ManUtdinPidgin's Posts
Nairaland Forum › ManUtdinPidgin's Profile › ManUtdinPidgin's Posts
1 (of 1 pages)
Manchester United manager Jose Mourinho don blast Real Madrid as e use style talk say the club and the people wey dey manage am na dead. “E remain small make i beg Real Madrid say make dem sack me onto say i don tire,” na wetin Mourinho. [img]https://manutdinpidgin.files./2017/07/dfr-qsnxcaagjqu.jpg?w=700[/img] “I dey reason say that kind thing no fit happen for Manchester United onto say i no wan commot for here.” We at MUIP believe say the fact Jose bin wan commot Los Blancos prove say the club no be am, say na yeye people (like dat Florentino Perez wey be ode) dey manage am. For Full Story, Visit: https://manutdinpidgin.com/2017/07/26/jose-mourinho-don-blast-real-madrid-na-dead-club/ |
Olofofo don yarn say Renato Sanches wan come play better ball for United based on Loan. The matter wen dey ground be say Herrera don injure and we need put options for ground. [img]https://manutdinpidgin.files./2017/07/renato-sanches-benfica_3416700.jpg?w=700[/img] Nor be today oga boss dn like the guy and Bayern oga dn yarn say d guy fit commot. |
No be today wey Anthony Martial case don dey worry us. We at MUIP don examine the French Winger but we still dey confused ontop why hin form dey behave like light bulb wey dey Nigeria. [img]https://manutdinpidgin.files./2017/07/img_5623.jpg?w=700[/img] The truth be say Anthony Martial dey behave as if say na PHCN dey control hin form and when dem wan make e play well, dem go 'On am' and when dem wan make e play rubbish, dem go switch am off. Just look at the Real Madrid match now, na only one moment of brilliance wey Martial get and that moment, E use am pieces the whole Real Madrid backline. Only am, destroy about five Los Blancos players before e do assist for Jesse Lingard. Before that mad run wey e do, na rubbish e play. For second half, e no worry them at all, na why the person wey win 'Man Of the Match' na Jesse Lingard. For Full Story: https://manutdinpidgin.com/2017/07/24/important-message-from-man-united-in-pigin-to-anthony-martial/ |
Journalists wey bin wakka enter Jose Mourinho’s press conference, bin ask am about how e see the matter say Kyle Walker don move from Tottenham Hotspur to Manchester City for £50million, The Reds boss con yarn say e dey part of the modern game. [img]https://manutdinpidgin.files./2017/07/js99190471.jpg[/img] “E no shock me, make i no lie,” na wetin Jose yarn. “I don dey talk am since, no be today, say many clubs get money and na why dem dey do shakara. If you wan buy their player, dem fit tell you say dem no dey sell or dem go tell you say if you no drop this amount, fashi. “I for reason say Manchester City go like pay £25million for Kyle,i fit reason am, but e sure me say dem disturb Spurs tire sote Spurs tell dem say if dem no bring 50 milla, make dem forget.” https://manutdinpidgin.com/2017/07/20/jose-mourinho-don-diss-manchester-city-how-you-go-buy-kyle-walker-for-50million/ |
Inter Milan don refuse the €45m + €5m jara wey Manchester United table onto say dem wan sign Ivan Perisic, na the reports wey we dey hear from Di Marzio. [img]https://manutdinpidgin.files./2017/07/img_20170710_142339_039.jpg?w=700[/img] Inter Milan talk say the only way dem fit change their mind, na if the Reds gree loan them Anthony Martial. How una see the matter? |
As e dey go, Manchester United don dey ready to complete £44million deal for Ivan Perisic. The Croatian international don dey strongly linked with move come Old Trafford this summer and dem dey talk say him dey do am like say make him join Baba special for United sharp sharp. [img]https://manutdinpidgin.files./2017/07/122222.jpg[/img] The red Devils don dey close to gree first fee of £39.5million for the winger after weeks of talk talk- the final amount go dey around £44m. According to the Daily Mail, Perisic don dey ready to comot himself from Inter pre-season tour for China for Tuesday ahead of him move to Theatre of Dreams. For full story, Visit https://manutdinpidgin.com/2017/07/18/manchester-united-go-soon-complete-44m-ivan-perisic-transfer/ |
