InSanety's Posts
Nairaland Forum › InSanety's Profile › InSanety's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 20 21 22 23 24 25 26 27 28 (of 90 pages)
geezprince:E no easy. |
RosyIsBlessed:She started tripping when the guy been no even fit talk. But if na this narrative you like, carry dey go. |
geezprince:She dey like all those aproko neighbors wey get everybody portfolio for hand, dem dey always dey for house, dey wait for latest development. Information Minister ![]() |
Lucy wan tell us say all this PDA wey Kidd and Erica don dey do, she been no dey aware? Wonderful. See as she cram everybody relationship, because she no get her own. Na so I dey always sabi celebrity people relationship, because I no get my own. Make una help me abeg, I need babe. |
Eeghe:Exactly. You know say, as far as Nigerians dey concerned, you must stay one place. Serious relationship or not serious relationship. She no want anything romantic, because plenty feelings dey disturb energy. |
Greizman:Anybody wey think say "sex" na "make out", no suppose dey have sex, because their mind never mature reach for am. |
Simran94:She finished talk with Laycon yesterday, they hugged it out for the last time and so far so good, she never follow Laycon talk anything plenty today. She was called out yesterday. E never even reach 24 hours, and una don dey conclude If na Kidd she give handjob, no harm done, as long as no be Laycon. She dey consistent with one guy, she never touch Laycon dick before, so, wetin bring slut come talk? |
stephleena:So, in your opinion, Kidd never change? The only person wey never shift ground plenty na Erica, Kidd has changed. E don tey wey he promise anybody trip to Mykonos, or diamonds from Botswana, he no even dey entertain girls like that again, so, which one be say, "We all thought Kidd would change?" Kidd don change, if you no remember as e be before. |
Eeghe:LOL. If you know the kain imagery wey I just get with this your explanation ehn ![]() Your pikin insist say she and Kiddi na just friends dem be, wey just dey attracted to each other. Nothing like romance. Dem dey connect and dem dey enjoy each other time, but no put mind say anything else dey there, at least for her. Tolani say dem no wan put name for wetin dem get, and e dey okay, because as long as two people dey enjoy each other company, no need to put tag on it, if dem no want am. BrightO come conclude everything, say two of them na strategy dem dey do. Nobody dey catch feelings, dem just dey enjoy themselves. So, there you have it. |
carammel:She go learn with the task. |
NLbabygirl:Dem no dey learn that kain yab, you gats spend at least one week for mountain, before the inspiration go hit you sef ![]() |
NLbabygirl:And Lucy obliterated her. The last time wey dem destroy person like that on international television, na when Tayo incinerate Sheila on BBA. If you wan confront person, better come prepared. Amoeba and Old cargo no be insult Na good entertainment sha ![]() |
Praise looks so much better without that nonsense dread wey e dey carry for head |
Biggie had to help Sisi Nene with terms like rape apologist and survivors. Sisi Nene come thank Biggie, she say she been no take English classes seriously. Lucy has been vindicated, she talk am, say Sisi Nene dey skip classes to follow man ![]() |
Sisi Nene don dey use Neo talking time. |
Eeghe:We are well my dear We just dey cruise for here. |
Bookworm001:I no fit stroke her for that one, na Ozo like him station, no be her fault. |
Nengi say she and Ozo never get relationship talk before. God is great |
Broobembem:As in, very wrong. Even if you follow me talk about any matter today, if tomorrow, you make general statement and I no hear my name, I no go even answer you. Na who collect market, get am. |
She dey keep Ozo till end of the show, so, in case her boyfriend outside don move on, he go be her rebound guy. A forward-thinking Queen. |
So, Lucy made general statement yesterday, Sisi Nene collect her sub. If you no dey do something, why the talk affect you? |
Chiefheywhy:I no dey like make anybody use ashawo as insult, those people dey try. |
Person sex Erica and her face no move, she no moan, she no squeeze face, she no do mouth A whole expressive Erica, just lie down like that. Picture of her enjoying sex, or it never happened. LOL. Una never start. Na so una go continue to lose sleep because you dey wait for Erica to have sex, until your eyes begin dey deceive you say sex dey happen. Consequences of sleep deprivation. If una continue to slutshame Erica, she go dey gain female fans more. No more crucifying women and protecting men for the same sin. |
Amya:Ese o! You quote me, na im be say I dey important. Nairalanders make una come follow me celebrate, Amya don give me importance, I don turn influenza for here ![]() Ese gan!
|
LordTheus:New week, new tears. We dey always hear the same line when dem don finish am. Na normal sturvs. |
Amya:LOL Epistle of Frustration
|
livelymatilda:NFCS o, na only NFCS care ![]() |
Eeghe:Na frustration cause am my dear Forgive and ignore. |
It is only a vile and bitter person that can identify vile and bitter people, na only ashawo sabi ashawo well well, na only failure sabi failure well well. Some people get PHD in identification of their kind. E better make I dey the same house with Lucy, than to dey same house with some people here. If you fit post all this bitterness and toxic words on this thread, on top people wey you never sabi before this house, na only God know wetin you go do if you dey house. Na wetin make I talk say some people for this thread for kill some housemates if na all of us dey house. We fit no sabi as you take be for real life, but this internet dey expose some serious personality traits. |
Amya:The way you are always so quick to call women you don't like ashawo and who/re dey always surprise me. Let me inform you, if you no know. Ashawo work is one of the most difficult jobs on this planet, because those who do it are always at risk. It is also a very important work, and if say Nigeria get sense, dem suppose dey use am make money, like sensible countries like Netherlands. No be wetin dem dey use insult person, because no be anyhow people dey do the work, the average ashawo is braver than people wey dey use the term insult them, and has probably helped more women in their marriages, than most married women know. The average 'Ashawo' na: Sex worker Therapist Psychologist Financial Analyst Business Manager Investigator Very highly-skilled individuals, wey if you siddon with them, you go know say you no get sense reach them. So, I no know wetin make you think say you better pass them, wey you go dey use ashawo as insult. Dem be ESSENTIAL WORKERS, so, drag your mind out of 1989, and realise that they are doing you a favor. You need to get more creative than using 'ashawo' to describe women any small thing, or wh.ore, because na yourself you dey cast for here if you dey talk some kain things. Be like you get register of all the failed and successful ashawo for Lagos, as Computer Girl wey you be. |
Blackhawk01:Erica is more relevant than her favs, so, she must use her for extra likes on these streets. Enjoy, e no easy to dey important |
77up:No be nonsense like wetin Archangel talk dem dey counter. He dey always write nonsense, so, why I go waste my time to counter that one? I don dey counter him rubbish since, but now, na only who never sabi am go believe wetin e write. |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 20 21 22 23 24 25 26 27 28 (of 90 pages)


