₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,325,189 members, 8,420,730 topics. Date: Friday, 05 June 2026 at 10:13 AM

Toggle theme

Maputohq's Posts

Nairaland ForumMaputohq's ProfileMaputohq's Posts

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 12 13 14 15 16 17 (of 17 pages)

Forum GamesRe: Let's Play This Word Game Called Last Man Standing by maputohq: 10:05pm On Jul 14, 2014
SammyHoe: Intentionally or unintentionally, both of them have 'tension' in them
them b looking at me with hateful stare.
Forum GamesRe: Let's Play This Word Game Called Last Man Standing by maputohq: 7:54pm On Jul 14, 2014
Sheenor: sick or afraid? be honest
honest boys lyk me wouldn't tell a lie intentionally.
Forum GamesRe: Let's Play This Word Game Called Last Man Standing by maputohq: 7:35pm On Jul 14, 2014
Missmossy: Ten times better is a motivational book i enjoy reading.
reading in the dark gets me sick.
LiteratureRe: Which Kyn Lyf? (IN PIDGIN) by maputohq(op): 5:38pm On Jul 14, 2014
I try check my UME again to see if dem don show my result. Na chibuzor shop I still go check am. Chibuzor no been dey shop dat day. Na the man wey try defend me the oda day been dey. I check am see say na 201 jamb gimme. God go punish their papa. I collect the one wey im print wan begin go house.
“Oga, you Neva pay na” the man call me back.
“hmmm...sorry.” I put hand for pocket comot 300 give am. I begin waka go again.
“come collect change na.” the man call me bak again. Im look me lyk say wetin dey do u, but I just give am fake smile, collect my 50 naira change begin go house.
201 no go fit gimme law. Maybe God no want make I read law. I change my mind say I go do the course wey I put for second choice; English and literary studies. Shey I hear say LASU been dey collect 200 sef.

LASU later gimme admission to read English. The thing follow for last list wey comot because I been pick am as second choice. The thing sweet me no be small. I hear say I go need to collect my result for the school wey I comot from, the one wey dem dey call statement of result.


The day way I go collect am, the stronghead wey I been dey do for school cause me wahala. As I enta sch, all the teachers just look me lyk say dem no know me. I no send, as I no even greet dem sef. I no know say one of dem don turn principal. Na one Mr Joseph. We been dey call am ‘Apari Joe’ because im get bald head and the head come big lyk bull dog own. I no dey greet Joe when I been dey dat school. Im be the numba one teacher wey I hate pass, and im sef hate me. E dey always fyn any chance to wipe me with im pankere. I report am to our principal dat tym. The thing vex Joe sotey im frustrate my life for dat school well well. If dem dey pursue pipu for school fees, as far as na Joe, I must go house because e no go free me enta school dat day.

I waka straight go the principal office. ‘Mr Joseph Edafe’ just dey boldly written for front of the office door. I begin wonder if dem don carry the principal office. I look up for the lintel see ‘PRINCIPAL'S OFFICE’. My heart jump hundred times. Which Joseph Edafe? Joe don turn principal? I begin pray for my head. I know say if I no get dat result for the next two weeks, LASU admission don end be dat, since dem dey end their screening for that tym. I dey owe the school 35 thousands and dat one no be school fees sef. Na money wey I no gree pay for extra lesson wey the school organize for SSCE period, and money for graduation. Why I go pay for something wey I no attend. I know say Joe must ask for dat one. My prayer be say make im for no see am.
LiteratureRe: Which Kyn Lyf? (IN PIDGIN) by maputohq(op): 2:54pm On Jul 14, 2014
I wake up for night with pain for all my body. E be lyk say all the wahala wey I been put mysef for d the other day don carry sickness put for my body. I no fit sleep as my body just dey do me lyk say person carry stick knack me for body. I been dey feel drum for my head. I try stand up, enta room to go carry water drink, as me and my bros dem dey sleep for parlour. My mama and the twins them dey sleep inside the room.

“Jaja, wetin dey happen?” na my mama voice for the dark room. I no need to on light as I been know where the water dey. I no surprise to hear her voice. E be lyk say she no dey too sleep, plenty tym when I enter dat room for night, she no dey sleep. E be lyk say too much thinking no dey let am sleep for night. Before 4 reach for morning, she don begin pray im own prayer before she go wake us later to pray family prayer. My papa no dey sleep for house because of im night work wey im dey do. Even if im dey house, na my mama go still lead prayer. Doctors don tell her make she dey sleep well as dem even give am medicine wey go make am sleep well. E be lyk say dat one been no work.

