OroGojigo's Posts
Nairaland Forum › OroGojigo's Profile › OroGojigo's Posts
1 (of 1 pages)
Hopefully oil go do Ghana more good than harm provided dem no follow dem brother footstep |
If you no dey comfortable about the difference then make you pull out; Adam old pass Eve. But if you no mind, carry waka |
God dey speak o, only be say e get different ways wey He dey take speak to different people. If you don't mind sharing ya experience with me you fit post your email on www.orogojigo. and I go send you my email or we go use that medium to chat. God speaks to me and I fit help you to discover how but if you never ready to pray, fast and bury your head for inside Da Word abeg no bother to mail. |
area boys don dey collect am since the only news be say government don join? The oda issue be say dem don tell you say e go take time for NEPA head to correct so they must milk you for daring to challenge NEPA |
na wa o! the world dey carry go, we dey follow am. , You don begin feel guilty yet you dey ask weda the thing bad. Ya conscience na ya greatest judge. If you no fit stand on top mountain shout am say u be gay u suppose go reconsider. everybody wan free; e no go tay wey animal go begin demand for right to enjoy intercourse with man since man don give am space on top bed. Consider, why man no get where you suppose put am? why man no get breast? why na only woman get womb, abeg think; you get plenty time to straighthen up. |
, yeye, somebody talk pizza; where you wan see that chop on regular basis for 9ja? |
Na wah for you o. People dey work out to become lepa you dey vote for orobo. Okay make you try this for breakfast: a bowl of akamu with tin evaporated milk and enof sugar eat am with a bowl of eggs (fry it with less oil but with full or half titus and some vegetables). Make sure sey you no dey miss breakfast. Make you chop poundy (small quantity but with lots of vegetable, meat, fish or chicken) or any heavy meal for lunch. If you no mind make carpenter re-fix ya door in a matter of months you fit take nap after the meal otherwise, you fit do ya normal runs for easy digest. For dinner anything fit come in but make sure say you take glass of milt with honey before bed time. You fit fat and wo-wo but the diet wey I show you so go make sure say your orobo no be put off and u go robo for every necessary place. I no be dietician o but na wetin work for my friend I give you so. on top everything you fit they take multivitamin that go ensure sey you hungry enough before the food and sleep well when you do. Make you post feedback for orogojogo. if the diet get effect. |
Her daughter no be pickin, make she confide in the daughter who may consider pulling out of the wedding. She fit tell am say e fit be dat the boy papa na im papa but for obvious reasons she no wan explore the possibility. Simply telling the guy that her mama no want make dem marry and she no wan mortgage her mama happiness could be enough reason. For all you care the guy may have another option or simply find it a hard truth to swallow and learn to live with it; sense go enter im head years down the line when he find out say e for don marry im sister. Sometime down the line she should consider telling her husband and the landlord. Nip it in dey bud but honestly incest na social invention which works to connect us with other people. You ever wonder aw d first man and first woman begin populate the earth? Who sleep with who, |
Of course not, there's an aeronotic school in Kaduna but I don't know anyone who had an opportunity to test fly while there ![]() |
Just jump down from a skyscrapper! ![]() |
Crazykid, you crase no b small. If the one wey e dump be ya sister will your shoulder be available to cry on. So make e dey test drive two ochara when e know say im money no reach; if e jam the one he no won buy wetin go happen? |
So much for kising - "9ja men no dey kis", "na women like am pass" , Wetin, me I be woman and I no dey kis; court dey to sue me? Notice say I no even know how to spell am, aw I go come know aw to do am. As poster don run, you may elect to teach those who are interested in knowing more. I'm out. |
Wallahi you no get frovlem, na you be the only frovlem wey dey inside dis mata. Is your life in Abuja or that of the woman in Okitipupa cast in stone? If yes, let go. If no either of you should move. Otherwise, will you accept same scale if used for you; my guess be say ya answer be no. So ![]() |
I no vote. I no too like am as I no vote. Sha, weda dem worth am abi dem no woth am, result don show face before voing and all of us now must play by Yar'dua's rules; hopefully he'll be fair. |
Tie or no tie just make sure say you present for the wedding. Do take the ring along when you go. ![]() |
E tire me o! Man dey live on borrowed life, breathe the air e no fit explain, use a brain that has more fundtion than a computer, etcetram etcetram. Still man say question and querry the existence the Supernatural One . Data or no data, Christianity is real; God the Father, Son and Holy Ghost don't merely exist, they are alive. Unfortunately, your point of view have no effect on that fact. |
I'm worshipping God through Jesus and I'm loving it. Come on board, its better now than later. |
What will be the business and social culture of people in Nigeria? I would be speaking to people who are interedted in working in Africa and they are interested in what to do and what not to do when in business or social settings based on different cultures |
wetin u dey smoke? person fit dey carry fire for im abunna make d fire no burn am? weda na goro, gbana, weed, eja, kainkain, apoteshi, na seed of wahala plus palava you don begin sow for ya life so. 2 much cofee fit cause am, too much salt na him brother, but ya own no need inspection na result of weed wich leads to waste, d level of waste especially inside ya brain is the result of da vivacious anger |
My mama na stickler for nutrition. When I dey grow up she go buy Milo because the nutrition show sey Milo get beta stuff than Bournvita but somehow I feel say their greatest selling point na dem name. |
what if? u would av erred on d side of caution. since it is not; believe and be saved! |
1 (of 1 pages)