Today get as e be for Red Devils fans, as Manchester United wakka enter pitch to knack Real Salt Lake 2-1. Many fans bin dey expect say The Reds go demolish dem but no be wetin happen onto say the USA based club worry. The people wey score for United na Hernikh Mkhitaryan (29th minute) and Romelu Lukaku (38th minute). [img]https://manutdinpidgin.files./2017/07/img_5514.jpg[/img] We wan sharply talk about the five things wey we observe for the match: The first thing wey we observe na say Manchester United no too play well. Dem allow make Real Salt Lake score first as L.Silva bin off our pant in the 24th minute. We sabi say e no tey before Mkhitaryan equalize but we bin dey expect heavy demolition but no be wetin happen. Enough room dey for improvement if dem go like carry Premier League title next season. Another thing wey we observe na say Andreas Pereira try wella for second half. For person wey hin natural position na CAM, e try wella for the CDM position wey Jose Mourinho deploy am. We just dey pray make e fight hard, so Baba Special fit get am for mind. for the remaining three, visit https://manutdinpidgin.com/2017/07/18/five-things-wey-we-observe-as-manchester-united-knack-real-salt-lake-2-1/ |
Manchester United & City target Alexis Sanchez don confirm say e wan wakka commot from Arsenal, say e don tire. The Chilean foward na one of the people wey Jose Mourinho and Pep Guardiola go like buy this summer and e don finally yarn about hin future at the Emirates for Radio Sport Chile. [img]https://manutdinpidgin.files./2017/07/683893852.jpg?w=700[/img] This na wetin e yarn for Radio Sport Chile when e wakka enter hin village Tocopilla to visit hin family. “I wan play ball for Champions League. The decision no depend on me alone sha, na Arsenal i dey wait for,” na wetin Sachez yarn. https://manutdinpidgin.com/2017/07/16/man-united-city-target-alexis-sanchez-don-provide-update-ontop-hin-arsenal-future/ |
Na small thing remain make Manchester United wingers ‘Anthony Martial’ and ‘Jesse Lingard’ fight for training. [img]https://manutdinpidgin.files./2017/07/jesselingardanthonymartialmanchesterunitedenoma5lfnc6l.jpg[/img] Lingard bin dey practice hin hand shake move with Paul Pogba… Then Martial con stone am with ball. Martial tell am sorry and e hug am. Lingard con dey misyarn say i go whoze you.. The thing con vess Martial and e wan shift Lingard’s teeth but na Lukaku and Pogba separate dem. https://manutdinpidgin.com/2017/07/15/anthony-martial-and-jesse-lingard-wan-fight-for-training/ |
News wey just dey reach us be say Manchester United don make official bid for Arsenal winger, Alexis Sanchez. The amount na £65 million. MUIP report say Manchester United don dey in talks with the Chilean since last year and the deal fit happen as Jose Mourinho dey very interested in the winger. https://cdn.images.express.co.uk/img/dynamic/67/590x/Alexis-Sanchez-632532.jpg https://manutdinpidgin.com/2017/07/14/breaking-news-manchester-united-don-make-official-bid-for-alexis-sanchez/ |
According to the tori wey dey commot from France, Manchester United don go toast Paris Saint-Germain shin shine bobo Serge Aurier Aurier, 24, been struggle to see time for game for Parc de Princes last season as Thomas Meunier show face for there and we don come begin hear say the ogbonge right-back don dey try to comot all him bag, shoe and Ghana-must-go dem before 2017/18 catch am for dia again. https://pbs.twimg.com/media/DEm4Gv7VoAAbBh8.jpg L’Equipe been talk say Aurier don follow him oga boss for PSG Unai Emery yarn wetin dey him mind to do as last season end and as we nor dey carry last, United don follow dem yarn to see if dem ready to sell the defender. https://manutdinpidgin.com/2017/07/13/manchester-united-don-yarn-with-serge-aurier-sake-of-summer-transfer/ |
This one wey Manchester United dun sign Everton striker Romelu Lukaku so, e fit see the club continue dem Interst for Antoine Griezmann enta next summer. The Red Devils dey respirate as to land the Atletico Madrid baller this off-season as mata take be, due to say dem dun upheld the club transfer ban, the Frenchman con decide say hin wan stay for Spain for at least one more year. [img]https://manutdinpidgin.files./2017/07/img_20170708_153909_9411.jpg?w=700[/img] As Manchester Evening News take yarn, Jose Mourinho dey keen to forge partnership between Lukaku and Griezmann as future dey near. https://manutdinpidgin.com/2017/07/08/manchester-united-dun-set-to-continue-dem-long-term-interest-for-antoine-griezmann/ |
Manchester United dun dey tipped to nack Chelsea another huge blow for dem transfer market this summer after the latest gossip con claim say the Old Trafford club dun ‘agreed fee’ with Monaco for midfield enforcer Tiemoue Bakayoko. [img]https://manutdinpidgin.files./2017/07/img_20170710_134127_152.jpg?w=700[/img] United gazump the Premier League champions to chop and clean mouth ontop £75m deal for Everton striker Romelu Lukaku last week as dem con suggest now say dem fir do the same with Bakayoko, player wey dun dey on verge to join Chelsea for several weeks. https://manutdinpidgin.com/2017/07/10/manchester-united-dun-show-pesin-say-king-pass-king-as-dem-dun-agree-35m-tiemoue-bakayoko-deal/ Chelsea dun set dem fish brain deg tink say dem dun propose £35m deal in place for the 22-year-old, but ‘exclusive’ from the Daily Star dun sensationally claim say United themselves dun show say money dey as dem now dun match the offer con agree a possible £35m transfer for dem own. |
