Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,151,842 members, 7,813,840 topics. Date: Tuesday, 30 April 2024 at 07:40 PM

Love Is Blind: How I Take Fall In Love With Agbo Seller - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Love Is Blind: How I Take Fall In Love With Agbo Seller (391 Views)

Agbo: When Was The Last Time You Drank This? (Photo) / Rhoda Ameh And Sunday Agbo Wedding At Lagos Beach / Share Your Experience With Agbo (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Love Is Blind: How I Take Fall In Love With Agbo Seller by LoveEtRomance5: 6:39pm On Nov 22, 2021
I dey busy dey sleep, when person call my phone, shey na my neighbour dey disturb my life with her useless music? Abi na who be this one na?

I wake up, pick the call, naim I hear one guy voice o.

“Hello, martins, how far man? Na the voice wey I hear be that. Na wao I said to myself. I even think say na lady dey call me?

“Hey guy, wetin happen na? I told the guy. Can I help you?”

“Bro we no dey fight na” the guy replied.

“OK, o wetin dey happen? And who be you?”

“Na Daniel your colleague na. So you no get my number? Na wa for you o”

“Daniel? Which Daniel? OK OK Daniel Chibuzor?”

“Yes na” he answered.

“OK na Daniel any gist? “

“Gist full pass st peter Catholic church jiwa o. Guy we get match with euro facade fc o. We don agree say na you go help us officiate am. Abeg na only you we trust for a free and fair officiating.”

“Which kain free and fair officiating be that one?

Una go pay me? A toad does not run for nothing on the day time o”

” no worry” he said to me, we no go pay on cash but in kind”

Well weda cash or kind. Pay na pay.

“When be the match” I ask am

Na today o. In fact na two hours time. He answered.

Immediately, sleep clear from my eyes. I run enter bathroom, the match venue na Gsm village Abuja, and I dey stay for gwagwa, I know say from my residence to Gsm village go take like one hour. And I need to dey there before the match.

In order to get balanced mind, based on my own analysis, I first rush go bath, then go meet mama Zola,

“Mama good afternoon malle, abeg you get original mc dowell?

Which kain useless question be that na? You dey craze abi you want make thunder fire your nyash?”

“Ha! Mama e nova reach like that na, shey na play I dey play na?

” your father lap, who dey follow you play that kain mumu play? If una don smoke that nonsense weed wey una dey smoke, una head to begin dey think say red label na beer”

Ha. I surprise for that kain mama wey even sabi red label. But I no wan follow her talk any how, so I just apologized to her and tell her say make she give me mc dowell of 350 make I dey go house.

As I reach house, I no even bother bath again, cos the argument and some other things took so much time, and if I bath, after the match I go still bath. That one be me like say na waste of time and water. Water scarce pass fuel for my side.

I pick my football kits, I know say na referring job i wan do, but I no be Howard Webb na abi na Martin acktinson? Abeg make una leave me jare.

I rush one keke napep wey dey go life camp.

Keke man, how much be life camp?

#100nahe said?

“Chai, eajala no good o. #100 for this kain short journey? Nigeria don baje like tomatoes.

” kei Dan isca na fa. Gutsun uwarka”

The mumu no know say I don spend many years for samaru in Zaria, Kaduna state.

“Ubanka shey na una go vote baba abi? Na una go suffer am pass na.

” kai, I go slaf me o. I dey craze? Why is dey sfoil our fresident credibility?”

“Abokii, carry your wahala dey go abeg. I no get power for your wahala. ” make we dey go na. I said to him.
Continue Reading…
https://tiktalkhub.com/love-is-blind-how-i-take-fall-in-love-with-agbo-seller/22/11/2021/
[b][/b]
Re: Love Is Blind: How I Take Fall In Love With Agbo Seller by Hezzyluv: 6:45pm On Nov 22, 2021
Me na Agege bread seller I go fall in love with for Isolo lagost grin grin
Even come dey think weda na juju the girl do me grin
But las las I japa...

(1) (Reply)

The Only Thing That Weakens You / Sperm Donor Price In Nigeria / Yahoo Boy” On The Run After Hacking His Girlfriend To Death (video)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 11
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.