Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,362 members, 7,819,304 topics. Date: Monday, 06 May 2024 at 02:04 PM

Zenith Bank And This Bae Dey Do Me Zazuu - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Zenith Bank And This Bae Dey Do Me Zazuu (1011 Views)

Almost Every One Looking For Bae Dey Claim Introvert / I Need An Advice B4 I Dump This Bae Or Marry Her / What Steps Should I Take To Get This Bae Laid (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Zenith Bank And This Bae Dey Do Me Zazuu by Dreadlock69(m): 2:01pm On Jul 05, 2022
I went to pos to withdraw 3k , unfortunately it failed but this zenith bank debit me , i do am again ee bounce and them debit my papa again , i just chill say maybe after an hour dem go credit me back maybe it’s network issue.
Omo dem know credit me my money i vex go meet the POS girl change am for am immediately I almost bite the girl how i go do transaction 6k I know see anything , she tell me say know be her fault nah the bank make i go meet the bank , omo me know gree ohh i still dey spark before her oga come confirm everything tell me say nah from my bank make i go there tomorrow since ee dun late .
As i dey trek dey go house one eatery for my area come dey play this music by portable zazuu especially that “ olamide verse”
Baddo sneh (zehh)
Pepper sneh (zehh)
Many many werey wa nle (zehh)
Ahn, repete (zehh)
Unruly (zehh)
Baddo Lee (zehh)
P Prime, gbemi de'be (zehh)
Ah, ba'be je (zehh)
Azarailu, e pa (zehh)
Mofo's can not keep am (zehh)
Bitch, I'll be goin' nonstop (zehh)
Huhn, zazoo (zehh)
Shii, hacker (zehh)
Ika (zehh)
Tes'ojue (zehh)
Tes'ojue bi ti Alaga (zehh)
Ayy, Gaza (zehh)
Eje l'oju bi ti Abacha (zehh)
Ru'oju pa (zehh)
Le oju pa (zehh)
Ma rerin (zehh)
Kala (zehh)
Daju (zehh)
Wu'wa ika (zehh)
The next day for port harcourt i enter bus wey i go use go zenith bank , the driver still play that very song ”zazuu” i reach bank ee be like say make i use stone stone there glass , but me keep calm no wam, enter reach customer care the lady just use sweet word finger my brain say i go see the alert before night fall “CAP”. I reach house say make i buy one or two provisions enter first bank stand i wan withdrawal 3k instead of 2500 omo dem debit me i know see money i wan cry like how is that possible I almost faint. I know fit sleep that night the next morning i go the bank beside the bank outside them still dey play the same song again “zazzu” i change am for everybody for the bank , them tell me say make i calm down make i do statements of transactions which was 1.5k i saw my 9k there but the money is not in my account , they told me I should calm down I would see the money this evening . So i went home smoke small weed any small notifications i dun run check am but nah mtn useless messages. Later i see alert but nah 1700 dem credit me , wetin happen to my remaining money.
Re: Zenith Bank And This Bae Dey Do Me Zazuu by Dreadlock69(m): 2:27pm On Jul 05, 2022
The next i carry one police wey i dey familiar with enter bank again , this time around i dey red i just dey change am for everybody for there but the customer care , until the police guy told me make i calm down say dem go refund this evening as i commot there my aunty call me say have i seen the 10k she sent to me ,i replied Ahhhh 10k since when she told me 10 min ago and I’m already on bus and have depatch the police man giving him 1k, almost reaching the bank i saw alert of 9800 like wetin happen to my 200 i just keep quiet go house i dun weak i wan go house go chop I know dey see front again make i rest small .
Reaching my hostel my bae showed i told her to cook for us , i went to my dearest friend to lend me 3k ,as per say I know wan use that useless bank again before them go debit me wetin go kill me or money wey I know go see.
Omo this bitch/bae buy one spaghetti and two egg ,come buy Pringles one mumu funny spicy snack like that with juice i ask am say wetin be this she say nah wetin we go chop this night , i telli am who and who dey chop pringles I know too dey bothered bout the juice,base on say i dun too weak that day , I know get strenght to follow woman talk .
The next morning i see credit alert of 1500 from zenith wetin happen to my remaining money I know no , i on television put MTV base them still play that music zazuu i just look my phone remember zenith bank and werey wey sleepover for my house .

2 Likes 1 Share

Re: Zenith Bank And This Bae Dey Do Me Zazuu by Flamethehussler: 2:51pm On Jul 05, 2022
Nigga grin wtf man
Re: Zenith Bank And This Bae Dey Do Me Zazuu by tayo60(f): 3:29pm On Jul 05, 2022
Is this a true life story or a folktale?
Re: Zenith Bank And This Bae Dey Do Me Zazuu by MegaPlayBoy: 3:33pm On Jul 05, 2022
I'm dying bro

Thanks for making me laugh today
Re: Zenith Bank And This Bae Dey Do Me Zazuu by InfernoNig: 4:11pm On Jul 05, 2022
Zazuuuu. Pocotuahhhhhh. grin
Re: Zenith Bank And This Bae Dey Do Me Zazuu by PrinceofAgoAre(m): 4:28pm On Jul 05, 2022
The bank wan zazuu you finish
Re: Zenith Bank And This Bae Dey Do Me Zazuu by Dreadlock69(m): 9:40am On Jul 16, 2022
PrinceofAgoAre:
The bank wan zazuu you finish


I dun move to UBA abeg

That bank dey frustrate me to confusion
Re: Zenith Bank And This Bae Dey Do Me Zazuu by Dreadlock69(m): 9:43am On Jul 16, 2022
tayo60:
Is this a true life story or a folktale?

Facts i dun move to uba ,


This shit happen when was on my neck
Re: Zenith Bank And This Bae Dey Do Me Zazuu by Dreadlock69(m): 9:49am On Jul 16, 2022
PrinceofAgoAre:
The bank wan zazuu you finish


Aza man ló ripper

I dun commot my change from there
Re: Zenith Bank And This Bae Dey Do Me Zazuu by Dreadlock69(m): 9:49am On Jul 16, 2022
Flamethehussler:
Nigga grin wtf man

Nah so i see am
Re: Zenith Bank And This Bae Dey Do Me Zazuu by Jmichael1(m): 9:55am On Jul 16, 2022
omoh u dn make me laff tire...

(1) (Reply)

See What Happened To Me This Morning / Unbelievable Caught My Wife With My Own Friends / Who Poor Pass

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 21
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.