Jose Mourinho want make Manchester United make Tottenham £60m offer for versatile defender Eric Dier. Dier, wey set yanch coole for central defence, midfield and for right-back, na pesin weu dem rate very high by Spurs boss Mauricio Pochettino as hin dun come prove say hin na baba baller if dem wan play play systems with either three or four-man defences. [img]https://manutdinpidgin.files./2017/07/img_20170711_181352_695.jpg?w=700[/img] Mourinho con dey eager to build squad wey capable to challenge wlla for Premier League after hin finish sixth last season and the Mirror believe say United wan sign another holding midfielder, wey fit be potentially long-term replacement for club stalwart Michael Carrick. https://manutdinpidgin.com/2017/07/11/jose-mourinho-sti-dey-hungry-for-60m-eric-dier/ |
Manchester United manager Jose Mourinho don condemn Arsenal’s new striker Alexandre Lacazette aka ‘Lacasera’, as the Reds boss believe say the former Lyon dangerman na confam otu, bend down select, Okrika. [img]https://manutdinpidgin.files./2017/07/jose-mourinho-doesn-t-believe-alexandre-lacazette-has-enough-stamina-for-the-premier-league-827051.jpg[/img] “We no even reason him matter at all because e no get stamina, e no strong. E no sabi impact match and e no sabi play big matches.” na wetin Mourinho yarn. https://manutdinpidgin.com/2017/07/11/jose-mourinho-don-condemn-arsenals-new-signing-lacazette-na-otu/ |
Manchester United manager Jose Mourinho don yarn say new Reds signing Romelu Lukaku no go play against LA Galaxy in their pre-season match wey go happen for USA. [img]https://manutdinpidgin.files./2017/07/dey6lk8xoaejpsc.jpg[/img] The 24-year-old bin wakka enter Red Devils from Everton for £75million, after the Merseyside club kick Chelsea enter gutter. https://manutdinpidgin.com/2017/07/10/jose-mourinho-don-confam-say-romelu-lukaku-no-go-play-against-la-galaxy/ |
[img]https://manutdinpidgin.files./2017/07/img_20170705_180129_304.jpg?w=700[/img] Report dun carry am say Manchester United dun knock back ontop dem latest attempt to sign Alvaro Morata, as Real Madrid dey demand fee of £79m for the striker. As Morata stil set yanch no shaking ontop United top transfer target, Jose Mourinho no wan know weda na cutlass abi dagger hin wan troway nack hin former club as to get the deal over the line, but the La Liga and Champions League winners no wan make the deal so seriri werere for United. For full story, click https://manutdinpidgin.com/2017/07/05/man-united-dun-improve-the-bid-wey-dem-reject-as-madrid-want-79m/ Goal dun report say the Red Devils increase dem offer from £61.5m to £70.2m buh the Spanish giants reject am as them still dey on top the level say dem want shamsham fee wey go sweet dem belle 24-year-old. |
Manchester United don fail again in attempt to sign Alvaro Morata. Real Madrid wan chop €90m (£79m) for the striker, MUIP don hear. The Red Devils don identify Spain international as their number one target as they wan ginger their attack force ahead of the 2017/18 season wey dey come. for Full Tori, visit https://manutdinpidgin.com/2017/07/05/breaking-news-man-utd-bid-for-morata-don-fail/ United don dey yarn with Real tay tay over the deal, because Jose Mourinho wan land Morata, 24, for the beginning of the club’s pre-season tour of the United States next week. [img]https://manutdinpidgin.files./2017/07/img_20170703_164448_206.jpg?w=700[/img] You feel say Manchester United go sign am before the transfer window close? |
Na who go dey better for us? Some people dey feel Alvaro Morata, while others dey feel Romelu Lukaku. This summer, the Reds don dey linked to both strikers and i wan sharply yarn una how i feel about the whole matter. For fully story, visit https://manutdinpidgin.com/2017/07/04/who-go-dey-better-for-manchester-united-morata-or-lukaku/ First na Alvaro Morata aka Real Madrid winsh danger man, the only man wey fit warm bench from Morning till night, but as soon as e enter pitch, e go tear net. On the other hand, na Romelu Lukaku, Everton yansh tearer. The only man wey fit score five goals in one match, then e go con dey do like mumu for another match. Who you feel say dey better for Manchester United?
