Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,043 members, 7,818,099 topics. Date: Sunday, 05 May 2024 at 07:50 AM

10 Bad Things Naija Babes Do (very Funny) - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / 10 Bad Things Naija Babes Do (very Funny) (3951 Views)

Angry Things Naija Babes Complain About / Some Annoying Things Naija Babes Do At Concerts / See Naija Babes Doing Things With Their Yansh In Public [see Photo] (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

10 Bad Things Naija Babes Do (very Funny) by LaurelP(m): 8:42am On Jan 06, 2015




10. STEALS UR FOOD
Na the least of the issue be this. You go carry babe enter restaurant, adjust your eye glasses, look menu finish. come order for pounded yam and afang soup. Then you go turn look your babe ask her “Honey, you no go place your own order?” The babe go just bone tell you say her belle dey full. Omo, na so person go dey happy for mind say him go chop tight but that na dream. The moment food land, your babe go come closer to you, look the meat, fish, kpomo, snail and okporoko wey dey the soup. “Honey, are you going to eat those?” She go pick one meat. Next thing na to wash her follow you chop the whole food.

This no be love, na confirm reducing of ration. Make una stop am abeg.

9. ALWAYS LATE
One of my friend and im former babe dey always get this issue. Normally we know say women get their time and e worse past African time. This my friend dey always add like 10 – 30 minutes for him babe so that she go do something quick but she must still delay. If na party, restaurant or Silverbird them wan go, na the same story. Na so this guy come device style o. Him go tell the babe say na 8:00pm be time for movie whereas na 9:00pm.

Well, the babe break up with am. Why? She say him too dey lie. What of her wey dey delay?

8. USES SEX AS A WEAPON
Make una no mind my language abeg. But must women make us beg for our right again? All the isi-ewu, nkwobi, cow tail and bladder wey dem don chop fa? Some babes own self na to allow you swim kpekus only when you do something special. Maybe you buy her the latest Samsung Tablet, if not, O.Y.O for you. Some of them self get the liver to tell you something like this. “If you don’t buy me something for valentine, then I promise you, there will be no show!!!” Chineke, wetin make Valentine gift special abeg.

Men still dey device their own plans sha.

7. SHE CAN’T PUT HER PHONE DOWN
Ladies, we know. We know say una family mean so much to una but na wetin na?? Na so una go just una eyes for phone like say something dey happen wey special inside while we go just dey bed dey toss around. This thing no fair o. Sometimes, we men dey like make una give us that eye to eye contact when we dey yan with una. Oya make we do deal. We no go look that sexy waitress wey go serve us drink again. Deal? Deal.

6. SHE CAN’T TAKE A COMPLIMENT
Women no just know how to take compliment. Them go begin dey ask everybody if them make sense. After you carry 1 hour rub make-up, wetin you wan know again? Seriously, na only one person compliment suppose matter to una and that na una boyfriend(s).



5. SHE EXPECTS YOU TO READ HER MIND
Why be say una dey expect us to turn to Nostradamus because of una? Una go dey smile one kind smile dey wink for us or dey pinch us. Ah ahn, wetin una want? Una no go ever say. We dey attentive o, loving and caring but seriously, reading of minds na only winch dey do am and we no be winches.

4. SHE GUILTS YOU
We know say all this films dey always portray say make we do everything for our woman. We don watch am and unfortunately, women ma don watch am. Na so them go dey force us to do things wey we no wan do. Na so my babe make me part with my last cash. Wetin be her claim? She talk say I suppose make sacrifice for her since I “claim” say I love her. My people, e fair?

3. I'M FINE
If una never hear am before, I go talk am again. The moment you Bleep up, your babe tell you say “Honey, everything is fine, just go to bed.” Guy, carry you cloth run comot go sleep for your friend house. Women sabi pretend until something don reach cataclysmic level before them go do you bad. A word, oyibo say dey enough for the wise.