I just stand for inside the dark room look the bed way my mama dey sleep, na one old bed wey the foam don thin. The foam and fifteen inches ruler go get the same fatness. E beta to sleep for ground dan to sleep for dat foam, as the foam strong lyk stone.

My mama carry body siddon for bed look my side “on the light.” she talk with tiredness. I use hand fyn the controller for the darkness. I on the light after my hand touch the controller.
She look me, tight face, “wetin dey worry u ”she ask.
“Mama, all my body dey pain me. I no well.” I ansa am.
“you well in Jesus name.”
“amen” I ansa her prayer. If I no ansa amen, e go b lyk say I b unbeliever, but I begin wonder wetin dat prayer go do for my body.

My mama put hand for window carry paracetamol give me. “after you don take dat medicine, go pray make God hep you.”
“hmmm.” I shake my head as I collect am from her hand.
I enta inside parlour knee down for one chair make i begin pray. E no tey wey sleep carry me go. I wake up later begin hear my mama do her prayer for inside room. She begin “cast, bind and loose.” she been dey talk say make baba God faya all the winch wey wan chop her pikin wey just pass im exam. Papa go don show am my result before im go work, because I no meet am for house when I check my result.

The sickness hold me for body reach one week. To go anywhere turn wahala. I sleep for inside church one Sunday, sotey my mama tell me to comet for church go house. E bad reach, my mama go borrow money carry me go hospital. Na after three days for there dem let me go house.
SportsRe: Germany Vs Argentina: World Cup Final (1 - 0) On 13th July 2014 by maputohq: 10:09pm On Jul 13, 2014
Germany match dey gather many views for naira land. 58 pages n still counting.
SportsRe: Brazil Vs Netherlands: World Cup 3rd Place (0 - 3) On 12th July 2014 by maputohq: 10:58pm On Jul 12, 2014
not up to forty pages
SportsRe: Brazil Vs Netherlands: World Cup 3rd Place (0 - 3) On 12th July 2014 by maputohq: 9:19pm On Jul 12, 2014
Brazil na basket
SportsRe: Brazil Vs Netherlands: World Cup 3rd Place (0 - 3) On 12th July 2014 by maputohq: 9:15pm On Jul 12, 2014
farells: Fastest goal in the world cup history......
Did you hear that?
daz not the fastest...the commentator said it's among d fastest...the fastest was in 2002 by hukun sukur...Turkey v s.korea
FamilyRe: 9 Baby Names Banned By Governments by maputohq: 10:34pm On Jul 11, 2014
hungryboy: This is my first comment here, abeg make una welcome me with likes
hungry boy is hungry...feed him with likes.
SportsRe: Chelsea Ready To Sell Mikel Obi by maputohq: 8:37pm On Jul 11, 2014
kpaofame: true but most of those passes were 2 rulers short or back passes ....
His crossing accuracy was 33.3 %...I Wish him well though
maybe those receiving these croses are as useless as Mikel...
SportsRe: Chelsea Ready To Sell Mikel Obi by maputohq: 8:35pm On Jul 11, 2014
hollandis: [s][/s]

Daft huh
I read the comment before seeing DAT hollandis posted it...listen, u are as hopeless as you paint Mikel to b.
SportsRe: Germany Vs Argentina: World Cup Final (1 - 0) On 13th July 2014 by maputohq: 7:26pm On Jul 11, 2014
bheemz: I pray Germany wins......I don't like dat Messi @ll
I so much love you...
Forum GamesRe: Let's Play This Word Game Called Last Man Standing by maputohq: 7:08pm On Jul 11, 2014
Bunchersstab: Do u like boobbyhuh
bobby conotes a name or female mammary gland.
Forum GamesRe: Let's Play This Word Game Called Last Man Standing by maputohq: 5:55pm On Jul 11, 2014
barackodam: Loudesthuh


Am not there ooooo
oooooo...I got you
LiteratureRe: Which Kyn Lyf? (IN PIDGIN) by maputohq(op): 5:53pm On Jul 11, 2014
Person wey escape death no go waka go meet death again. If say dat man moto for jam me, e for bad pass pass wetin i dey think. Shey oyibo talk say where there is a will, there is a way. Person no dey get will inside grave. E beta make i for hustle enta school than make i die with all my effort inside graveyard.

