Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,228 members, 7,818,773 topics. Date: Monday, 06 May 2024 at 02:26 AM

Diary Of A Rugged Chaiz Man. - Literature (2) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Diary Of A Rugged Chaiz Man. (5999 Views)

Life Of A Rugged Guy +21 / Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi / Must Read : Confessions Of A Rough , Rugged And Raw Naija Guy ( 18+) (2) (3) (4)

(1) (2) (Reply) (Go Down)

Re: Diary Of A Rugged Chaiz Man. by Nicheey(m): 8:46pm On Dec 08, 2019
Vibesvbs:

U fit tag me abeg��

No qualms

1 Like 1 Share

Re: Diary Of A Rugged Chaiz Man. by bro4u: 7:37am On Dec 20, 2019
Nicheey:
Chapter 4.

Our matriculation was fast approaching, some of the people that were evicted returned. Though we reach an agreement second semester they will go,and they agreed.

Me and pepple turn enemy, i no dey even bother go him class.

The porter has been frustrating my life like madt,unlike my previous university this one you'll have to sign into your hostel.

Providing them with ya passport,your school fee receipt and other credentials (100 level mostly)

The man refused to signed me in,the first time i was in his office,he said i should put my papers in files,i was like no qualms na.

I hurried down to complex center front hostel D...
When I got to his office it was locked,mehn the outrage i felt ehh.

I just retired to my hostel for the day.

Ahboy,ahboy.. Which kind sleep you dey sleep like this na ote,i could hear Abel from my dream world.

"Leave me oo".. I said sleepily. "You know waytin be time?"... Someone asked me.

Na 6:45 pm oo,and you start sleep 2pm...

I felt 6 hand on my body,they pulled me up.
"Boy e don do wake up"... Afonne's voice hit my ear.

I stood up from where they had left me to sit.
Went outside to wash my face,i was so hungry. Immediately i remembered what had happened at environmental science faculty (the man's office). I got angry.

"Boy come make we go smack" Abel said standing front of me.

Me:you hold rubs?.
Abel: no issue that one dey

"Are you guys going to smack?"... A voice said behind our backs.

We both turned,it was caleb. Another of my room mate.

Abel:waytin sup?
Caleb: i fit follow una?

Abel looked at me,probably seeking my approval.

Me: caleb may we dey go already.

I said turning around.

Abel: why you tell that chaiz man may him follow us na?.

Me:leave the boy,no be smack we wan go smack?.

Soon we got to a place inside our hostel compound(our hostel F N G be like barrack).
There were two different people selling food there,though both under the same canopy but different tables.

Caleb:where una dey chop ?
Abel:mama Africa.
Caleb: oya na may we enter.

Well,usually the crowd at mama Africa fit dey like line that lead to hell( heaven no dey crowdy,lol)
But today every where clear,maybe na because we come early.

Waytin you wan buy? A woman probably in her late 20s asked,immediately Abel handed three plates to her.

I walked inside the canopy to sit,i still dey vex bout waytin sup today,i brought out my phone lazily and started surfing the net.

Hello!, a voice said. I brought my eyes up from phone,behold a pretty girl was front of me.

I'll describe her,no vex. Lol. She had a long thread braided. She's light skin in complexion,her body set! Asin every thing washing and setting.

She fine scarra,or ahbi na because since i come RSU (ust) na ugly girls i don dey see since?. Her boobs were burgin from the black hood she wore.
Mehn and e tey way i touch boobs.

Hello! The voice brought me to reality...

"Hmm..yeah? May i help you?"

"Would you mind if i and my friends sit down here ?." She asked

Sure!!,i said almost immediately.

Okay!.. She said with a smile,"just a sec,i'll go call them"...

Abel and Caleb came to the table i was seated,Abel had two plates of food in his both hands while Caleb had one.

Abel: aboy hwfa...(he said dropping a plate front of me).

Me: i dey.

Abel : who be That banny...(he meant the girl).
Me: she say she and her friends wan sitting with us.

Caleb: (with mouth full) hope her friends na girls o.

Abel: i hope them em be girls too ooo.
Me: we're bout to find out.

