Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,447 members, 7,816,028 topics. Date: Friday, 03 May 2024 at 12:02 AM

Getting A Green Card By Adjustment Of Status: My Yankee Experience - Travel (17) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Travel / Getting A Green Card By Adjustment Of Status: My Yankee Experience (347016 Views)

Former Erosion Site Transformed Into A Green Park In Uyo (Before & After Photos) / B1/B2 Change Of Status To F1 / B1/B2 Change Of Status (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (14) (15) (16) (17) (18) (19) (20) ... (110) (Reply) (Go Down)

Re: Getting A Green Card By Adjustment Of Status: My Yankee Experience by Nobody: 2:36am On Nov 13, 2017
BlowJobs:


Oh yes.. i am adding PIDGIN2. The most patriotic Nigerian, Buhari pikin. grin grin

Where ever you are PIDGIN2, drop your number. You sef must enjoy a tiny bit from our obodo oyinbo hustle. At least your mind go dey pray for us secretly.

Na me suppose send u airtime for there na, as I dey here glo don dash me N200,000K for their jumbo package, 9mobile dey give me 10times my recharge everyday, Mtn dey bless me with awoof daily and person talk say Nigeria no good

Nigeria my beloved country grin

2 Likes

Re: Getting A Green Card By Adjustment Of Status: My Yankee Experience by Fish123(m): 3:24am On Nov 13, 2017
Nah your reply got me lolz bro
wunmi590:

Why you dey laugh? grin
Re: Getting A Green Card By Adjustment Of Status: My Yankee Experience by Fish123(m): 3:24am On Nov 13, 2017
Nah your reply got me lolz bro
wunmi590:

Why you dey laugh? grin
Re: Getting A Green Card By Adjustment Of Status: My Yankee Experience by Nobody: 3:26am On Nov 13, 2017
TheManOfTheYear:
Try my MTN line which I gave bro

Sir,
I apologize....but I think I'll just take a "rain check" on the pidgin class....
I have someone who can help me.....in a more practical way.
But thank u so much anyway!

2 Likes

Re: Getting A Green Card By Adjustment Of Status: My Yankee Experience by Nobody: 3:32am On Nov 13, 2017
bolakale30:

Your sense of humour is refreshing, I laughed out really hard when reading your posts. The disagreement here is (to me) purely cultural, Nigerians generally dislike "poke-nosing", which is probably what what you are doing can be termed.
P.S: I have never stepped out of the country, so my opinion might be as empirical or significant as the 'P' in psychology

Thank u so much..
I so love to laugh...which is one thing I do a lot when I read threads on N.L....
I love the word "poke-nosing"....never heard it phrased that way.
Yes I think u may be correct with your statement.
I did make an assumption..which I apologize now to the author....as I cannot read his heart/motives.
But I didn't see anything wrong with asking that question.
But boy did I feel like a gazelle amongst a pack of jackals...
Re: Getting A Green Card By Adjustment Of Status: My Yankee Experience by Solitin40: 5:31am On Nov 13, 2017
BlowJobs:


Na dem Solitin40 and Pronmix i selected. they seem to be the 2 people that needed it so i'm waiting their numbers. but i'll add you as the third person. Being that you sef dey visit the thread steady.

So, 3 numbers. Expect the credit from me between now and tomorrow morning (Eastern standard time)

Dashing credit done for now
Blowjobs so sorry for the late reply I was ban by the anti spam bot when I drop my phone number anyway this is the number ‭090three7threefive02sixsix Mtn Thanks
Re: Getting A Green Card By Adjustment Of Status: My Yankee Experience by sirhamilton(m): 6:34am On Nov 13, 2017
Pidgin2:


Na me suppose send u airtime
for there na, as I dey here glo don dash me N200,000K for their jumbo package, 9mobile dey give me 10times my recharge everyday, Mtn dey bless me with awoof daily and person talk say Nigeria no good

Nigeria my beloved country grin


I didn't say anything cool

1 Like

Re: Getting A Green Card By Adjustment Of Status: My Yankee Experience by TheManOfTheYear: 7:17am On Nov 13, 2017
Pidgin2:


Na me suppose send u airtime for there na, as I dey here glo don dash me N200,000K for their jumbo package, 9mobile dey give me 10times my recharge everyday, Mtn dey bless me with awoof daily and person talk say Nigeria no good

Nigeria my beloved country grin
Look around you and tell me if this country looks good in your eyes

13 Likes

Re: Getting A Green Card By Adjustment Of Status: My Yankee Experience by TheManOfTheYear: 7:19am On Nov 13, 2017
MsNgo40:


Sir,
I apologize....but I think I'll just take a "rain check" on the pidgin class....
I have someone who can help me.....in a more practical way.
But thank u so much anyway!
OK mademoiselle
Re: Getting A Green Card By Adjustment Of Status: My Yankee Experience by YungJo207(m): 7:52am On Nov 13, 2017
Pidgin2:


Na me suppose send u airtime for there na, as I dey here glo don dash me N200,000K for their jumbo package, 9mobile dey give me 10times my recharge everyday, Mtn dey bless me with awoof daily and person talk say Nigeria no good