I no just try think again. Make i no forget myself again enter inside tipper head. Shey na moto i just escape. I try to sing some song for inside my head make i for fit focus till i reach house. The road sef wey i dey follow kon begin dey long for me; i no just get mysef . Plenty person for road dey jist theirself dey laff, e be lyk say na only me no happy dat day. I just keep face like person wey give woman belle wey the papa come pursue comot for house.

Na how i go enter school dey wahala me. My JAMB sef neva gree show, i wan kill mysef wit worry of how i go take enta school. E be lyk say the jamb sef add to my wahala. No b person wey get only five credit been dey jubilate for chibuzor shop? Me i get eight distinction and i still dey keep face like evil spirit.

The song wey i dey try sing for head no fit stay sef. Na chibuzor shop my mind dey. The way im be dey look me as my result show sef, e be lyk say im be dey expect make i jump, shout and scatter im shop lyk how the other guy been do. The way i keep face, im go dey think say i carry winch for body. I know say as i comot for there, dem go don carry me form topic for dem shop dat day.

E tey small before i enta house. My papa been dey backyard dey hear news from one small battery radio wey im buy, since NEPA dem no wan follow us smile na, na battery radio man dey use jolli. Where man get money to but generator?

I just wan sleep and forget all the wahala wey dey front. Afterall, na papa fault say i dey give mysef wahala. Im don gimme too much pressure already. I waka go meet am to show am the result
“papa, good evening”
“evening, ahnahn, jaja na u”. E be lyk say my papa too dey do im own thinking sef.
“you don come”? Im ask.
“yes papa” i answer. “i don go check the result ”. I give am the result. Im first look me well well before im open the result. Im know say no be fear dey do me. Wetin im be dey think be say i no well. After im don look the result, im smile kon look me.

“well done. Congratulation”.
“thank you papa”
“hmmm” my papa clear im throath. I been think say im wan yarn something. Nothing. Im carry my result give me, shake im head, carry im radio enter inside house. As my mama no dey house, me sef enta inside to go sleep. Wetin i plan be say na till the next morning. To dey stay awake go mean say i dey know kill mysef. I carry mat put for ground. I neva even close my eyes before sleep carry me.
LiteratureRe: Which Kyn Lyf? (IN PIDGIN) by maputohq(op): 5:46pm On Jul 11, 2014
I carry body waka comot for chibuzor shop, dey go house. Na so so thinking i been dey think. How e be say i fit make eight As when e be say i no carry beta body go write the exam. My papa go happy well well and my mama go cook correct soup. Dat one no too sweet me as i also been dey think of plenty other things.


The other chibuzor, wetin im sef go get? Im go get reach eight A's? Im go get A for everything? Im go fail? Wetin b my own sef? Weda im fail or im pass, dat one no be my headache, but why i been dey bother? Maybe i want make im fail. My real headache b say UME neva gree show me my result. Anytym wey i go check am, na to dey see ‘pending’. I no sure if i go fit pass dat one. Okay if i fit pass, i no go fit reach 250 wey UNN set as cut off mark for person wey wan read law. Why me sef go put law? Wetin make i no put mass comm or theatre art? Maybe i no just like them.


Na for where i go see money take enter school? Me wey dem dey pursue everyday comot for school say i neva pay school fees, pay hostel money, and man must wack. The result wey i check no even sweet my body at all; wetin man wan take result do if e no fit see money continue school? Okay, na to dey teach small small pikin dem for nursery school. “tufiakwa” i shout.


“jesuuuuu o”. i stop to dey waka because of the noise, na im i see as pipu plenty dey look me.
“dis boy, u dey crase? God punish you. If u wan die, no b me go kill u. Alakoba”. I no sabi wetin to tok. I just see say i don think too much enter inside road no know the tym wey d man for jam me. I look back see im moto for back. So i for don die? I stand just dey look the man.


