Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,156,704 members, 7,831,208 topics. Date: Friday, 17 May 2024 at 03:31 PM

Naija Love Rhymes For Valentine - Literature (16) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Naija Love Rhymes For Valentine (61299 Views)

Must Read: Naija Love Part 1 (one) / Re: Naija Love Rhymes For Valentine / A Space For Peoms, Hot Rhymes, Quotes And General Sayings (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (13) (14) (15) (16) (17) (18) (19) ... (40) (Reply) (Go Down)

Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 5:27pm On Jul 24, 2009
FL Gators:

@House

I no know exactly wetin I go  do
I just dey drown in my own blues
Deep In  the sea  of lover’s  tryst  gone wrong
While Cupid dey agonize me with his evil song ---
I just dey reminisce the phase of our love exchange
When still Innocent to Cupid’s unpredictable shift change
I don dey plan to bring am to my village
To meet my family and pay a homage
But so so sha the mugu dey change him mind
Cupid sang to me say na love he wan go find
House, you wan know wetin I tell this man?
“If na love you wan find, make you go to Sudan!!!!”
But the knife just dey twist and hiss
As I lay crying, longing for his kiss
E be like say my heart never go sate
Expertised to the mischief that Cupid creates.

make e no be like i over-stupid,
but e be like u shack beer wey get lipid
whish wan worrey u sef na d man abi na cupid!?
u berra go find dat bobo with speed.

infact ur talk na very true,
to say u no sabi wetin u dey do,
u dey drown inside blue,
wait e go soon be all-omo wey new,
before u know e go be flu.

u say d thing go wrong,
becuz cupid sing song
abi na inside ya head im beat d gong!?
wetin come concern short inside long!?

how manage,
u wan carry mugu go village,
make im go pay homage,
so now e don become demurrage
extra ka'ya to carry as luggage.

us sef harsh pass pesin wey no know kind,
how d mugu no go shange mind,
wen usef do like u wan gum am bind,
i no blame as im leave u for behind,
im no wan enter ur villa una take im head grind,
u sef na love abi marrey u dey find!?

u tell am to waka go Sudan,
u for carrey am come give maedan,
for soup no onion, pepper or vedan,
even if d bobo name na dan,
na to pick race with im kpafuka sedan.

shuo make me sef even hiss,
ur case na real for pastor chris,
now u don dey hungry to kiss,
mouth dey ur front u open eye miss,
and u wan sleep with peace!?
u try like my 5yrs niece,
abegi mai leave ur mata go piss.
grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 9:43pm On Jul 24, 2009
RuuDie:

make e no be like i over-stupid,
but e be like u shack beer wey get lipid
whish wan worrey u sef na d man abi na cupid!?
u berra go find dat bobo with speed.

infact ur talk na very true,
to say u no sabi wetin u dey do,
u dey drown inside blue,
wait e go soon be all-omo wey new,
before u know e go be flu.

u say d thing go wrong,
becuz cupid sing song
abi na inside ya head im beat d gong!?
wetin come concern short inside long!?

how manage,
u wan carry mugu go village,
make im go pay homage,
so now e don become demurrage
extra ka'ya to carry as luggage.

us sef harsh pass pesin wey no know kind,
how d mugu no go shange mind,
wen usef do like u wan gum am bind,
i no blame as im leave u for behind,
im no wan enter ur villa una take im head grind,
u sef na love abi marrey u dey find!?

u tell am to waka go Sudan,
u for carrey am come give maedan,
for soup no onion, pepper or vedan,
even if d bobo name na dan,
na to pick race with im kpafuka sedan.

shuo make me sef even hiss,
ur case na real for pastor chris,
now u don dey hungry to kiss,
mouth dey ur front u open eye miss,
and u wan sleep with peace!?
u try like my 5yrs niece,
abegi mai leave ur mata go piss.
grin

