CandyOps's Posts
Nairaland Forum › CandyOps's Profile › CandyOps's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 11 (of 69 pages)
OlaOfLagos:Hmmm you obviously haven’t stayed in Lagos during the rainy season, from your comment. Any coastal cities Asaba, Lagos, Uyo etc the rain no be same as others |
Elxandre:Na the online specs be that.. that car nearly send me go back village lol |
MaziObinnaokija:Why you dey laff? what's funny? Country dey spoil u dey tribalize am? Dey laff on top Students sent to school by hardworking parents and all u have to say is mention PO? Ha! smh... see people wey we call youths.. u dey laf when thief dey waylay our daughters and sons SMFH |
2 years later and i'm here lol My RX300 is after my life I wan sell am for like 6m put money buy Rav4 2010 version, V4. just say Rav4 dey boring inside and no leg space Venza 4 plugs nko? |
Politics. Anywhere belle face na front |
Amotolongbo:No mind the werey. Him think say play we go just comot him teeth now now |
We also have a serial coke sniffer herein Aso r rock. He’s also a serial drug offender ![]()
|
Antivenom:Him dey chop wire wire on a steady! Could be govt wire could be Maga wire. Could be NEPA wire. Just know say wire na wire |
Nonexisting1:I think the opposition should also build their positive media and not leave it to chance |
Lagos, centre of madness. Person jump out of bus say the driver no dey follow road wey him suppose follow. She no pay complete. Okay no wahala, she later realize say na financial mistake come use her leg with her load for head chase the same bus reach where traffic stop the bus use back window climb enter back same bus because conductor no gree open door for her. lol Lagos wey LASTMA go direct your car enter one way lane him colleague go come extort you. Lagos wey be say if you comot house go message like 25 mins away if you come back you go just tire like say you done do one very hard work. Ordinary message you go oo! Lagos wey be say police must search you if you too fresh comot house. Lagos wey be say na by 9pm we use dey go beach lol. I never go beach for afternoon before lol City of hustlers I relocate come Enugu first thing I notice was that people in the East smile more. Like no be so we dey do for Lagos. Like what’s funny lol Enugu sweet abeg You go just dey see fine fine people You go dey feel your lifespan increase by few years here. Na just say commerce is kinda slow here but mostly both places |
Nonexisting1:And you dey laff? What’s funny? Your house is on fire and you are smiling. Remember, no think say e no fit happen to you. People wey e Dey happen to also been no gree say e go happen to them |
iwaeda:Police wey dey release prisoners for night to carry out operation after which them go share loot with the same police abi another one? Ask Obasanjo, Yerima and the police chiefs in charge then wetin happen to the $400million dollars awarded for CCTV installation across Lagos and Abuja for a test project which was supposed to come before the nationwide CCTV Project? Only 40 was installed abi 50. Ask Dasuki wetin him do with almost half a billion dollars for security. The thing with Nigeria is we are too docile. Even if them steal 100 trillion dollars nothing go happen because nobody go talk. Masses dey accept every nonsense because we allow unqualified politicians and thugs take charge. SMH. https://punchng.com/on-fgs-new-nationwide-cctv-project/?amp This isn’t even about tribe. It’s a clear case of neocolonialism because if the bastard oyibo government no support those animals in agbada them no go get liver Dey do nonsense without facing the consequences. Money wey for better country dem go carry dash oyibo back. It’s sad that after years of suffering in Nigeria person go still japa begin serve the same oyibos wey be say na their government make us japa in the first place. You go just Dey see say all these things na strategic plan. Also known as neocolonialism— the indirect takeover of global economies and power without direct military intervention. Oyibo done perfect that indirect rule strategy well And the only way to defeat them is one mind. And it cannot be achieved with Nigeria. The aim is simple - quench any effort at economic growth and make it hard for citizens to prosper so they dream of leaving their homes in search of better living conditions and economies abroad. After almost 16 years of schooling in Nigeria, I go still hustle pay better migration fees just to go serve oyibo when my people dey lack. I rather die for my people than dey abroad dey clean old oyibo person ynash. Or even work for them (that’s plain slavery, mehn) You know how much I spend for school plus the risks and late nights. It’s all wasted effort to me E no go better for Nigeria, Britain and US and and all religious leaders here. Oyibo no dey hard to defeat we know who and who dey help them from inside. Them first start with SUG and NANS (because na there be the hotbeds where revolution dey begin) Them use military men arm cult boys give them admission and use them scatter student unionism and even outside schools (NLC) so we no go fit talk. Na part of the reason GEJ take on massive school projects for North because him know say to comot power for oyibo hand na the only way forward & North no go gree because them lack education Have you ever wondered why them former Borno governor Sherima abi Shettima na Boko Haram father? Including current VP? The plan is to stall anything that will bring enlightenment or illumination of any kind to our people. So they (oyibos) went with our weakest link (North) & cajoled them to work with our enemies. Na why Mazi Nnamdi Kanu go tell you say our enemies friend is our enemy. Imagine trying to grow a nation with people wey dey push for direct opposite direction? People wey open mouth tell you say “education na crime” Na why Yoruba people involvement dey baffle everybody because say dem dey educated from day 1. Na why when AF0N.JA the warrior really messed up because he sold his brothers out because of power. Power wey him no still see. 