Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,151,128 members, 7,811,183 topics. Date: Sunday, 28 April 2024 at 05:32 AM

2go Babe Wey I Invite To My Village For Xmas And New Year - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / 2go Babe Wey I Invite To My Village For Xmas And New Year (3851 Views)

Would You Serve Jail Term For Your Babe To Be Released? (photo) / Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! / Is There Anything Wrong If I Invite My Galfrnd Home? (2) (3) (4)

(1) (2) (Reply) (Go Down)

2go Babe Wey I Invite To My Village For Xmas And New Year by Nobody: 3:56pm On Jan 13, 2013
Na wah oooo but some naija babes dem too like free things sha grin.Na one of my babes for 2go wey i come invite her to come my village spend christmas no do no do na so she jus pack all her travelling bags come my village.me be jus invite her thinking she go refuse but to my greatest surprise she jus agree come spend the christmas and new year for my village.thank god say small money be dey my hand during the christmas and new year becos me for no know how i for take care of her.on christmas day this babe almost finish all the pounded yam and egusi soup plus fried rice wey my mama be prepare.she no jus bother wether person go chop.as my mama jus finish preparing the christmas pounded yam na so this babe go rush carry bowl cut almost all the pounded for hersef.this my 2go babe sabi chop no be small sotay even my mama come dey marvel at this my 2go babe healthy appetite.na so i jus tell my mama say na so Itsekeri babes dey chop.i jus heave a sigh of relief when the babe comot after new year.my mama go dey use style ask me if na dat be the babe wey i wan marry and wen i come tell her say dat one jus be my platonic friend na im grin she jus dey thank god.my mama say e no go good if the woman wey i wan marry na woman wey too like food.she say such a woman go jus finish all the food for house and me sef even agree wit my mama.
PS:hope say una enjoy una xmas and new yr ooooo cheesy
Re: 2go Babe Wey I Invite To My Village For Xmas And New Year by Nobody: 4:01pm On Jan 13, 2013
ok

1 Like

Re: 2go Babe Wey I Invite To My Village For Xmas And New Year by heed101(m): 4:12pm On Jan 13, 2013
Your name tell me say u b clown and u go sabi lie angry

2 Likes

Re: 2go Babe Wey I Invite To My Village For Xmas And New Year by kinchiso(m): 4:48pm On Jan 13, 2013
Lefool Lefool is at it again... grin grin grin
Re: 2go Babe Wey I Invite To My Village For Xmas And New Year by ikechukz(m): 4:57pm On Jan 13, 2013
y u dey complain,abi u no chop the girl ponmo.
Re: 2go Babe Wey I Invite To My Village For Xmas And New Year by slimchi2k2(m): 5:07pm On Jan 13, 2013
his back again,remain ur pally tory waitin to hear
Re: 2go Babe Wey I Invite To My Village For Xmas And New Year by Kingslaw(m): 5:13pm On Jan 13, 2013
Your name self, dey even make me de laugh grin
Re: 2go Babe Wey I Invite To My Village For Xmas And New Year by Nobody: 5:21pm On Jan 13, 2013
Kingslaw: Your name self, dey even make me de laugh grin
my name get meaning ooooo.make u no disrespect am
Re: 2go Babe Wey I Invite To My Village For Xmas And New Year by Nobody: 5:22pm On Jan 13, 2013
ikechukz: y u dey complain,abi u no chop the girl ponmo.
i no even use broom torch the girl wink
Re: 2go Babe Wey I Invite To My Village For Xmas And New Year by hakunajay(m): 5:22pm On Jan 13, 2013
2go chat? you be real small pickin o if you dey control 2go runs... hahahahhaha.
Re: 2go Babe Wey I Invite To My Village For Xmas And New Year by Nobody: 5:27pm On Jan 13, 2013
hakunajay: 2go chat? you be real small pickin o if you dey control 2go runs... hahahahhaha.
broz i every runz i dey do.i dey do 2go runz,facebook runz,road runz,mama idewu peper soup runz etc.from wetin i don experience babes from 2go and facebook dem no go too bother u for money as long as u pay their transport and give dem free food grin
Re: 2go Babe Wey I Invite To My Village For Xmas And New Year by Nobody: 5:49pm On Jan 13, 2013
Bros, ur mama na ogbonge runs woman o. She understand your body language helep u incubate your runs...sharp mama.

If na my momma, she for declare war war3 if she no get the girl mission, mtcheeeew for ibo women sef.

1 Like

Re: 2go Babe Wey I Invite To My Village For Xmas And New Year by Tiwanna(f): 6:45pm On Jan 13, 2013
LastApostle: Bros, ur mama na ogbonge runs woman o. She understand your body language helep u incubate your runs...sharp mama.

