Jacobjamie's Posts
Nairaland Forum › Jacobjamie's Profile › Jacobjamie's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 13 14 15 16 17 18 19 20 21 (of 34 pages)
Salliet:Pls note : this is not a Friction, also I couldn't wait for the paint job before I created this post cuzz am overjoyed by the car looks already, also to tell other readers about my experience, I made it this long so I can carry everyone along the experience with so much fun at the end, make I continue where I stop |
buygala:Oga calm down, we Nigerians body to dey Hot, na everything una like too suspect lol, Monkey go come near ur babe window una go dey suspect the Monkey if ur babe dey cheat on u with that monkey, or u person wai Mess for public, na the ugly guy una go dey suspect, bros this no be Promo, I just want carry every one along my experience, at the end we will all learn a big lesson from mine, so next time we all will know some point about sellers and buyers of cars online |
Slynation:bros, that was an article, anyway for u na wai no go school, lol, make I continue where I stop yesterday before una make this my journey long |
hastane:don't worry bros, Oga dictative, I am coming to ur point, |
Dantedasz:bros, that was an Article I reposted, sometime back oh,not my life story, anyway I Don come back from church, where I stop yesterday sef? |
Mathscum:Oga na process, he is not done yet , I will send u some pics here tomorrow, na make the suspense much na, that's the idea |
Blacklaurel:bros I go impress every one of u here, no worry last last na brand new car I go drive go house, for me to open this post no be play oh |
Slynation:bros the love dey strong oh, I no mind to use my Leg, last last na for love lol |
Whobedatte:
|
promotervickky:u go come with ur own food and drinks oh, sha stay far from my babe as we go dey the dancing floor if u na show, I no even trust nairaland guys with woman, also carry ur babe come oh, no come share babe with me oh |
awumen:car never fully ready yet na, u think say na one dey Mr Labie go take work all car to 2020 model for me lol, relax na, I am waiting for him to send me pictures of the car at its present state before we finish am, no to rush my brother, life na small small lol, even Beans dey take Long to Done for fire, beans wai dey inside pot, 70% stone, 30% Beans, yet e still dey done, so relax, just dey follow my story |
My baby's Birthday is coming up next month's, so when I asked her what she wish to have as a birthday present, she requested I get her the New Nokia 3310,I think it's about 16k or so, she lost her phone and told me she likes the look of the new model phone, most girls go say IPhone X or IPhone 11, so I felt she deserves more than that.... |
peeps4u:I got The car here 650k, here on nairaland, if u look at the negotiation pics and advert placement I sent, u will see he wrote 700k, but got it for that at the end of the day |
Jubreal19:bros, u see as the car fine for that picture for Cars45?, on seeing it in person was like 20 years after the picture was taken lols, which is another lesson we all should learn when buying a car online, it might just be the same car but not the present state at which the car is in, so always ask for present picture before going for inspection make u no waste transport money for nothing |
Jubreal19:bros, it might be there, and the seller or poster no remove am for sale, well pls call the person if they will say the car is still available, then come back to quote me here as a big Lie Muhammed, I go dash u money, I see no reason why I should say what's not true, abi I go Get money from it? No, I didn't even know it was on Cars45 till I saw ur post, I got it here on Nairaland, anyway some people don't believe God is real, why should everyone believe my story, the story isn't for everyone, made this post just for people to follow my up my Experience since I got the car here, so we all could learn something from my whole experience at the end
|
2cribz:Bros them no tell u say na small small? People wai dey drive Benz today no start with Benz, for the mean time wake we still dey manage the one God give us, we are thankful, at the end of my story u fit choose my Honda Crv to a Benz sef who knows?? |
NnamdiChidi:Bros no vex, No how person go talk about Nigeria no go mention Buhari, na how person go talk about Nairaland no go mention Seun or Gazzuz, Lalaticlacla, Nigerians no go fit talk about car no mention Corolla lol,, Talk about phone no Hype China IPhone with Nokia battery wai most of Una wai they Read this comment dey use, |
Abe make u na no cast me for my babe place oh, after Mr Labie finish the car, I dey present am as Brand New or Direct Toks to baby oh, cuzz I know say e get plenty guys wai get big eye for this Nairaland wai ready to spoil my show collect my girl friend, before them tell her say na one Mr Labie Transform the car like that, ME I go Just Deny u na oh, na only u na know say the body of the car was like that before the upgrade, Una agree Before I continue my transformation Updates |
