Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,155,804 members, 7,827,959 topics. Date: Tuesday, 14 May 2024 at 08:11 PM

Naija Love Rhymes For Valentine - Literature (26) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Naija Love Rhymes For Valentine (61281 Views)

Must Read: Naija Love Part 1 (one) / Re: Naija Love Rhymes For Valentine / A Space For Peoms, Hot Rhymes, Quotes And General Sayings (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (23) (24) (25) (26) (27) (28) (29) ... (40) (Reply) (Go Down)

Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 6:52pm On Dec 09, 2009
I still dey as I no go anywhere
Na just the stress of work no let me show for here
Me just wan wish una merry Xmas & happy new year
And I pray 2010 brings u'all joy & happiness and not sorrow & tear
And may the Almighty lift you'all heads 'n' shoulders above your peer
Bye for now, I'll log on via PC later tonite
And drop some pidgin rhymes that are real tight.

Ciao!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 7:38pm On Dec 10, 2009
very very boring thread

Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 3:52am On Dec 11, 2009
I know we dey closer 2 chrismas dan to valentine
but to talk a bit about love no go be a crime
na Ruudie & Roty be d experts 4 romanticity
but i go stil try 2 toast wit some authenticitysmiley

d luv i feel 4 u no go eva pass away
my heart just soft like say dem mould am 4rm clay
sometimes i dey shy 2 tell u my mind
but u dey turn my head like say na fan blade dey windtongue
No be just ur looks, tho' u get plenty charisma,
but ur touch dey make my heart palpitate like who get asthmacheesy
D way u smile na like d sun of d early morn
na only with u i no go eva fit form!!!


Phew! This toasting hard no be small
i no know how u guys dey cope at all at all!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 5:00am On Dec 11, 2009
That iz it cheesy grin
u try wel wel no b small,
just mak ur luv stand lik iroko wey kno fit fall,
i must b there wen una go marry 4 hall,
no b only me go cum na all, cool
my gift 4 u dat day fit b ball, cheesy
b4 dat day abeg give me a call,
i go shayo to_say my body go shake like goat gall, tongue
u nd ur husband, i go draw una picture 4 wall, cry
dat tyme u go don tall, kiss
less i 4get, d pastor go b Uncle Paul grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by backlash09: 6:50pm On Dec 11, 2009


@ adebayo201

i know since say you get mouth
the thing just dey run from north to south tongue
anyway, this na maedan, i just wan informate you
make you dey mind your yarns make person no take style hate you tongue

and as for semid4lyfe

i no like wetin you write for my Untitled thread
u be like brother wey don put poison for im sister's bread
well I no too surprised, I take style know the kind person you be
So e no too pain me because I know my true friends and dem know me cool cool cool
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by backlash09: 7:02pm On Dec 11, 2009
Anyway. . .

To those that were truly took me as a friend
And stood by me till the end -
Yep, this is the end, 'cos I'm sick of this place tongue
Being unfairly "banned" was like a slap in the face
So the Moderators(spikedcylinder aka BSAN and her toyboy debosky)
Can eat Nairaland since they use it to flex their muscles and be pesky tongue
What have I gained from here recently anyway?/ Nothing!!
It's now a watered-down version, like a fake diamond with no bling tongue.

Like I was saying, to those who always and truly care
I'm off to greener pastures, 'cos it certainly ain't here tongue.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 9:27pm On Dec 11, 2009
@ Maedan

Frankly, I no like how and wetin you dey talk
Me & u don sabi tey and we don waka the walk
So tell me how I wan take put poison for your bread?
See - I no be murderer and I no want you dead
Haba! u suppose know wetin I dey imply 4 dat 'untitled' thread
Me just dey use style diss those two guy
But e be like se my true intent fly you by
Believe me, no be thinly veiled reference to your ban
Rmbr in the PB thread, I dropped exactly that yarn
E be like se na my post for that ganja thread still dey make u vex
Shebi I explain am to you se I just dey play and flex
And I no mean wetin I talk as I just dey wind
But now you come dey talk like se me & u get axe to grind
Finally, finally, I dey hurt se you think I be fiend
When I have been nothing but a good cyberfriend.

N.B Try send a mail to seun.osewaATgmail.com & you could also enlist the help of a moderator in restoring your posting previleges. It's exactly what I did when I was banned.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by backlash09: 9:40pm On Dec 11, 2009
It's ok, semid, I should have known you couldn't be so unkind.

And as for contacting anyone to give me back my maedan privileges then I don't give a rat's arse. That username means nothing to me now. I only formed backlash09 to tell those mods my mind. After that, nothing can make me linger here as a member. Not like I'm gaining anything on NL anyway.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 10:17pm On Dec 11, 2009
backlash09:

And as for contacting anyone to give me back my maedan privileges then I don't give a rat's arse. That username means nothing to me now. I only formed backlash09 to tell those mods my mind. [b]After that, nothing can make me linger here as a member. Not like I'm gaining anything on NL anyway.

