Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,162,741 members, 7,851,547 topics. Date: Wednesday, 05 June 2024 at 10:20 PM

Naija Love Rhymes For Valentine - Literature (15) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Naija Love Rhymes For Valentine (61502 Views)

Must Read: Naija Love Part 1 (one) / Re: Naija Love Rhymes For Valentine / A Space For Peoms, Hot Rhymes, Quotes And General Sayings (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (12) (13) (14) (15) (16) (17) (18) ... (40) (Reply) (Go Down)

Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 12:33pm On Jul 10, 2009
no be 4 mouth dat MJ guy dey very great,
if anybody like make im hate,
e no change wetin im don achieve,
d kain blessings wey im now dey receive,
see d way im dey move crowd,
and how people dem dey cry loud,
i shake wen im pikin climb stage,
come see cry from people wey be my mama age,
d small thin' wey she yarn let us sabi d truth,
2 God, e chakara all those yeye talks 2 d root,
abegi MJ u don over-try,
confirm na inside heaven u dey now so dey fly,
only u one dey helep 30-something charity,
oh men o, dat na real ogbo'onge generosity,
u make river from small fountain,
enter thick forest move mountain,
4 all d love wey u show d african pikin,
d food wey u give em wey sweet pass chicken licking,
we no jus no how we go do,
but to say thank you,
na lie if any man talk sey u go go hell,
becuz true true, ur name suppose be Angel Michael. . . . .
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 10:38am On Jul 11, 2009
RuuDie, thank u for dat ur commendable eulogy
u show say ur own no be just grammarcology
u speak am straight from de heart
but make we no let d bag out of d cat grin
bc dis one u call am Angel Michael, some haters go vex
i hear some pple walk out during d minute of silence
which dey hold for am for U.S. Senate
their mind no just fit relate
say MJ no need their label of "American Legend"
Which them come refuse give am for d end
For us, he go always be a shining Star
Wey we go always dey see from the skies afar wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 5:17pm On Jul 12, 2009
i still get wan picshure of u inside my heart,
i dey close my eyes see am weneva day dark,
i still get ur memory plenty inside my soul,
i dey tie am like wrapper around me wen d nyt cold,
i still get dat ur sweet laff laff inside my mind,
i dey replay to pursue sorrow & make me fine,
i still get d kiss wey u throwey wen we been meet,
i dey take am wash mouth wen e need,
i still get d words wen u use first tell me sey u love me,
i dey bring am out read wen head dey ruff like sea,
i still get ur hand as e hol' my own tight,
i dey hol' am when i dey weak & no jus dey fit,
i still get everything about u,
i dey everly regret sey now no be we two. . . . . .
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 9:45pm On Jul 12, 2009
I got to say RuuDie, u be one sweet talker
but e be like say u go soon turn to stalker cheesy
ur love no get fullstop, not even comma
if dem leave u, u go dash d girl hummer grin
in a way, ur romantic lines dey very moving
these ur feelings no go need 2 much proving
e dey in d open for all to see
u wan pull dis babe like honey dey pull bee wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 11:06am On Jul 13, 2009
I no be sweet talker,
e betta make u jus call me poet,
God forbid sey I don become stalker,
pesin no fit write wetin im no knoweth,
becuz e go mean sey i be johnie waka,
but na wusai we power dey na im be we bonnet.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 11:17am On Jul 14, 2009
but RuuDie u sef know say i no mean any harm
i just dey hail u, as u want slay d babe with ur charm grin
what is worth toasting, is worth toasting well cheesy
e no too long now, d storyline go gel
as for me, i go be the innocent bystander
wey go ensure how well the whole thread go tanda wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Turiano(m): 4:58am On Jul 15, 2009
It pay me say MJ don finaly commont 4 this earth,thd question when i gt bi say we helep beg God make him bring another MJ for us.as i dey rite this thing i dey cry make him soul rest in peace.AMEN.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by TOYOSI20(f): 12:04pm On Jul 15, 2009
First things first ma peoples I hail una shocked grin
How body, how life and all??, I don miss all of una

Ma b day dey grand cos I bin get all those wey I hold very dear, kiss kiss
Truly ma people nothing fit beat having all those people near.