@Ruudie
I hope say you no think my tune be real
cuz the way you dey roll on like a cart wheel
dey  gimme something to wonder about
Bros, make you calm down or your pimples go break out
My bro, stress no good for  the body
He go scatter scatter  your face with acne
I been dey meaning to ask una
Why you dey defend cupid’s aura?
Shey Na him dey  entice  you with him atmosphere
Abi you just dey drunk from too much beer?
E be like say Cupid don dey bribe you
Abi wetin make you dey laugh at my blue?
Anywaz, Meadan talk am say you love this girl
Shey na her dem call  Ruddie’s  pearl?
Ohhhh now  I know why you don dey defend Cupid
So he no go pour your heart him  acid
My boy, sucking up to Cupid  no go work
Na pieces him go tear your heart  like artwork
So make you learn make you listen
Cupid no be soft like cotton
Na by decree Cupid was banished
Which allowed hate him heart tarnished
Cupid no go help you get “am”
He go just  blend your heart to jam
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 10:03pm On Jul 24, 2009
@Maedan
Thank you jare my sister
Your words are the  saving anchor
Wey dey  drag me  outta  Cupid’s prison
Where he dey keep me from season to season
My sister, na true you talk
Its better e no dey work
When time come for marriage
I go find better man to pay them homage
But abeg o, make you warn that Ruudie man tongue
If you no wan lose one of your clan
Cuz when Cupid is done with him
Everything to him go be grim tongue
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 8:08am On Jul 25, 2009
FL Gators:

@Maedan
Thank you jare my sister
Your words are the saving anchor
Wey dey drag me outta Cupid’s prison
Where he dey keep me from season to season
My sister, na true you talk
Its better e no dey work
When time come for marriage
I go find better man to pay them homage
But abeg o, make you warn that Ruudie man tongue
If you no wan lose one of your clan
Cuz when Cupid is done with him
Everything to him go be grim tongue



babe, sorry say i no reply quick
to read RuuDie's post i go need 800G memory stick tongue
abeg no mind am, na im name e dey answer

na so so rude e go dey rude lyk say im PC get cancer
if not how e go yab me join for inside im post
wen since im enter d place na me support am most
but i take God beg u, no let him drive you with im indiscretion
we need more female amazons to ease dis pidgin tension
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by TOYOSI20(f): 9:07am On Jul 25, 2009
Maedan, ma dear, how come I check ur profile I nor come see yah face
No tell me say na cos of werrin take place tongue

Ma sis nothing do u jare, make u dey relax and free
U know say one of the reason I like u na cos of the down to earth gurl wey u be wink smiley

If I talk say I know sabi werrin dey shele, na lie I dey yarn
Make u tune up yah sawg, like hay stacked up high in a barn

Just been get off the phone with ma friend wey tell me say her love they do her like burning fire cheesy
I tell am say make she keep am up like fully inflated  Dunlop tire shocked cheesy cheesy

Say love na like a growth process in which every day we learn
And it must be reciprocal, in other words both parties must show genuine concern
That way peeps sabi say they na the true worth of love they dey EARN!


PS. Where ma personal pesin, semid4lyfe dey?? sad undecided
Make una summon him out oo, cos I don see am tay tay
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 10:06am On Jul 25, 2009
TOYOSI20:

Maedan, ma dear, how come I check ur profile I nor come see yah face
No tell me say na cos of werrin take place tongue

Ma sis nothing do u jare, make u dey relax and free
U know say one of the reason I like u na cos of the down to earth gurl wey u be wink smiley

If I talk say I know sabi werrin dey shele, na lie I dey yarn
Make u tune up yah sawg, like hay stacked up high in a barn

Just been get off the phone with ma friend wey tell me say her love they do her like burning fire cheesy
I tell am say make she keep am up like fully inflated  Dunlop tire shocked cheesy cheesy

Say love na like a growth process in which every day we learn
And it must be reciprocal, in other words both parties must show genuine concern
That way peeps sabi say they na the true worth of love they dey EARN!


PS. Where ma personal pesin, semid4lyfe dey?? sad undecided
Make una summon him out oo, cos I don see am tay tay




ol' girl, i happy say u don show
remain small make alarm blow
for now make my profile dey as e dey
like oyibo dey say, let sleeping dogs lay cheesy
in d meantime, make we promote the love theme
cos e dey brighten the atmosphere like sunbeam wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semidaraeb(m): 3:15am On Jul 26, 2009
From Semid4lyfe


Hmm--e be like se somethin dey amiss
But pls make una stop to dey diss
Becos here na place of peace
And make una rmbr se the theme na love
That emotion wey dey strike like lightning 4rm up above
And go make person dey at peace like dove
Rite now, I dey at a loss for word
So make I return to my drawing board
To think plan and re-strategize
So fresh 'n' better rhymes go materialize
But 1st, make I apologize
For how I take abandon una for dis zone
I be like dog wey dem starve of bone
Becos I miss dis thread and all of una tire
Upon my return, dis thread still dey burn like fire
Becos maedan, ruudie n co no go ever retire
Even sef some new peeps don join to carry the torch
Infact, all of una dey too much
Make I stop here for now
But to all of una, I dey give a bow
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 12:59pm On Jul 26, 2009
semidaraeb:

From Semid4lyfe


Hmm--e be like se somethin dey amiss
But pls make una stop to dey diss
Becos here na place of peace
And make una rmbr se the theme na love
That emotion wey dey strike like lightning 4rm up above
And go make person dey at peace like dove
Rite now, I dey at a loss for word
So make I return to my drawing board
To think plan and re-strategize
So fresh 'n' better rhymes go materialize
But 1st, make I apologize
For how I take abandon una for dis zone
I be like dog wey dem starve of bone
Becos I miss dis thread and all of una tire
Upon my return, dis thread still dey burn like fire
Becos maedan, ruudie n co no go ever retire
Even sef some new peeps don join to carry the torch
Infact, all of una dey too much
Make I stop here for now
But to all of una, I dey give a bow


na u we dey wait for since
as na u be the main charming prince
ruudie don enter my own black book
but as i dey v.forgiving, i go let am off the hook wink
u know say i be peace-loving soul
and to spread da luv na my only goal
dis na d only place wey we fit let down out hair grin
so wen eva una enter dis place,throwey all ur care wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 5:55am On Jul 27, 2009
shebi una sabi my name,
anyhow e be na d same,
if u wan swear make i lame,
me i no dey sey'kee for any game,
wether na come or came. . . .

no be today i begin dey enter bad book,
very soon na ya pot for cook,
i no shake talkless of shook,
becuz anyhow pesin do im be crook,
u dey u no dey dem go say u look. . . .
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 5:57am On Jul 27, 2009
@ gators

i been jus dey try give u remedy,
e been be like ur mind no steady
now u don kuku cast me already
for ur mind u jus set dey ready,
massacre me like i be J.F kennedy,
as una say i be smallie cuz i neva get teddy,
i go die d matter make anger no rise like eddy'. . . . .
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 6:03am On Jul 27, 2009
RuuDie:

@ gators

i been jus dey try give u remedy,
e been be like ur mind no steady
now u don kuku cast me already
for ur mind u jus set dey ready,
massacre me like i be J.F kennedy,
as una say i be smallie cuz i neva get teddy,
i go die d matter make anger no rise like eddy'. . . . .
Maedan don say make we no fight
So I go withdraw my fangs before I bite
Me sef no know how you go come dey vex me
E be like say before I don dey sting you like a bee
Oya, make I ask una where we don meet before
Cuz I no know why the acid my head you wan pour undecided
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 12:30pm On Jul 27, 2009
it's ok, ruudie, u know u be my fav'rit wink
u don prove many time say u be legit
i explain well well to FL Gators say
all your things na so so play play
no be say u dey find trouble, you just dey tease
in your heart, u be d kind wey like to please
if no be 4 u and semid4lyfe, i wonder how dis place go be
just take am say, u get a good friend in me cheesy
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 7:01pm On Jul 27, 2009
shuoo shocked na ruudie una dey beg,
abeg lef m'ey im leg,
abi im don shop crase,
una show me dat im wo'wo face,
i for like dis-arrange am,
m'ey know sey no be beans and bread plus yam,
who im dey try panic!?
abi dem tell am sey here na titanic!?
me i dey like play, jolly and flex,
but dis otondo don make me vex,
una try fine me betta chilled pure water,
becuz if i continue think dis matta,
heavy gbe'ge go jus burst,
i so believe myself pass trust,
for kwanta levelz i no dey carry last,
dis wan no be issue to go fast,
my dogs no dey slack,
we go take wella front and back,
who sabi am make e jus go warn dat ruudie,
or else im head go scatter pieces like pastor goodie.