Awww! You wan make Ogaga, Dgreatrock, Adeabayo and co cry? grin . Abeg, no leave o. If I may say so, I like having you around too.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 1:06pm On Dec 12, 2009
What ! Maedan, ban. For what?!.
Me don ready dey cry cry
y u wan live u dey dy,
ur wordz just dey make m dey think night and day,
greena pasture? I go folow u today,
na true semid yarn no b play,
abeg just try to reply,
how wil "untitled and 9ja rhymez for val" be but to dy,
any wey u dey, maedan abeg notify,
if ruudie nd frank hear diz their mind go fly,
no b like ant bt like butterfly, cool sad
Maedan is whom we need nt backlash . . . shocked
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by backlash09: 4:26pm On Dec 12, 2009


adebayo201, no need to regret or even fill up with rage
as I don dey banned, e be like say I don dey free from bondage tongue


On a more serious note, I saw your post and decided to let you know that there is no way I'm officially coming back to this forum. As far as I'm concerned this Nairaland is dead to me and nothing will ever make me want to continue as a bona fide member.

Why do I say this? There is one yeye moderator called spikedcylinder. In my opinion she is just a pest. I was having an issue with one oyb on Wande Coal, Ganja Man topic on Celebrities section. The issue ended but she annoyed me by putting in her mouth with one stupid post. In other words, she was "looking for my trouble" -at least so I felt.

In any case, no need for me to go over it again. If I could, I'd do the same thing over and over. She is the biggest sympathetic alien on Nairaland, so I said and so it will remain.

Pls @ adebayo don't expect a reply because after this post I AM NEVER COMING BACK. Cheers!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 3:01pm On Dec 14, 2009
i no be father kiriminji,
but if u gree luv me,
na so so give i go dey give. . . . .

dem no born me for inside kiresimasi,
but if u be my babe,
walahi i go sleep inside manger. . . . .

i no ever claim to be wise man,
but baby jus call me
and i go trek follow that star for north. . . . .
grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 7:22pm On Dec 14, 2009
i know how you feel . . . cry cry
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by illusion2: 7:26am On Dec 16, 2009
cry cry cry cry cry cry
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by richpitt(m): 12:38pm On Dec 16, 2009
rotimy and maedan
e deep down for una bodi
i no blv say una still they joli
after all this while
me i get lollipop
for anybabe wey fit to lick,


i they feel una rhyms sewiouzly, Olulu,Roty and maedan peace
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 1:47am On Dec 18, 2009
cry :c :p ;(
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 2:37pm On Dec 18, 2009
maedan abi na backlash,
u dey make bodi do me rash,
wen pesin koboko pikin for nyansh,
dat no mean im harsh,
yes oh, dem no dey give we cash,
and e no be like dis na bash,
but e no set make u jus fash,
to sey u wan lef dey do me like cane lash,
think of we, cuz na we head u wan mash. . .
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 2:42pm On Dec 18, 2009
if u say u no wan stay,
make u think am again,
d luv pass d bad belle,
e easy to vex waka,
but e no reash to stay and joli,
so dat people can happy too. . . . .

i no even know ur name,
but inside my mind i get pally
& dat pally be u,
as u dey waka go,
na small small kpai,
becuz slow slow i don loss,
i don loss 1 ogbo'nge friend.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 2:52am On Dec 19, 2009
@ Ruudie
Mint! If those two poems don't make her come back, nothing will.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by efepro(m): 9:04am On Dec 19, 2009
Una dey try o! see as guyz dey yarn as if na rhyme contest,
me i no fit 4 all dis stress,
i just wan let una knw say my birthday na Dec 26,my ppl dis 1 no be trick,
e dey happen for my end,
e go start to shelle by ten,
chicks and drinks go yakpa,u go high-lazy b4 u go waka.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 8:27am On Dec 20, 2009
efepro:

Una dey try o! see as guyz dey yarn as if na rhyme contest,
me i no fit 4 all dis stress,
i just wan let una knw say my birthday na Dec 26,my ppl dis 1 no be trick,
e dey happen for my end,
e go start to shelle by ten,
chicks and drinks go yakpa,u go high-lazy b4 u go waka.


Happy, happy birthday
That is all I can say
And I wish u many happy return
Me, just hope se this your groove go be fun
Becos I no dey like dull parties
I go like shak enuff bacardies
And I wan carry chika go as take away grin
So nothing do you if dis things dey
Becos me na man of enjoyment
And I dey like fun and merriment
You no get problem, my dear friend
As me go show on the 26th for ur end.