All day long na so so gift wraps pesin dey tear
Eventually @ the end if it all I dey so overwhelmed as I see how much ma love ones care

Most lovers they try to fit in
Cos they nor say if not dey fit end up for bin

This summer na public display of affection dey reign pass
But all these old peeps go dey look @ am like say yawah wan gas shocked grin

Our peeps talk say variety na the spice of life
So guyz try incorporate am into “things”, but nor be say e go be wid strife

They even get advanced love for (2010) Twenny ten
We go come dey look back like say werrin we sef they do then

I nor too like koni koni love, cos e they quick fade
Make we dey original like ma fav gem stone jade

Materialistic things like cars for driveways
Showing off on run ways

And hobnobbing on the sideways
Na all secondary cos eventually, e go all seem so far away

Finally e be like say I don dey detox ma self off Nairaland shocked cheesy
But I know for sure say I go drop some bars sha any time I LAND!! cool
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 4:47pm On Jul 15, 2009
@ maedan,

all dis wey u dey read,
na me dey write am down,
no be only wetin dey my own mind,
d poem na for many people,
yet na all about 1 pesin,
from 1 pesin wey sabi d many feelings,
and d many feelings wey relate to 1,
people wey dey see but no fit talk,
those their hands don tie for ground,
d 1s wey still dey wait,
and those wey near there but neva reash. . . .

I dey write for the rish,
the 1s wey jus dey ruff am
and dem wey poor pass chursh rat,
those wey go betta betta skool dem,
wey can download grammar like okotie,
for dem wey use common slate,
wey learn their own for makaranta,
even the 1s wey no know d skool road,
na inside bush and main road dem learn dem own. . .

I dey speak d mind of people everywhere,
for where dem use gold line street,
and where koro-tar don chop finish,
ontop d rock where fly no dey reash
follow enter d ko'ro wey kpako and bota dey mix
and even for dem wey dey inside abule ghetto
who don chop belle full throwey,
and dem wen dey into dry fasting . . . .

I be d mai' ruwa,
as e full na carry go
d message na im I dey give,
wetin dem feel na im I go write,
dem dey inside me,
and me inside dem,
dis na tory of 1 and many,
and d many wey dey inside d 1. . . .
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 7:14pm On Jul 15, 2009
no be only mai'ruwa, na mai'shai grin
RuuDie, no need make u dey explain why
e dey clear tey tey say u be one for all
u no be playa wey just wan shoot ball wink
no be say u dey here for the fame,
or just to boost up ur name
i don see say u dey here to share
and u dey always show say u care
if only dis world go get more pple like RuuDie
we no go get so many wey just care about d kudi smiley
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 5:54am On Jul 18, 2009
our way still dey far,
and i dey miss u die,
even as u dey my side,
water still dey comot for my eye,
na u near my heart pass any other,
only u fit make me laff like crase man,
make wan bend down pick pin,
u be my only cure,
still come follow be the poison,
the only thing wey go belle full me,
comot my eye from road,
and e come be sey my hand no reash,
for sey make i love u forbid no allow,
i dey halla oh why Papa God, why!?
why betta go come fly me pass!?
how somethin' wey sweet so dey pain!?
why my own present come resemble swear so!?
wetin i go come do to find d way!?
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 9:50pm On Jul 18, 2009
I must to say that dis RuuDie guy
get one kain skill wey money no fit buy
dis art of love explanation na very big gift
im fit paint sweet picture which fit give babe lift
me i no be softie, but i dey somewhat romantic cheesy
and im last poem dey very quite fantastic grin
he do am in d real rotimy style
wey be the foundation of this naija love rhyme file wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 6:32am On Jul 20, 2009
i don dat thin' wey people dey call blog,
well ma own small e no even get rug,
na jus my own personal poem log,
so people go sabi sey i no be thug,
or guy man wey dey pursue women like dog
and i no dey do drug,
abegi make una dey take style dey show for the 'sog,
if u no like wetin i write, text me correct flog,
yes oh, u can even call me frog,
yarn okpa'ts wey go worry pass bed bug,
but if e sweet u, abegi try gimme betta hug. . . . .

http://mypoetrycrib..com/
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 7:06am On Jul 20, 2009
maedan:


I must to say that dis RuuDie guy
get one kain skill wey money no fit buy
dis art of love explanation na very big gift
im fit paint sweet picture which fit give babe lift
me i no be softie, but i dey somewhat romantic cheesy
and im last poem dey very quite fantastic grin
he do am in d real rotimy style
wey be the foundation of this naija love rhyme file wink

maedan no be lie,
sometym meself dey tire for dis ruudie guy,
d way im dey manipulate,
e be like machine wey dey calculate,
im dey try sha but even if im na devil,
i no sure sey im reash ur roty level,
d bros dey deep,
e fit even write wen e dey sleep,
anyway, my own na to siddon look,
man must wack even if im no fit cook. . . . winkgrin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by sugabelle: 1:46pm On Jul 20, 2009
oga ruudie, how you go tire for yaself
abi u get two personality for dis NL shelf
lol, i still dey enjoy all una rhythm and rhymes
make we dey use am cool us in dis hot times
i go relax dey read with my glass of gin and limes tongue
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 1:58am On Jul 21, 2009
RuuDie no vex say I neva get time to see your blog
i wish i fit just sweep all my work for under rug cheesy
and stay for here just dey rhyme and play
na d very best way to pass the day wink


but one more thing I must to add
wey don make me a bit somewhat glad smiley
na d nice gesture of one certain congoshine
no think say i no appreciate your two thread combine
wey u use to confess and speak ya mind
i hope say u go see dis and understand
say you don win a piece of my heart, tho' some1 else don take my hand wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by congoshine(m): 10:02am On Jul 21, 2009
As I don get ur heart
That one don do me fine

Even if na part
E still go suffice

No vex say I no get
all the literary skill

Make we continue our love
On top yahoo instant messaging
wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 5:25pm On Jul 21, 2009
maedan no yawa,
from eko to nasarrawa,
u get mouth pass balewa.
abeg no throwey work,
if u fit sef jab sotey e tire clock,
so that pepper go dey to buy pork.
you still be my person,
i believe u to teach me lesson,
and wire me correct blessing. grin

na my first time to see congoshine,
shu bobz e be like im don sign,
but as i can see sey u dey do fine,
u jus do maedan like sey she drink wine,
dat thin' wey u do toush am like tine,
i swear u tight like nowadays babes ja'ins grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 3:35am On Jul 22, 2009
na so, i know d issue go bring plenty teasing grin
and yes, d prospect dey very pleasing
but e no good to get too carried away
make mr. loverman no come lead me astray cheesy
since i know say na play, i go try act mature
& becos i dey reserved, i come remove my picture tongue
soon the dust go settle& things go return to d same d same
but at least i go remember say i enjoy some 3minutes of fame wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Turiano(m): 6:38am On Jul 22, 2009
hmmmmmmmmmmm
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 9:12am On Jul 22, 2009
na true!? u remove dat ur fine face,
e be like wen pesin throwey betta lace,
me i no like as u comot d small trace,
abi u no know to some na amazing grace!?
abegi try give us light for dis place. . . . .

shuo 3 minutes of fame,
me so'ji sey u be confirm dame,
wey fit make o'mo boy lame,
only to mention ur name,
so abegi no begin dey play game,
jus yarn am wether u feel d same. . . . .

wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 9:21am On Jul 22, 2009
sugabelle jus mellow,
shey u be babe or fellow,
make i try to do am solo,
i get shadows wey dey follow,
some of them dey carry plenty sorrow,
others dey live for bright tomorrow,
na dem i dey relate to wen i dey feel low,
days wen e be me like to go down below
wen life don nack me betta blow,
na dem dey use my hand so,
dem dey go d words flow,
sometimes sef me i no dey know
but na dem dey make me glow. undecided
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 11:35pm On Jul 22, 2009
hmmn, RuuDie, no worry, na me know wetin dey my mind
you know say true love dey hard to find
when man open im soul and even im mouth
come display him heart from north to south
girl must to respect, and even admire
dis angel wey used to be congoshiner cheesy
but as e be say, rotimy never comot me from house
for now i go siddon for one place for dis NL like timid mouse tongue
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 12:10am On Jul 23, 2009
My pidgin is kinda . . . .well sha


