Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,161,106 members, 7,845,648 topics. Date: Thursday, 30 May 2024 at 09:40 PM

Naija Love Rhymes For Valentine - Literature (24) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Naija Love Rhymes For Valentine (61413 Views)

Must Read: Naija Love Part 1 (one) / Re: Naija Love Rhymes For Valentine / A Space For Peoms, Hot Rhymes, Quotes And General Sayings (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (21) (22) (23) (24) (25) (26) (27) ... (40) (Reply) (Go Down)

Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 5:19pm On Oct 06, 2009
Yeh,
[b]inside my rum i sit dey meditate,
haw me and u go elevate,
baby, i fink aw we go forwardate,
4 diz side of obodo wey bad tin don penetrate,
calculator i carry try to calculate,
haw many tymes i don try to kissiate,
bt doz guyz stil dey disturb to_say u kno get tym 2 regulate,
don worry, i'l mak sure i giv dem sum rhyme_educate,
inshort they must b isolate,
abi aw u see 'am
many tymes 4 my dream, i see u dey dedicate <my children>,
u see, ur luv don dey contaminate,
to d xtend dat deir is no day i kno go decorate ur face ,
ur beauty dey mak me accelerate,
pls, shey u wan mak i debilitate
Tym upon tyme na ur name nd luv me and my frends dey debate,
shai, mak una see as her luv dey mak me liquedate,
even 4 my studies, i don dey decelerate.,
see as even i dey du mistake[/b].
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 6:48pm On Oct 08, 2009
Na ou'side i dey so,
Wen e go clear, i neva know.
Knock, knock na im i dey since,
Dis tori k-leg now no be beans.
To show me d way,
From wen we jam till today.
No be small road-block,
Like dem hol' me with padlock,
People say u don jazz RuuDie,
But na jus my turn 2 sort custom duty,
D shenke don dull me finish,
& her NL name na creamish!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 10:21pm On Oct 09, 2009
IMAO!

CREAMISH
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 6:40pm On Oct 28, 2009
i enter no jam anybodi inside room,
shuo, how all man come take zoom!?
dis place been dey boom,
as oyibo go talk, e been don pass bloom,
but na e don enter matter of oyibo gloom,
area jus clear without even moto vrrrooom,
but nah e be like dem sweep am with broom,
e don resemble after war for khartoum,
bodi pepper me like wife wey loss im groom,
how we do sotey our thread doom!?

