Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,774 members, 7,817,169 topics. Date: Saturday, 04 May 2024 at 07:37 AM

10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) - Travel (6) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Travel / 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) (78975 Views)

Coldest States In Nigeria / 12 Beautiful Resorts In Nigeria Where You Can Enjoy Your Honeymoon / 10 Cities In Nigeria Where Pidgin English Is Most Spoken (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (13) (Reply) (Go Down)

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by Nobody: 4:53pm On Jul 20, 2018
erico2k2:

leave that guy, E dey learn.,E nor know say saffi boys tire pass dem for waffi

We just dey konkey nor mean say we nor sabi, na so Timi for delta Tv dey kplaim blessing okagbare say na warri babe wey we all know say the girl marle and parle na koret safarians

We dey lowkey nor mean say we lost key, we just dey observe them make them dey sakra

4 Likes

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by UNIBENDON: 4:53pm On Jul 20, 2018
johnmattew:
edo state shud be number 1...it's only delta central and south that speak pidgin...Edo entirely is a pidgin state
Dem no know!

Who no go no know!

If you like be Professor for Edo state,if you no sabi Pidgin,you be correct obote!

4 Likes

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by 1Sharon(f): 4:53pm On Jul 20, 2018
Amberon11:
Keep calm, I certainly wasn't shaming yorubas and nor was anyone else on the thread.

It is not Pidgin English alone that is eroding our indigenous languages. English language itself is slowly eroding our languages and yes even the Yoruba you
think is intact isn't very much intact because at the end of the day most yorubas cannot write in Yoruba language.

It's not that deep you know, it's just a language and nothing stays the same forever.


It is very deep and it is not just a language. It is about identity and believing that is worthy of being known and propagated.

1 Like

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by erico2k2(m): 4:54pm On Jul 20, 2018
BiafranBushBoy:
pidgin isn't good!

It destroys your proficiency in English. Should be utilized while typing? ... pretty cool

Spoken? should not be used at all unless you've run out of options.

your height of ignorance kno no bound, Pidgin is our language we should preserve it and speak it at will. The British in their day to day life speak Pidgin 60% of the time in informal conversation.so which level U dey here dey form like say U nor dey shiiit.
abeg branch angry angry

6 Likes

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by Amberon11: 4:54pm On Jul 20, 2018
Hahahahaha
UNIBENDON:
I don talk am say any place for Naija wey dem no dey yan Pidgin I no fit live their!

Dem never baff!!

1 Like

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by peacengine(m): 4:54pm On Jul 20, 2018
1Sharon:
Let me further add and rock the boat even more:

Certain ethnic groups in Nigeria are noticing and worrying that their language is going extinct. Why won't this happen when you shun ur language and favour pidgin English?
You want to laugh at Yorubas but they are having the last laugh. Because at the end of the day their language is intact

That list up there is shameful!


Ma'am u no go understan. For we side every local govt geh differen lingua. Na pidgin we de use reason things together if noh we no go de hear we sef o. Na Nija delta lingua be diz. Buh my fear be say make we noh carry lass for English lingua

1 Like

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by Nobody: 4:55pm On Jul 20, 2018
ALKARULEZZ:
10. ABUJA
Based on based ehn, dis na d capital of Naija as all of ona know. The softness wey dey ooze for this coast na highest for the full country. The softness don real attract crowd from different holes come assemble for this arena.. The crowd nor get choice but to settle for pidgin make adagba nor for hang bulb-wire in the long-run.

9. ANAMBRA
Still on still ehn, this state still get small levo unto the pidgin spirit based on say na jur river share am from the capital of Delta state.. dat na wetin white men dey call "clash of culture"..

8. KOGI
O Bob! This state nor suppose sight road enter this list sha.. but still on the clash of culture things, most strong men here dey ball in Edo state steady unto one or two tiings based on say places like Auchi, Okpella etc nor too give Kogi state yard..

7. CROSS RIVER
Calabar people sha.. Their pidgin dey sound like Chinese dat year sha, but some kind Urhobo boys don hustle enter there come give their girls belleh finish.. this belleh-giving nai make new generation calabar children dey tear pidgin like Sapele agbero these days.. Pikin must resemble papa unto one or two tinz na.