2. SHE HOLDS GRUDGES
This one go hand and leg with the number 1 of this thread o. The moment you carry wrong answer give her for question, or you do something wey she no like or you say something, hhhun. Even if na before una start to dey date, before una marry or when una just marry, wahala dey oo. Just know say she go dey remind you that eff up all your life.

1. ENTRAPPING QUESTION
“Do I look fat in this?” “Is my friend Amara pretty?” “If I ended up in a wheelchair would you still love me?” All of us know this question. Na the answer go determine wetin you go hear and wetin you no go hear. Seriously, women go just use innocent question make you trap yourself. Kai, na so one of my babe those days tell me say one other girl dey eye me. Na quick quick I go burst kpekus. I no ever know say na plan. Well, I single now sha.



From hiphopnaija.com

3 Likes 1 Share

Re: 10 Bad Things Naija Babes Do (very Funny) by xpac01(m): 8:55am On Jan 06, 2015
Hahahaha.True talks.
Re: 10 Bad Things Naija Babes Do (very Funny) by BasseyJ(m): 8:58am On Jan 06, 2015
So very true, especially no1, imagine a bro is about to insert and she holds him and asks 'do you love me Which nigga is gonna say No at such time

1 Like

Re: 10 Bad Things Naija Babes Do (very Funny) by Nobody: 9:05am On Jan 06, 2015
grin grin

You go burst kpekus!



That No 5. ShaAaaaaaaa

1 Like 1 Share

Re: 10 Bad Things Naija Babes Do (very Funny) by xpac01(m): 9:07am On Jan 06, 2015
*falls from my office chair, hits head on the floor* guy una no go kpai person with laugh oo!.
Re: 10 Bad Things Naija Babes Do (very Funny) by LewisO: 9:09am On Jan 06, 2015
grin
Re: 10 Bad Things Naija Babes Do (very Funny) by Mutuwa(m): 9:13am On Jan 06, 2015
And this is why majority of them regret in life.They always shoot without aiming.
Re: 10 Bad Things Naija Babes Do (very Funny) by Welrez(m): 9:41am On Jan 06, 2015
Funny...
I wish more people would write in pidgin.
Re: 10 Bad Things Naija Babes Do (very Funny) by LaurelP(m): 9:57am On Jan 06, 2015
smackimorn:
grin grin

You go burst kpekus!



That No 5. ShaAaaaaaaa

Na dat one u go see
Baddo
Re: 10 Bad Things Naija Babes Do (very Funny) by dechandel(f): 10:01am On Jan 06, 2015
grin grin grin
I do number 10 alot

There is love in sharing na grin

Funny write up
Re: 10 Bad Things Naija Babes Do (very Funny) by Nobody: 10:15am On Jan 06, 2015
LaurelP:


Na dat one u go see
Baddo

grin
Na d sweet part of the story!
Re: 10 Bad Things Naija Babes Do (very Funny) by freezyprinzy(m): 10:38am On Jan 06, 2015
rotflmao
Re: 10 Bad Things Naija Babes Do (very Funny) by ggrin(f): 11:57am On Jan 06, 2015
Liesundecidedlipsrsealedlipsrsealedlipsrsealed
Re: 10 Bad Things Naija Babes Do (very Funny) by SortCode(m): 4:08pm On Jan 06, 2015
number 10, kinda funny
Re: 10 Bad Things Naija Babes Do (very Funny) by ireneony(f): 4:10pm On Jan 06, 2015
Guy, na comedy fit you grin
Re: 10 Bad Things Naija Babes Do (very Funny) by thecommunist(m): 7:05am On Jan 07, 2015
No 1 tho...lol. she is actually adding weight and she knows it, yet she goes : " baby, am i getting fat?. Of course i will lie and tell her no...in fact " you are shedding fat" and then she accuses me of lying!
Re: 10 Bad Things Naija Babes Do (very Funny) by Davidolives(m): 7:29am On Jan 07, 2015
especially the reading minds thing

(1) (Reply)

For The Ladies:what Do You Like Most About Being A Lady / Woman Says She's Having Incredible Mind-blowing Sex With Son. Plans To Have Baby / Can You Strip Off For G.O.T

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 21
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.