Northsouth's Posts
Nairaland Forum › Northsouth's Profile › Northsouth's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 (of 35 pages)
The purpose of OK movement is to keep on embezzling and syphoning campaign money If Dem say walahi talai Tell Dem say na lie Dem lie |
It must and should be deflected B4B4 Nigeria na lawless nation So no be today Dem just wan pretend to be lawful E no fit work Una know say that useless president get issues with certificate when he contested for governor and won Also when he contested for presidency and won Una know o, shey na now wey he don enter suffer Nigerians for almost 4 years una just wan dey raise matter Abegi carry nonsense talk commont my face Me ah no even support Tinubu self before and as matter of fact, all these other aspirant self wey call Demself Atiku and Obi, they are all the same set of people like Tinubu But Tinubu na human being wey God create as all of us was created, so God self dey him side, no be only u God dey him side God na for everybody My own be say since Nigeria don spoil, make e spoil finish, generation wey go make changes go come some day As for me, I hope and pray Nigeria divide and disintegrate Because we are not one nation Even you wey dey read my comment self and aboki self know say we no be one nation |
Well Na UK take nonsense If na America now and portable no come be citizen join My brothers and sisters Na police ICE go rough handle am first come put am for jail before Dem go deport am He go wise U see all those praising portable for standing his ground or whatever Dem be him enemies in disguise Dem wan dey give am implicating liver Na Dem go first abuse am when Dem deport am reach murtala Mohammed airport |
If I tell you say any 4 star general Senior any former or current governor or minister nko Dat one na another one Na retired naval chief boys block wike and him entourage that time from moving further with their rascality And shey u hear say even Tinubu self no fit talk for that matter that day My brother and sisters, u need to fear the military even if na small, just fear Dem Me ah know say d matter pain wike more say even president no fit talk for the matter I know Nigerian soldiers sometimes misbehave a lot, and they are somehow lazy when it comes to fighting insurgency, but na the presidency and top political appointee we go blame for that part But El sir and ma Military get power, forget play and that's because they have their own constitution, assuming they take over, Dem go cancel that our yeye constitution wey we think say e strong like say Dem tear paper throway Be that as it may, Obasanjo no be ordinary president, though he is a useless man too just like the current and past presidents But Obasanjo na both former military head of state and former civilian president U self u see that kine thing Ah go lie for u? |
Haydens:e be like say e dey constitution say na only man thing You just open your brain to say nonsense |
nairalanda1:how about those very old men at their 80s and 90s and still smoking right from their youthful time Why didn't they have cancer ? After all they must have been smoking it for the last 60 to 70 years at least So what happened there that they don't have liver or cancer issues? |
Though am not sure it was because of how I lie down to sleep But certainly I think it's because you age too much Basically that's constipation accompany by stomach inflammation |
ebubeson:i don't know about distant history anyway But I will go with pep guardiola Ancellotti is not that far behind though |
Be that as it may, both the apple and Samsung phones will still fall eventually regardless of how long they last or reign Sometimes the present and current seem like forever But the truth is... So it would seem. In the end, it's just a new beginning for another |
Sirianese:na misunderstanding be your problem, and you lack Honor na why u will never be honored |
Where u no drop money or keep money for your house. I swear you no fit see money for there Even Ayelala self know |
Useless brutai Dem wan cover fire to hide the smoke Na lie All these reasons are irrelevant |
Because its wartime Some people may not want or may not feel in any competition, I can understand their choice of feeling which is cool But we all are in war whether we like it or not Life is war War everyday Na why I hide my read receipt |
Because of misinterpretation and misunderstanding Even my read receipt is off |
When you talk too much, you can begin to say nonsense Tony don too dey talkative these days Dangote bami, the man wey get the money self no dey news reach elu |
The only reason I should agree with this useless man's opinion now is that If any certificate of useless Tinubu is now missing or didn't submit now self or whatever Shey no be the same qualifications documents Dem submit for past elections? And besides, I don't think incumbent president needs to submit any documents self for second terms, maybe am wrong about this my opinion because the law must not be regardless, I can't say, it's just the way I see it But be that as it may, abeg make una commont fiction and come to reality Na Nigeria we dey And we all know how our presidency stuff dey behave and misbehave As Dem no dey ever step down even if caught Na so all these allegations no dey even affect Dem Na masses dey vote incompetency, make the masses live with the fallout |
Ghost workers Dem fit add person wey don die name for there so Abi no be this country so Who no see him name for there now fit dey vex of no recognition The recent and latest decampees can have nothing to say |
There's no competence among all Nigerian presidential candidates Even the incumbent is useless Obi and Atiku are mediocres self Even Nigeria self no be one country We need to divide and disintegrate |
El sir That first one is just a kid Not a woman, but you can still call the second one a young woman anyway So na 4 generation of women I see here, plus one little girl Make una dey talk am well before setting record You don't call a little girl a woman That's a fallacious bogos hocus-pucus |
We keep worrying about where we are going Why not think about where we come from in the first place Now if we know where we come from, na there we still dey go back to right? Una just dey play Wetin me I believe is death just be like sleep The only difference is person no go wake up here again So if you die, you don't exist anymore Simple, make una no dey talk about hell or heaven anymore |