|
Jose Mourinho wan sign Juventus forward Paulo Dybala, as e go like make the guy wakka enter Manchester United this summer, na wetin reports dey yarn. Mundo Deportivo talk say Mourinho no dey feel Lyon’s Alexandre Lacazette, as e believe say the guy no dey the same standard with Antoine Griezmann. Na why d guy 'Lacasera' wakka enter Arsenal. Also, Baba Special no dey in full support of the fact say Ed Woodward wan use big money buy Gareth Bale from Real Madrid. For Full Story, visit https://manutdinpidgin.com/2017/06/06/jose-mourinho-wan-sign-paulo-dybala-for-manchester-united-e-don-fashi-gareth-bale/
|
La Liga side Real Madrid sti dey carry hope upandown ontop say dem wan sign French wonder kid Kylian Mbappe from Monaco for world record transfer fee but watin dah one go con mean for Cristiano Ronaldo, Karim Benzema and Gareth Bale? Report dun yarn am come outside say Mbappe dey open to any move to Bernabeu but con fear say hin no go get the kyn game time hin need with the likes of Ronaldo, Benzema and Bale just jampack demsef for the side. As mata take b, Give Me Sport and European football expert Graham Hunter yarn say if Madrid con last last bring Mbappe to Spain, them fit con offload one of their front three to make Mbappe yanch warm wella for dem side. If Mbappe wakka enter Real Madrid, Gareth Bale fit be on hin way to Manchester United... For Full Story, Visit https://manutdinpidgin.com/2017/07/04/mbeppe-move-to-madrid-fit-catapot-gareth-bale-come-premier-league-back/
|
Manchester United go table new offer for Inter Milan winger Ivan Perisic on Tuesday, na the reports wey we dey hear from Di Marzio. No be today wey the Red Devils don dey purshue the Inter Danger man but Inter dey prove stubborn as dem no wan reduce their asking fee (£40m).. How Inter Milan go dey ask for £40m ? Fear God na, person wey be bend down select.To see full story, visit http://manutdinpidgin.com/2017/07/04/perisic-update-manchester-united-go-table-new-offer-for-the-inter-milan-yansh-tearer/
|
Alvaro Morata dun marry him yori yori Alice Campello for Venice as him dey prepare for him mega cash waka to ManUtd. The 24 year old bin pop question give the Italian model and tailor for one wuru wuru show like that for Madrid for December wey just pass. Na him as bad guy wey him be, him no waste time come marry am shapally for her village six months later. Him Personal people wey show for the Owambe wey take place for Basilica del Redentore Na people like Real Madrid team-mate Isco and Simone Zaza wey been tap ball with am for Juventus. To see the rest of the story, Visit https://manutdinpidgin.com/2017/06/18/manutd-target-alvaro-morata-dun-marry-alice-campello-before-old-trafford-move/
|
We just say make we hail Manchester United defender Matteo Darmian onto say the guy don marry the love of hin life Francesca Cormanni. The way the babe take love am ehn.. Why she no go love am when e dey play for the best club wey dey this world. With the kind heavy salary wey United dey pay am, e sure me say she go beat any woman wey near am. Dem two dey on their honeymoon now.. We dey hope say she no go break hin waist. God abeg, The matter dey your hand. Visit Here for full story: https://manutdinpidgin.com/2017/06/14/manchester-united-defender-matteo-darmian-and-francesca-don-marry/
|
The first na Paul Pogba £89m; Juventus to United for 2016 Pogba na arguably one of the best midfielders wey dey this world today and long-term investment as hin still be only 24 years old. Hin dey very influential and fir dun end the season with better goals and assists figures also if hin no dey nack woodwork plenty plenty times or if hin teammates finish some of the clearcut chances hin create. The second na Diego Costa – £32m; Atletico Madrid to Chelsea for 2014 When Jose rejoined Chelsea for 2013, hin get struggling mata ontop Fernando Torres and Demba Ba for hin disposal. Hin con sign Samuel Eto’o as hin cover for these players but even then, hin con play Andre Schurrle last last as the lone centre-forward. To rectify these problems wey hin get, hin sign Diego Costa and the Spaniard con repaid hin manager faith in full as hin tear 20 goals for just 26 league games for 2014/15. To find out about the remaining 8 most expensive players wey Jose Mourinho don sign? Visit https://manutdinpidgin.com/2017/07/03/jose-mourinho-ten-most-expensive-signings-ever/