Just then the girl walked in with three other girls... Mehn em too goes well.

Hii,she said while dropping her plate of food on the table.

There were chorus of greetings from her friends,we returned their greetings too.


Nice story.
Re: Diary Of A Rugged Chaiz Man. by Nicheey(m): 11:07pm On Jan 06, 2020
Chapter 10

Emmy:this one no goes well sef, why we no go that trophy own side?

Caleb :or that Goldberg?

Emmy :you get 3k ? For just one white thing wey you wan Comot from your preek.

I just de dey look em as em dey call Ashawo joints,even small Emmanuel sef even know price join.

Abel:we Don too tey here na, we dey enter inside?

Emmy:no oo, we're broke not poor.

That Emmanuel statement I no come understand, no be small thread hold brokenness and poorness ni?.

Caleb :ahbi o, see as the place dirty any how.

Kai shey na ground we find come ahbi na Ashawo we find come? I no come understand again.

Abel: where we wan go now?

Emmy : trophy joor..


Abel :no qualms, may we dey go.

See as I just dey follow Em like goat wey em win kill.

This time we walked straight. We stopped at one duplex like building, e be upstairs ,for front na bar. I no see any girls ahbi na drink Emmy carry us come drink ni.

Na so we waka enter the bar o, I just the anticipate waytin I go see.

Abel:focus o...

Abel whispered to me.

As we enter inside the bar, na daddy yo! By wizkid em dey blast. See different colours if lights, as we comot from there we burst out for the main building. See topless girls dey stand front of room. "fine boy,fine boy " just dey full every where, both big brezz o, small brezz o, medium o, all if em dey. I still dey waka when person touch my preek from behind.

Hold catch me, I comot e quick. Abel notice m come stop with Emmy and Caleb.

The girl wey I turn Face, see boobs. For an Ashawo she has a nice medium boobs,e still dey firm or this one just start work new?

I carry face look her, Godddd this girl done scarra, come get that innocent smile, the urge do fuvk that mouth come dey hungry ME.

Where are you going, she said stroking my eggplant from my joggers.

Kai, I thing Don strong like who em use Red Bull create, before I go talk she don dey blink her eyes dey do all this innocent stuff.

"Franklin use your head"... Na set up o....voice in my head kept screaming.

Abel :ahboy may we dey comot na.

Me:gimme 2 mins may I yarn her.

Waytin I wan tell her sef?.

Me: excuse me (I was yelling, the song blasting from the speakers wasn't helping either), I'm not here to straff.

Her: sorry I didn't hear you, she said talking directly to my ears, while her hand still dey stroke my dick.

Which kain wahala be this na, ahhh. Hama sef the if not for the tight butthug wey I wear the idiot for Don disgrace me, no be say e long sef.

Me :im not here to Bleep. .. I yelled to her.

Her : oh, sorry. (she said taking her hand off my dick side.)

Me: and you look pretty.

I said and walked out with abel, the kind Bonner wey I get now ehh... I no just fit wait for go back hostel.

As we dey waka dey go back hostet, Emmy and Caleb just deg yarn bout the place wey we just comot from.

"if you see that girl body ehh,her ass badt I swwear" Na waytin comot for Caleb mouth.

Me I just quiet,I come dey get this feeling say I don cheat on someone.

Me;hwfa we never reach already? I don tire o.

Abel; we dey near diobu,just try hold ur self O,those boys dia own no good.

'see me see trouble?!,I be ask if any body own good?'

Emmy;cant we turn round? Follow through main gate instead of diobu.

Caleb:you and who get that. Strength ? Ahboy shhh,walk ahead,we don dey near.

As we enter Diobu belle start bite me,and Na anytime something wan burst that thing dey happen

Me:guys,any time from Na we dey wizz o.

Emmy:waytin sup?.

Caleb:wizz asin wizkid?

'it took the grace of God for me not to respond to caleb'

"Shhhhhhh ahboy!" May Una lap.

Some voice from behind us said.

Abel: I understand waytin u mean now.

Emmy:gear 4 or 5?

Me:put m for 5.