Them don say Make I give this thread a try
I go admit am, me sef  wan know the laws  that love defy
I don dey observe all of una and una ‘s never ending tryst
I no know say na this thing wey I don dey call beast
Na him dey make all of una lose control?
Anywaz sha, make I leave una to find my  own
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 7:56am On Jul 23, 2009
well maedan na true u talk,
we no be pikin dem wey still dey suck,
and me i no dey do amebo work,
carry rumor like market hawk,
so make i die am before i go gawk,
i go close mouth like shirt wey tuck lipsrsealed grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 8:08am On Jul 23, 2009
well well well FL Gators
na wa for dat communicator
wey tell u make u "give us a try"
only for u to come contaminate, baby but why? grin
who be dis ur beast, wey dey make us lose control?
pls dis our undefiled love zone no be for parol
any beef you get, keep am out of dis compound
u just waste ur good rhyme to just bark like person 4rm dogpound wink cheesy
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 9:23am On Jul 23, 2009
@ FL gators

bobz see confirm ajebo' pidgin,
omo u write like ayositelu wey be deakin,
na una type dey le'm wella 4 chicken lickin',
boyz wey dey clear JAMB only 1 sitting,
baff ups go get orijo' fitting,
with all the gbo'gbo'ti'gbo kitting. . . .  grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 6:14pm On Jul 23, 2009
@Maedan
Maedan, I hope say you no dey vex for me
But you sef know I never go call you beast
Na this thing wey call love I  dey instigate
E be like say cupid no know where to navigate
One minute my man dey come with flowers
I don dey think say our love never go sour
Then e don dey come say our love don wither
Na so so love made half of my heart shatter
See me see trouble, another man come dey give me the eye
E no know say I know he just dey lie
Wetin I go do with this thing called beast
Wey dey make my heart beat increase?


@Ruudie
LOL, shey na me you come dey make laugh
See you dey form when aftermath
Na you go come dey beg me not to vex
I don say your head sef no dey correct tongue
But you know you be my little brother
So I no go even bother kiss
You men are all the same
You no even fit get shame
Na so to dey make her fall in love
Then to leave her as if she wasn’t enough
Anywaz, I don dey start my own congregation
From women of all nation
So that twice every year
We go give every man something to fear.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 7:33pm On Jul 23, 2009
FL Gators

na now now the thing come dey click
i know before say u be correct chick
now wey u break am down, i come get ur drift
i no wan make we ever get any foolish rift wink
cos dis pidgin be like say e get different grade
some don dey since d British come invade grin
while some pidgin(like my own) still dey take babystep tongue
so i must to do my best to improve my own street rep wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 12:35am On Jul 24, 2009
LOL, Meadan, you think say your pidgin suck, you better pass me cheesy cheesy

Yea na true you  dey talk
I no want our friendship to balk
No ma dear, you pidgin dey alright
Sbebi na him dey give Ruudiie’s heartbeat take flight


@House

I no know exactly wetin I go  do
I just dey drown in my own blues
Deep In  the sea  of lover’s  tryst  gone wrong
While Cupid dey agonize me with his evil song ---
I just dey reminisce the phase of our love exchange
When still Innocent to Cupid’s unpredictable shift change
I don dey plan to bring am to my village
To meet my family and pay a homage
But so so sha the mugu dey change him mind
Cupid sang to me say na love he wan go find
House, you wan know wetin I tell this man?
“If na love you wan find, make you go to Sudan!!!!”
But the knife just dey twist and hiss
As I lay crying, longing for his kiss
E be like say my heart never go sate
Expertised to the mischief that Cupid creates.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 8:24am On Jul 24, 2009
chei, who be dat bush man who no like beta thing
he no know the diff'rence btw kpanda and bling
so close to the prize, im choose to back out
na so many guys dey fill themselves wit' doubt
when the time come to take the marriage route
well, FL Gators my sis, look am as no-more-loss
i trust you, soon u go find a betta bros wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 9:45am On Jul 24, 2009
by d way, FL Gators, make i quick clear d air
no be me get RuuDie eye o, but she dey v.near
she too dey drop some lines wey dey make him heart melt
and as he look her picture, he see say she tight pass belt grin
since then, he dey quench for am plenty plenty
d name of dis damsel na d fine babe TOYOSI20 wink

(1) (2) (3) ... (12) (13) (14) (15) (16) (17) (18) ... (40) (Reply)

Oyeku:story Of Lust,injustice, Destiny And Human Wickedness, 18+ / Wole Soyinka: Things You Never Knew About Him / Nephilim

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 63
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.