Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,155,966 members, 7,828,436 topics. Date: Wednesday, 15 May 2024 at 09:36 AM

Abeg Judge Na My Fault? - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Abeg Judge Na My Fault? (791 Views)

Na My Choice Woman / No Man Deserves To Be Called A Broke Ass: Do Not Judge Him / My Girlfriend’s Mum Is Pregnant For Me, But It’s Not My Fault. (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Abeg Judge Na My Fault? by bankable: 9:18pm On Mar 01, 2016
my dear country pipu. na so i siddon for my backyard dey collect fresh air dey reason how my life dey progress at snail pace and also minding my bizness me no ready for wahala o. na hin yeye nepa bring light o i wan cum do good Samaritan for our neighbor wey on generator this our neighbor get fine pikin as daughter i bin wan use dat as opportunity see d babe make i do good boy for her front.na so i carry my two waka waka leg go dem compound i tell dem say light don dey. dey happy say i tell dem cos fuel don scarce so d papa cum go off gen. i suppose don comot jejely buh because of this fine babe i no comot i no no say my own wan pafuka. na so d papa off gen o. chai b4 gen go off nepa don carry dia light go ooo. see me see trouble. if u c d kind eye dem take look me chai e b like say make ground open mouth swallow me. nd d babe in question dey enjoy telemundo final episode na so d papa try on gen o d gen no gree start. d man whine am whine am e no start naso e go inside.as i dey waka dey comot after shame don rent house for my body i dey hear dia sound dey lament. i no hear wetin dem talk buh na me dem dey abuse. chai i don suffer mak i kukuma siddon for my house ehn.wetin cum worse pass b say since dat day wen i greet dem u go tink say na deaf nd dumb i dey ff talk .chai nairalanders na my fault?

3 Likes 1 Share

Re: Abeg Judge Na My Fault? by AfroKnight: 9:24pm On Mar 01, 2016
Chei! My belle o. This is funniest thing I've read in a long time.

cheesy cheesy

1 Like

Re: Abeg Judge Na My Fault? by vizkiz: 9:24pm On Mar 01, 2016
watin you sef dey find upadan? grin
Re: Abeg Judge Na My Fault? by crismark(m): 9:36pm On Mar 01, 2016
loooooolz......laff no gree me do anitin again
Re: Abeg Judge Na My Fault? by Nobody: 9:46pm On Mar 01, 2016
lmao,no be your fault jare.
Re: Abeg Judge Na My Fault? by Nobody: 9:49pm On Mar 01, 2016
hahahahaha....
Re: Abeg Judge Na My Fault? by Nobody: 9:54pm On Mar 01, 2016
Lol. Na how nepa don turn plenty relationships upside down be dat.
Re: Abeg Judge Na My Fault? by firstking01(m): 10:09pm On Mar 01, 2016
So, you wan tell me say you nofit chyke that babe or whatundecided
Re: Abeg Judge Na My Fault? by Nobody: 10:37pm On Mar 01, 2016
Na ur fault undecided mind ya biz nd leave d babe alone undecided
Re: Abeg Judge Na My Fault? by KingTom(m): 11:09pm On Mar 01, 2016
grin grin grin grin grin
Re: Abeg Judge Na My Fault? by skywalker240(m): 11:37pm On Mar 01, 2016
grin this guy no go kill person oo,
Re: Abeg Judge Na My Fault? by lacruz12(m): 12:17am On Mar 02, 2016
No kon use ur wahala kill me abeg grin grin grin
Re: Abeg Judge Na My Fault? by Smellymouth: 12:18am On Mar 02, 2016
Na my fault undecided
Re: Abeg Judge Na My Fault? by Richy4(m): 12:59am On Mar 02, 2016
Don't worry, your reward is in heaven grin

(1) (Reply)

BREAKING UP / Ladies, Five Ways To Make A Man Happy! / !

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 15
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.