grin grin grin grin grin
i'm jus crazy like dat!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 12:48am On Jul 28, 2009
I happy se una don end the travail
And common sense and peace don prevail
Na so e suppose to be
so this thread go sweet like honey
Thank una 4 taking to my advice
We no suppose dey hate like cat and mice
Instead,we suppose dey live in happiness and bliss
And dey share plenty hugs and kiss
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 4:52am On Jul 28, 2009
pls, semid4lyfe, make u helep me spread d word
say those wey live by, go kpai by, the sword tongue
dis ruudie no wan know; instead of to kiss cheek
im go land am slap like say him b garage boy taofeek tongue
i no know where im go collect dis im crase
im don put dis love thread into much disgrace
if we continue dis way d thing go just kpafuka cheesy sad
and we go give bad example to d average onlooker
anyway, i don wash hand from im matter
make e no come face me, cos then, this place go scatter wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 10:47am On Jul 28, 2009
sumtym e good me'y pesin vex,
after enuff work and flex,
pesin fit dey carry sumtyn for mind,
wey if im no annoy we no go find,
at least wen pesin 'voke
and we real know sey im no be joke,
dat time we go learn some lesson,
even if na small thin' about d pesin,
e go helep us to understand we'sef,
wetin we suppose drag or lef,
and e go dey make us dey flow,
jus dey waka together as breeze dey blow. . .
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 11:59am On Jul 28, 2009
alright o, ruudie, if you feel say u need to let off some steam
but no turn dis our pidgin mansion to a land of d grim tongue
if u no fit kiss and make up with our sis FL Gators
at least no chase am comot like say u be d Terminator
make u no turn this place to "brothas only"
i need me some chicks to make dis groove lively cheesy wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 7:04pm On Jul 28, 2009
una no worry, me no dey violent,
sometimes i dey shock but i no be current,
no be for there i get my talent,
in fact for real life i dey too silent,
and wen head clear me , even obedient. . .

if na to make-up and kiss, wink
dat wan i no go miss,
gators before u start to hiss,
and throwey me dismiss,
my mouth no dey smell piss. . .

grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 12:17am On Jul 29, 2009
Beware: ROUGH PIDGIN grin grin grin


@Maedan wink

Make you give up on that boy
He think say his words na simple toy
So I don dey let him play without limitations
Na him dey allow am  feel mightily brazen

I already talk am say I no go fight
So later on I no go feel contrite
Peaceful thread don dey decline chaos
Like a disobedient horse his master toss

Lol, wetin? Chase me comot for where?
My dear, of what power him get I no aware?
Even Cupid’s song no dey strong enough
So why I go fear a boy who only thinks he’s tough?

Anywayz, I DON DEY LEAVE HIM MATTER
His issues I no go even bother
My time don dey choose important things
Like projects and counting my blessings.

cheesy cheesy
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 1:34am On Jul 29, 2009
FL Gators, him don hint say e go change
Indeed dis im attitude dey very strange
d ruudie I know na mr romantica
but now he dey hassle our own "scholarstica"
hope say ur project go get "A" plus
and if you need a hand, make u hola us wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 2:05am On Jul 29, 2009
maedan:

FL Gators, him don hint say e go change
Indeed dis im attitude dey very strange
d ruudie I know na mr romantica
but now he dey hassle our own "scholarstica"
hope say ur project go get "A" plus
and if you need a hand, make u hola us wink
Thank you my sister, I been (or being,w/e one sha) say na u be the voice of reason
No wonder congoshine dey follow una like kid after a bacon grin
lol, me sef hope my project gets an A
My hopes, I pray my instructor no betray embarassed
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 10:01pm On Jul 29, 2009
as e be say I like to hold it down
FL Gators, i no want anyone to ever frown
i go always try to maintain d peace
cos e hard to find such friends as these cheesy
as for my person congo, i no know where e go
many of d better members just dey blow
noone like to take yawa, this much i overstand
but make we no lose all d good ones from dis Nairaland wink cry
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 5:49pm On Jul 30, 2009
maedan:

as e be say I like to hold it down
FL Gators, i no want anyone to ever frown
i go always try to maintain d peace
cos e hard to find such friends as these cheesy
as for my person congo, i no know where e go
many of d better members just dey blow
noone like to take yawa, this much i overstand
but make we no lose all d good ones from dis Nairaland wink cry

I know rightz, gotz you
Do what you do wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 5:57pm On Jul 30, 2009
nothing go ever sweet me pass,
to be with you na d ultimate,
fall sotey i flat like sil'pas,
but e go always dey late,
becuz every night na goodbye,
na nature talk am and we no go taka,
plus all d tears inside we eye,
na only 1 road we fit waka,
and only 1 wey dey see go cross,
enter dat house of plenty milk and honey
for the other e suppose be loss,
things wey carry weight pass all kain money. . . .
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 10:06am On Jul 31, 2009
thank God you don come back to your senses cheesy
for all your rudeness, you for pay many expenses
but as e be say na just passing phase,
u dey welcome back to dis pidgin maze
true true i prefer dis side of you
to your good side, make you always stay true wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 7:05pm On Aug 04, 2009
maedan i no loss my sense,
well dat now be past tense,
e don reash time wey i go cross fence,
take hanky wipe my lens,
return back home to my friens. . . .