If na my momma, she for declare war war3 if she no get the girl mission, mtcheeeew for ibo women sef.


shocked shocked shocked shocked shocked shocked grin grin grin grin grin grin grin grin grin
Re: 2go Babe Wey I Invite To My Village For Xmas And New Year by Nobody: 6:58pm On Jan 13, 2013
heed101: Your name tell me say u b clown and u go sabi lie angry
Very obvious
Re: 2go Babe Wey I Invite To My Village For Xmas And New Year by Exponental(m): 7:10pm On Jan 13, 2013
Village...2go babe.....ur mama.....
U just had a fling with an ogbanje!
Re: 2go Babe Wey I Invite To My Village For Xmas And New Year by Mynd44: 7:29pm On Jan 13, 2013
He is back!!!!
**dancing Azonto**
Re: 2go Babe Wey I Invite To My Village For Xmas And New Year by sylvacoin(m): 7:54pm On Jan 13, 2013
Lol **falls from dinning chair still laugh** grin
Re: 2go Babe Wey I Invite To My Village For Xmas And New Year by Nobody: 10:23pm On Jan 13, 2013
OP, why you dey shout?
because she no bring cooler abi?
na.cry u for still dey.now!
Re: 2go Babe Wey I Invite To My Village For Xmas And New Year by cindyrella(f): 10:35pm On Jan 13, 2013
Hahahahahaha!
*falls from mango tree*

Welcome back oga lefool. We have missed you.
Re: 2go Babe Wey I Invite To My Village For Xmas And New Year by Meegadough: 10:38pm On Jan 13, 2013
Don't mess with a food goddess. Lol
Re: 2go Babe Wey I Invite To My Village For Xmas And New Year by yuzedo: 10:39pm On Jan 13, 2013
wpope: ok
Dammit! grin grin grin grin
Re: 2go Babe Wey I Invite To My Village For Xmas And New Year by Nobody: 10:39pm On Jan 13, 2013
*falls from Olumo rock*

Lefool lefool, your stories are just something else...happy new year to you too
Re: 2go Babe Wey I Invite To My Village For Xmas And New Year by Nobody: 3:16am On Jan 14, 2013
grin grin grin
Re: 2go Babe Wey I Invite To My Village For Xmas And New Year by Nobody: 11:49am On Jan 14, 2013
cindyrella: Hahahahahaha!
*falls from mango tree*

Welcome back oga lefool. We have missed you.
na christmas cowleg and head wey i dey flex na im make jus scarce.hope say u enjoy ur own christmas and new becos me enjoy my own wella.but then hope say u no chop ur boyfriend head becos of xmas.u new say federal govt no dey gree wan pay minimum wage cheesy
Re: 2go Babe Wey I Invite To My Village For Xmas And New Year by Nobody: 4:52pm On Jan 14, 2013
Lefool lefool don come again ooo cheesy

Lefool if I say I nor miss this your yarns, na lie I dey talk o. grin. But why you come dey yab Itsekiri babes naw? My mama na Itsekiri babe she be grin.

Anyway Shey you nor chop the babe ni, as poundo and fried rice fill her belle ni? cheesy

Shey you don learn ya lesson grin
Re: 2go Babe Wey I Invite To My Village For Xmas And New Year by DrGee1(f): 7:33pm On Jan 14, 2013
Trouble dey inyanga go wake, na trouble u go get.
Re: 2go Babe Wey I Invite To My Village For Xmas And New Year by Nobody: 12:14pm On Jan 15, 2013
pDude: Lefool lefool don come again ooo cheesy

Lefool if I say I nor miss this your yarns, na lie I dey talk o. grin. But why you come dey yab Itsekiri babes naw? My mama na Itsekiri babe she be grin.

Anyway Shey you nor chop the babe ni, as poundo and fried rice fill her belle ni? cheesy

Shey you don learn ya lesson grin
i no insult ur mama oooo.u be my correct paddy nah wink.anyway i for no complain if to say this babe wey i invite no too chop
Re: 2go Babe Wey I Invite To My Village For Xmas And New Year by Nobody: 2:08pm On Jan 15, 2013
lefulefu at it again!
cheesy
Re: 2go Babe Wey I Invite To My Village For Xmas And New Year by Mynd44: 2:18pm On Jan 15, 2013
lefulefu:
i no insult ur mama oooo.u be my correct paddy nah wink.anyway i for no complain if to say this babe wey i invite no too chop
But you chop am?
Re: 2go Babe Wey I Invite To My Village For Xmas And New Year by Nobody: 1:41pm On Jan 16, 2013
Mynd_44:
But you chop am?
i no torch the babe oo grin
Re: 2go Babe Wey I Invite To My Village For Xmas And New Year by Mynd44: 1:44pm On Jan 16, 2013
lefulefu:
i no torch the babe oo grin
You don short

(1) (2) (Reply)

The Alarming Rate Of Leak Nude Photos/video Of Naija Ladies / ★ OMG!! See What Maheeda Posted On Her Instagram Page Because Of Christmas / I'm Not Attracted To My Girlfriend Anymore,

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 24
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.