Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,067 members, 7,814,677 topics. Date: Wednesday, 01 May 2024 at 05:21 PM

Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? - Culture (5) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? (20402 Views)

Some Interesting Nigerian Proverbs With Pictures / Proverbs From The Streets Of Warri / Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (Reply) (Go Down)

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Joetttimua1811(m): 2:14pm On Jun 22, 2023
Who chop Bellefull go still hungry.

Na the size of plate wey you carry borrow gari you go still take return am.

Who belleful no dey do longer throat.

Rat wey take speed enter snake hole the speed wey he dey carry commot dey pass the one e carry enter.

Person no fit kill snake make even the skin no reach am chop.

Wetin goat see keep quiet if dog 🐕 see am e no go let person rest with barking.

2 Likes

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by viodemus: 2:14pm On Jun 22, 2023
No matter how moto take speed for movie, e no go jam you.



On another note, I dun dey code say, my yarns dey inspirate who see am. The haters among them, go divert their journey from spiritual guidance, ---- viodemus


Abundant blessings for who teach me and/or bless me, e join my prayer lines --- viodemus

Empty kpangolo na still no content. --- viodemus




we no dey force am. to be continued

1 Like

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Stallione(m): 2:16pm On Jun 22, 2023
Who no no go know

4 Likes

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Angrymode: 2:17pm On Jun 22, 2023
Mosquito way dey hungry no dey fear die.

2 Likes

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by arsenal444(m): 2:18pm On Jun 22, 2023
SonofGod231:
Soup wey sweet na money kill am.
soup wey sweet, na who sabi cook cook am

1 Like

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Nobody: 2:22pm On Jun 22, 2023
Honeybadgerxx:
Dem no dey tell blind man say rain dey fall, if him enter inside him body go tell am

cheesy grin cheesy grin this is a wicked one
Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by cfree14(m): 2:23pm On Jun 22, 2023
Who dey sell nama no believe say who dey sell fowl dey make money

Rat wey die untop bag of rice nor be hunger kill, na over excite

Who dey roast corn no dey waka go far

Dem no dey carry knife enter gun fight

Igbo no get sign board but dem dey buy am

If trust dey water for no boil fish

Dem no dey use two leg test if water deep

Every malam with im kettle

If trust dey, water for no fit boil fish

10 Likes

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by LeoMaxtalk: 2:25pm On Jun 22, 2023
PERSON WEY NO PREPARE DON ALREADY PREPARE TO FAIL

2 Likes

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by richmondefosa(m): 2:26pm On Jun 22, 2023
Dirty water dey quench fire no mean say you fit drink am.

5 Likes

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Ketam(m): 2:26pm On Jun 22, 2023
Na small small,toto dey take tear pant

2 Likes

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Entanglement: 2:28pm On Jun 22, 2023
Olowoshako:
Dem no they slim fit borrowed clothes?
preek matter no dey ever get end!

1 Like

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Jolly1010: 2:33pm On Jun 22, 2023
I no know wen we start geography wey you dey draw map.

3 Likes

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Maxsunny: 2:33pm On Jun 22, 2023
Monkey sabi jump na because tree near each other,

5 Likes 1 Share

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by frankbonus(m): 2:36pm On Jun 22, 2023
Weting concern agbero with overload

Na from clap them dey take enter dance

Weting no hungry you, you no dey put am for nose smell am

Goat wey follow dog Waka must chop shit

Person wey dey inside house na him know where the roof dey leak

8 Likes 1 Share

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Popeonah(m): 2:36pm On Jun 22, 2023
Ashawo way get too many customers no dey Wash toto well 😁

4 Likes

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by coputa(m): 2:37pm On Jun 22, 2023
If you get big teeth, you must use big lips to cover am.

Nor curse crocodile until you don cross the river.

Nor be who dey first for race dey carry first.

Na two hands dem dey take open Yansh for stubborn shit to come out.

4 Likes 1 Share

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Salae: 2:38pm On Jun 22, 2023
Fowl wey dey lay golden egg na im know the way nyash take dey pain am

I no go fear toto carry prick go chuk for lap

Pikin wey say im mama no go sleep im too no go sleep.

Cockroach wey jam fowl early in the morning jam bad luck.

2 Likes

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Salae: 2:42pm On Jun 22, 2023
Salae:
Fowl wey dey lay golden egg na im know the way nyash take dey pain am

I no go fear toto carry prick go chuk for lap

Pikin wey say im mama no go sleep im too no go sleep.

Cockroach wey jam fowl early in the morning jam bad luck.

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Bosch10(m): 2:44pm On Jun 22, 2023
Lame man wey go use shit medicine,na him family members go work tire


If fowl go where him no know,na one leg he go take stand

3 Likes 1 Share

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by TheEndless: 2:48pm On Jun 22, 2023
Olowoshako:
Dem no they slim fit borrowed clothes?
Toto wey nor sweet na him dem dey use condom fvck🙄

2 Likes

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by saintegs(m): 2:49pm On Jun 22, 2023
Dem no dey use power take dey stand prick.
Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Babysho(m): 2:50pm On Jun 22, 2023
B4 we dey open pant to see nyash, now we dey open nyash to see pant.

2 Likes

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by ImeAsian(m): 3:03pm On Jun 22, 2023
Person Wey Naked No Dey Put Hand For Pocket.
Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by FireUpNow(m): 3:09pm On Jun 22, 2023
Dodo nor be the same with suya. Khaki nor be leather
Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Hugoempirecargo: 3:13pm On Jun 22, 2023
No matter how goat stubborn reach... E must reach market

3 Likes

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by lieutenantprime(m): 3:14pm On Jun 22, 2023
PerfectStranger:


Otilo

Erigga Next Track
Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Lookingback: 3:14pm On Jun 22, 2023
dyera:
I came up with these:

No matter how fast your car be, you no go fit drive am go abroad.

No dey proud because of say you get money, your net worth na some people tithe.

No matter how many net you throw, you no go fit finish the fish wey dey inside river.

No matter how food sweet reach, e no go hungry you if you bellyful.

#Drops mic


Nice , u tried.
Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by olawonder(m): 3:15pm On Jun 22, 2023
19 wey dey take 1 as enemy, to become 20 go hard for am!

To slap people dey hungry dwarf sef, na where hin hand reach!

4 Likes

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by lieutenantprime(m): 3:17pm On Jun 22, 2023
cfree14:
Who dey sell nama no believe say who dey sell fowl dey make money

Rat wey die untop bag of rice nor be hunger kill, na over excite

Who dey roast corn no dey waka go far

Dem no dey carry knife enter gun fight

Igbo no get sign board but dem dey buy am


Erigga get flows bro
Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Kuramushe(m): 3:18pm On Jun 22, 2023
Olowoshako:
Dem no they slim fit borrowed clothes?
pikin wey carry for back waka, no go no say the road far.
Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by chiboycue: 3:18pm On Jun 22, 2023
Olowoshako:
Dem no they slim fit borrowed clothes?

Fly wey no dey hear word dey follow dead body enter grave.

Warri no dey go transfer.

1 Like

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by chachanga: 3:20pm On Jun 22, 2023
Dem no dey beg persin make her no swallow coconut whole, na wen time to shiit am comot Dem go ask am how far.

1 Like

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (Reply)

Lets Know The Full Oriki Of Your Home Town.. / Why Do Nigerians Think White People Are Ugly? / Shocking Village That Eat Human Meat **pictures**

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 22
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.