6. LAGOS
Ma first hail some kind lost souls for this yard before I fire down.. Men like RMD, Basorge-Tariah, Ali Baba and other staunch wey abandon us go that way.. I jur like let ona know say nor be so o.. Cow wey smart go America go come back as cornbeef one day sha..
Still on still ehn, this state kari-get population from different parts of the country.. But we all know say dia pidgin melting pot dey Ajegunle where Area borku yakata.. Still on the hustle, AJ boys turn musicians o.. all we slangs for Area na dem pack full dia music.....and ona know say music dey kari-spread.. slangs spread so tey market women dey chew dem like gum based on say nor be everybody fit speak Yoruba na.. so d pidgin jur serve as dia lingua franca for dah way.... example of dose slangs wey dem thief na "Who You Help" wey Olamide thief from Shuun Bebe...

5. AKWA-IBOM
No doubt, militants don teach these people pidgin finish based on the oyel tinz.. dem try!


Down to the big four

4. RIVERS
This na one gallant South-South state wey jur gather people from different tribes like Tower of Babel.. Oil industries borku for this state and even omormor know say business must full anywhere oil industries gallant put. These people of different tribes based on say dem nor get unified language come dive pidgin make quarrel for nor too dey sup unto business tidings.

3. BAYELSA
Ijaw full this state nor be small.. Naturally their lingua franca suppose be Ijaw, but based on say d state near Delta anyhow, dem jur gat copy dia elder brother (Delta) main language make e for nor loss..

2. EDO
Oba a to pe'e.. Before 1991, this state dey conjoined with Delta state.. dem regard dem as one den (Bendel).. This state nor be number one for this list based on say some kind villages there near Yoruba states like Ondo and Ekiti.... This kari-near don weaken dia pigin anyhow.. na jur Benin come get level unto the lingua..

1. DELTA
Area!! 12 Kpokos for all the Nairaland Waffarians.. Any Effurun pesin here? Abeg signify make men observe ur kpai number..
Dem nor dey drag seat with Oba o..... The full state gallant for d pidgin level sha.. from Warri/Effurun to Sapele, Ughelli, Abraka, Oghara, Osubi, Asaba, Agbarho etc.. Area! ona too much abeg.. I throw backy give all of ona. Dem say overfamiliarity nai nor dey make man chop house rat..

Fly go gather any kporkpise wey like smart for this thread..





Kpoko 4 u # warri no dey carry last#
Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by erico2k2(m): 4:56pm On Jul 20, 2018
UNIBENDON:
Dem no know!

Who no go no know!

If you like be Professor for Edo state,if you no sabi Pidgin,you be correct obote!
Bross for your church mind u sef know say nah lie.nah we 4 Delta be pidgin English, warri-Sapele.dem small but dem dey yan grin grin grin

3 Likes

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by KangaIye: 4:56pm On Jul 20, 2018
1Sharon:


Gerrout of here. So you think Yorubas don't have different dialects?
You no fit compare Language Wey dey Edo with Dialect Wey full Yoruba.

2 Likes

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by Nobody: 4:58pm On Jul 20, 2018
All Edo and Delta cities represent for pidgin. Other notable mentions are Lagos and Port Harcourt. Every other places are debatable.

1 Like

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by erico2k2(m): 4:58pm On Jul 20, 2018
peacengine:


Ma'am u no go understan. For we side every local govt geh differen lingua. Na pidgin we de use reason things together if noh we no go de hear we sef o. Na Nija delta lingua be diz. Buh my fear be say make we noh carry lass for English lingua
Dem nor go understand, as I dey so, if I meet Yoruba person, nah pidgin we go take yan make people around us nor know wetin we dey talk, if I meed Edo guy same thing but if I meet my fellow Area, case close! grin grin

4 Likes

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by Sinistami(m): 4:58pm On Jul 20, 2018
[quote author=peacengine post=69556236]

Ma'am u no go understan. For we side every local govt geh differen lingua. Na pidgin we de use reason things together if noh we no go de hear we sef o. Na Nija delta lingua be diz. Buh my fear be say make we noh carry lass for English

Correct Yarn tell her. E no easy to be Nigerdeltan .

2 Likes

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by peacengine(m): 5:01pm On Jul 20, 2018
erico2k2:

Dem nor go understand, as I dey so, if I meet Yoruba person, nah pidgin we go take yan make people around us nor know wetin we dey talk, if I meed Edo guy same thing but if I meet my fellow Area, case close! grin grin

Na so bros, na pidgin be de way o, if u know u know

1 Like

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by UNIBENDON: 5:01pm On Jul 20, 2018
1Sharon:


Gerrout of here. So you think Yorubas don't have different dialects?
Yoruba get different versions,na so Ibo and Hausa get.Even Esan , Ijaw or Izon and Urhobo get their own dialect.

Most Yoruba and Hausa people no sabi Pidgin.

All Igbo people sabi Pidgin,but their matter bi say dem no dey like speak for their own place especially when dem know say u no sabi their Igbo talk.