|
Alvaro Morata be confam young goalscorer wey dun prove hinself, Champions League winner, Real Madrid player – watin be d other tinz wey make am, or make we say hin game, stand out more dan one mile. 1. Hin be ball-carrying forward Many go just look the 6’2 striker con dey see lanky clumsy individual, but many times for Real hin been dey able to sustain counter attacks as e go dey follow ball run ontop long distances, as dah one go allow the likes of Ronaldo and Bale to make runs off am. Hin get dah kyn rear engine to be box to box midfielder, the skill to be attacking midfielder con join am to shooting technique to be confam striker. To See the Other Four reasons? Visit https://manutdinpidgin.com/2017/07/03/five-reason-why-alvaro-morata-go-be-legend-for-manchester-united/
|
As una sabi say reports bin dey fly up and down say Manchester United winger Anthony Martial wan wakka commot for Old Trafford. As e dey hot, Anthony Martial dun put full stop ontop all the yamayama rumours wey dey fly upandown say dem dun link am with another club wet fit carry am commot from Old Trafford. Jose Mourinho need both Matic and Fabinho ontop this long season wey go soon show. Another rumour na the wey we hear ontop Middlesbrough Marten de Roon as midfield option. For full story, visit http://manutdinpidgin.com
|
Na Two weeks don wakka past wey Alvaro Morata talk say e wan wakka commot for Los Blancos, Real Madrid and Manchester United don dey negotiate since o, I no know the kind money wey Madrid dey ask for, wey make this deal never happen and time dey go. The thing wey dey pain Real Madrid pass na say Manchester United no wan give dem David de Gea We dey hear rumour say the deal don almost dey complete. You fit follow up on the deal on http://manutdinpidgin.com
|
Manchester United dun make ogbonge move for Barcelona star Neymar, as report for Spain take yarn. Spanish publication Don Balon dun claim say the Red Devils dun make contact with Barcelona con dey willing to pay £173m release clause so as to prise the Brazil international away from Nou Camp. The dubious report also claim say Ligue 1 giants PSG sef get interest to sign Neymar, as e be say hin score 13 goals con add 11 assists to hin 30 La Liga appearances for Barcelona as dem con finish as runners-up for league to champions Real Madrid. For Full Tori, Visit http://manutdinpidgin.com |
E dun dey clear say Manchester United dun close to finalize transfer for the 24-year-old, as e be say na him be the club top target by manager Jose Mourinho after early end to kolobi Antoine Griezmann come Old Trafford. Del Bosque yarn: “D tin wey beta foram na to dey see play chance every time but I think say hin dey do wella for Real Madrid" You think say e go enter Manchester United? Make we know? visit http://manutdinpidgin.com for full story
|
To celebrate the three year anniversary ontop Luke Shaw move to Manchester United from Southampton, we con do troback ontop players wey start poorly for Old Trafford. Na our top seven picks be this. 1. Luke Shaw E be unlikely say things go even gel wella for Shaw for United, especially the one wey be E be unlikely say things go even gel wella for Shaw for United, especially the one wey be say na Jose Mourinho dey in charge. The 21-year-old still dey posses great amount of promise, but gats to convince manager Mourinho wella ontop hin pedigree. Shaw dun make 47 appearances for United, as hin struggle with injuries since hin carry leg enta Old Trafford. Weda na hin village people dey follow am we never know. Buh we dey pray make papa God heal am quick quick make hin carry hin balling charm put for boby again... Visit http://manutdinpidgin.com for Full Story.
|
1 (of 1 pages)
? Fear God na, person wey be bend down select.