InSanety's Posts
Nairaland Forum › InSanety's Profile › InSanety's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 17 18 19 20 21 22 23 24 25 (of 90 pages)
Animog:It was fine then, because na Kidd. |
BrightO and Tricky don dey do plantain and egg BrightO food dey always dey after midnight |
Sellout:Sorry o Na as I see am, I report. Thank you for watching. |
Wetin Kaisha dey try remember so, wey she dey talk to herself? ![]() |
Erica dey tell Kidd say she been no dey reason say Kidd go get her back, na wetin make she dey look am with corner eye. Kidd say make she no reason am like that, say he cares for her and he will always have her back, whether na inside house or outside |
See the Erica and Kidd, feeling bad for the Laycoon fellow, pitying somebody that is slandering their name left and right. Erica say she been want win HOH last week, because Laycoon injury been remove am from playing the game and she been dey assure am say she go win for them, make dem get immunity. She been no even dey reason say she go sleep on the same bed, with Laycoon that time. But say, this week, she reason am and she no like the guy like that and she no wan give am ideas. Besides, e go dey awkward if Laycon don see her kiss Kidd finish for outside, only for them to enter HOH room together, to sleep. Kidd say he for dey okay if she choose Laycoon, because his life don set and he feel say Laycoon for need immunity pass am. |
Chiefheywhy:I reported what I heard, are you as daft as your Laycon, or is comprehension an issue for you, like your Laycon? If it was half-baked, it was because that was as far as I heard. Like I told ArchAngel before, if you heard more, post your own and go, no dey quote me to tell me what to post, as if you buy my data. You dig? Maybe you go about spinning shit too, na wetin make you think say I dey like you. |
livelymatilda:I swear This same Erica that was his only friend when Praise, his latest buddy, dey use am catch cruise, na who the guy dey bad mouth so. Erica wey go dey gush about Laycon for diary room, when nobody else remember the guy name, na she he don do all these things to. Dey like Nigerian film, wey you go help person finish, only for them to turn against you. Make I see any baggar come here dey claim, "Women turn down nice guys like Laycon...." Again. |
Chiefheywhy:I report as I see and hear. |
Women go arise on top that yeye Laycon head. Disgusting creep |
Laycon: "...the only reason I will pick Erica (for DHOH), is to spite Kidd" A bitter soul. |
Dansuqi:That is if he no use him hand cast him game. |
Last last, Kidd, and Ozo are the only friends Erica has in that house. Nengi sef don dey do her well. But the rest, tufia! |
geezprince:if you no know the meaning of that statement, I fear you too. |
More views from people wey their brain still dey work on Twitter.
|
geezprince:What os the meaning of, "She's the kind of girl that of I put pressure, e go enter?" Wetin e mean? |
doziefrank07:Dem don dey look am another way for Twitter. Na wetin make I talk say e go soon scatter. E never scatter yet. We dey watch. |
Laycon don enter Stage 3 of Lamentations of a Rejected Man: Slander. He don pass Stage 2: Delusion. Now, na to dey bad mouth her, dey imply say she be ashawo, say the guy wey she choose no send am and he go break her heart. Very familiar behavior. It will get worse. |
doziefrank07:lol Bright dey tell am say hope no dey, but make e dey delude himself |
Even BrightO don dead this guy hope
|
igasiboy98:Is that why he has continued to slander her? Say dem say make you come talk about person, mean say make you rub mud all over them? Same way una talk say na the content of Erica discussion with Laycon dey vex una this evening, na the content of Laycon's conversations that are disturbing. |
Laycon Highlights: "Erica is the kind of girl that if I put pressure, e go enter" "If I won HOH, it's Kaisha I will even choose, I cannot choose Erica, except to spite Kidd" "You guys (Priase and co) don't know what we talk about" Yes, Erica slander session as always. Not a good word about Erica, but Laycon no do bad thing, na just aside with Praise. In Erica's front, he will say, "I only want to best of you" But once any housemate calls him for aside, he go turn, "I get sense pass her." "Kidd will break her heart, she doesn't know" "She's emotionally manipulative" But his fans still dey talk say he no do bad thing. No problem, we go dey here when everything scatter. |
eleshin:An aside is between two people. How Bright take enter the talk? Or are you denying that anybody wey enter that room fit join the discussion? He don discuss this matter with Neo and Vee already, now Praise and Bright, before youknow it, Tolani and Kaisha go ask for their own aside and Laycon go dey oblige people. Because the whole world must have update on your heartbreak. |
Medunah:Praise called him aside ke? No be general room meeting be this? BrightO don even join the meeting, anybody wey enter the room, fit join the meeting. If you know the meaning of 'aside', this is not an aside. This na full meeting. |
Laycon relaying his decision to step back to Praise Every single time, we go dey hear this progress report from Laycon. Now, he is telling Praise during the HOH challenge, say he been give Erica sign say make she calm down, say he no know whether she see am or not. This is funny. Because, Laycon mention this thing to Erica earlier, say he been give her sign, and she tell am say she been no dey look him way, say she dey look the game, so, she no notice am. E be like he don forget her reply, wey na this version he dey tell Praise. |
Laycon to Erica: "Everybody in this house, and everybody watching this show know that I think about myself, and then, I think about you" Why he dey shout out people wey dey watch show? Script o poju |
Why are we still here? |
doziefrank07:He did I In week 1, during introductions, he talk say he get girlfriend, suddenly suddenly, he don forget the babe under three weeks, and his fans are not concerned about the babe. |
BluntTheApostle:Tell that to your team members. Dem don dey call Erica names since last week and I never see your hypocrite ass tell them this rubbish. Na hate go kill team Laycon members finish. What happened to Laycon's babe? Una don kill am? |
I almost forgot Is it not this unfortunate Laycon that told us he has babe outside the house? Why is he now exaggerating whatever Erica is doing? He even send the babe wey dey watch am for television? Which kain manipulative, two-faced, modafvcker some people dey use their chest support? Wetin do Laycon babe? Why is he simping without a care for her feelings? Even Nengi wey we don dey insult for here, remember her boyfriend, wey she no even sure say still dey wait her. But this lizard wey no break up with him babe wan die on top Erica matter, like say he never see woman for him life. |
Meanwhile, Team Erica, we don dey trend worldwide again o International content.
|
galaxyball:Read well. I said "Demonize" for a reason, I know why I use that word, make nobody come ask me this kain question. In that discussion, Ozo talk bad thing about Nengi? |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 17 18 19 20 21 22 23 24 25 (of 90 pages)