👁️ Check out when Nigeria been get steady growth metrics — it was when things were done on merit. Then because say Igbos, Benins, and a lot of Yorubas embraced schooling well they qualified mostly for major of the public office positions (and country dey move fwd) … but then wetin happen? The oyibo begin media war, begin sow seed of hatred and confusion amongst us via Northerns and a few paid mercs to destabilize us. The result was complete envy which led to constant ethnic cleansing and bloody massacre of Igbos Next thing we know… the propaganda spread to the Yorubas. They began to teach them to hate Igbos. Okay… we agree, you no like Igbos. Let them go and start their own country nko?, the answer was a big capital NO!! Why? Oyibo dey fear say Igbos go succeed nationally and that success will open the eyes of other tribes to the possibilities that lies within us. This generation just dey obsessed with calling names on NL and it’s sickening because if it happens to you you go understand say nobody go help you. And the annoying thing be say, na wetin we pass. It’s just like we Dey complain of hunger when Benue State, Ogun, Abakiliki, Enugu and Kano fit feed the whole country. See what’s happening— them use paid fighters begin scatter farmers so we go dey hungry. And who is hungry no fit think about development because he is still playing within the first level of Marslows human needs. For people wey dey bomb foreign CL have you ever wondered why they find it weird when you ask them questions like, “have you eaten today?” because they no dey lack food. Food banks dey. Food security Na poor country wahala be that. Same with ulcer. Ulcer na where water supply no Dey dem dey suffer Ulcer. Kidnapping nko, crime nko — all these na effects of hunger and poverty. So when we say our choice of politicians matter it really does. When I see people ambush a criminal who stole I laff because his crime only affects 1 person or a few directly. But a politicians crime affect millions. So do the maths |
Oh wow! This one na case of Romeo and Juliet (Onitsha version) wey dey on colos When the highness clear for him eye maybe na PVC pipe dem go fix for him gbola or then go just kuku do am major surgery make him turn transgender because how? |
I thought.. *giggles* I thought.. when I saw “used 1 finger to…” you already know what I thought so no need to write it in full **giggles again** ..put one finger wriggle it then bring the finger close to your nose and sniff it ![]() **Shakes head vigorously*** Nyama! |
Sad but truth. Baba Blue done put him kinsmen for every decisive postion. Even if Peter Obi filed Tinubu as him running mate UK govt no fit ever support am because it’s obviously them calling the shots from Chattam house |
Summary for people that don’t have time to read — OP is saying, don’t wait till you have lots of money to invest. Start with as little as 10k and use automation |
If no be Federal, he will be out because the police is on their payroll |
MaziObinnaokija:Nwanne were ire gi guo eze gi onu. Ihea bu oru aka ndi uwe ojii. Ha na ndi kpara aru ha ji n’ulo mkporo |
richiemcgold:Guy you be fool ah swear lol 😂 ![]() They call it demon for a reason. Na that hand shocking trips I hate pass. I gats dey barefooted most times or touch hand for ground to earth myself because the current too much 😂 .. I done drop my new iPhone 13 twice because I lost motor control. Come crack back screen Now if I wan dey on colo, I go put my for purse. Colo trip no make sense at all And I hear say most long term users dey finally really colo las las Colo no good. E dey give out of body experience you go come dey see yourself from 2nd person pov come dey pity yourself say “see how your life done spoil” rotflmao 🤣 Guy one puff 💨 and you gone! lol And na only JK dem dey collect smoke or cake without asking “abeg wetin be this?” Na rule of thumb say you must ask And anybody wey pass you Colo without telling you na big enemy. That person fit kill you |
Funny enough I’ve not been with 1 before. Not like I want to. Ijs |
ruggedtimi:No dey confuse yourself. Blackmail and wire na fraud but not the same |
ruggedtimi:No be wire money. Read the post. Na BEC wey dem move the balary via crypto |
All these things na plan wey oyibo done set low key to destabilize 9ja. Na the introduction of cultism to schools by Nigeria military and yorubas kill student unionism. As SUG, NANS and other young vibrant student movement was killed the lecturers and Chancellors and everyone involved in academics begin misbehave. See NLC, completely disorganized and divided because if you talk them go send thugs after you. Imagine say FG arrest a whole NANS president last 2 months over a claim that Seyi Tinubu wanted to him to bribe him with #100 meters to support BAT and that his refusal led to disruptions and attacks at a NANS inauguration ceremony. Isah also accused Seyi Tinubu of involvement in his abduction and torture.… and yet the whole Nigerian universities didn’t even say a word. In fact, schools was still in session. SMH Guys, only a fool will keep doing the same thing over and over yet expecting a different result. Nigeria with its current metrics and policies won’t grow. Watch this 10% growth in electric supply, for example, if that growth continues in that sector it will be undermined one way or another. Take note. Go to the official website of the Nigerian Nursing and Midwifery Council, the official fee set for indexing of student nurses says #8k some but National Orthopedic Hospital Enugu College of Nusting School charges 90k for the same fee and nothing will happen. I’ve sent the council a mail yet no respond. If we don’t violently smoke out these crazy babylonians leaders and their thugs out of their holes our future will always be in jeopardy |
Like… how can you be so informed yet choose to be blind to the other side of things. Well, we all have biases and I don’t know how you built up your premises and logic to come up with such a distorted view of what makes up your reality of what is true/false. It’s really fascinating tbh. It’s like trying to hold a convo with a literate person who probably has a formal school education yet they lack the simplest idea of how things really work because they’ve been sold a media version of what is ‘ morally’ acceptable/right. But then knock yourself out. It’s your world and you can wallow all you want in the unending cycle of your own self-made ignorance |
GodisStriking:You should take a step back and really observe who’s the one playing the ostrich here. You talk about accountability but fail to call out the albino Caucasians for their atrocities and crimes against humanity? For how they’ve only been spreading hate, discord, diseases, mayhem and complete destruction in the world? It’s surprising how one can be so enlightened yet so ignorant |
Mr Everything-Black-is-evil is here again to bash his people again and to praise the white man |
Make she loose guard first lol I won’t do it but some other guy could |


you already know what I thought so no need to write it in full
About time the government do something about these IPOBIDIENTS TERRORISTS 