Me ah even believe say Dem too like prick D way d thing dey do Dem for body when e enter en, e b like say Dem dey fly in the sky of the moon So na wetin Dem dey anticipate already be that na why Dem just still dey take their time dey imagine am Shey... So na this prick wan dey knack me now? Dem go just dey picture am for head, so they need time for shakara and all Na to buy time to think am, and with the nervousness self join If u like no understand all this wey I talk, of course it's not my business |
There is a time for everything Regardless of the purpose and interest Everyman get him season When they come for you, you will go Na tomorrow dey mysterious pass, no be present Let wike enjoy him rollercoaster E get where him enter the ride, and surely, he will either get off it or be taken off it Na overdo some people no dey sabi know when Dem dey misbehave Ovation fit dey clap for u, among Dem who Dem pretend clap dey there Na slap dey their mind Carry on if you can and wish or must, when e reach the time, nobody go tell am, na body go alert u |
That lady dey crase If dog dey bark dey mad, shey dog no dey know him owner ni? If una dey call una selves or colleagues for work or training by first name, shey chairman be like una mate? Even if u wan copy modern American or western lifestyle self, Person wey no be even ur papa or elder brother, na your boss for company and u dey call am by first name E be like say chin chin too plenty for her head Dem suppose chase her out and away Nonsense Shey e even possible make subordinates of Trump cabinet workers make Dem call am Donald no Who dey crase self? Abeg d lady wrong and make her supporters or sympathizers go get common sense Even addressing him as Mr Tony self is wrong, what is Mr Tony when e no be say u and ur friend dey play for university campus It's chairman or Mr elumelu Simple as e suppose be, so make una no turn anything upside down |
Cleanmouth:am even a victim of the click bait now self And I've been trying to reduce the level of my succumbing to these fake news/propaganda of a thing Na only God go dey help me more in identifying them instantly and making the decision not to fall victim of clicking useless and fake news anymore. Seriously am trying my best These people will not stop wasting people's time with misinformation and causing disinformation Apart from wasting people's time self, they are wasting our data which we buy with money o, and also misleading people with wrong info Fake news en One person go just sit down and publish fake news because of self interest propaganda and just to make money. I wish government can enforce law and order on these online media journalism. government should enforce law on them to save the people And it's not as if if they publish real and true news that they won't still make money self o But just selfish interest upandan |
Before now, anti party is a scary and dangerous forbidden thing to do in Nigeria But wiki have practiced it and still performing it on a very straight line And nobody seems to remember it's wrong anymore Meanwhile I know there's a beginning for everything anyway so maybe Dem wan make am normal now sha Nevertheless, political parties are like football clubs, you can switch sides anytime. And u can also score oan goal for the opponent victory in ur own interest In conclusion, the supporters or followers of every leader must make sure sense never leave them while following and serving Because anything can happen |
You see all these petroleum of a thing en, maybe that's our wealth base or whatever o But that's not actually my own concern because all is to enrich the government more to embezzle with unyielding consistency My own na electricity Abeg make Dem allow make light dey 24 hours across every corner of the country Everything go start to dey alright from there Even many youth will be employed and motivated to start any business with such interest at heart Look at developed nations Na electricity be their bedrock Forget oil or whatever , it may be the highest grossing products But electricity is never a problem in those country Make una sha try do the electricity make e dey well |
Well, in this life en Everybody get their own right to opinions But na constitution we must follow anyway Anything outside constitution is savagery My own opinion about what this lady says is this... If anybody can hit you violently or beat as they call it The person can kill you indeliberately Be that as it may, there's no excuse for error I can only support violence for self defense as the law supports you too Because everything in life is necessary But it's not cool for men beat women, we are mostly basically built more stronger than them When we hit them to caution them, it can go south, you never can tell and for sure you never wanted such Nevertheless ladies can be very frustrating and provocative They can deliberately implicate a man even at their own detriment Let's be cautious and vigilant, diligency is the key |
Leadership is everything to the followers Followers is everything to the leaders. In this life, Pray you are not unfortunate with a wrong leader You see en, My people say one adage the ability to fight and also run away sometimes is the credibility of a brave man When the time comes, when the followers suffer reach, Dem go summon bravery through frustration and commont the wrong leader |
Kelklein:change this your mentality, so you too can make it like them |
yarimo:that's why you're still at the level you are today You better change this your mentality so that you too can have a more comfortable life as they do mumu You don't even care about making a better life for you coming generation, you're here criticizing a very rich man. Anyway you can continue though, na ur human right dey carry you go south so |
NDC must be crazy upstairs What kind of party is NDC They are looking for sympathizers of supporters Adeleke already endorsed Tinubu before osun election So why the useless wailing and weeping Abeg NDC should gettat Party wey go get 3rd for presidential election I don't know why Obi was scared of running in primary in ADC Opposition for make sense now But he ran away If you were scared of ADC primary How do you expect to win General election No be juju be that? |