₦airaland Forum

Welcome, Guest: Register • Login • With Google • Trending • Recent • New

Stats: 3,344,742 members, 8,513,477 topics. Date: Thursday, 05 November 2026 at 05:52 AM

Toggle theme

DopeJemi's Posts

Nairaland Forum › DopeJemi's Profile › DopeJemi's Posts

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 45 46 47 48 49 50 51 52 53 (of 386 pages)

European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by dopeJemi: 7:41pm On Mar 22, 2018
elrony:
Lol.. na tracts I share o..
Indeed cheesy
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Official Manchester United Fan Thread:''20 Times EPL Champion by dopeJemi: 6:32pm On Mar 22, 2018
I was here
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by dopeJemi: 6:30pm On Mar 22, 2018
elrony:
Una school girls dey do excursions reach southside o.

I preach to some sha grin cheesy
Hahahahahahahahahahahahahaha, you climb pulpit with your mic abi? Our girls spoil die ehn, all those girls wey dem don cage tire for house wey don finally gain freedom na full there, na there you go see babes wey dey take Tramadol, refnol, Crack, Codeine and weed together, one babe even die in top the matter, e dey take the grace of God to comot that school say you no spoil
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by dopeJemi: 6:25pm On Mar 22, 2018
Nihilstjnr:
my egbon,

I weak.

When he say magic tricks, I think say he dey make panties disappear.

My dude dey actually do magic tricks with whot card grin grin grin

Flying paper ffs cheesy
You no be better person grin make I disappear another man babe pant for public, if na that magic trick you dey talk about, na bedroom I dey perform that trick, the only thing I dey disappear for public na hair bands, watches, ear rings, na for house dem take dey come collect their properties then for there I perform my second act
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by dopeJemi: 6:15pm On Mar 22, 2018
elrony:
Houdegbe huh
You don talk am
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by dopeJemi: 5:55pm On Mar 22, 2018
Nihilstjnr:
Good Lord
I had to get that babe one way or another, I am talking a Beverly Naya kinda chick, I don use tricks take date 2 of the hottest chicks for our vicinity, and no I didn't do card tricks
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by dopeJemi: 5:53pm On Mar 22, 2018
afrodoc2:
grin

You sef shock?
Paper float for air abi wetin i read? Dopejemi why you no float paper for these sugar mummies na?
Na floating paper those ones wan chop? This thing I dey talk na about 5 years ago, I don even forget everything sef
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by dopeJemi: 5:42pm On Mar 22, 2018
Nihilstjnr:
When you say magic tricks...

What do you mean?

Hope say you no be one of those boys wey dey carry deck of Whot upandan shouting, pick a card, any card...
Lmao, No. Na improv own I dey do, I dey use wetin dey around me, the only time I use cards na when babe come my house, but outside na improv, that day na paper wey I see for ground I use, I make the paper float for air
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by dopeJemi: 5:35pm On Mar 22, 2018
diggz:
Make e just be for there....cuz if na babalawo elrony school wey him graduate from with plenty waffarians.....you too know say all of una go die well on top the matter abi? cheesy
Unless say I get two heads, I no go try am cheesy cheesy
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by dopeJemi: 5:29pm On Mar 22, 2018
diggz:
For which kind school naim you use run that kind package for in front of the bf? If na wen I go school walahi....dem for use ur face use scrub Kota.......
The tag wey follow my name that time sef no fit let anybody do anyhow come my side, the fear of a warri boy for my school is the beginning of wisdom, besides na the two of them I run the magic tricks for, but for my mind my main audience na the babe.

Na one school for Benin Republic
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by dopeJemi: 5:17pm On Mar 22, 2018
Nihilstjnr:
oboi you don ever razzle babe, wey even the babe hail your for your smoothness as you dey collect the number?

Omo things dey happen for this world.

Dopejemi I believe in you. E go happen
This one happen to me tire for school, the second one na when I use Magic tricks take Razzle babe from her boyfriend hand live and direct, I been sabi some kind magic tricks for school that time, as I sight the babe with her bobo from afar, na my body ginger me once based on say I dey very sleek with the thing, the next day na me and the babe for beach na
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by dopeJemi: 4:20pm On Mar 22, 2018
diggz:
Ibime n that oloriburuku Raumdeuter suppose sort things out....
Na wash
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by dopeJemi: 4:14pm On Mar 22, 2018
diggz:
I get...but try have a reasonable and realistic one bro...cuz no be everybody dey fit arrange well before dem settle down....most guys can only afford basic things before them settle down e.g accommodation, a single vehicle and feeding.
You have a point, but wait oh, with all these plenty talks of sugar mummy, I think say una go make donations sef undecided as per una paddy wey I be. Na wa oh, so much for brotherhood undecided
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by dopeJemi: 4:06pm On Mar 22, 2018
Skimpledawg:
Beautiful man, beautiful!

Oluwa will make it be true for us all. No be only diggz go go grin
Amen oh
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by dopeJemi: 4:05pm On Mar 22, 2018
diggz:
Na here una take dey make mistake so....in life there's always the right time or period or phase for everything. if you no do am when time reach based on some side goals....e go turn into carryover wey fit affect you or stress you out in the future.