onegig:no oh bros, he isn't doing any thing on suspension,or adjustment, na just say i want change an ugly dead Nigerian use car to a brand new even more than Tokunbo if possible, which am on it, that my babe go love me die after the end product. |
bfn1:, Yes he is on nairaland, I met him here, I saw his advert here on nairaland of what he does so I contacted him, na so I take connect oh, , but u no go wait till. I finish my story first? U na too dey rush person, now now u na all want number, make I finish post the final transformation pics first na, anyway see him contact screen shot below
|
Whobedatte:bros I like the fact say u dey proud of ur car, and u didn't call it *Big for nothing * lol just kidding bro, I love that camry so much sha,I hope u know u can get an android screen for it, no be those yeye dvd screen oh, bros sincerely Mr Labie never finish the car oh, na next week I go mobilize for paint job, , Sikkens paint, first grade, oven bake, world standard nai them talk say be the paint, that it's the best paint, factory paint, although it's way expensive sha,, I go dey Carey una along no worry, for now I will later post pics of interior and exterior as work dey go on, that's why it's called transformation no be for mouth (Android screen on a Big Daddy Camry)
|
jojofola:That's the idea na, I want make u na just dey follow the motor transformation u na go all Thank Me Later oh, it's just to say don't look down on any car u see drive by, na just wisdom and small money go make am be big man motor |
CyberEBOLA:bros as I see estimate of all I want gonna spend, it's ended up a good buy, plus say e go even better pass Direct Tokunbo onto say, the 2011 Crv goes for 2.8 to 3.3M, without the Android screen and all mind u, I am spending all together 1m, buying the car and fixing both mechanical and body work plus upholstery and alllllllllll.... If u sale am for here 1.6m u na all go rush am, but I no sale lol, make u na go buy u na own lol |
From tomorrow I will upload the new look 80%, I couldn't upload the video he sent, non what apps if u care to see, 07031112795, I asked for pictures from him, I will keep updating u guys, at the end maybe I fit come sale the car for Nairaland as Brand New 2019 Honda Crv, I know say many of u na go price am for 6M, as u na go dey impress with my baby's baby to be |
buygala:OK I will send him a what apps message for him to snap and send, just for proof, so everyone can see its the same car before and after |
So I needed the car to have an Android 2019 screen,( Note : not just yeye DVD, China model wai look like MA Grand father radio oh,) I mean latest Benz looking android screen wai Map dey, voice command dey, I supprise him say 65k original one, that one no cost na, people no know sef, make the car look like say na 5M I buy am, I gave him money to change that stupid chairs wai Don tear to fall look factory Leather (Original Leather) oh.... Reverse camera night vision,, this was how the Interior looks like before, picture below guys
|
buygala:bros, go and follow my signature, u will see months back on nairaland I was asking everyone for help on where to find parts like the A. C component, front and back Bumper and all, also let me give u send u the advert on this same car so u can check it here on nairaland and u will see my name as those who commented on this same car..
|
Na so I Tell Mr Labie my plan, How I want this Mumu looking car to be like, who I buy am for and what I want them to think of it, cuzz I no want make the babe disgrace me unto say I want try impress her to buy car, then na this kind thing I carry come show her, so days back, Mr Labie sent me some videos and pictures on Whatapp on the work already done and the body work, all parts have been mounted already, néw model Crv body kits, without paint sha, make I see if I fit upload video here, or I go screen munch show u na process to process oh, |
IkpuNnegiEwu44:bros, thank God say u Run oh, no be me come enter Gbese last last? Na so u for carry the car go show off, ur boys or babe go just dey laugh u,, for u, u for no know that Mr Labie wai be my Miracle Saver na |
See ehn, The whole idea na say make her people accept me as the best inlaw, the first person for the family to buy her car, at least make them know say I dey try as young boo boo, na Legit I be oh, atleist make she no say NO when I knell down with a Ring to propose, make she say Yes, even if I no get money to buy Real Gold Ring, make them know say I still dey try. That's why I say I must change the Yeye looking Motor to direct Belgium standard of 2019 sef if possible, even if money no reach to get that one, ABI MY PEOPLE? No be so? At all at all |
dadabashua1:bros no vex, na madam come seat close to me as I dey update u na, I no want make she code, so I off my data oh, |
Katier00:, but madam, if na me Buy u this can car like this as birthday gift, u no go slap me pour me hot water? The color sef no enter, anyway make I continue the gist dey go |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 13 14 15 16 17 18 19 20 21 (of 34 pages)


Before I continue my transformation Updates