Nigeria my beloved country grin

Same 9mobile we all know angry? Which plan you dey on give us the code asap before I blow you whistle grin
Re: Getting A Green Card By Adjustment Of Status: My Yankee Experience by rapheeky(m): 8:08am On Nov 13, 2017
DAT pidgin de lie sha....mk I no talk again
YungJo207:


Same 9mobile we all know angry? Which plan you dey on give us the code asap before I blow you whistle grin
Re: Getting A Green Card By Adjustment Of Status: My Yankee Experience by YungJo207(m): 8:23am On Nov 13, 2017
rapheeky:
DAT pidgin de lie sha....mk I no talk again

Thank GOD say I no dey the thread when you talk am cool I dey very sure say she go drop code Sha na very sure Naija pikin oya pidgin shame them.
Pidgin love
Pidgin boo boo

Drop code ooo no fall my hand.
Re: Getting A Green Card By Adjustment Of Status: My Yankee Experience by FuckYaAll: 8:36am On Nov 13, 2017
Pidgin2:


Na me suppose send u airtime for there na, as I dey here glo don dash me N200,000K for their jumbo package, 9mobile dey give me 10times my recharge everyday, Mtn dey bless me with awoof daily and person talk say Nigeria no good

Nigeria my beloved country grin

this Post Made me Laugh like
ha


ha

ha ha ha
grin grin grin

1 Like

Re: Getting A Green Card By Adjustment Of Status: My Yankee Experience by jayriginal: 8:45am On Nov 13, 2017
ferhyntorlah:
Why do some people like to rain on others' parade?

Makawhy?

Kungaga tuangaga grin

1 Like

Re: Getting A Green Card By Adjustment Of Status: My Yankee Experience by jayriginal: 8:47am On Nov 13, 2017
MsNgo40:



Sir or ma'am,
Good morning. ...
And the mentions keep coming....although it's over and done with.
I guess you wanted to add your "words of wisdom" too....lol.
Your last statement is incorrect.
However, thanks for schooling me though.

CC: Lovelani

They will keep coming because you were very condescending.
Re: Getting A Green Card By Adjustment Of Status: My Yankee Experience by lovelani(m): 9:35am On Nov 13, 2017
you guys should pls let @ MsNgo40 be na. Haba. person no fit play with y'all ni?
Re: Getting A Green Card By Adjustment Of Status: My Yankee Experience by Nobody: 11:43am On Nov 13, 2017
TheManOfTheYear:
Look around you and tell me if this country looks good in your eyes

This country is good in my eyes, as I don tell u wetin wan happen? grin
Re: Getting A Green Card By Adjustment Of Status: My Yankee Experience by Nobody: 11:45am On Nov 13, 2017
YungJo207:


Same 9mobile we all know angry? Which plan you dey on give us the code asap before I blow you whistle grin

Na secret, pipo like u no fit understand grin
Re: Getting A Green Card By Adjustment Of Status: My Yankee Experience by YungJo207(m): 12:11pm On Nov 13, 2017
Pidgin2:


Na secret, pipo like u no fit understand grin

I go blow your whistle 9mobile dey come after you.
Re: Getting A Green Card By Adjustment Of Status: My Yankee Experience by bolakale30(m): 12:42pm On Nov 13, 2017
MsNgo40:


Thank u so much..
I so love to laugh...which is one thing I do a lot when I read threads on N.L....
I love the word "poke-nosing"....never heard it phrased that way.
Yes I think u may be correct with your statement.
I did make an assumption..which I apologize now to the author....as I cannot read his heart/motives.
But I didn't see anything wrong with asking that question.
But boy did I feel like a gazelle amongst a pack of jackals...
Hahahahahaha... Nwanem Nwanyi (you should understand this, since you said you are Igbo), we should be friends, you retorts are legendary, it's sounding, smelling, feeling like what the doctor ordered.

1 Like 1 Share

Re: Getting A Green Card By Adjustment Of Status: My Yankee Experience by BlowJobs: 2:03pm On Nov 13, 2017
bolakale30:

Hahahahahaha... Nwanem Nwanyi (you should understand this, since you said you are Igbo), we should be friends, you retorts are legendary, it's sounding, smelling, feeling like what the doctor ordered.

Guys, una dey see. My thread bring people together. I like this guy. Sharp shooter. grin

2 Likes

Re: Getting A Green Card By Adjustment Of Status: My Yankee Experience by BlowJobs: 2:04pm On Nov 13, 2017
Solitin40:

Blowjobs so sorry for the late reply I was ban by the anti spam bot when I drop my phone number anyway this is the number ‭090three7threefive02sixsix Mtn Thanks

D way wey you take write this number sef..
I go send am.. next 2 hours.
Confirm number first bro.
Re: Getting A Green Card By Adjustment Of Status: My Yankee Experience by BlowJobs: 2:07pm On Nov 13, 2017
Pidgin2:


Na me suppose send u airtime for there na, as I dey here glo don dash me N200,000K for their jumbo package, 9mobile dey give me 10times my recharge everyday, Mtn dey bless me with awoof daily and person talk say Nigeria no good
Nigeria my beloved country grin


Habba Pidgin2. 200taousan credit. Una no even dey lie small.

