzubi:




aaaaaaaaaaaaaaaaaahhhhhhhhh!!!!! and i been reason am say i nor go puff!!! jombo today eh!,see as this ya comment make me begin rap papersmiley nbanu make i sechara! only one bo!!

After you na you again cheesy wink
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Johnsown1(m): 8:16am On Aug 02, 2018
wizsolzy:


After you na you again cheesy wink
Baba how far where is Ur guy
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by punter9(m): 8:29am On Aug 02, 2018
Safi abi na wafi. Your tori funny die. My G kwantinue. Brotherly you teeth complete.
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by wizsolzy(m): 8:38am On Aug 02, 2018
Johnsown1:

Baba how far where is Ur guy
Baba I no know where my bro ikombe enter oo. undecided
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Johnsown1(m): 9:13am On Aug 02, 2018
wizsolzy:

Baba I no know where my bro ikombe enter oo. undecided
Maybe he is in IDP camp, ikombe
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by wizsolzy(m): 9:26am On Aug 02, 2018
Johnsown1:

Maybe he is in IDP camp, ikombe

No ooooooo my guy dey Sabimsa forest dey fight bokoharam grin
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Johnsown1(m): 9:29am On Aug 02, 2018
wizsolzy:


No ooooooo my guy dey Sabimsa forest dey fight bokoharam grin

I doubt
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by wizsolzy(m): 9:35am On Aug 02, 2018
Johnsown1:


I doubt

I know my guy cheesy
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Holywizard: 10:17am On Aug 02, 2018
Nice one bro.
May Spana's sperm be thicker
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by MrsEvakinqz(m): 11:54am On Aug 02, 2018
Thumb up bro...... keep them coming
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by youngimporter: 12:20pm On Aug 02, 2018
my man I dey I still dey follow the story bumper to bumper but as thread don full with sure guys I say make I dey back seat they observe wetin they happen

(1) (2) (3) ... (13) (14) (15) (16) (17) (18) (19) ... (51) (Reply)

"Ocean Of Secrets" A Story By Millieademi / 1985.... 1987.... 2014--[a Crime Story] / An Evening With Eva (2013 Triple Award Winner in Crime. Thriller. Action.)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 50
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.