Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,154,385 members, 7,822,794 topics. Date: Thursday, 09 May 2024 at 05:02 PM

Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! - TV/Movies (60) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / TV/Movies / Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! (205744 Views)

Big Brother Africa 'hotshots' Official Thread / Big Brother Amplified (The Official Thread of BBA 6) / Big Brother Africa 4 (The Official Thread) (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (57) (58) (59) (60) (61) (62) (63) ... (179) (Reply) (Go Down)

Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by Nobody: 10:37pm On Sep 01, 2010
D Adetayo person na 9ja, I get friends in common wit him for facebook, d guy dey vex me
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by stankayy(m): 10:56pm On Sep 01, 2010
Abeg, Abeg, Abeg dat bushman na real cricket jo. The Kaone wey i dey see dis year no be d fun n likeable one i see last year. Im jst dey try to hard to be like Kevin dis year n im dey irritate me wit his pretence n fakeness. E go open mouth dey yabb Uti but wen Uti yabb am bk e go begin dey suck up to other housemates. E dey even cal Uti mad dog today. Make im go sit down. The truth is dat no matter what Uti does, he will still be hated and targetted becos he's from Naija. SADC peeps are just intimidated when it comes to Nigeria. And i personally dont give a f, what Uti does and what he didnt do, i'll keep rooting for him and support him whichever way i can. Moreover Munya is d most annoying, irritating and fake housemate ever but his die hard mumus r still makin lots of noise abt him. Guys we cant make those who already hate Uti like him, all we can do is to keep showin our support and make we dey continue to dey bombard am wit our votes. We gas show dem say we baba.
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by shalom1234: 11:01pm On Sep 01, 2010
e be like sey our talk sef don too much, na so we make mouth so tey last week dem pull d rug comot for under our feet, i beg make we no shame ourself again this sunday ooooo. LOL!!!  those small boys no just get respect at all,  see where 11M dey wan disgrace 150M with grey hair. this time around na odeshi we go use for them.
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by Nobody: 11:05pm On Sep 01, 2010
shalom1234:

@Hail Naija

na Sheila ex

ok.thankd
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by montelik(m): 11:07pm On Sep 01, 2010
Munya's fans are not only from Zimbabwe, stop underestimating their numbers. Most of the country men and supporters of housemates like Paloma, K1, Code, Tatiana are core mufc members/supporters.  Stop underestimating them or you will be shocked again come Sunday.

Is Yacob so loveless that they couldn't find a guest to bring for him? sad
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by Nobody: 11:10pm On Sep 01, 2010
Wetin dey work for dem na d whole Sadc tin, dey get upper hand and person no fit beat dem except by kurukwere as dem pass d oda regions. Dat na way we must use our kuruwere talent for full make me take even dere Obodos.
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by stankayy(m): 11:15pm On Sep 01, 2010
@Tatiana, i dont want to say the Adetola guy is a fool but he seems to be like one. @Shalom, true talk but we need talk to motivate n ginger ourselves. Truth is am not even watchin d show rite nw, dont knw wats going on. I just dey front of my lappy dey vote wit all d multiple apa i don create n waitin on d next hour to continue. So i just dey while away time 4 here to read n contribute. I wont be sleepin early 2nyt cos i gas bombard dat site wella.
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by Nobody: 11:20pm On Sep 01, 2010
Make we concentrate well well for d 5 obodos wey we get last wk, does 1s dey weak and den we try add bro sammi and smelly, we get some correct ppl for ground for dose obodos.sa fit possible cos our ppl dey dere plenty, hope den dey work sha
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by stankayy(m): 11:59pm On Sep 01, 2010
^^^^ We fit get sa cos e be like say our pple 4 dere do wetin dey suppose do. We also need to put eye 4 drunkard obodo n roa plus d obodo u mention. If we do our job well den we no suppose get wahala. I don dey try download mxit 4 ma fone all nite but e no dey go, i no no whether na d network or na d site. U dey get d same problem?
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by Nobody: 12:25am On Sep 02, 2010
Na, I don put am and comot am up to 5 times now now.http://m.mxit.com
Dats d link. U fit vote up to 500 a day sef wit diff obodos. Just dey comot am after each round and put again. U pick d obodo u wnt and use d type no den dey use for dat obodo
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by 14(m): 12:32am On Sep 02, 2010
What have been happening on BBA 5, Never watched BBA the whole day
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by Sarah886: 4:35am On Sep 02, 2010
pleas does anyone know where to watch bigbrother africa 5 online
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by babuji(f): 6:20am On Sep 02, 2010
Abeg make una yarn me how i go fit use sms vote for other obodos. Una do well o!
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by user32(m): 6:24am On Sep 02, 2010
Mxit na de easiet way to beat those big mouthy zlm hands down. I get two acts with nambia and ghana, no need to vote 4 as nigerian because he go win 9ja 4 sure.Make we focus our effort on other non sadc and rest of africa. Vote 4 uti unstop
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by user32(m): 6:35am On Sep 02, 2010
Forget strapping, vote uti!!!
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by user32(m): 7:39am On Sep 02, 2010
I dön vote 4 uti 30 times using ghana and nambia profile under 10 minutes. Vote as if dey pay u to do am.
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by montelik(m): 7:40am On Sep 02, 2010
user32:

Mxit na de easiet way to beat those big mouthy zlm hands down. I get two acts with nambia and ghana, [b]no need to vote 4 as nigerian because he go win 9ja 4 sure.[/b]Make we focus our effort on other non sadc and rest of africa. Vote 4 uti unstop

E go be like film trick wen Naija go vote Munya, like Ethopia and Namibia abandoned their reps grin. Na biggie dey write the script.
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by v24m(f): 8:31am On Sep 02, 2010
@ user 32 abeg how i go tk vote 4 mxit because i don download am for my blackberry but i no dey see where dem say mk we vote for big brother abeg help cos na telecomms i dey work for so i go fit ginger my people here mk dem vote via other obodos.
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by groovychik(f): 9:26am On Sep 02, 2010
On mxit you go click on tradepost, from tradepost you go select voting, them go show you options like mnet, you go click, bba you go click etc, then you'll go back to homepage and you go now see bba, you go open, click on voting, select Uti then vote 10times, comot am put another one. Guys I dey vex this morning. Munya people don dey talk am openly for that yeye Munya United Fan page for facebook sey them dey stamp from other Obodos, we need to double up our efforts, that mxit own dey easy once you get the scope the first time, and I don dey hear na two people dey comot. Shame go catch us well well if Uti waka. Those for Telecom mek una helep us
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by Nobody: 9:31am On Sep 02, 2010
@V24m wen u der register make u 1st change d part wey get 9ja on top for d obodo wey u wnt and put 1 of d town for region and for d no put d code of dat obodo+any 5nos wey come ur head. After u don register, make u go tradepost, it go give u options pick voting.after that pick mnet and den pick BBA and put y. Close tradepost and go back, u go see BBa don appear after info. Press am, pick vote, it go show u d names. U fit vote 10times den u comot am, dwnload back and do am as many as u fit and dey pick diff obodos
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by Nobody: 9:36am On Sep 02, 2010
I beg who know babuji for here? Se na our person make I send am d email? Cos some of d mumu people dey come dis side, make I no give expo 2 wrong person o
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by v24m(f): 10:26am On Sep 02, 2010
thnks guys am on it
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by BluMalam(m): 10:27am On Sep 02, 2010
Na so my people, make una dey hammer mxit & wap lyk say tmoro no dey, i don do 40 today for mxit & 5 for wap, i neva start, whish one be say if i wan vote online as naija dem go dey giv me error, if na play make biggie stop am o because dis hanshake don dey reash sholda. Make una dey vote gbamu gbamu
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by Nobody: 10:34am On Sep 02, 2010
For sms vote make we send many for ROA and obodo Yacob cos dose 1s easy. Since d no bigge give use get + already dat means say it no go matter where it dey come from. Dat na why we get obodo yacob last week but we no do enuff for ROA
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by Nobody: 10:40am On Sep 02, 2010
+2783142100413, +2783142100414 . Make una send plenty Vote Uti for dese 2 nos
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by montelik(m): 10:42am On Sep 02, 2010
Blu Malam:

Na so my people, make una dey hammer mxit & wap lyk say tmoro no dey, i don do 40 today for mxit & 5 for wap, i neva start, whish one be say if i wan vote online as naija dem go dey giv me error, if na play make biggie stop am o because dis hanshake don dey reash sholda. Make una dey vote gbamu gbamu

I don talk am be before say BB dey do upgraded yahoo yahoo, una na no wan hear. grin
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by stankayy(m): 10:49am On Sep 02, 2010
@tatiana, apart from dose two obodos, d rest obodos no dey go abi? Cos i try tati n smelly obodo as u say 4 d email bt e no dey go, abi dey don block am? Thanx 4 d mxit, e rily make sense and i don do 60 4 smelly obodo and dey do sum 4 drunkard obodo nw. I wan concentrate on dis 2 obodos 4 nw. And moreova mnet no gree make i vote 4 deir website 4 abt 5 hours nw. Dem dis guys wan frustrate our efforts.
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by stankayy(m): 10:57am On Sep 02, 2010
Montelik u 4 try vote small and troway dis ur pessimism 4 gutter till Sunday. I undastand where u dey come from but make we give dem benefit of doubt 4 dis week and vote like say our lives depend on am. Abi u be MUFC agent wey dey try discourage our ppl, LOL
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by whiz(m): 11:22am On Sep 02, 2010
abeg make una help download and upload dat mxit itthing for here, my phone dey use windows mobile os and anytime i go their site to try do d thing e dey carry me go itunes.
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by v24m(f): 1:13pm On Sep 02, 2010
abeg tatiana and co dem tell me say d bb voting service no dey available for ya country nd an tatiana place na im i select ooooo i.e an, go, lah.
Re: Big Brother Africa 5 (the Official Thread) Is Here! by kbone(m): 1:26pm On Sep 02, 2010
My people make una jel with yacoperv obodo n roa if na esemes you wan use, if u dey ontop mxit make sure say u enter any chosen obodo with phone wey get that obodo code. Otherwise they fire dey go ontop web n wap like a yahoo boy

(1) (2) (3) ... (57) (58) (59) (60) (61) (62) (63) ... (179) (Reply)

Some Nigeria Movie Stars Profile / MTN Project Fame Season 9 Official Thread / Power TV Series Fan Thread: STARZ

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 41
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.