MTN give you awoof? grin grin. The same MTN i know?. Una no even lie with etisalat. MTN? Why una dey lie nah.

13 Likes

Re: Getting A Green Card By Adjustment Of Status: My Yankee Experience by BlowJobs: 2:13pm On Nov 13, 2017
denbaba:

Oga BJ Ur story is very motivating. May God continue to bless u.
I am a 31-year-old Medical lab scientist. I finished NYSC last year. Since then i have been working where they pay me #50k monthly. D money no reach anywhere I don't even have a savings. Pls advice me what route will be easy for me to leave this hopeless country. I'm ready for any menial job sef.

I always advise people to go through student because of the perks that comes with it.

Like i've said in the past, i won't encourage any illegal route in NL however, the hustler in me dey tell you say e no matter which kain visa you enter yankee with. If na B1/B2 u get, when you come, start to dey ginger your brains o. Like i said, a lot of people will help you out as long as say you dey humble.. go through this thread again, you go pick up one or two hustler things here.

I don't have no issue with anyone trying to better their lives so i won't totally discourage visitors coming here.

10 Likes 2 Shares

Re: Getting A Green Card By Adjustment Of Status: My Yankee Experience by BlowJobs: 2:21pm On Nov 13, 2017
I saw my secondary school mate picture for FB yesterday night. D guy na US soldier now o. If you see as my guy neat for the Army Uniform. The thing con dey do me like say make me sef join military. But i be gentle boy, i no dey like too much wahalah. grin
As i see him picture, i inbox him, him read am no gre reply (maybe him think say i dey naija wan disturb am grin ).
I con send am my us number make he call me

We talk all night, he give me full gist of how he enter here. Wetin him eyes see. My people, naija people get mind o, we dey hustle grin grin

He tell me say when him wan join Nigerian Army years back, person wey wan help him talk say make he go bring money. So, if una wan die for naija, you go still pay money to die for your own country? grin grin.
My guy now dem dey hail am for here, i see comment for him picture people thanking him for his services. My head dey swell, i wan join Army but my mind no carry am grin

43 Likes 2 Shares

Re: Getting A Green Card By Adjustment Of Status: My Yankee Experience by Fish123(m): 2:36pm On Nov 13, 2017
BJ make you no join army o, nah air-force go fit you ocheesygrin
NB how him take jab enter Yankee,no experience gained wey go waste o
BlowJobs:
I

We talk all night, he give me full gist of how he enter here. Wetin him eyes see. My people, naija people get mind o, we dey hustle grin grin

He tell me say when him wan join Nigerian Army years back, person wey wan help him talk say make he go bring money. So, if una wan die for naija, you go still pay money to die for your own country? grin grin.
My guy now dem dey hail am for here, i see comment for him picture people thanking him for his services. My head dey swell, i wan join Army but my mind no carry am grin
Re: Getting A Green Card By Adjustment Of Status: My Yankee Experience by BlowJobs: 2:42pm On Nov 13, 2017
Solitin40:


When ever you ready, i dey double your credit. Might not be much but i see say you need am. I saw your profile, the sections wey you dey enter most na Jobs/Vacancies and Travel. And i can totally relate with you. God bless your hustle bro.

32 Likes 1 Share

Re: Getting A Green Card By Adjustment Of Status: My Yankee Experience by BlowJobs: 2:44pm On Nov 13, 2017
Fish123:
BJ make you no join army o, nah air-force go fit you ocheesygrin
NB how him take jab enter Yankee,no experience gained wey go waste o

Na conference my guy come do for here years go.Now my guy na US citizen. God is good. grin

22 Likes 2 Shares

Re: Getting A Green Card By Adjustment Of Status: My Yankee Experience by Nobody: 4:37pm On Nov 13, 2017
BlowJobs:


Na conference my guy come do for here years go.Now my guy na US citizen. God is good. grin



Oga BJ, expatiate on this na....every way na way oooo. I been dey eye that US army like mad...I dey look for way to tear race ooo cheesy

1 Like

Re: Getting A Green Card By Adjustment Of Status: My Yankee Experience by Fish123(m): 4:39pm On Nov 13, 2017
Hehe all the time bro grin
BlowJobs:

Now my guy na US citizen. God is good. grin
Re: Getting A Green Card By Adjustment Of Status: My Yankee Experience by Fish123(m): 4:45pm On Nov 13, 2017
Baba you suppose don code nao,hin no need expatiate more o
NB... Nonnyg i sight you bro
comradespade:




Oga BJ, expatiate on this na....every way na way oooo. I been dey eye that US army like mad...I dey look for way to tear race ooo cheesy

(1) (2) (3) ... (14) (15) (16) (17) (18) (19) (20) ... (110) (Reply)

Giving Birth In Brazil / Somali Girls Are The Most Beautiful In Africa! / At The NVC Processing Stage Of The U. S Family Based Preference Category.

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 46
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.