InSanety's Posts
Nairaland Forum › InSanety's Profile › InSanety's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 18 19 20 21 22 23 24 25 26 (of 90 pages)
homesteady:Ozo has never gone to demonize Nengi to anybody because she dey rebuff him advances. NEVER. Since he even present him problem to Biggie, nobody don hear him matter for that house again. He dey him dey, accept him fate. He is four times the man that scrawny thing will ever be. Na wetin make Laycoon no fit carry this him mumu Erica talk to Ozo, he dey look face well. Ozo will never sit down through such discussion. |
All these useless unrequited love BS, na always woman dey suffer Last year, Esther wan finish Frodd destiny, na she be demon This year, Erica dey try dey nice to Laycoon, na she still be demon. Women no go ever win, because men no fit handle rejection anyhow wey you wan dish am. Na just the truth be that. If na woman dey beg man for love, na that one una dey enjoy. |
galaxyball:If she fvck, she fvck. So, bloody what? |
Beze992:Exactly. And anybody wey fall for him bullshit, is either as gullible as Erica, or as slimy as Laycoon. |
MizzD:No mind them. Dem dey drag with we wey no dey vote. |
Dannyxy:Bring Me one time that Erica has said a bad word about your snake, or SHUT THE FVCK UP! No just try dey unfortunate with me this night, before you begin dey lament like your dada boy .Voting begins in minutes, better go hustle the giveaway wey you go use save your guy. I get time this week, my fave is safe ![]() |
scondy:Why the FVCK should she give him immunity? He asked forspace, she go meet am to confirm if he still want the space, the slimy snake, talk say he still want the space. If she chose him, the same you for come this place, to accuse her of not letting go, now you are asking this very stupid question. Your little rat, for waka round the house, to declare say she truly love am and na she no wan release am, and you for dey here dey declare say Erica no gree release him destiny. Again, why the FVCK should she give him immunity? Una go vote tire, immunity finish una there. |
Vickmanny22:We have seen enough of that with Laycoon In front of Erica, he will say, "I'm happy for you, just do what makes you happy. I won't hold anything against you" Behind her, he will tell others, "She is an actress, she is manipulating me" He's a vile human being, scum of the earth, the worst type there is, that will declare their love in your presence, and make you a villain in your absence. Erica has NEVER said anything in Laycon's presence, wey she no fit talk for him absence, even to her supposed love interest, Kidd. |
Let it be on record, that Erica has NEVER said a bad word about Bros Laycon. She dey always declare say he be her guy for that house, say na only am get her back. She don even throw Kidd under the bus for Laycon, multiple times. We no fit talk the same thing about Laycon, wey don demonize Erica to half of the house. I go remind everybody this thing, as many times as I can on these streets. And anybody wey get proof that she don demonize the guy before, bring am come. |
geezprince:He don lose the connect. Naira Marley know road to Def Jam? Time will tell |
Blackhawk01:And the thing wey burst my head pass be say her so-called friend, Vee, dey there with Laycon, dey help am demonize her. She will not go to her 'friend', Erica, to tell her all these things wey Laycon talk and get her own side of the entire thing. Dem go just dey paint the girl black dey go. I no know maybe na jealousy dey worry them, but anyhow anyhow, dem go leave that house, before her, and she go still thrive. |
MamBi:He cannot learn, if he learns he has to move on, there is nobody else to move on to. He needs a villain for his movie, Erica is it. And thankfully, she no get enough sense to leave matter as e be, so, no moving on. Layrickidd triangle forever. |
Blackhawk01:And she open her mouth dey declare say na only Laycon care about her. I talk am from Week 2, say Laycon only cares about himself, and anything wey go elevate am. The mumu Erica just go donate herself as villain for him film, because of her need to be in everyone's good books. She no fit stand her ground for anything. As Praise talk say two of them dey quarrel, but Erica go always come meet am before he sleep to apologise, na wetin make me know say the babe na people pleaser. No be only Laycon she dey do this nonsense with, she must explain herself to everybody. Very harmful behavior. |
Brethren, na this kain thing dey make people say make you help yourself, because nobody go help you Hopefully, Laycon go fit win HOH next week, instead of depending on Erica for immunity. |
Blackhawk01:No be wimp he be. He dey demonize the girl and she dey give am ammo Na normal story- 'poor', physically unattractive man, losing to buff, rich guy. Na the woman be the demon for her. I hope this is the last we have this discussion. Although, I don tire to even dey talk that line. We agree say she be actress, now, wetin I don establish be say, Laycon sef na actor. Make we dey watch film. |
Dotez:Exactly. |
geezprince:Because dem been get agreement say dem go choose each other before. So, she wan clear am, make e no be say she been forget the agreement. Yes, she dey try release herself from guilt, that one dey |
Last week, Ozo go meet Nengi, follow her talk so tey we think say na Nengi he go choose, only to go and sit with Nengi to announce Dora. Laycon stop wailing abeg. Take this shit like a man, even Nengi took it better. |
Laycon Laycon For somebody who was not expecting to be chosen, you are really taking this thing personal. |
Laycon we agree, na script, abeg, log out of the film. Nengi no dey lament like this and na do Ozo been spend over ten minutes dey talk to her lastweek, before he choose Dora. Yet, Nengi no go dey tell anybody say na script Ozo dey act. |
Neo is always there for anybody wey lose out on these entanglements. |
Lazyyouth4u:If you know the queue of men wey dey wait Erica after the show, you go know say all these ones na unnecessary questions. Make una just enjoy housemates while you are seeing them on your screen, make una no dey imagine wetin go happen after the show. Dem go continue their lives, wetin wan happen again? Una dey always talk like say the world no big pass 20 housemates for BBN |
Kidd don pack reach lounge, even the person wey win the HOH never pack finish ![]() |
Erica dey concerned say she been get agreement with Laycon in week 1, and as early as last week sef, say, if either of them win HOH, dem go pick the other person. Na as she renege on the agreement, na wetin she dey feel bad for. I understand the basis of the feelings, but this thing na game and you gats dead such nonsense feelings. Kidd is even very understanding of her situation, if na me you dey tell all these things, I for tell you make you jazz up. Wetin? |
This girl wan give me heart attack. I go punish she and Kiddi with votes for this heartache in 2 weeks ![]() |
Thank you God! |
Fucknengi:Dora |
fairygeh:They punished them by removing all their Betway coins. |
Munzy14:If she picks Laycon, it means she has lost the game irretrievably. She's done. Pray make she pick Laycon |
Two people agreed to give each other space, on the request of one party. The other party come win HOH, the normal thing? Keep the initial agreement. This nonsense discussion is annoying and unnecessary. I repeat, if this babe picks Laycon, I no do again. Ozo go tension person last week, this one go bring her own this week. Abeg, make entanglement people no win HOH again, if na so dem wan dey do |
Medunah:When did you see Erica coming to him? They returned from break and we saw them together, so, how you know who go meet who? |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 18 19 20 21 22 23 24 25 26 (of 90 pages)



.