2 Likes

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by Manofvalor1: 5:01pm On Jul 20, 2018
abeg dis na slangs u write there! doh!!.no be pidgin u hear? no come dey fall ur hand! una don leave origin pidgin dey speak cultist plus armed robber slangs.

1 Like

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by Amberon11: 5:02pm On Jul 20, 2018
Rotflmao to Syria cheesy
Rosebloom:



correct talk... Anambra no suppose near the list.

O boy! I remember when a de serve for Delta da year, we even de use pidgin teach if the Queens English no too de enter.

Nai a go one wedding for Osubi, small thing a for no gree come back. From the keke driver to my friend's Mumsie and brother, na laugh wan Kee me. Their pidgin sweet die. Lagos de learn for waffi dem.


Oya may person con teach me cos me na learner

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by searay(m): 5:02pm On Jul 20, 2018
fratermathy:
Akwa Ibom nor follow at all for this matter. Na only Ibibio and good English dem dey yarn here. Dey nor sabi catapult pidgin at all. Even the small ones wey open eye for the matter sef nor sabi am wella. Their pidgin dey sound like good English mixed with Ibibio.

As for Anambra, na Igbo dey reign for there. Pidgin nor too follow. Na only for Onitsha dem dey speak small pidgin based on Asaba influence and based on say strangers boku for there. So Onitsha nor too follow up. Even Asaba sef, na Waffarians dey spoil that town. Normally, na Igbo dem dey yarn but Waffi boys don change am follow them. Some Asaba people don even get Warri tongue now sef.

For Bayelsa matter ehn, Yenagoa na correct pidgin area. The people wey get the town na Epie/Atissa dem dey speak normally but Izon people and Ogbia people plenty for the cabal so na pidgin naim dem take dey control their matters for there.

Lalasticlala and Seun, how una see this thread na? E nor suppose to loss like that. Make dem reason the matter na.
Well spoken. Pidgin is regarded as Motor park English in Akwa Ibom.

1 Like

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by Sinistami(m): 5:03pm On Jul 20, 2018
Takeproft:
All Edo and Delta cities represent for pidgin. Other notable mentions are Lagos and Port Harcourt. Every other places are debatable.

Guy wetin Yu de Kap sef. Yu Don kon Yenagoa before. Wi nor de drag seat with Oba o (Benin Warri PH) But Lag no reach us o.

2 Likes

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by charlsecy(m): 5:05pm On Jul 20, 2018
@ALKARULEZZ
Pidgin in Anambra? That's not true. It's used majorly when an outsider is met.

1 Like

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by Nobody: 5:06pm On Jul 20, 2018
ALKARULEZZ:
10. ABUJA
Based on based ehn, dis na d capital of Naija as all of ona know. The softness wey dey ooze for this coast na highest for the full country. The softness don real attract crowd from different holes come assemble for this arena.. The crowd nor get choice but to settle for pidgin make adagba nor for hang bulb-wire in the long-run.

9. ANAMBRA
Still on still ehn, this state still get small levo unto the pidgin spirit based on say na jur river share am from the capital of Delta state.. dat na wetin white men dey call "clash of culture"..

8. KOGI
O Bob! This state nor suppose sight road enter this list sha.. but still on the clash of culture things, most strong men here dey ball in Edo state steady unto one or two tiings based on say places like Auchi, Okpella etc nor too give Kogi state yard..

7. CROSS RIVER
Calabar people sha.. Their pidgin dey sound like Chinese dat year sha, but some kind Urhobo boys don hustle enter there come give their girls belleh finish.. this belleh-giving nai make new generation calabar children dey tear pidgin like Sapele agbero these days.. Pikin must resemble papa unto one or two tinz na.

6. LAGOS
Ma first hail some kind lost souls for this yard before I fire down.. Men like RMD, Basorge-Tariah, Ali Baba and other staunch wey abandon us go that way.. I jur like let ona know say nor be so o.. Cow wey smart go America go come back as cornbeef one day sha..
Still on still ehn, this state kari-get population from different parts of the country.. But we all know say dia pidgin melting pot dey Ajegunle where Area borku yakata.. Still on the hustle, AJ boys turn musicians o.. all we slangs for Area na dem pack full dia music.....and ona know say music dey kari-spread.. slangs spread so tey market women dey chew dem like gum based on say nor be everybody fit speak Yoruba na.. so d pidgin jur serve as dia lingua franca for dah way.... example of dose slangs wey dem thief na "Who You Help" wey Olamide thief from Shuun Bebe...

