Northsouth's Posts
Nairaland Forum › Northsouth's Profile › Northsouth's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 (of 35 pages)
He just dey console himself Me I understand u oga Na male dey become president for Nigeria even in America |
Simple Na person wey dey behind person wey dey front needs to run more to at least have a chance to catch up |
It may not be roadworthy or not But this bus may not have accident for next 50 years, and several roadworthy new cars may perish in accident for the next few years |
Regardless of your reasons for asking this question, which am very much aware of as well Be that as it may The real size is of great importance to me and some people that understands better If it wasn't important at all, the USA won't counter the vote Look my bro, as important as the map is as important as the true size, simple. Sometimes some intelligent people can even look at the map and navigate correctly without mathematics Of course you can't understand all these |
Kukutente23:sir, no be trump o, na American mentality, especially the far right, they like to portray their country a bigger and better place even knowing that Canada big pass dem |
Oakenshield:even if no be even firewood Just be old dry wood self, u go catch flame |
politicoNG:e get one man for silver bird owner row, d person resemble wike small abeg E be like him brother rep Atiku o Same way oyegun wey be former APC national chairman turn opposition self rep Atiku o Na only P.O own ah never sabi . that guy no look like who wan be any president See level as e low He no even get entourage talk of convoy No envoy, nobody wan follow PO |
obacasmir:smiles, you have taken it far far Slow down, it's internet, no one is fighting. |
Me I kon even like this one wey she wear so o It's more sexier than any other ones Good job from her She do like real African pikin I like that |
This one that nobody wants to be talking about Obi anymore Obedients will not like this o Atiku na main opposition I knew Obi was irrelevant |
Sonnobax15:how much I typed wasn't the problem. How much you failed to understand is still the problem No manual to how much anybody should type. We are in democracy, you're not the one to tell how anyone should type. Just learn, that's it |
Osimhen don dey crase E good make person dey learn from other's experience Learning from self experience na hard way |
But truth be told All iranian supporters here in Nigeria on nairaland should voluntarily submit themselves to iran to fight the Americans Because me as an American supporter now, if America drop free application list, I swear to my ancestors and gods of the land, ah go apply o Because me am ready for fight for America So are you all the Iranian sympathizers and supporters too ready to fight for Iran? |
Sonnobax15:shut up and sit down, stop all these dragging wizkid matter into whatever that's David's matter Am a wizkid fan, and yes wizkid self get him own nonsense for internet, we never lose memory of the better pass fela saga wey me personally no like that from wizkid But na still normal thing to have issues like this on the internet, if it's not normal, e no go dey happen What's abnormal is u and some of fellow wizkid fan dragging wizkid into the matter as comparison It's not cool Same as some Davido fan self dey like to drag David into the matter of wizkid Nobody get time for such argument anymore these days Just drop ur own matter online and live with the consequencial comments that follows Simple |
The song make sense small Bad belle, ah no get any other addition and subtraction |
RecentHistory:Me self observe am o Obedients only wish say na obi Dem dey talk about. But unfortunately anyone wey sabi politics suppose know say Obi no fit top Atiku in any election in Nigeria If not, why Obi no stay for ADC to test his power against Atiku for primary Instead, he ran Away because of fear, abeg how he wan take win if him dey fear like that |
Na because say na aboki dey sell suya and na my fellow yoruba men dey sell meat beef meat pass for my area here southwest So e must small pass suya My fellow yoruba too dey take life hard for their fellow Yoruba people Na so if aboki bike man carry u, Dem dey charge or take less money than these same my fellow yoruba bike men D hausas no take life too hard, na we dey do our selves Nevertheless.., If una like make una talk say na dinosaur meat or dragon meat Dem dey use for suya Me and people wey don like am to chop don already like am E no get wetin badmouth wan do about the sweetness of honey E don sweet e don sweet, e no fit bitter, to spoil am self no gree If u like u say na magggi all aboki dey put wey dey make we no sabi Abeg make Dem put am or whatever they want put Nobody send anybody |
mastermaestro:I swear, even more civilian percentage self than the military never marry |
Na Muslim just dey influence some directive of many officers in high places Britain na christian country So make Islam no come dey trespass with their influence Islam get their own countries, make Dem go dey influence all those ones |
Sorry my dear I feel your pain But there's no advice or anything anybody can do about it here No manual Na make u pray one man come approach u or u yourself go toast man Na luck Even civilians self never marry |