^^^^Wish you a Happy birthday, merry Christmas and a happy new year.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 9:06am On Dec 20, 2009
@ Maedan/Backlash09,

Frankly, I no know wetin to say
Since you waka, here just be like stable without hay
As nothing dey for we animals to graze upon grin
So abeg, try change your mind and return
Becos dis thread don dey take style dey dry
In fact, dgreatrock $ adebayo still dey cry
Me still no believe as I still dey in shock sad
Se how u go just abandon NL & dis thread? (ehn)
After u don groom many rhymers with pidgin cred
Also, remember se bone to bone no dey good
So abeg change your mind and return to dis our hood
Becos without you, this thread no fit be the same
As you be master for this our pidgin rhyme game.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by waleski(m): 10:09pm On Dec 20, 2009
U dnt knw wat u got til its gone nw peeps are realy missing meadan dat dere is ryhme 4 her self hehehe louf on nl
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 5:00pm On Dec 21, 2009
efepro, not let boys wound oh,
becuz dis wan na open i.v so,
e dey pain me sey i no go dey town,
i for change ya house paint to brown,
dis wan wey come be klismas,
omo na to brutal pass klinsman.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 5:08pm On Dec 21, 2009
@ semid,

not to worry,
for dis life no be to hurry,
na as papa say e go be
for now we still get we,
if we pally no return,
no be im go make we work burn,
e no mean sey make we all run,
night come no be d end of sun,
she go always dey inside we mind,
becuz all we luv glue don bind,
me sure any who'sai she dey,
she go cool'ee shiddon or lay,
becuz she sef how we been blendz,
and for inside we, she gather confirm friendz.

grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by efepro(m): 5:01am On Dec 22, 2009
Semid, thanks 4 d wishes,
If u no come,i go order Ruudie make e give u ten lashes,
dis 1 na from efepro d boss,
Na me talk am say i no go fit pause,
i must run my bash dis kirismas wit full force,
like horse wey dey run to drink water from e source,
i go send command like MS-DOS,
make dem order cow frm Jos,
e be like say guyz no happy as maedan no show face,
No worry another rhymestar fit surface.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 6:53am On Dec 22, 2009
Hmmm, i kno kno wetin i fit talk kiss
all my system just dey stalk,
haw e go b mak 4 two luvaz mak 1 cum walk
Heart go break,
even death fit wake, tongue
for sure hope stil dey,
let'z see frm naw to MAY shocked


celebrant,
me kno get much wey i wan yarn.
U see, dem born u for boxin day,
dat day u dey du ur birthday,
abeg if i kno dey dat day,
just rmain sumtin 4 Uncle Bay,
i get many tinz on d way,
me kno get babe wey go cum dat day cry
dat 1 kno mean say i b gay cool
shey u undastand wetin me dey say
i go advice u mak u start to dey mak hay
my fine i go pay, cheesy
mak rain kno fal oh coz i kno say semid nd ruudie kno go wan lay grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by illusion2: 8:02pm On Dec 22, 2009
All these rhymes for maedan. . .na wa for all of una sha. . . .

Anyway. . . keep trying  grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 9:45pm On Dec 22, 2009
Hmmmm, make una support one of una own for here. Abeg click on link below and vote for me grin

https://www.nairaland.com/nigeria/topic-370018.0.html

Thanks.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 4:27pm On Dec 23, 2009
chai una come see my life as e frustrate,
no be sey she don gree and we don dey relate,
na jus mai-mai to meet and fix date,
ontop whish smallie wey no reash my mate,
pikin wey na last week e jus begin menstruate,
pesin wey s'pose see me dey postrate,
worry me like ma'loo wey dem wan castrate,
na there i jus tanda dey wait,
gbu'gbe dodo like aboki for gate,
see fine boy don turn mu'gun by fate,
keep man for main road dey demonstrate,
piss hol man yet im no fit titrate,
sun don bulala me sotey i no fit concentrate,
kai, see d wahala wey luv dey create.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 8:20am On Dec 25, 2009
kai e jus dey do me regret,
like sey things been set,
& i been meet that 100milla target,
u wan try as pepper for yaa'pa wallet,
some dey throwey comot pocket,
bobz no'to yarn dis xmas groun' 4 wet,
shuo' u wan bet?
d kain party dem neva see 4 market,
boys 4 shayo sotey name dem forget,
i sey men 4 high like golden eaglet,
hennessy, s'ampagne, clystal abi na mo'wet,
we for jus dey flush am like toilet,
ehen, abegi make i continue my jab racket,
before oga come hijack my salary packet.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 4:31pm On Dec 25, 2009
MERRRRRRRRRRYYYY CHRISTMAS TO YOU ALL.

(1) (2) (3) ... (23) (24) (25) (26) (27) (28) (29) ... (40) (Reply)

Oyeku:story Of Lust,injustice, Destiny And Human Wickedness, 18+ / Nephilim / Wole Soyinka: Things You Never Knew About Him

Viewing this topic: 1 guest(s)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 58
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.