Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,756 members, 7,809,910 topics. Date: Friday, 26 April 2024 at 05:02 PM

Jokes For The Day - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / Jokes For The Day (633 Views)

Jokes For The Week, let us hear urs / Hot Jokes For You All / Funny Nigerian Jokes for Everyone (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Jokes For The Day by muyico(m): 5:06am On Dec 05, 2020
Dis delay for salary don make my eyes chi chun chin. I dey settle matter since last night na him make me never greet una dis morning Police extend hand to driver, driver come pour am hand sanitizer, na the matter we dey settle for roadblock since morning. As Nepa bring light this evening na so the happiness make the house boy hug madam infront of Oga. Infact, we don dey beg Oga since morning. Landlord no gree pay NEPA bills, Tennant disconnect Landlord light... We dey inside rain since dey settle the matter. Madam called DPO to come and arrest her husband's side chick and the side chick happens to be the DPO's wife....we don pack ourself go another police station go seperate fight! My guy carry 2k enter boutique go test trouser of 25k, now zip don spoil. As I dey talk so, na d shop him dey, dey mop ground since morning. Tenant impregnated Landlord's daughter and Landlord impregnate Tenant's wife! We still dey settle am.. Maid mistakenly called Oga 'naughty boy' in front of madam, na the matter we dey try settle before gate man come tell madam 'baby calm down'. We are going to the village square now becos matter don tie wrapper. Oga borrow madam ATM card to support him business for morning, Side chick carry same ATM card go shopping for madam boutique for afternoon. Madam is still with the ATM card requesting for the owner or sidechick go spend time for prison. Na for de matter we dey ooO! Tenant dog no allow Landlord enter house, na so rain beat oga Landlord for outside. Na the compound we dey since dey beg oga Landlord. Na the matter to make someone happy we dey so, na laughter therapy wey you need we dey settle......On a lighter note enjoy your weekend.

(1) (Reply)

Get Professional Logo For Your Business At An Affordable Price / I Dey Do Guy With Hausa Langugue / How Nigerians Now See Reno Omokri

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 8
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.