my bro & sis' dem in love,
correct people wen blend like glove,
as we mind pure like white dove,
make we try lift d thread up-up above,
no jus let we jolly fall burn inside stove,
dis kain flows we no fit see for palmgrove.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 6:43pm On Oct 28, 2009
i waka sotey where i reash,
when i look look finish,
na only u i dey see. . . .
no matter how soap panic my eye,
or alu'bosa wan comot d tears finish,
baby still yet,
na only u i dey see. . . . .
even when i dey h die,
longa throat hook me for coo'ro,
na only u i dey see. . . .
make alarm tear me pieces,
money take shine,
pally dem shyte for shursh,
na only u i dey see. . . .
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 1:06pm On Oct 29, 2009
e start like play,
now if e pass wan day,
im go do me like na since may,
anytime we jam i dey halla "hooray"
pesin try u i can can'tab am with shoo'lay,
i don fall in luv & no be today,
e been dey grow now e don tey,
like we been dey run marathon relay
how u snash my heart with no delay,
e don reash to shout ole',
wether with calabar or bob-marley,
inside buba-shokoto or designer donnay,
u rub ororo or oil of olay,
your beauty pass money wey i no fit repay,
if no be u then na which way,
all dis no be scopes kpere i jus say,
baby na u i go luv u till head gray,
and even wen i don die throwey!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 8:06pm On Oct 29, 2009
When i read ur post, i dey delight,
b4 i go kno my papa don on generator light,
semid, maedan,fl gatorz and even u mr ruud,
it'z high tyme wen put on our rhyme mood,
as una see,
diz thread don dey go sea,
any aw e wön b,
i go mak sure say i du my part b,
u dey lauf,
ok, mak i kno rouf,
wey tin i dey talk,
yeh my tongue don stalk.
Finaly, mak we start,
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 8:46pm On Oct 29, 2009
Ruudie 'n'Adebayo, una do well - oya, pass me the mic
See as una don make my emotions dey soar like kite
Sorry se I go a.w.o.l on top this our pidgin thread
No b my fault, na the unending hussle for daily bread
But be that as it may, I happy se dis thread still dey on track
And we still dey strong kakaraka like bagco super sack
Hmmm, I don get serious case of 'pidgin rhymers block'
So make I drop my pen ,stop here, & no push my luck
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 9:09pm On Oct 29, 2009
;d ;d ;d ;d ;d
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 11:46am On Oct 30, 2009
all una welcome back,
and as una dey give so una no go lack,
for we hassle lai-lai we no go slack,
kwanta no go jam we for dark,
if no be white we no go call black,
baba God scatter all winchy attack,
anytime anywhere na pass mark,
maga go pay for inside sack
and luv go waka meet u wen ur time nack.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 7:25pm On Oct 31, 2009
chei see dat sexy chica,
i swear she fine pass monica,
d wey she wine i don dey weaka,
bodi don begin turn harda and thicka,
who wan taka with u shey na veronica?
baby na u blend jus like de'rica,
too sweet like calypso and soca,
man fit grub u like tapioca,
becuz of u i refuse visa to america,
only she can fit keep me inside africa,
u don gum me finish like sticka,
me no be playa talkless of strika,
i no get any jersee not even the nika,
confirm, u be my 1 and only angelica.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 8:25pm On Nov 01, 2009
ruud, walai diz ur rhyme dey make me dey high,
i know say u don realy prepare to go river nile,
because ur girl where dey 4 sapele,
don put peper(for ur eye)
join me to go chicago,
he get i babe her name na machio,
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 12:01pm On Nov 02, 2009
why finger go dey man no fit scratch nose!?
u dey boo'ga ontop all my flowz,
wen u sef sabi sey i betta pass all those,
ur yeye boys wey no sabi pass clotzes,
dat na after dem don throwey blowz,
inside dis film, i no wan be d boze,
even harmattan no go make me froze,
if no be u den make i shack overdose,
make my shapter jus kuku'ma close,
d end na only baba God dey knowz,
but for dis wan, me sef go follow bulldoze!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 5:32pm On Nov 02, 2009
My name na adebayour,
in dat film i want b d actor,
make doz boyz b d bus conductor,
dem turn 2 b diz thread terminator,
if no b maedan,ruudie,semid and fl gator,
i go don throw dem in2 my farm regulator,
1,2,3,4 into Seun'z refrigerator,
ruud, shey una get incinerator
Make i show dem say i don tey to sey i b rhyme generator,
bt u see maedan, semid,fl gator,and oga ruudie are rhyme professorz grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 5:33pm On Nov 02, 2009
My name na adebayour,
in dat film i want b d actor,
make doz boyz b d bus conductor,
dem turn 2 b diz thread terminator,
if no b maedan,ruudie,semid and fl gator,
i go don throw dem in2 my farm regulator,
1,2,3,4 into Seun'z refrigerator,
ruud, shey una get incinerator
Make i show dem say i don tey no b like motor
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 5:44pm On Nov 03, 2009
ol' boy ur back 'trong like aligator,
abi u wear face protector,
ur gear dust hummer navigator,
or ground tanda u like ta'minator
if not u no go dey hia dey halla adebayor,
cuz gunners fi twa'yan u pass incinerator,
kpo'kpo u d way of illegal tax collector,
or d man wey wan fa'ap generator,
dem eye sharp-red blue-tooth communicator,
d wa'yaring go be chas'co ololo-ma'tor.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 10:57pm On Nov 03, 2009
Tommorrow, I go add one more year
I go throw party and celebrate with my peer
Chops go plenty and Men go shak enuff beer
So make all of una fall in for where e go happen
All man dey welcome cos the invitation dey open
Make una sha come with my gift
I hope se una understand and get my drift
So come one, come all, make we celebrate all the way
Because tomorrow na my birthday.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 10:58pm On Nov 03, 2009
Tommorrow, I go add one more year
I go throw party and celebrate with my peer
Chops go plenty and Men go shak enuff beer
So make all of una fall in for where e go happen
All man dey welcome cos the invitation dey open
Make una sha come with my gift
I hope se una understand and get my drift
So come one, come all, make we celebrate all the way
Because tomorrow na my birthday.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 11:00pm On Nov 03, 2009
Tommorrow, I go add one more year
I go throw party and celebrate with my peer
Chops go plenty and Men go shak enuff beer
So make all of una fall in for where e go happen
All man dey welcome cos the invitation dey open
Make una sha come with my gift
I hope se una understand and get my drift
So come one, come all, make we celebrate all the way
Because tomorrow na my birthday.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 11:00pm On Nov 03, 2009
Tommorrow, I go add one more year
I go throw party and celebrate with my peer
Chops go plenty and Men go shak enuff beer
So make all of una fall in for where e go happen
All man dey welcome cos the invitation dey open
Make una sha come with my gift
I hope se una understand and get my drift
So come one, come all, make we celebrate all the way
Because tomorrow na my birthday.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 11:01pm On Nov 03, 2009
Tommorrow, I go add one more year
I go throw party and celebrate with my peer
Chops go plenty and Men go shak enuff beer
So make all of una fall in for where e go happen
All man dey welcome cos the invitation dey open
Make una sha come with my gift
I hope se una understand and get my drift
So come one, come all, make we celebrate all the way
Because tomorrow na my birthday.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 11:01pm On Nov 03, 2009
Tommorrow, I go add one more year
I go throw party and celebrate with my peer
Chops go plenty and Men go shak enuff beer
So make all of una fall in for where e go happen
All man dey welcome cos the invitation dey open
Make una sha come with my gift
I hope se una understand and get my drift
So come one, come all, make we celebrate all the way
Because tomorrow na my birthday.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 12:11am On Nov 04, 2009
Let me b d 1st 2 wish u happy birthday,
4 person 2 add one year no b play-play,
how i wish d day go stay,
semid, i fink sey na May,
plz d venue, i wan kno d way,
abeg tel doz galz make dem lay,
'coz me kno get tyme 2 delay,
and i kno get pawa 2 run relay,
HAPPY BIRTHDAY!!!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 12:12am On Nov 04, 2009
Let me b d 1st 2 wish u happy birthday,
4 person 2 add one year no b play-play,
how i wish d day go stay,
semid, i fink sey na May,
plz d venue, i wan kno d way,
abeg tel doz galz make dem lay,
'coz me kno get tyme 2 delay,
and i kno get pawa 2 run relay,
HAPPY BIRTHDAY!!!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by sugarcane: 10:57am On Nov 04, 2009
My turn!!
E don take me 3 days to reach 24 pages, I swear I no go lie e feel like ages.
I no fit stop I just dey read dey go, no so so laff be wan kill me oh!
From the beginning to the end e dey too interesting,
the way una rhymes just dey do d wrestling.
Make I be the 2nd person wey go say,
semid4lyfe make u have a very happy birthday!
I wish to say I fit flow just like you,
I for no dey here dey flow like jew.
Maedan na u be the number 1 madam,
for this thread wey hook me like gbam!
I hope say you no go ever change,
cos ur type na pidgin rhymes top range.
Wetin happen with rotimy sef,
he create the thread but left!
una loff trip me die, make I no lie!
Anyway e don do make I stop here,
if not I go dey here till new year.
Una well done again all of una for this thread,
it's time for me to go get some bread!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 7:34pm On Nov 04, 2009
semid4lyfe, sorry for the belated wishes, tried to post you a nice poem yesterday but something was wrong with my avatar and my post kept disappearing! I hope you had fun though!