Everybody wey gather come tok for the matter carry wahala go remain me and the man there. I no know if na to tell am thank you, weldone or sorry. word no gree comot for my mouth. The man begin look me wan kyn. Maybe im dey wonder why i no talk anything to anybody. E look my hand see me dey hold paper.
“make i see da paper wey u carry”. I give am my result. As im look am finish, e smile nod im head.
“na ya result be dis”? I just nod my head. My mouth no just wan gree to open.
“hmm, so nice” e giv me my result, look me wan kyn. E be lyk say im no dey vex again. Maybe im e wan ask wetin dey worry me as my face dull, but e be lyk say im b dey hurry. E enter im moto drive comot. I begin continue my journey but na after i don do small fake smile make pipu no begin dey look me again.
LiteratureRe: Which Kyn Lyf? (IN PIDGIN) by maputohq(op): 5:40pm On Jul 11, 2014
segun544: Bros, u dey try, no be small............I hail ooo
tnx bro
LiteratureRe: Which Kyn Lyf? (IN PIDGIN) by maputohq(op): 10:29am On Jul 11, 2014
Timzy234: Will be great if you spaced the paragraph.... looks bulky....please do that. Thanks
alright...I ll do just that.
LiteratureRe: Which Kyn Lyf? (IN PIDGIN) by maputohq(op): 9:18am On Jul 11, 2014
“chai, my UPS sef get wahala, dis thing go begin dey boot again”. The guy kon look me tok say “dis boy na bad luck, na as im come light waka comot”.
If no b say na result i wan check, i for jab the guy for mouth abi im no know im mate? No b say i senior the guy sha, e just b say i dey big pass my age. I just dey enter 16 but person wey see me go dey think say i b 22. So if dat guy fit follow me yarn pawuff, e be lyk say im no go get respect sef. As i been dey look am, na 18 im go be.
Dem try start Gen but the thing no gree. Wetin been dey my mind be say na how i go take check dat result if light no gree come, as e b say dat na the only cyber cafe wey dey we area. E no tey sha before my guyz(nepa) return light. Na d speed wey light dey carry i take rush go front of computer. The mumu guy just dey look me one kine, but i been no send. In short, make im go die. I go catch am deal with am later but make i see my result first.
I stand near the guy as im dey check the result for me. I just dey vibrate like say i carry electric current for body.
“Na only u wan check result, wey u wan die for here”, na so the guy take hala me.
“Chibuzor, take am easy. Na tension the guy dey on ooo” Na so one man for there take defend me. As i sabi sey the mumu name na chibuzor, na im kon vex me pass. Chibuzor na the name of my biggest rival for school. We dey always fight for everything, whether na for who go carry first o, who fine pass, who girls like pass. The only thing wey i no dey follow chibuzor fight for na who get money pass. The difference dey clear for dat one, im get money pass me. Wetin make me hate the gut be say im win me for election for batch president for school. Before nko, na im money dey talk. Hmmm. Another chibuzor wan join dusturb me. I begin dey wonder if people wey dey ansa chibuzor no just like me.
“guy, come see your result oo, e be lyk say you b masquerade o”. Chibuzor no dey vex again. Na smile dey im face as im dey talk am.
“wetin you mean” i ask chibuzor.
“na A1 parallel i dey see here o but you get F9 for yoruba”. E just be like say person pour me cold water as im talk am.
“wetin b my own with yoruba, or i resemble yoruba boy? Abeg print am out jare”. I carry the 500 naira wey my papa give me give chibuzor, but im wan kon scope me because i pass well.
“Oga, drop something for the boy na”. I look am with one bad eye collect my change from im hand waka comot. Wetin be my own with am, Shey im don curse me finish?
“mtcheeeeew”
LiteratureRe: Which Kyn Lyf? (IN PIDGIN) by maputohq(op): 11:26pm On Jul 10, 2014
Kweenliz007: patiently waiting ooooo
Alright ooo...I ll get to add them soon
Forum GamesRe: Let's Play This Word Game Called Last Man Standing by maputohq: 10:51pm On Jul 10, 2014
dre11: ofada rice is very sweet if u know how to prepare it
it should not b that way...life has other ways, making your choice complicated.
Forum GamesRe: Let's Play This Word Game Called Last Man Standing by maputohq: 9:49pm On Jul 10, 2014
Missmossy: Words will just be words till you speak meaning into it.
it is not ofada it can Neva be ofada
LiteratureRe: Which Kyn Lyf? (IN PIDGIN) by maputohq(op): 9:14pm On Jul 10, 2014
As secondary school don become history for me with my eyes for university, i begin hustle make i for fit see money take hold body even as SSCE result neva show. I hustle sotey man begin taya for hustle. Result later show na but the kine fear wey hol me no gree me tell anybody say result don show. I know say if i fail, na to go dey sell okrika for Alaba because my papa no go gree gimme money to go write anoda exam. The UME wey i go write some weeks before been dey fear me too as man no put body for ground read well. Wetin been dey my mind be say if i pass my SSCE kon pass UME join, i don become undergraduate be that o. I begin pray like mad man say make baba God help make my result fyn. I still no gree to tell my papa sef say result don show. The day we im know how far, im call me “jaja”.
“papa”. I answer am. “u dey call me”?
“yes”.
The way papa take call me dat day fear me no b small. Wetin been dey fly for my mind be say abi im don see my result. Papa no smile at all. Na da one kon fear me pass. Na so im kon talk.
“i hear say una result don show since last two weeks, why u neva go check your own?” Na so im ask.
“me neva hear o, na now i just dey hear am”na so i blow lie give papa.
“hmm, make you go check am tommorrow”
“no yawa papa”
I stand dey look am as im waka go one shirt wey im dey put money comot 500 naira.
“Take, use am go check your result tomorrow”
I just stand collect the money begin dey look am like slowpoke. To say thank you sef begin hard me. E just be lyk im gimme the money to go suffer. Im just waka comot for my front, like say im no mind. Wetin dey hook am for body pass to dey fyn thank you.
I carry body waka go cyber cafe to go see which kyn scores dem gimme. As i enter the cyber cafe, i see plenty person wey result carry them come too. Dem plenty inside the cyber café like say dem be sand. E kon be like say na everybody wey come check result fail as dem carry face keep like shit wey person march. Na so i begin hear noise. “ope o! ope oo!!!!”. Na so i turn face see one guy wey dey jump around like say im get cricket for inside yansh. Vex begin catch people wey full there, as dem come pursue the guy comot for the cyber cafe. I take jeje waka go meet the guy “abeg, make i see your result". The guy carry the result gimme. Na only five credit, the guy sef get and two pass. Im carry F9 for yoruba and french. The better thing b say im don pass the subject wey im need English and maths join. Wetin im even need french and yoruba for sef. I no care to congratulate am sef, my own fear be say if i fail, i no go return to that house and i no go bother to check my jamb again. Na so i carry body enter the cyber cafe again.