'now!.' I yelled while I took on my heels,foot steps wey dey follow us for back many,see as Emmy dey front front front. Upon say I first m run.

Abel:burst in asikiwe,burst in asikiwe.

'abel dey shout ontop him voice. We don already pass asikiwe oo,we come. Reverse come back.

As we follow asikiwe ehh,Na straight route to back gate,if to say we be follow where we be wan follow ehh,this police people for Arrest us,call us cultist.

Caleb:where emma?.

Me:him dey back.

As we reach dey gate Na so we dey shout clear way,until we burst in school. E don reach like 2 mins wey we enter before Emma enter. Baba dey breath with both mouth and nose, Na so I sit down for the asphalt road,people dey see me dey laugh,sha no be em fault. Who know the kind km wey I just road go dey gimme medal.

Abel:may we dey go collect our phones.

Walai to move ehh hard,e dey like every where knock.

Sha Na we Bleep up,why we no just follow emma advice. Follow through main gate.

Come dey pass diobu for night.
Re: Diary Of A Rugged Chaiz Man. by wisestar(m): 10:24pm On Mar 20, 2020
following jeje li
Re: Diary Of A Rugged Chaiz Man. by mystery22: 11:57pm On Mar 20, 2020
Following
Re: Diary Of A Rugged Chaiz Man. by Doubra12(m): 6:41pm On Mar 29, 2020
Next episode pls,nice rugged story
Re: Diary Of A Rugged Chaiz Man. by Nicheey(m): 5:02pm On Mar 30, 2020
Chapter 11

We just came from my cousin hostel and were heading to ours when we met Lizzy.

She be no see us o,I come dey get joy say at least may she no see me for my sorry state.

"Lizzy!!" Emma yelled waving his tired hands.

'i just weak,I don soak with my own sweat, who see me go think say then pour me water.

She waved back while she head towards us.

Lizzy:where Una dey from come.

Me:ahan ahan,so we can't go out again Ni.

Caleb:ahbi oo

Lizzy:no body dey say may Una no go out o,but why Una come dey shout clear way when. Una be dey enter,come dey run people wey em threaten say if em stop em go cut dia preek.

'the kind big spit wey I swallow ehh.'

Abel: Hwfa come buy us smack Na?.

'sha no be him fault,I fit finish 2 big cows as I dey like this.'

" may we dey go" Na waytin she talk next.

Her scent is good,while I walked behind her. I just thought maybe,maybe if I ask her out it wont be bad after all.

To be continued...
Re: Diary Of A Rugged Chaiz Man. by Doubra12(m): 8:48pm On Mar 30, 2020
Nice story
Re: Diary Of A Rugged Chaiz Man. by Nicheey(m): 2:53pm On Apr 23, 2020
Lizzy:franklin hwfa na, why you come dey do like who mad woman naked swear for?

(i be no no say this girl bad mad mouth pass my own o).

Caleb: aunty place orders na. Boys dey urge.

'see this one, like say on him own him be don come foodie come eat'.

Emmy: i still no dey comfortable o, who dey pay for the food, this one wey you carry us come foodie so.

Lizzy:ahan ahan calm down na, una be dey sweat, so i say may i bring una come where ac dey come chow na. Ahbi na bad thing ni.

'hwfa how much dey ya account' na waytin abel send me for WhatsApp.

'I get like 3k'... I texted back.

'thank God, we go still need like 4k join' he replied.

'for waytin na' i texted, trying to hide my reaction.

'you know how much be a plate here?' his message came.

'how much'? I replied with curiosity..

'950-150'.

Immediately i saw it cough hook me, serious cough o. Wey be say em gas run go fridge go carry water gimme...

Lizzy :frank are u okay?... "She asked stroking my back.."

Me:yes I'm okay.

'abel don laugh me finish eh, sha no be him fault.'

Lizzy, oya Emmanuel follow me let's go and order something to eat .

Lizzy paid our bills total of 6700,i dunno where she got money from buh mehn this girl no dey comot for my grips I swear down.

Walking down to our hostel I check time it was 8:30pm. She walked us to our block, after much pleading for her to enter the room she finally agreed. See as people dey look her as she enter, mehn even me no believe say crowd go dey room.