d hassle 4 naija delta no easy,
wen dem boys dey do efizi,
waka kurukere holo' lizzy,
shayo sotey eye red turn dizzy,
dem go sabi how im work dey busy. . . .

na jab carry me reash dis oil block,
i pray baba God make i jam luck,
becuz d way time dey tear race 4 clock,
e no make mei' omo boy siddon dey suck,
or mumu like wetin oyibo call "sitting duck". . . .
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 11:21pm On Aug 04, 2009
ruudie, oyibo also talk say, make we make hay while the sun shine
so I hope say you go soon hit your own gold mine
e no good make youthful chap like you turn to layabout
too many promising lads don end up like garage tout
just becos them no develop on their potential
abeg, no fail o, continue to build up ur credential wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 6:06am On Aug 09, 2009
Baby i go luv u till i die,
D way u dey make me high,
Dis wan no be lie,
Na 4 ur end my hand tie,
Upon u no get kobo all my heart u don buy,
4 u i no fit ever make guy,
& i no go ever make u cry,
Sey na cake or meatpie,
Shawarma, ice cream & french fry,
I go deposit till my pocket dry,
Dis no be matter of try,
Na me & u everyday wey go by,
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 7:42am On Aug 09, 2009
I think say this day will never come
The day I'd honor a man with a poem
My feelings:  chaotic, hard to contain
Pysically, I 'm calm. Lavishing in cupid's chain
Too much, too sweet, too painful
It pulls from every angle
I pray and hope that this is not love
Hoping that the softness of a butterfly's wing does not become rough
Not that I can't live without his voice
Only that its enough to make a woman rejoice
His touch, oh his touch, its feeling
Are the medications that keeps me from aging
The days run by, but my feelings stays the same
Giving Death a wink as it puts him to shame
I don't want this feelings to get stronger
The stronger the sweeter
The sweeter, the harder Death performs
And the more and more chaotic my feelings becomes
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 10:52pm On Aug 09, 2009
FL Gators, e be like say you need pidgin practice grin
Your poem fit break head with all d big grammar antics
But I no be olodo, so I understan' wetin you mean
Be like say one bobo out there dey make you keen
But like a smart babe, you no wan fall
Abeg do jo, no hesitate to answer loff's call
Life dey too short, love makes it sweet
Just leave yaself to dance to the fast heart beat cheesy
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 12:10am On Aug 10, 2009
maedan:

FL Gators, e be like say you need pidgin practice grin
Your poem fit break head with all d big grammar antics
But I no be olodo, so I understan' wetin you mean
Be like say one bobo out there dey make you keen
But like a smart babe, you no wan fall
Abeg do jo, no hesitate to answer loff's call
Life dey too short, love makes it sweet
Just leave yaself to dance to the fast heart beat cheesy
rotfl. I don talk am say my pidgin no good grin
But right now pidgin no fit control my mood
I no fit walk, am flying in my own cloud 9
Flying to my own space of stars aligned
Maedan, wetin I go do? I dey fear the fall and where I'd land
I didnt want to move from the safe ground  and neither did I want to sink in a quickstand
Na that bobo I tell una about dey cause this raucous
His personality is str8, his looks. . . . a bonus kiss
But the thing dey fear me, since morning na escape I dey plan
Or should I stay and fight the storm with this man?







*had to make something up with the "land" grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 1:03am On Aug 10, 2009
Eeeyah, i don see say love dey shack you
As you dey cloud nine, i hope d sky dey blue? cheesy
If na me, I go stick to this bobo like glue
since him get d personality&looks to be your boo
Complete man for dis world dey hard to find
No try escape o, allow am to blow ya mind wink grin

(1) (2) (3) ... (13) (14) (15) (16) (17) (18) (19) ... (40) (Reply)

Oyeku:story Of Lust,injustice, Destiny And Human Wickedness, 18+ / Nephilim / Wole Soyinka: Things You Never Knew About Him

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 108
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.