5. AKWA-IBOM
No doubt, militants don teach these people pidgin finish based on the oyel tinz.. dem try!


Down to the big four

4. RIVERS
This na one gallant South-South state wey jur gather people from different tribes like Tower of Babel.. Oil industries borku for this state and even omormor know say business must full anywhere oil industries gallant put. These people of different tribes based on say dem nor get unified language come dive pidgin make quarrel for nor too dey sup unto business tidings.

3. BAYELSA
Ijaw full this state nor be small.. Naturally their lingua franca suppose be Ijaw, but based on say d state near Delta anyhow, dem jur gat copy dia elder brother (Delta) main language make e for nor loss..

2. EDO
Oba a to pe'e.. Before 1991, this state dey conjoined with Delta state.. dem regard dem as one den (Bendel).. This state nor be number one for this list based on say some kind villages there near Yoruba states like Ondo and Ekiti.... This kari-near don weaken dia pigin anyhow.. na jur Benin come get level unto the lingua..

1. DELTA
Area!! 12 Kpokos for all the Nairaland Waffarians.. Any Effurun pesin here? Abeg signify make men observe ur kpai number..
Dem nor dey drag seat with Oba o..... The full state gallant for d pidgin level sha.. from Warri/Effurun to Sapele, Ughelli, Abraka, Oghara, Osubi, Asaba, Agbarho etc.. Area! ona too much abeg.. I throw backy give all of ona. Dem say overfamiliarity nai nor dey make man chop house rat..

Fly go gather any kporkpise wey like smart for this thread..



Remove Anambra from that list.
Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by 1Sharon(f): 5:07pm On Jul 20, 2018
searay:
Well spoken. Pidgin is regarded as Motor park English in Akwa Ibom.

Haha I agree. The ppl quoting me in pidgin are really doing my head in

1 Like

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by Nobody: 5:07pm On Jul 20, 2018
BiafranBushBoy:
pidgin isn't good!

It destroys your proficiency in English. Should be utilized while typing? ... pretty cool

Spoken? should not be used at all unless you've run out of options.

Pidgin is good. It is unique, nice and has swag. Speak oyibo for market dem go chop u raw or cheat you

2 Likes

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by Gracespecial101(m): 5:07pm On Jul 20, 2018
Sinistami:
Dis kain thread de dis nairaland nai dem kon allow am for loss. Wida na!?
Baba wida no be area slang sha... If you know you know
Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by 1Sharon(f): 5:09pm On Jul 20, 2018
.
Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by 1Sharon(f): 5:10pm On Jul 20, 2018
peacengine:


[s]Ma'am u no go understan. For we side every local govt geh differen lingua. Na pidgin we de use reason things together if noh we no go de hear we sef o. Na Nija delta lingua be diz. Buh my fear be say make we noh carry lass for English lingua[/s]

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by Gracespecial101(m): 5:11pm On Jul 20, 2018
Manofvalor1:
abeg dis na slangs u write there! doh!!.no be pidgin u hear? no come dey fall ur hand! una don leave origin pidgin dey speak cultist plus armed robber slangs.
Thank you oo, i no just dey understand them parole any longer
Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by 1Sharon(f): 5:13pm On Jul 20, 2018
UNIBENDON:
Yoruba get different versions,na so Ibo and Hausa get.Even Esan , Ijaw or Izon and Urhobo get their own dialect.

Most Yoruba and Hausa people no sabi Pidgin.

All Igbo people sabi Pidgin,but their matter bi say dem no dey like speak for their own place especially when dem know say u no sabi their Igbo talk.

Exactly my point. So why don't you lot speak a unifying language like yorubas?
Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by peacengine(m): 5:15pm On Jul 20, 2018
1Sharon:



Na wetin de work u?

2 Likes

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by donbachi(m): 5:17pm On Jul 20, 2018
Abobi whither u...make u focus dia,peel out make aboy chop..i rep my PH.

1 Like

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by 1Sharon(f): 5:17pm On Jul 20, 2018
Double post
Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by 1Sharon(f): 5:17pm On Jul 20, 2018
peacengine:


Nna wetin de work u?

You tongue and the jargon you wrote up there
Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by Icon79(m): 5:17pm On Jul 20, 2018
Delta state is definitely the #1, followed by Rivers state. Third should be Lagos and 4th Edo.

As per the rest, I am not too sure.


O pari

2 Likes

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (13) (Reply)

Akwa Ibom And Europe Standard Of Road Na 5&6 .. Photos / Train Goes Through The Centre Of A 19-storey Block Of Flats In China(photos). / The Only Street In America With A Nigeria Name

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 64
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.