“bros, you wan check result too" d cyber cafe guy ask me. Me just dey vibrate kon answer “hmm...result... okay...yes i ...wan check". Na so the bros hala me “which one kon be ya own sef , you wan check abi you no wan check?"
“i wan check"
“oya wetin be ya numba"?
As i sabi say my voice go finish me there, i just write the number for paper give am. The guy collect am come look me one kine. “better no die for here. If u wan die, enta ya papa house first". To vex sef no b the issue, i must check dat result unless, my papa go chop me. As the guy begin check the result, na im nepa people begin work. Light don go.
LiteratureRe: Which Kyn Lyf? (IN PIDGIN) by maputohq(op): 6:27pm On Jul 10, 2014
Everybody wey dey dat house park their kaya comot for there remain only we, as money no gree come. Wetin us small pikin carry put for mind b say all our pikin padi don comot for compound remain we. No pikin wey we go follow play. E no tey sha, wey we pack comot sef, but wetin man fit do. As we still small na, no yawa. Wetin we sabi b say b say house dey , and say we con meet small pikin dem make we jolli small. Wetin pikin sabi pass play?
E tey before dem tell us to pak comot for house again. I don enta 14 da tym sef why my broda chike don enta 12 years. My broda chidi wey follow am for back just dey enta 9. E bad pass my mama born twins follow body. We full house like say we wan form football team with correct bench. Na so we pack everytin wey we get port go anoda far area. Na so money wahala follow catch us again.
Me finish primary school now kon reach tym wey pikin go enter secondary school. Na one kine ajebo school wey dem be dey call Johny comprehensive college na im my papa carry me go put. The school fees kon dey like money wey person wan collect for babalawo hand. My papa n mama money combine sef no go sabi pay the school money sef but wetin me been wonder b say why im go put me for ajebo school. Chike sef tell my papa say na ajebo school im sef go enter na. My mama carry eye look am talk say “shey e get where u dey dig money abi”. Chike see say mama no dey smile, im just carry matter keep for mathias no follow person talk am again.
Na so me take sabi how dem dey carry form ajebo. Fine ajebo girls full school like water but me just dey think wetin my mama talk say woman dey kill o. Me i neva ready to die o. Na so me no look woman sef for eye. E reach tym wey i sabi say woman no dey kill sef, but if u too like dem, your career fit spoil. All na the same. If woman spoil your career or woman kill you, na die person go still die. Me just take am say woman bad.
Teachers no kon like me sef say me get stronghead. Na so i do sotey i write my SSCE comot for the school. Me don tell my sef say e bad reach, i no go see any of my teachers as i been dey vex for dem. I even dey tell dem say i no go greet them if we jam for road. Na laugh dem go dey laugh me say i b mumu. Na later i kon sabi sey i b real mumu.
Forum GamesRe: Let's Play This Word Game Called Last Man Standing by maputohq: 5:44pm On Jul 10, 2014
PrinceAdepoju: People with great visions; let them open their minds and you shall see.
see how great thou art o lord. I'll sing of your greatness and always bow to worship your majesty.
LiteratureRe: Which Kyn Lyf? (IN PIDGIN) by maputohq(op): 5:39pm On Jul 10, 2014
“All passengers going to lokoja should get to the terminal now, the bus is ready”.My papa carry my bag dey waka go the terminal, na so me follow. Say i dey leave my people dem for lagos dey go lokoja make me wan cry but i be big boy, so i bone. As dem check my bag finish, na so i carry am from my papa as dem no gree am enter the bus terminal. Sadness enter my body well as per se e go tey before we see again. I no sabi look back do my papa byebye sef. I just take sofri enter the bus waka go where dem gimme to siddon. “Who is jaja”? Na so i turn my head dey fyn person wey call me. “Na me”. Na so i answer. “Person dey fyn u outside”. Na so i comot for bus see my papa wey wan gimme money but the thing wey make me laff be say anoda girl for the bus dey ansa jaja. I jump for bus again waka go siddon before bus begin move. My papa just stand dey look as we dey comot. I no sabi how i go carry cry that dey. Na one fine lady dey siddon near me. Me just greet am comot face begin dey tink my life. E no even consign me if she ansa sef. Wetin dey my mind no let me see fine or worwor girl sef. I no just dey ok. Na 7:00 sharp our bus take begin journey. As we no chop for house na, na so them give us rice and chicken. Me wey dey vex before kon kule turn my face look this fine Aunty wey siddon near me as she dey chop, me too open my own begin chop as i wan form ajebo before.
No be say me sef b ajebo as my papa sef no get money but im just want the best for im pikin them. My mama dey always tell me say i neva enter two sef before i begin go skul. Na one akwa-ibom mama been dey carry me go skul come house. Na so e reach d tym wey my papa no get money send me go skul again. Na so me and my small bros go dey play for house na (im na 2 while me na 4 dat tym). The tym wey small money enter my papa hand, im put me inside one private skul wey dem dey call JABULANI INTERNATIONAL SCHOOL. Bad belle people begin dey vex say why my papa wey no get money carry im pikin go private school if no b crase dey worry am, but im no send. The thing hard am wella as dem too dey pursue me comot for school say me neva pay skul fees. I go cry come house but na to stay for house reach tym wey papa go get money pay small. He bad sotey landlord pursue us comot for house wey e neva tey wey my mama born anoda pikin.we don reach seven wey dey live inside one room. My papa, mama, two aunty, my bros and me with the small pikin wey dem just born. Na d house wey landlord sef dey pursue us be that.
LiteratureWhich Kyn Lyf? (IN PIDGIN) by maputohq(op): 5:32pm On Jul 10, 2014
Well I will use the language I understand best to express myself.
The story is on a young boy ‘jaja’ on a journey which is suppose to make or mar his future. He takes us back to his real life telling us who he is and the difficulties he faces to create a niche for himself in future.