Good move Especially when the woman no dey kneel for him husband Na early move |
Nobody knows what God has decided Nobody fit explain anything Everything has been predestined because I believe God knows the beginning and the end |
This is the most reasonable thing any opposition supposed to know But Obi and his obedients no go ever gree to understand or learn Normal na coalition make APC defeat Jonathan, and these obedients dey alive to understand am o Even independents party of Kennedy merged with republican of Trump to win back the presidency in USA But Obi just dey whine him supporters wey believe in movement, yet maybe na him supporters self dey whine demself If Obi no fear primary challenge, why him run from ADC? |
Iran self don try, make we sha clap or Dem small But Dem go suffer en, Dem go head when if Dem no surrender You see all those existential threat wey all these embattled countries dey shout up and down Na lie be that phrase All the country wey don fight wars and lost, Dem still exist till today Na just one system some stubborn people just like to preserve because of money |
ReubenE:who big pass you don big pass you. Unless say u fit beat am for fight then no talk anything |
Racoon:you just dey play rough play up and down, u think say na Nigeria prison Dem dey go, Dem fit even come serve Nigeria own self after united States own U dey whine |
Na this kine lady me dey find self. Even though she no go radio vision station go talk wetin she talk so And even if ah no even notice the wealth wey she dey hide from me Na sha this kine woman ah need She will understand the difference between the last and the present together with the future |
As Nigeria and kidnapping be like rice and beans now Na so unknown gunmen and Nigeria known government na potato and ketchup E no get wetin anybody wan tell If my pikin no go serve, e no go serve Nigeria Na why ah don dey make business down for am to head and live their life unless any of dem Choose to pursue their careers in other profession Because when I say Nigeria no be one nation, na so Dem go carry another person child go borno go serve kill Dem for there God no go gree for my enemies E go better make Dem go higher school for better country self I know some nairalanders here will come and criticize me Thank God say na my pikin matter I care about no be their own Person wey Dem kidnap kill him pikin go dey inside sorrow, many of us wey no dey their shoes no fit understand the pain But me ah no wan wait to learn the hard way E better make I learn from people's experience Learning na learning Make ur choice, no be NYSC dem dey take become president of even a company |
If you say you no like being hugged at all at all I will say you're worst than the devil himself You are a dangerous and wicked soul But if you say e get some kine people in ur life wey u fit hugg only Then I believe that one is normal and very okay Why I mention the dangerous part be say, even president Putin wey be hard man get people wey him dey hug Even idi Amin of uganda or abacha of Nigeria self get who Dem dey hugg when Dem dey alive So if u no like to hug anybody at all all, then it's not normal, because even ur wife no for be ur wife today thats if u even get one now self, and if u never get, u no fit get woman or wife, talkless of children U self know say Dem no go be yours So it's better u choose that my second paragraph before u lose yourself |
Though am a Trump fan and yes I know sometimes he misbehave a lot just as every human self dey misbehave sometimes But El sir Na Abraham Lincoln be the greatest for me Though George Washington self try a lot Because e no easy to be the first president where he had wars against Colonial masters and also indigenous war with the red indians that first settled in that land first and yet he settled the wars and united people to begin a country from that point He try well well But what makes me choose Abraham Lincoln very simple thing that's hardest to do Mr Lincoln stopped and abolished the slave trade and also united the country back by winning the civil war wey for make united States no exist today Imagine Abraham Lincoln as a white man, wey him fit think say it's not moral to take blacks as slaves anymore Just imagine that time o, wey among every white, na him first think that kine thing Slave trade wey be better business that year for him people o That is not an easy task my brothers and sisters Let's give Abraham Lincoln a round of applause God dey that man mind abeg As for my adopted grandfather Mr Trump Well sir, I will say No sir you're not even in Top 3 greatest president The funniest thing is that am an obama fan as well I may not like some of his policies o like his support for bisexual and transgender wey Trump self no support But Obama too try, he was the first black president of white supremacists united States of America, and he was elected twice for that matter, so it was not an easy task, he was brilliant in governing as well, na even him tenure Dem kill American worst nightmare sir engineer Osama bin laden, GCO, GCFR of the terrorisr armed forces in the world ever Meanwhile na that same slave trade wey Mr Lincoln stopped na Im give Obama chance to be president So Lincoln is still the greatest |

