Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,248 members, 7,818,850 topics. Date: Monday, 06 May 2024 at 06:38 AM

Make Una See How This Woman Do Her Landlord House Before She Pack Out - Health - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Health / Make Una See How This Woman Do Her Landlord House Before She Pack Out (522 Views)

This Woman Got A Breast Exam On Live TV. No Bra, No Blurring. / Look At The Position This Woman Is Fetching Water To Drink For Her Family- Photo / 550lbs To 210lbs: See The Amazing Weight Loss Of This Woman (Photos) (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Make Una See How This Woman Do Her Landlord House Before She Pack Out by dailybuzzng: 1:00pm On Sep 11, 2019
Fear catch One Landord wey even vomit self as he find out dirty plus including food wey don rotty even poo poo self wey one woman wey get four children leave for him house as she pack commot.

This Landlord Shahin Miah na him get this house for Eridington, Birmington, him dey claim say him former tenant wey don dey live for the house for five years with her four children, pack commot con leave the house for condition wey fit make person sick well well.

As him take yarn, to tidy this mess go cost am more than £2,000.

Him talk say since last year, she no open window or curtins. she no throway dirty wen dem dey throway. Him say him con dey suspect her wen he go visit her and she no let am enter.

She dey always talk say she dey busy. him go ask for appointment she no go answer.

About four months wey don pass, Gas work been dey on for the area so them say no gas for that whole day.

Gas people need to enter the house but them no fit coz she no dey. Na neighbour con direct them to go see the landlord.

him say Gas people tell am say no gas for the house for one month now - him con dey wonder... hw she wan take survive?
Him dey call, but she no pick. when she con pick, him tell her say see o see o this people need to enter house because gas don finish, she say okay o, but e no happen.
Mr Miah don too put pressure to enter the house sotey she call police foram say na court matter.
Las Las as August end na him she tell am say she go pack out, she no even drop info of where she dey go.
Mr Miah say she no drop key o, he gas to break inside. as hin see how d house dey, fear catch am. dirty full everywhere, no place to match leg self. food scatter everywhere, him no fit waka round because na shit(poo poo) na him cover everywhere. omo the guy say vomit catch am for driveway.

Mr Miah still talk say him no sure wether she be humanbeing sake of say normal person no go fit do this kind thing.


Make we hear fromm you (use the comment side)....Abeg wetin una think say go fit lead to this kind behaviour

Source: see more pictures for here: https://www.dailybuzzng.com/2019/09/make-una-see-how-this-woman-do-her.html
Follow dailybuzzng for more tori www.instagram.com/dailybuzzng

Re: Make Una See How This Woman Do Her Landlord House Before She Pack Out by DonBenny77(m): 1:02pm On Sep 11, 2019
Hehehe must be some sort of payback.
Re: Make Una See How This Woman Do Her Landlord House Before She Pack Out by Davash222(m): 1:04pm On Sep 11, 2019
The dirty look sexy compare to Nigerian dirty or maybe it’s from the image quality of the camera.
Re: Make Una See How This Woman Do Her Landlord House Before She Pack Out by PapaNnamdi: 1:05pm On Sep 11, 2019
stingy woman not even paying for lawma grin


too bad oga landlord, to say u de Nigeria, I for direct some iron condem guys come your place ,
they will take 90% of that trash for free
Re: Make Una See How This Woman Do Her Landlord House Before She Pack Out by majamajic(m): 1:07pm On Sep 11, 2019
give a junkie $100 , he will clear all those mess

the woman is a bad tenant
Re: Make Una See How This Woman Do Her Landlord House Before She Pack Out by jovialswag(m): 1:08pm On Sep 11, 2019
see person house grin you sure say snake no dey too grin grin grin
Re: Make Una See How This Woman Do Her Landlord House Before She Pack Out by PrincessB1(f): 1:21pm On Sep 11, 2019
Maybe they were at loggerhead so she decided to wicked him that way grin grin


Bad tenant grin
Re: Make Una See How This Woman Do Her Landlord House Before She Pack Out by sirqeeboi(m): 1:27pm On Sep 11, 2019
Is it that I can't read pidgin or na writer no sabi
Re: Make Una See How This Woman Do Her Landlord House Before She Pack Out by daddytime(m): 1:33pm On Sep 11, 2019
Tenant from hell
Re: Make Una See How This Woman Do Her Landlord House Before She Pack Out by restore8(m): 1:42pm On Sep 11, 2019
maybe she turned the house to a recycling center.




do you wish to build an Instagram page?


do you need someone who can help you grow your page to up to 1000 followers?

do you need someone who can manage your Instagram page?

kindly check my signature and contact me below. kindly contact me for more information.

(1) (Reply)

Advantages Of Outdoor Play On Children / USB Electric Mosquito Zapper,get Rid Of Mosquitoes Once And For All / Can Myoclonic Seizure Be Cured?

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 17
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.