This story is dedicated to every poor Nigerian out there struggling to make ends meet and students also who are not privileged to enjoy the luxuries of this life.
Forum GamesRe: Let's Play This Word Game Called Last Man Standing by maputohq: 8:43am On Jul 10, 2014
Sheenor: prepare for the day. as it promise to be an exciting day.
day after day life goes on, man moves closer to his death.
SportsRe: Germany Vs Argentina: World Cup Final (1 - 0) On 13th July 2014 by maputohq: 6:19am On Jul 10, 2014
blackprowler: Most ppl are followers in this world, easily impressed by the latest emotions. Germany has played other games before the semis. Check them out. I blame Brazil for the noise disturbing my ears now about Germany
I've been supporting Germany since their final loss in 2002...that was the first world cup match I understood. though I was expecting Brazil to win as host but I so love the Germans...Talking bout latest emotions, Germany is a great team.
SportsRe: Argentina Vs Holland- World Cup Semi-Final (4 - 2) On Penalties On 9th July 2014 by maputohq: 10:44pm On Jul 09, 2014
nairaland viewing center no full lyk yesterday.
SportsRe: Argentina Vs Holland- World Cup Semi-Final (4 - 2) On Penalties On 9th July 2014 by maputohq: 10:43pm On Jul 09, 2014
a beg, make person flash me if dem score...snoring

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 12 13 14 15 16 17 (of 17 pages)