Afone: frank HwfA na
Me:I dey baba how e dey be.
Afone:every where good, na my visitors o hope u no mind.
Me:no lele.

Emma and Caleb Don lie down on top bed, they can't come kill em selves.

Emma:Lizzy thank you o.

Lizzy : you're always welcomed.

EMMA:ALWAYS?
Abel:tah shut up Dia, on your own u no no wey foodie dey?

Sha I climbed my bed leaving Lizzy standing beside my bunk.

Lizzy:you climb up leave me, see this 48 o.

The thing weak me, may this girl stop to dey call me 48,our two go fight o.

She climb up sitting beside me, I could perceive her fragrance. Damn this girl is fucking expensive, she pulled off her hood leaving only a armless shirt.

Lizzy:do well I Wan lie down.
ME:u no go do dey go your hostel?
Lizzy:time still dey.

She collect my hot5,used my finger to open my phone at this point I was completely oblivious bout every body except her.

Lizzy :this movie go well?
Me:yes
Lizzy: aight

Na so she watch the film reach 11pm,me kuku leave her may she forget.

Me:waytin be time?
Lizzy :11:20pm,i know.
Me:why u no come go?
Lizzy:this movie dey interesting
Me:okay.

"I Wan off light o" afone voice echo, no body oppose so him off am.

Me and Lizzy ontop one bed, I no get pillow so she dey use my hand as pillow like damn as if that wasn't enough rain come start dey fall.

She off my phone leaving only the outside light luminating through our window,her whole body was on mine.

Me:Lizzy wait I Wan come down.
Lizzy:where u dey go?
Me:I Wan go collect something outside.
Lizzy:okay.

She raise her body from mine, I come down open my locker carry soap dash inside bathroom, baf well. My towel be dey outside so I just clean my body one time, now I dey smell nice than before, I spread my shirt out side leaving my bare chest.

Wasn't long I was up on the bed she didn't even wait for me to offer my hand as her pillow she just climb on me, placed a kiss on my lips. I never expererit, our tongues dey rub together, she carefree my body as she did. I dunno what that is but I don't want it to stop,she was sitting on my D**k that's trying to rip out of my my trousers, she kissed my neck my throat, the sensation was outta this world. If na Mami water she be I no send I no want this day to ever stop.

'Bleep me' she whisper in my ears.
With pleasure I said to my self, it was then I noticed she had already taken off her joggers. She lay flat on my body while she pulled her tight, she unzipped my trouser immediately my dick Burge out with only my boxers restraining it, unbutton my boxers soon enough my d**k was in her hand, she kissed me while she stroke it.

Me:bae
Lizzy :yeah?
Me:I don't have condom
Lizzy:we don't need one.

She slowly sit on it, mehn gradually it all fit. She's so tight and warm slowly she raise her hips and drop, my hand was moving through her body, her waist, her ass, her boobs.

After 15 mins of the I ejaculated, every single drop of semen. She got off me, then peek me in the cheek. I dunno what just happened buh damn I'm asking her out this very moment.

Lizzy :where is the bathroom?
Me:just outside
Lizzy:do you have a towel?
Me:I do
Lizzy:bring it for me.

Lizzy was on my towel, she looks so pretty even in dim light. Ma do ask this girl out o.

Lizzy :let's go and bath.
Me:okay, I said closing the down behind me.
Re: Diary Of A Rugged Chaiz Man. by Nicheey(m): 3:16pm On Sep 07, 2020
Chapter 12.

I lay on my bed tired and exhausted,the room lights were on already. I checked time in my phone it was 5 am. I no dey see lizzy, ahbi she left already?.

Me:afonne abeg u see that erima wey be follow me sleep?
Afonne:that erima wey dey give us ring tone na, wey una no gree let us sleep.
Me: I have no idea what u talking bout (my facial expression dey betraying I swear lmao)
Afonne:how u go know?, Sha she Don go. She drop money for u, see am here. (he hands me notes of a thousand naira).
Afonne :na 5k dey Dia, be like she pay you to Bleep am.