In essence, I am saying you should continue to live your life head on....if you think its time for you to marry, you have someone to marry and you can afford to marry and take care of your family......strolling abroad with your family shouldn't be enough to stop you from getting married now....if not, you go be like 70 years still dey train kids dey go....that's if you want kids to start with.
Basically, what I meant was, I want to be very comfortable before getting married because it is hard for me as it is, as an independent young man, I wouldn't want that too when I am now responsible for the lives of maybe 3 or 4, I wouldn't even want to see any sign of difficulty
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by dopeJemi: 3:58pm On Mar 22, 2018
raumdeuter:
You fit marry diggz and follow am go Europe
Why you be like this for Pete's sake grin grin grin grin
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by dopeJemi: 2:49pm On Mar 22, 2018
Ibime:
I no need airmax again, I need Ipad wey I go dey flex with my pikin. If oga Nihilist fit do that one, I go happy pass monkey


[img]https:///media/3-22-2018/NPcTlQ.gif[/img]
Lmao grin grin if na that one, then just forget nihilist no go fit
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by dopeJemi: 2:43pm On Mar 22, 2018
Skimpledawg:
The recession matter sef eeh...mans just tire.

But Oluwa sure pass. Person gats dey plan marriage o but no bars


Are you sure?
Marriage for me is near with age but far from mind, before I marry I wan make sure say going to Europe go be like taking a stroll for us
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by dopeJemi: 2:32pm On Mar 22, 2018
elrony:
Ehmm...Nihilist dey owe Ibime one solid pair of Nike Airmax !!!

grin grin
Lol, Ibime Don get airmax be that
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by dopeJemi: 2:24pm On Mar 22, 2018
Nihilstjnr:
And you still nor know why Nancyboys dey always call your name? cheesy
Lmao grin grin grin surely I must learn to use my words wisely whenever you are around
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by dopeJemi: 1:11pm On Mar 22, 2018
Skimpledawg:
Egbon, finally all these matter no dey pay finally at the end of the day. Slow and steady hustle wins at the end with your life intact. cool
To make some cheddahs after 3 attempts no bad na cheesy recession dey happen since but na now e dey really tell on me
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by dopeJemi: 12:55pm On Mar 22, 2018
Skimpledawg:
I dey hate all those unnecessary celebrity stunts eeh.
Naso for warri when I been dey serve. My guy uncle Wey dey work for Chevron invite us during their Easter light party for Chevron. Omo, I package wella go o with my guy, sharply I locate one fine matured lady dey scope am, she was just smiling giving me hope and joy... Na make I push to the next level na em Uti Nwachukwu ball in with his guys Mehn naso everywhere scatter brother

e vex me eeh... Naso I no take see the cute lady again. I so much vex I no gree eat there. I for burst person head that day.

This happened 5 years ago in warri
Lmao, Uti na my guy oh, I hate to dey famz all these celebrities ehn, if you no come from Hollywood I no fit famz you, because even our so called celebs for here dey famz them. You know say warri people sabi act local well well, as celebrities barely dey reach there so, you no go blame them.. PH go be my next destination after Benin
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by dopeJemi: 12:47pm On Mar 22, 2018
elrony:
grin grin grin grin grin

DopeJemi, you don see am ?

Nihilist be feeling some typa way whenever he goes past a Nike Shop! cheesy
See as man leg fresh like runs girl own, na wa oh, wait, Nihilist promise ibime airmax too if bakayoko no score reach 10 goals?
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by dopeJemi: 12:30pm On Mar 22, 2018
Skimpledawg:
Baba, e plenty die for here.

I carry my Uncle soft ride enter SPAR (Porthacourt shopping mall) during the Mothers day to get stuffs, omo Wetin my eyes are that day eeh.

One lady just kept looking my side, I knew I had to act, but this church thing no go lemme shake body. Those days at Abia, I used to have a sugar mummy, so I sabi how to run their package wella.


But, but.... huh
I been done get opportunity to run the package in the past, but I overlook am based on say I dey use money shine then, Now no one Don cross my path, I play enter Ikeja city mall on Saturday make I for at least jam one, na that day denrele with him gay ass know say he wan come showcase himself, na so everybody dey gather am like fly wey see sh.it, I just Cary my pop corn enter cinema go watch Black panther

I go play enter PH very soon
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Official Manchester United Fan Thread:''20 Times EPL Champion by dopeJemi: 12:02pm On Mar 22, 2018
5400 coming soon
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by dopeJemi: 11:58am On Mar 22, 2018
Skimpledawg:
Buahhahhahhahh Hahbahahahahah... grin grin grin

You and afrodoc2 no good at all cheesy

Omo, I visit Salvation Ministries headquarters for Ph few Sundays back, omo the level of sugar mummies I see no be here o. Come see tight ladies with Oyel money all over smiling and joking with young guys after service. I was like Chai, I gave my life to Jesus too early grin

Dopejemi, try come around, your life will not remain the same again.
Funny enough, one of my guys invite me over to PH, say one of him auntie say make I come PH, say dem plenty there
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by dopeJemi: 11:21am On Mar 22, 2018
Diggz, that one na broke oyinbo, you no see say she dey find work for cheap brothels, dey use fantasy dey cover up
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by dopeJemi: 11:19am On Mar 22, 2018
sod09:
abeg use one of your scummy guys for ritual, una useless anyway.
the painful thing be say nah cowries and kobo una go they vomit cheesy cheesy
I hear say for ogun state, na dead body dem dey go uproot for graveyard for rituals, na that una thread wey already don be graveyard I go use for the ritual cheesy

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 45 46 47 48 49 50 51 52 53 (of 386 pages)