As 50 cent talk say, go shorty, it's your buffday
make we pop champagne abi na chadonnay
i write one better poem for you yesterday
but it kept disappearing, now i don forget am throwey cry
but the good wishes na d same, i hope say you flex
and if you no come with takeaway for me, i go vex grin wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 7:44pm On Nov 04, 2009
@ sugarcane, i happy as u come enter our lane wink

i always dey glad when ever I see a new fan cheesy
make you feel free abeg to join our clan
your poem dey very articulate, like say u be expert
e go good if you go become our latest convert
thank you for all the good things you talk about me
but if not for rotimy, semid, ruud and co, how I for be
just make yourself at home, i hope you dey here to stay
i no too get time to rhyme as b4, but with this thread i no dey play wink.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 10:14pm On Nov 04, 2009
I dey overwhelmed and I no know wetin to say
Thank's 4 d good wishes & may good things come una way
Special thanks to Baba God 4 keeping me alive till dis day
Becos many peeps don pass away in the last yr
But me still dey kick and I still dey here
So I thank Bros Gode' for seeing me thru all the strife
And all the blessing I have recieved in my life.

THANK YOU ALL.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 6:09am On Nov 05, 2009
Mr sugancane u ar welcum 2 rhyme thread,
just make ur rhyme blend,
4 diz place we b rhyme mate,
if na lie ask ms. Kate,
please, pigin na our language,
xcept if worse come to worst we go speak yoruba or inglish language,
as i dey talk, ms. Maedan na my rhyme mistress,
ruudie na my oga 4 diz business,
semid na my one and only witness,
bt u see fl gators na my rhyme semistress.
abeg kno let am hear.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 2:24pm On Nov 07, 2009
oh baby boo listen to d racket,
me be short black boy from eket,
but i no small for month-end pay packet,
money no dey finish for my pocket,
u wan try i dey buy full super-market,
as i see u my heart beign yori-yori like bracket,
my love for u don full bucket,
infact, if i get u i don comot eye for market,
ur virus ehn don re-format my diskette,
inside cold i go off shirt follow give u blanket,
pls come follow we go see mr. & mrs. ekat-eket,
together we can start we own mmo'ereket. . . . .
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 3:32pm On Nov 07, 2009
;d ;d
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by sugarcane: 11:24am On Nov 09, 2009
Correct rhymes plenty for here,
make una enjoy this cold beer
Na morning now but you fit save am,
For evening use am chop stew and yam.

Thanks adebayo201 for the welcome!
But na miss I be where I come from.

(1) (2) (3) ... (21) (22) (23) (24) (25) (26) (27) ... (40) (Reply)

Oyeku:story Of Lust,injustice, Destiny And Human Wickedness, 18+ / Nephilim / Wole Soyinka: Things You Never Knew About Him

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 48
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.