People I thought were asleep burst laugh, prince laughed the loudest. Mehn I just weak.

The day was fast, I was in class already. As usual lecturer hasn't come yet, buh the class is filled to capacity. Going through my phone i saw pictures of lizzy, she must have taken a selfie yesterday.

'is that your girl friend?' a familiar voice said behind me.
I turned back to see whose voice was it, it was Lizzy. Standing there right behind me.

Me:lizzy
Lizzy :are you mad? Call me Bae.

See me see trouble o, just like that? I talk for my mind.

Lizzy:you dey curse me for your mind ahbi?
Me: ah me? I'm I mad? Who me, how I form? How I exist?.
Lizzy :shut up already.

Her fragrance as always has a sweet aroma, she hugged me so tight I thought I may suffocate between her two breasts.

Me:you and this your hoods eh, wear another thing na.
Lizzy: did I complain?
Me:kpele.
Lizzy :you too kpele.
Me:waytin you dey do here?, no be for ent u dey learn?
Lizzy :I come find man.

'good morning class, if you're for this class please make your self ready for studies, if you're not please leave the class'. It was our lecturer, Mr liberty. He walked to the front of the class beside him were two boys, one held his bag while the other his books.

Lizzy :by Bae, love you. (she peaked me on the cheek, mehn I mad).

This man boring eh, Kai. I Don yawn like 7 times under 1 min.

'so class see you next time', immediately I closed my book and made way to the door. School no dey excite me again, nothing just dey excite me.

'baba wida your eyes na, why you dey pass our middle'? Voice came from behind. See me o, I pass road em dey talk Dia middle, shey I see any body hia?

'abobi wida u na?' this time the voice was loud. I dey contemplate whether to turn back answer em or ma run. Die it I exclaimed in my mind,las Las hand no go touch me.

Me: senior men, no perre for me.

They were 4 two beside me sitting on a plastic chair while the other two were standing. From their dresses I can tell they're med lab (medical laboratory students). Normal white and blue.

Boy 1: you get mind o, no salutation just straight to the point as we be your elder brothers na.

Kai which kind wahala be this, the senior men wey I call una just now ni? Ahbi ma prostrate?

Me:senior man no be so.

'ahboy lap' a voice said from my left.
Me:I should come?

Boy2: no o, my father should come.
Me: senior man no be so.

I moved closer to him next thing I hear na one loud shout 'abobi focus dia'. Ahan ahan is this one normal? No be the guy say may I come ni?.

Boy 3: you dey mad?
Me:ahan ahan senior man waytin sup.
Boy 3:u dey ask me waytin sup?.
Me:as per normal levels na so I fit to avoid am next time.
Boy3: shey u no dey see capon shadow?.

I just weak. Ahsin I just weak.

Me:no vex senior man.

Boy 1: waytin make u pass this road sef.
Me:na my usual route be this senior man.
Boy 3: so u mean all this while na hia u dey pass?
Me:yes senior man.
' you dey Bleep up o, HwfA may we blow am Kala na?. I no like him face'. The fourth and last boy boy3 addressed as capon finally speak.

Blow who Kala? This people well?.

Boy 1: na WA for u o, chill as hear capon?.
Capon: na cuz of u o.

I just dey look em like fowl wey em Wan kill for Christmas.

'aboy capon you dey Bleep up o' a fermin voice came from behind me. I turned na those two girls wey cousin mount on me,i have never been happier as I see em.

Boy 1: kizaz you say?.

Who em dey call kizaz biko? E go be either of the girl Sha ma quiet.

Kizaz : shhhh ahbobi jonsing j man die your capping.

'una dey do do o, who una Wan blow Kala?' the second girl asked

Boy 2: winchy even you?.

Capon: waytin dey happen hia na? Why you leave your Iceland come disturb me for my Panama?

Before I say jack every body dey reach to em waist. Na so I take die? Just cuz I cross person middle? Waytin I go tell God? Say I dey cross for road by mistake I cross person middle so em puff me.

Winchy: frank lap hia.
Boy 3: if you move.

Omo this time e dey as if em concrete my body for where I stand, I no move back I no move front.

Kizaz: you know who be this? Shey una want may we Plunder una Panama?.

Capon: you're capping, who him be?.
Winchy : na striker brother be this, shey u go talk say u no no striker for this school?

The boys looked at each other, after brief mummering between em selves em say MA disembark like I be dey inside ship before.

As soon as we burst out to main road winchy hala me like say MA die. E for better if those boys be puff me o cuz as e dey be like this winchy fit puff me.

Kizaz:girlie e do, free am.
Winchy :ahboy from now hence forth the only place we no go dey follow u go na toilet.

Tor what can I do? My appearance dey bring unnecessary attention towards me.

Kizaz :waytin u find come management science?
Me: I find Lizzy come.

She was gonna say something but she kept quiet, Sha me no even reason am. I enter inside the big hall, many people dey pass up and down. Lizzy say MA meet her for en2.

I dey front of en2 see say people full dey talk, some dey read and do on.

I enter inside see Lizzy, one boy be dey her front. I swear the boy goes well pass me for everything, height, dressing, handsome, asin I dey learn.

As soon as our eye hit each other's she wink at me. Mehn I felt a quick rush in my stomach. she was wearing a white glasses, she kept nodding her head from time to time and still steal glances at me.

I tap my chest then pointed at the door (I Wan dey go) she point me then point door then do make slay sign (if you go I'll kill you).
Tor, I was forced to watch her flirt.

I brought out my phone o, plug my ear phones. On my data enter whatsapp, mehn abobi Eddie roll 'satisfy you' dey jam for my ears, I Don krass. Fan dey blow me breeze I just lay my back on the desk, this song go go well with weed Sha.

'ahboy where u' message popup. Na Abel, 'I dey en2' I replied.

'I dey lap', I see the message ' okay I dey wait u'.

I dropped the phone on my lap, I put the song on repeat. As the song dey hit me remain small I for sing aloud. I looked at Lizzy, she blow me kiss. Mehn even though person dey chyke her she still dey show me affection, Kai if I ask her out now she fit talk no nah I no go ask her out. If na friendship we get may e remain like that.

I Don dey here for 10 mins already, I stand up Waka go meet her.
'big man HwfA' I greeted the guy that was talking with her.
'I dey oh bros' , baba greet me comot face for my side.

Tor I be Wan ask am if him fit excuse me, buh for this nonsense attitude tah forget.

Me:Bae HwfA
Lizzy smile one wicked smile eh, look the guy she was talking to.

Lizzy: Daniel meet Franklin my boyfriend, franklin meet Daniel my very very good friend.

Mehn the guy shock, I no blame am Sha, even me shock.

Lizzy :Daniel later na, my boy friend wants to take me out.

Since when I turn her boyfriend? Where I tell her say I dey go biko? Mehn I don't know what just happen buh fuvkkk, I Don get her.

2 Likes

Re: Diary Of A Rugged Chaiz Man. by Sliss(m): 4:30pm On Sep 07, 2020
Welcome back
Re: Diary Of A Rugged Chaiz Man. by crystalmoon(m): 8:53pm On Sep 07, 2020
?
Re: Diary Of A Rugged Chaiz Man. by Nicheey(m): 7:52pm On Sep 11, 2020
crystalmoon:
Update pls I love this story

Update, next episode is Tomorrow
Re: Diary Of A Rugged Chaiz Man. by Carterj007(m): 6:57pm On Aug 08, 2021
I swear, I so much love this story. I was smiling from the beginning. Please updates.
Re: Diary Of A Rugged Chaiz Man. by silverlinen(m): 8:46am On Aug 11, 2021
Nicheey do come update us now
The thread make sense
Buh meanwhile try reduce the amount of O.T you dey put down or write them up in another way...if you're a real sailor,you go no say 48 lap for this platform plenty and e no good for illegal ears to know the words of the gods
Anyways I mount here ruggedly no update dey pass me by

(1) (2) (Reply)

At His Funeral: A Flash Fiction / Exam-In-(My N)ation / How I Fell In Love With An Agbo Seller. Pidgin Story

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 109
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.